Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 219. (Read 1343708 times)

hero member
Activity: 1148
Merit: 555


My people make una see wetin dey happen for Lagos. Our government has sold us out without taking into account the concern of the people. Their slogan is "Vaccine is the answer!". Pharmaceutical companies and international interest have persuaded them with big loads of cash and as usual their brains are turned off.  How many cases has there been in Nigeria? Last year malaria patients were misdiagnosed as covid patients thereby increasing the cases in the country. At a point, states were competing for highest number of covid cases so more money can be allocated to them. Covid in Nigeria is a hoax and a poor one at that.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Quote
Nigeria News
Nigeria is seventh most populous country, and most populous in Africa. Nigeria also has the largest economy in Africa, with more than $500 billion of nominal gross domestic product. The World Bank considers Nigeria to be an emerging market and is widely seen as a perspective economy. Still, it ranks 152nd in the Human Development Index and has a large variety of problems regarding the lack of education, organized crime and human rights. Bitcoin is legal in Nigeria, but the Nigerian SEC, or Securities and Exchange Commission, warned citizens about cryptocurrency investments being risky and sometimes even fraudulent. However, the Nigeria Deposit Insurance Corporation and the Central Bank of Nigeria have plans to adopt cryptocurrency technology and have several sub-committees working on implementing blockchain into governmental insurance and financial services.
https://cointelegraph.com/tags/nigeria

Naija here we come again o
It's surprised me seeing this updates on how far my beloved country has gone worldwide with a good and recommendable recognition it has even in the crypto world despite our bad governance, security and high rate of corruption, we are still among the best in Bitcoin, no wonder they call us the giant of Africa, we the youth are no more lazy, as initially purported by our president I quote "lazy Nigerian youths". This makes me to recall the story of Jabez who determine to change his given name and condition, our youths are making us proud in technology and development worldwide as we top most of the tables on good reputation in businesses and innovations.
God bless Naija
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
I dey salute una for the house and wishing you all happy weekend, I been get this question wey I want to ask o, that why naija no dey for the local board of the forum, wetin dey appen, shey na our fault ni or them fault, abeg wetin we see to this oh.

Small time make una dey bump dat Charles trend na small small we go reach dat promise land. If we fit dey bump am like monthly so theymos fit dey get the OT e go make sense. Like reason dis thing, theymos dey update DT every 1st of the month, so make we target am, dey bump am for morning on that 1st atleast when e dey do e update e fit see am.

E make sense and e go go wella if Charles dey bump that thread like after 2 weeks interval since na him me the OP make den no fit dey chock eyes say we dey bump bump our thread. I dey sure say theymos don see and read that thread before but him attention no dey for those kind thing again ever since Cyrus became the heir ( administrator) na him dey handle most of the forum activities now

where theymos dey active na for advert placementt for the forum. So ma Cyrus attention we need seek now make dem tell us the look


My People Afghanistan matter don wear wrapper ooo The Talibans don give US and NATO deadline to vacate the country ooo say no extension meanwhile Russia say den no go gree make Taliban take over Afghanistan... Talk talk plenty oo
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
If we have to follow how the forum is working, I will suggest (just a suggestion) us to have this in mind:

Bitcoin discussions, 60%
Altcoin discussions, 20%
Economy, Politics and Society, 15%
Off-topic, 5%

Like me, I will like to get more involved in Bitcoin, altcoin, economy, politics an society discussions than off-topic, but yet there are some off-topics that can be interesting to post about, which I will love to post about, but, I hardly respond to off-topic.

I just happy dis days sha, I no understand wetin happen to nepa dey just dey bring light like mad. I no fit remember when last I buy fuel for like two weeks now. Any body dey notice same thing for e area?.
Nigeria is using more of hydroelectric power plant, the more water is flowing the more the current to drive the turbine used for the energy generation, light (electricity) supposed to be available in rainy season than dry season when the water current would have reduced to drive the turbine for electricity generation. I did not read anything good lately about increase energy transmission, so I think rainy season is the main reason for the recent good electricity supply in our country.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Discussing BBN no go mean say we no serious. Nobi only the matta go dey on ground, other topics go dey flow as well. Me I no dey watch dey show but if d discussion come I go follow put mount as one or two review online u don get the whole gossip for the day. Wetin we dey find na discussion no be Bitcoin that or Bitcoin this. Since we dey discussion Bitcoin matta dey don reason us? For check other boards, different things dey welcome for discussion.

D tin be say we no go just focus for one discussion if not e go dey boring, oya check now since we bring up BBN mata thread don dey active small atleast we get one or two things to talk after the mata finish we go come enta ano discussion we fit be crypto focus, no so e supposed be.

I just happy dis days sha, I no understand wetin happen to nepa dey just dey bring light like mad. I no fit remember when last I buy fuel for like two weeks now. Any body dey notice same thing for e area?.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Make we yarn about BBN because na wetin I think fit bring content wey no go dey boring for naija so, like this Live show wey they wan do this night, Biggie yarn Maria say make she nominate 2housemates for Fake eviction. I no fit wait to see the reaction wey go dey housemates faces when they find out say everything na prank
Abeg nor dey do this kain tin lol maybe when we get our board we fit put am for off-topic cos that yawnings nor follow cause if we start am e nor go end there...another go suggest superstory or worse zeeworld. As Bit bender talk e go well say we focus on other aspects of the show like the involvement of fintech companies like Patricia, abitTrade as sponsors of the programme.
hero member
Activity: 1666
Merit: 709
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
Quote
Dis na matta we don address tayah but theymos dey form buhari for where we dey. Well my findings na say we never plenty of the forum atleast of we plenty, dey never identify themselves and local board don tire dey reason d thing mata. Make we just dey dey active and wait for any new local board to come on board, I dey believe say we go follow. Like now, na only us dey worry well.

Small time make una dey bump dat Charles trend na small small we go reach dat promise land. If we fit dey bump am like monthly so theymos fit dey get the OT e go make sense. Like reason dis thing, theymos dey update DT every 1st of the month, so make we target am, dey bump am for morning on that 1st atleast when e dey do e update e fit see am.

In the mean time na campaign to keep the board active na e we dey on any discussion wey you believe go bring talk come dis trend, just drop am no reason wetin e concern, we get men dem wey go follow you talk. Weda na ball oh, politics or BBNaija just bring am make we talk.

Make we yarn about BBN because na wetin I think fit bring content wey no go dey boring for naija so, like this Live show wey they wan do this night, Biggie yarn Maria say make she nominate 2housemates for Fake eviction. I no fit wait to see the reaction wey go dey housemates faces when they find out say everything na prank
I don't think so, if we want them to take us seriously I think we should not have conversation about entertainment, except it has connect with crypto-currency, if we going to talk about BBN maybe it would be about their crypto-currency partnership with Patricia and if there are any other crypto-currency game, quiz going on in the house, but if it's about what's generally going on in the house they won't take us seriously, Big brother is not only in nigerian, there is Big brother america, big brother India.


I was was not referring to the rules of this our nigerian board, I was like if the main forum that's Bitcointalk can give an open requirements to make it in getting a local board like what are those countries that doesn't have a local board are to do to get it and what those countries who has a local board did to get it.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---snipped---
There is no much rules to follow than:

1. This thread are for Nigerians
2. English, Pidgin and all Nigeria languages are welcomed
3. Lastly, to obey the rules of the forum. If we have local board, we can have a thread for rules to follow if necessary.

What I am still suggesting us is to increase our activities here, though I have later come to know that it is not something we can force or have in mind too much, but we should dedicate our time here help our ourselves, this can later possibly turn up into having enough activities that can lead us into having our own local board.

I have noticed many of us will introduce newbie to this forum, letting him/she knows about this local thread is very important, some do not even know local thread is important, this is part of the reason we can not have local board ASAP. We should introduce this thread to our fellow Nigerians, let them know how important it is, all newbies like to post on their local boards because they will feel like being among the people of their own kind.

I expect us to fill 1 or 2 pages (20 to 40 posts) or more daily with good, quality and constructive posts before we should be expecting local thread. Although, this is not what we can easily achieve, but we will achieve it and become easy when the right time come. We have to do what can convince theymos that it is high time Nigerian board should be created.
jr. member
Activity: 38
Merit: 14
Quote
Dis na matta we don address tayah but theymos dey form buhari for where we dey. Well my findings na say we never plenty of the forum atleast of we plenty, dey never identify themselves and local board don tire dey reason d thing mata. Make we just dey dey active and wait for any new local board to come on board, I dey believe say we go follow. Like now, na only us dey worry well.

Small time make una dey bump dat Charles trend na small small we go reach dat promise land. If we fit dey bump am like monthly so theymos fit dey get the OT e go make sense. Like reason dis thing, theymos dey update DT every 1st of the month, so make we target am, dey bump am for morning on that 1st atleast when e dey do e update e fit see am.

In the mean time na campaign to keep the board active na e we dey on any discussion wey you believe go bring talk come dis trend, just drop am no reason wetin e concern, we get men dem wey go follow you talk. Weda na ball oh, politics or BBNaija just bring am make we talk.

Make we yarn about BBN because na wetin I think fit bring content wey no go dey boring for naija so, like this Live show wey they wan do this night, Biggie yarn Maria say make she nominate 2housemates for Fake eviction. I no fit wait to see the reaction wey go dey housemates faces when they find out say everything na prank
hero member
Activity: 1666
Merit: 709
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
I dey salute una for the house and wishing you all happy weekend, I been get this question wey I want to ask o, that why naija no dey for the local board of the forum, wetin dey appen, shey na our fault ni or them fault, abeg wetin we see to this oh.
Firstly it's not our fault that we haven't gotten a local board yet, I honestly think maybe the forum should make a clear memo or article about the requirements to meet before a country can get a local board, so we can know how to go about it, I must have not been active here before but by number of pages on this our board I think it isn't bad, so if when can have a memo or article about the critical to meet, we would know how to channel effort so we can at last get our nigerian local board.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I dey salute una for the house and wishing you all happy weekend, I been get this question wey I want to ask o, that why naija no dey for the local board of the forum, wetin dey appen, shey na our fault ni or them fault, abeg wetin we see to this oh.

Dis na matta we don address tayah but theymos dey form buhari for where we dey. Well my findings na say we never plenty of the forum atleast of we plenty, dey never identify themselves and local board don tire dey reason d thing mata. Make we just dey dey active and wait for any new local board to come on board, I dey believe say we go follow. Like now, na only us dey worry well.

Small time make una dey bump dat Charles trend na small small we go reach dat promise land. If we fit dey bump am like monthly so theymos fit dey get the OT e go make sense. Like reason dis thing, theymos dey update DT every 1st of the month, so make we target am, dey bump am for morning on that 1st atleast when e dey do e update e fit see am.

In the mean time na campaign to keep the board active na e we dey on any discussion wey you believe go bring talk come dis trend, just drop am no reason wetin e concern, we get men dem wey go follow you talk. Weda na ball oh, politics or BBNaija just bring am make we talk.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I dey salute una for the house and wishing you all happy weekend, I been get this question wey I want to ask o, that why naija no dey for the local board of the forum, wetin dey appen, shey na our fault ni or them fault, abeg wetin we see to this oh.
We don try our best to get our own local board, we don request for it two times but not given yet, the last time we requested for it na even this year. We just need to focus more on achieving it, our activities here go count towards achieving local board, although if we get a common local language, it would have helped, but something good may still come up if we no relent.
full member
Activity: 140
Merit: 128
I dey salute una for the house and wishing you all happy weekend, I been get this question wey I want to ask o, that why naija no dey for the local board of the forum, wetin dey appen, shey na our fault ni or them fault, abeg wetin we see to this oh.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
How is/was the buyer supposed to know that the funds which he or she bought or want to buy is a stolen fund?
Lots of questions and questions with little answer I guess, if what you said is true, then, this is highly unfair on the buyers, except the buyers know the funds are stolen and still went ahead to buy cus its cheap, then that's a different story but then, the question, why the exchange allow the scammers to place the sell order still lingers.
Na here way the biggest question of all dey for this matter. E con make the thing dey like deliberate act to just hold person funds for hand. Like the way our local banks dey do way be say, feds go fund them to pay people, them go just hodl am small via say, them wan use am trade and earn small profit. Sometimes, e dey tire me when you go enter to check your account with biometric for your front, the go still tell you bring ID and na you stand there...

Make I no move plenty but, e dey wrong in this regard say, na you advertise something @Exchange and then, you dey crucify who wan buy abi who buy like say, e know watin sup normally and na decentralized shit we dey run so. How them wan even start to dey judge the matter cef...!
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---snipped---
Not you key not your coin, if you are using centralized exchange, your account can be frozen at any time due to suspicious transactions, also like you don comment, scammers dey very smart, we don know how scammers can be so anonymous and put another person for trouble. But, we should know that to have full control, we need to use noncustododial wallet, some will first prefer to mix the coin, some people will prefer to make use of CoinJoin wallet like Wasabi and then perform ricochet to make the coins not/less suspicious before making use of custodial exchanges, but noncustodial exchanges like Bisq is still the safest while users still need to be careful of scammers, but you own the private key to your address. Only what I can use centralized exchange for na to do p2p transactions within the exchange which I know no issue go dey, and use reputed exchange like Binance, and as CryptopreneurBrainboss talk ham, use verified merchants is better.

paxful(I no even know whether this one na p2p exchange)
Paxful na p2p exchange.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Make God continue to the lead and guide him children ooh, make person no go use him head carry wetin he no know anything about.

I dey tell you. Me I dey use Binance P2P the moment you just login you go see scammers tayah, like dey plenty of their ehh but if you dey wise you no go fall mugu. For binance option dey to only trade with those dey done verify as merchant and na their I dey based. I never trade with number traders because their price dey always too good to be true. How person go dey sell naira for 700/$ where e theif the money from?.

Na only if you greedy na e dis people go dey use you shines. Remitano too cost of you wan buy and low if you wan sell na e make I no dey use dem I get account their as well. For the other mata, you no go blame the exchange, dey only take action when the transaction get flags.

Normally the coin fit dey the exchange and dey no go know but if time to excute transact, d system flag the Bitcoin as stolen den their system go automatic detain am.
legendary
Activity: 2422
Merit: 1083
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Guys these days scammers are pushing stolen funds to exchanges and once you pay, exchanges freeze your accounts. Be mindful who you are buying bulk coins from. Overly cheap coins and bulk coins with no sources too sometimes has egbese. I can’t start dropping screenshots or proofs of that. Try to use decentralized exchanges if you receive coins on exchanges. In the quest to make  10k profit, I pray we don’t pay 5m debt
Now, my question is, why would this exchange(s) accept the stolen funds in the first place? Why did they even allow the scammer to place a sell other? Why didn't they froze the scammers account immediately they deposited the stolen funds? Why did they allow innocent buyers to buy the stolen funds from the scammer only for them to turn and block the innocent buyer's account,? How is/was the buyer supposed to know that the funds which he or she bought or want to buy is a stolen fund?
Lots of questions and questions with little answer I guess, if what you said is true, then, this is highly unfair on the buyers, except the buyers know the funds are stolen and still went ahead to buy cus its cheap, then that's a different story but then, the question, why the exchange allow the scammers to place the sell order still lingers.
It's easier said than done. You would think the exchange would take responsibility.  I have occasionally encountered scammers in p2p exchanges they are very cunning
OK, na now you talk wetin I hear, say the exchanges dey cunning, well, me never encounter any of this kind of problems before ooh since 2016 wey I enter this industry, maybe because I no too dey into p2p trading Sha, the first local exchange wey I start with when I enter crypto na luno, from luno, I moved to remitano, na remitano I still dey use till now, though I get account for other p2p exchanges like localbitcoin, paxful(I no even know whether this one na p2p exchange) etc, but I never for ones use any of this exchanges.
Make God continue to the lead and guide him children ooh, make person no go use him head carry wetin he no know anything about.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Guys these days scammers are pushing stolen funds to exchanges and once you pay, exchanges freeze your accounts. Be mindful who you are buying bulk coins from. Overly cheap coins and bulk coins with no sources too sometimes has egbese. I can’t start dropping screenshots or proofs of that. Try to use decentralized exchanges if you receive coins on exchanges. In the quest to make  10k profit, I pray we don’t pay 5m debt
Now, my question is, why would this exchange(s) accept the stolen funds in the first place? Why did they even allow the scammer to place a sell other? Why didn't they froze the scammers account immediately they deposited the stolen funds? Why did they allow innocent buyers to buy the stolen funds from the scammer only for them to turn and block the innocent buyer's account,? How is/was the buyer supposed to know that the funds which he or she bought or want to buy is a stolen fund?
Lots of questions and questions with little answer I guess, if what you said is true, then, this is highly unfair on the buyers, except the buyers know the funds are stolen and still went ahead to buy cus its cheap, then that's a different story but then, the question, why the exchange allow the scammers to place the sell order still lingers.
It's easier said than done. You would think the exchange would take responsibility.  I have occasionally encountered scammers in p2p exchanges they are very cunning
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
@Pokapoka124 Gee boys done wise up, dem dey use innocent guys like us as pickers. If you know how many contacts I dey get ehh like sometimes I go just weak say I no do the trades as the money much. Funny part dem go request your address and if you no dey careful na dat address dem dey give their clients to fund you and when yaweh gaz na the address dem go report and god punish you the address dey linked to your real Identity, your own na sorry as you dey go join hush for that side.

Wetin man wan ro na, na just God dey help us for the industry we enter, within you no know fit put you for prison and no body go believe you say no be you dey run am. 

@igehhh all ur yarning for dat Afghanistan matta fit be true as I dey fear those people die. You see USA fear dem pass satan oh. If dem dey help you no be free oh  dey get other intentions na e make I dey laff any country wey dem dey say dem dey help. If dey give you suya, go check your cow because na there dem go most likely get d meat from.
Jump to: