~snipped~
Wait until you enta launchpads, na den you go know sey crypto na pure blood money. D major issue with launchpads na d capital to stake the crypto of choice. But once you enta am, the IDOs na instant hit.
If you nor fit enta am alone, try collabo with a trusted friend to try one out. Those people wey enta BSCPAD wen d token be less than $1 and stake for higher tier are very comfortable now, I dey tell una. Two days ago, BSCPAD do BitOrbit at $1 = 142 units. Go check BitOrbit current price now. It's on 🔥.
I just check this your BitOrbit now shah, e be like e don dey fall though, e don register $1 before and na only for pancakeswap e don list on. That na to say, the token no bad o, once e turn up for other exchange them, e go be major hit. Any which way, we go dey watch am shah, if na to enter with one leg.
And I still follow you confirm am say, crypto na full time blood money! No be play o, boys don turn milli and Billi men them with crypto in no time. Na watin dey tire some prominent men them be that, say watin them catty there lifetime archive, na watin person dey archive in few days, weeks, months or year from no where!! Crypto sweet, no worry!!!