Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 198. (Read 1028948 times)

sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Wetin una think of E-naira? Una dey buy the coin if e come out? With the history of the way naija government dey do their things, how sustainable is E-naira? Na all this question dey worry my mind for this matter

No worry yourself about that one na abandon project be dat.

You de correct for that comment but kai, you hammer our government enter ground with this. This one na real seeing finish and I de sure say that old man for Abuja no go de happy with you like this o. That Lying Mohammed too go rush to defend wetin any reasonable person no go want to defend. This government na so so comedy them de show us everyday.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Naija Monday morning trending news updates

Na so i come with d tori 4 net talking about how plenty companies don dey accept btc all over d world like Google, Amazon, Microsoft, and PayPal, and awa own pipu too bin don dey yarn say na d tin wey go pay dem be say to join d train dey accept bitcoin for payment since all their ogas mentioned above don dey do so. I dey tell you las las awa our government no get option than to accept bitcoin, imagine d contry pipu dey run btc, companies and organizations too don join, na only d govt. bin dey remain to endorse it. Naija businesses dey seize opportunities 2 expand by embracing bitcoin as a payment method

On the other side of the news, i hia say buhari govt. bin dey make moves to dey do aproko on our WhatsApp o dey wan dey sabi everything wey dey go there con dey spy us, maybe soon e go wan place ban like twitter, him mumu never do. But tanx to d Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) wey bin dey fight for us against buhari dem pipu say e no make sense na violation of human right be that and intruding into pesin privacy be that, abeg give it a click hia to read more tori on that. Na wetin we see concerning dis mata onground?
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

For Yankee people nor dey change party anyhow because them believe in wetin their party stand for. Even for Trump administration, many Republicans way dey office nor like am personally but them still dey support the party decisions. We nor hear say them jakpa but for here every two two days na defection.


If you know this and see am say e no dey happen for Yankee, wetin come dey wrong for naija, wetin make e dey happen for naija... Money.

See Nigerian political party no get agenda wey no be only to win election. You still talk am say Republican no get choice than to stick with him boss or party candidate etc. How many houses Obama sell before him go contest election abi na triumph or Biden, these na new generation politicians for there oo. If them stop cross carpeting, we go still see some focus.

Them dey follow America but dem dey corrupt pass .
member
Activity: 67
Merit: 10

I believe say with our PVC and our new resolve we go exodus to the promised land


My guy no believe say PVC go do anything oo as far naija system dey concern, the rigging of election na still wahala wey face d country.
I hear wetin u dey tok nai make I add say with our new resolve which means the new mindset wey we don carry we don sabi the system. Their old tricks nor fit work on us again. Shey na boys them go still carry to rig election when everybody say we nor dey go them go carry their children to go tiff ballot box
Na make them allow for independent candidate to contest. We know say as far to win president dey concern, na PDP or APC the thing dey come from and these two parties no mean well for naija because na same people.
This one nor go ever fit happen. Even for America them get political parties but how many u dey hear na only democrats and Republicans you dey see for news every time but other parties still dey. But these two na the major ones. Politics na game of power no single politician fit dey independent.
Two be say make them stop cross carpeting. Make every person stay for the political party wey them take enter office until the tenure finish. At least for America I no dey too hear these nonsense movement from Republican to Democrat vice. versa. Make dem make am at least conditional that once general election finish, no more moving out. Our government no just dey try.
For Yankee people nor dey change party anyhow because them believe in wetin their party stand for. Even for Trump administration, many Republicans way dey office nor like am personally but them still dey support the party decisions. We nor hear say them jakpa but for here every two two days na defection.
Three be say make them demonize politics. Too much money dey flow inside the politics and na that one make contestants and aspirants go sell properties to contest. You know how much be tickets, campaign rallies, bribes , wetting of hands, sharing of money, god fathers etc etc. If them spend all these money finish, where we think say them go get money replace the house and choicest properties wey dem sell, the rest na history my brother. I know say for US, some group of people, corporation, business people dey support a candidate and help them in campaign with printing of campaign stuffs etc e no be like that here , so that your road no go get attention when the money come your local government chairman (if they exist self), go wak am or take am go bring another woman, cars, house. I beg naija story plenty.
Even for US na the same thing. My guy politics na money play.  See ordinary SUG for universities the kind money way them dey tiff nor be here. Come talk of those way dey senate and aso rock. This country tori don taya me make we gist better things
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

I believe say with our PVC and our new resolve we go exodus to the promised land


My guy no believe say PVC go do anything oo as far naija system dey concern, the rigging of election na still wahala wey face d country. Politicians here too dey desperate because na work dem dey find and election na application wey make dem go enta any length to enta the office and steal back money wey dem take bribe themselves in. Sebi we know say electronic transmission of result wey dem don pass into law now still go need make (NBC) Nigerian broadcast corporation approve am before transmission.... Wetin this one mean ? E mean say the incumbent  go still get power to influence am to him favour and to friends since him still dey incharge and dey pay the workers salary, we remember say incumbent wey dey recontest still has all powers as person wey dey office.

See wetin I think as some solutions to our naija situation as e concern politics and election, and na these politics and election dey kill every other sector and Nigerian system.

One na make them allow for independent candidate to contest. We know say as far to win president dey concern, na PDP or APC the thing dey come from and these two parties no mean well for naija because na same people.

Two be say make them stop cross carpeting. Make every person stay for the political party wey them take enter office until the tenure finish. At least for America I no dey too hear these nonsense movement from Republican to Democrat vice. versa. Make dem make am at least conditional that once general election finish, no more moving out. Our government no just dey try.

Three be say make them demonize politics. Too much money dey flow inside the politics and na that one make contestants and aspirants go sell properties to contest. You know how much be tickets, campaign rallies, bribes , wetting of hands, sharing of money, god fathers etc etc. If them spend all these money finish, where we think say them go get money replace the house and choicest properties wey dem sell, the rest na history my brother. I know say for US, some group of people, corporation, business people dey support a candidate and help them in campaign with printing of campaign stuffs etc e no be like that here , so that your road no go get attention when the money come your local government chairman (if they exist self), go wak am or take am go bring another woman, cars, house. I beg naija story plenty.

Recently for this Anambra election wey dey come, an aspirant carry campaign go Lagos wey na Anambra people him go govern oo as if him go unseat Babajide Sanwo-Olu. Grin Grin
member
Activity: 67
Merit: 10
October 20 na in two days. Make we nor forget say 20/10/2020 na when lekki toll gate massacre happen. The blood of our brothers and sister still dey cry...they gave their life believing in a better Nigeria. Weeks later, Nigerian politicians continued in their childish ways and one was playing Sherlock Holmes during the lekki Massacre investigation. Till date no army personnel has been brought to book, the governor of Lagos State denied involvement in the matter. We as a people have slowly given up on the issue to face the loads of problems they heap on us. Endsars movement is more than just police brutality it is a force we need to achieve a better Nigeria. Atm police and the military have been stationed at lekki toll gate to stop any form of demonstration. Let us not forget the cause our brothers and sister died for while holding the national flag.

Naija need leader wey go package many sectors for this country make we the youths still get options too. We need better schools, constant electricity very important, inproved health care , good transport system etc. If leader dey wey go fit run all this for us for naija, even if e nor too get idea about crypto and e nor form to wan use am deceive us, na him i go vote.
Rruchi man you just talk the koko. Naija need the chosen one to come out cos right now we be like Israelites for Egypt. The suffer don too much we need our Moses to come asap. I believe say with our PVC and our new resolve we go exodus to the promised land
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I am going for good leadership even if the person never yet understand crypto-currency to support am, so long as the person carry better for mind for nigeria I go support am.

Yes o brother, i like the way you dey reason. If na cryptocurrency supporting president you need for naija, if person wey wan contest hear am, two seconds e go add am to e political agenda, talk am for Rally or media just to gain support.

Naija need leader wey go package many sectors for this country make we the youths still get options too. We need better schools, constant electricity very important, inproved health care , good transport system etc. If leader dey wey go fit run all this for us for naija, even if e nor too get idea about crypto and e nor form to wan use am deceive us, na him i go vote.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Quote
Someone ban twitter still dey pass back dey use VPN
This government na follow follow. We don tire. As if no intelligent pesin for naija wey go fit pilot d naija affairs.
My good peple of Naija, 2023 election don near, Sha all does pale dey tink say dey no hw to do do d game abi, any leader wen no support cryptocurrency for Naija  no dey go anywere 4 2023 becos all thus old pale dey no want good tin 4rm their pikin.
 
Omo I no dey in for any leader wey support or no support crypto-currency, that no be my main target for good leadership in nigeria, our leaders are very deceptive if na crypto-currency supporting leader you want them fit change give am to you just because them want you to vote for them.
I am going for good leadership even if the person never yet understand crypto-currency to support am, so long as the person carry better for mind for nigeria I go support am.
member
Activity: 67
Merit: 10
Quote
Someone ban twitter still dey pass back dey use VPN
This government na follow follow. We don tire. As if no intelligent pesin for naija wey go fit pilot d naija affairs.
My good peple of Naija, 2023 election don near, Sha all does pale dey tink say dey no hw to do do d game abi, any leader wen no support cryptocurrency for Naija  no dey go anywere 4 2023 becos all thus old pale dey no want good tin 4rm their pikin.
 
where you wan see politician way e head correct. Na pdp abi apc wan produce am? Not to young to run na one of the biggest sam this government don do. Abeg proTECH hold your pvc tight no be only talk for social media make we come out to exercise our right to vote our leaders. We don carry the mentality say our vote nor dey count nai make we no dey  gree come out to vote. I believe say the first step to change na within the people. Our future dey our hand.
member
Activity: 1120
Merit: 30
Bisq Market Day - March 20th 2023
Quote
Someone ban twitter still dey pass back dey use VPN
This government na follow follow. We don tire. As if no intelligent pesin for naija wey go fit pilot d naija affairs.
My good peple of Naija, 2023 election don near, Sha all does pale dey tink say dey no hw to do do d game abi, any leader wen no support cryptocurrency for Naija  no dey go anywere 4 2023 becos all thus old pale dey no want good tin 4rm their pikin.
 
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin

For Nigeria trend dey change like nothing. You remember say no be paw paw dey trend few years back when you reason memes matta, na dat Yoruba actor (I dun forget e name).

Na Odunlade Adekola be the guy, I know the guy and him meme dy also trend for twitter too.
Me self dun reason this matter why this oyinbo's go just dy hype this NFTs, imagine that cyberpunk image weh one cartoon just hold Ciga come get value pass even Bitcoin.
Everything get him time and I think na NFT hype for now but e no go last sha.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
For this our naija, na only few know the worth of this Non fungible tokens, the popularity no dy like the way other coins and tokens dy for market and the for this our naija just dy low and undervalue, our paw paw NFTs still dy on sale, lets always support our own, who knows what the king of meme NFT might worth tomorrow.

For Nigeria trend dey change like nothing. You remember say no be paw paw dey trend few years back when you reason memes matta, na dat Yoruba actor (I dun forget e name). This one means say if you buy paw memes now, e go still get value come tomorrow or another mumu go just takeover everything. No use oyinbo compare us oh, dem they believe in vintages, nothing dey old there infact the more e old the more value e dey get but here, we dun chop finish?.

Besides I think say NFT dem, dey dey in graphic forms like cartoon but that one I dey see there, people get am plenty for their phone na why you go buy am when I fit WhatsApp you am lol na wetin people go dey think. Also me I believe this NFT thing na scam/pump and dump majorly no be say people no dey chop from am oh but e just over cost for nothing. E go improve sha just like Defi and ICO trends.

The legit one dey but scam or hyped nonsense plenty pass, make una shine una eye if you wan see how that side be. Belike igehhh get one or two idea I dun read about am dey talk about am.
member
Activity: 67
Merit: 10
NFT still dy undervalue for Naija
Brotherly I disagree with you on top this matter. For this crypto levels Nigerians dey try with all the kasala wey government dey do. Our people still dey find way to involve their self for crypto currencies and Nfts. If pawpaw nft nor sell e nor mean say others no dey do well. Josh2funny, the skit comedian for Instagram sell him nfts for 4 ETH each. People patronize am home and abroad. Don jazzy today don go buy nft of a Nigerian artist

https://diutocoinnews.com.ng/donjazzy-donates-nft-proceeds/7018/
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Make I just save this significant and most popular section of the Nigerian Criminal Code Act here.






I dey sure say most of us grow up saying and hearing people say you be 419 or you want do me 419. The 419 na a section of criminal code and infact e get 419A and 419B but them dey talk same thing abt taking wetin no be ur own wit wayo way.

Lmao, normally i nor go jealous 419 oooo, but like this i dey jealous this your 419 so loll, congratulations o brother, me i tap from your grace, make 419 number still reach me lol.

NFT still dy undervalue for Naija
For this our naija, na only few know the worth of this Non fungible tokens, the popularity no dy like the way other coins and tokens dy for market and the for this our naija just dy low and undervalue, our paw paw NFTs still dy on sale, lets always support our own, who knows what the king of meme NFT might worth tomorrow.

Economy good well well for abroad, nai make anything wey you dey do, you get audience and you go fit easily sell. Secondly, as economy good, people nor dey over work themselves, dem get better time to get information, for naija, make we talk true...how many people really know wetin be NFT? our economy nor too balance, almost everybody dey find way to cut expenses, spend less and save more.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
NFT still dy undervalue for Naija

As I dy usually do when boredom wan kill me, the place weh I dy like stream na Tiktok and Instagram to get small vibes and trend. I dy usually notice say I dy see small small ADS for there because say i like to do cryptocurrency, na him I come across Snoopdog as the father figure of Metaverse NFT private, he was selling out a 1000 NFT for private Ethereum Metaverse party worth $17 million and my mind just dy do me somehow, how this guys like NFT collection so much in there gallery. I been like the site and I was scrolling down Dycript web, na him I see some related NFT news and the one weh surprised me well na him be the one wey person buy one girl image weh popular for net with one weird look meme for $75k [Side-Eyeing Chloe NFT Sells for $75K to 3F Music]. Everything for this people na business and cashout for their place and if they mean am, it must sell even as many people no like NFT idea and hype.

Coincidentally, I see another update from one of my favorite artist weh the whole Twitter and other platforms known as King of Meme with stage name as pawpaw, he posted some NFT on his IG for sale and i decided to follow the link and I was redirect to his profile page on Rarible with other meme that everyone has been using for trend across the globe but wetin shock me be say, none has been bought so far despite been cheap and affordable with low price. This NFT on a normal day, dem go dun rush am base on how the guy popular, funny and very trending but people bid just small for am, out of all the 5 NFT weh dy open for sale, known has been bought.

For this our naija, na only few know the worth of this Non fungible tokens, the popularity no dy like the way other coins and tokens dy for market and the for this our naija just dy low and undervalue, our paw paw NFTs still dy on sale, lets always support our own, who knows what the king of meme NFT might worth tomorrow.
I never check this mata wey you just drop now, na my first time to see this story be that, wetin I dey normally do be sey when I hear stories like this I dey make sure sey I verify am myself, but I go let curiousity get me, na why I dey ask sey you sure? I dey follow Snoop dog on line but recently I never check him handle but the last time wey I check him been dey complain about people wey dey use him name for crypto-currency to sell their market.
hero member
Activity: 1078
Merit: 903
Not Your Keys, Not Your Bitcoin
NFT still dy undervalue for Naija

As I dy usually do when boredom wan kill me, the place weh I dy like stream na Tiktok and Instagram to get small vibes and trend. I dy usually notice say I dy see small small ADS for there because say i like to do cryptocurrency, na him I come across Snoopdog as the father figure of Metaverse NFT private, he was selling out a 1000 NFT for private Ethereum Metaverse party worth $17 million and my mind just dy do me somehow, how this guys like NFT collection so much in there gallery. I been like the site and I was scrolling down Dycript web, na him I see some related NFT news and the one weh surprised me well na him be the one wey person buy one girl image weh popular for net with one weird look meme for $75k [Side-Eyeing Chloe NFT Sells for $75K to 3F Music]. Everything for this people na business and cashout for their place and if they mean am, it must sell even as many people no like NFT idea and hype.

Coincidentally, I see another update from one of my favorite artist weh the whole Twitter and other platforms known as King of Meme with stage name as pawpaw, he posted some NFT on his IG for sale and i decided to follow the link and I was redirect to his profile page on Rarible with other meme that everyone has been using for trend across the globe but wetin shock me be say, none has been bought so far despite been cheap and affordable with low price. This NFT on a normal day, dem go dun rush am base on how the guy popular, funny and very trending but people bid just small for am, out of all the 5 NFT weh dy open for sale, known has been bought.

For this our naija, na only few know the worth of this Non fungible tokens, the popularity no dy like the way other coins and tokens dy for market and the for this our naija just dy low and undervalue, our paw paw NFTs still dy on sale, lets always support our own, who knows what the king of meme NFT might worth tomorrow.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624
@CryptopreneurBrainboss me 2 think say naija dey rush this digital money thing & I no sabi dere own reason abi dem want show oyibo pepo say dem too dey work, all na follow follow. Dem never arrange the crypto ban account with bank levels finish dem dey jump enter digital currency . How dem want take marry these two things together, you ban something then pass backyard dey still accept the thing that looks like what you ban somehow. Them just dey shoot themselves for leg.

Someone ban twitter still dey pass back dey use VPN

This government na follow follow. We don tire. As if no intelligent pesin for naija wey go fit pilot d naija affairs.

Okay see na, America put restriction for employers with up to 100 employees if dem no take covid-19 vaccine, our own gofment too don follow dem put mandate for covid-19 vaccination for federal workers on December Ist. Dem just dey follow follow instead of thinking and coming out with deir own ways. Our societies no be the same tin & pepo dere no be the same too , den dem need do tins to suite pepo here.
Covid-19 date
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Wetin una think of E-naira? Una dey buy the coin if e come out? With the history of the way naija government dey do their things, how sustainable is E-naira? Na all this question dey worry my mind for this matter

No worry yourself about that one na abandon project be dat. This na something our government na experts for, dem Sabi abandon project so dey fit dey chop money constantly from the project. You know how much dey don budget for that rubbish, again dem go bring up the mata still pocket the budget and japa again.

From the very beginning  the project na waste, how many weeks dem take plan am, they just wake up say dem wen do cryptocurrency. Country wey be say our banking system never stabilize yet them wan bring 100% digitalized project. Where una dey here say dem dey do that one, country wey internet no dey and the small you manage see dey cost like within I no no.

Even d name, dem no get right to use am. You mean say county like Nigeria no fit do research to make sure the name eNaira dey available. Abeg make dem commot.
member
Activity: 67
Merit: 10
Wetin una think of E-naira? Una dey buy the coin if e come out? With the history of the way naija government dey do their things, how sustainable is E-naira? Na all this question dey worry my mind for this matter
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Make I just save this significant and most popular section of the Nigerian Criminal Code Act here.
I dey sure say most of us grow up saying and hearing people say you be 419 or y
ou want do me 419. The 419 na a section of criminal code and infact e get 419A and 419B but them dey talk same thing abt taking wetin no be ur own wit wayo way.
I love this your concept. How I go take upload mine for my profile? "Naija criminal code''.
I believe sae, one day Nigeria go better for all of us. Wey be sae we go all live in peace and harmony
Even up till now my brother we still dey use the word 419 if we one describe corruption or wen we dey talk about person wey dey corrupt, this na the normal yarnings for we nigeria, but I sure sey for forum mata na just exciting coincidence sey your merit hit 419.
Congratulations my brother you dey very hard-working for the forum and you dey make our land proud, you be that kin better member wey dey show the world sey nigerian dey very dedicated and relentless and we too sabi do things with out 419ing
Jump to: