Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 220. (Read 1030740 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Well, about bounties – Na if you get luck pick d wan wey blow oh and dem try make distribution before e blow. Most times these thieves wey be project teams nor dey like distribute once dem token begin do well for market. That's why I dey like follow only projects wey d bounty manager escrow funds after I hear am for dem hands. Experience na im I gather for the matta after several failed involvements. Otherwise, na bounty me I for just go relax put. See my CTSI wey I push, e dey do wey like dis. E go even do wey pass like dis. But the manager don retire from bounty management. D dude sabi pick projects wey dey do well.


One good thing about bounties be sey even if your rank small but you get betta social media presence you go still chook head enta Facebook/Twitter campaign go pack tokens, or even do article writing join sef.


I dey greet u na 4 d house wey be our own 1 & only naija trend, I'm a newbie here & lemme introduce moisef

Username  - Doan9269
Gender       - Female
State           - Osun
Skill             - Digital marketing
My sista, I use betta teacup and agege 🍞 welcome you for house. You go enjoy here but just make sure you observe the rules of the game. Welcome!
hero member
Activity: 812
Merit: 560
I dey greet u na 4 d house wey be our own 1 & only naija trend, I'm a newbie here & lemme introduce moisef

Username  - Doan9269
Gender       - Female
State           - Osun
Skill             - Digital marketing
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Kuda Bank Is Blocking Accounts; Attention To P2P Traders

~Snipped
Omo the way this country dey go eh, I don kuku tire. Create jobs, them no fit create. Something wey boys dey try manage take hold side, them still no gree. Them wan spoil am for boys. I been stop using kuda some 2-3 weeks ago because their service come dey unavailable most of the time plus them start dey give some very suspicious news.

This is another move from federal government to prevent Nigerian people from using crypto because them discover say 95% of p2p traders dey utilize Kuda for local financial transactions.
full member
Activity: 140
Merit: 128
My oga at the top @Igehh you've spoken well and the advice is well acceptable, we should go beyond what we can ordinary see, it's always good to aspire for better things, let's double up all efforts in working hard for a brighter days ahead. And @Wiwo let the target go beyond bounties, it's the labour time we are now but very soon the harvest will soon start Poppin in, let keep the good works, and also to all our ghost mode members, it's time to "soji" let keep the ball rolling.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Me na bounty make sense pass, because one sure bounty fit give u rabbas were three years signature campaign no fit give u.
E depends sha if you get big account you go sure benefit from any job because ur payment go make sense but small account like us, na to dey hustle to rank Grin up be our own for now.

Na him be say you be bounty hunter... Lol well it's also a good choice but just work hard to scale through the progress ladders and every other things will be added unto you other than just bounties, you're highly welcome here, pls feel at home.

Nothing come out for that way na 2017 wey bounty been dey pay major via say the ICO been dey go well and the project too been dey get better fund crowding wey been dey make them list their coin to the market faster unlike like now wey everything don cast, even money from pre sales self no even dey enough to pay listing money for better exchange.

Bounty for this forum for the past 3 years na legit scam nothing come out big manager or small manager all na the same, no manager wey dey reject work once dem get their own cash out nothing concern them again.. No more research on project again.

My brother I go advice you to think beyond bounty for this forum oo if not you no go last pass man wey wear condom.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Me na bounty make sense pass, because one sure bounty fit give u rabbas were three years signature campaign no fit give u.
E depends sha if you get big account you go sure benefit from any job because ur payment go make sense but small account like us, na to dey hustle to rank Grin up be our own for now.

Na him be say you be bounty hunter... Lol well it's also a good choice but just work hard to scale through the progress ladders and every other things will be added unto you other than just bounties, you're highly welcome here, pls feel at home.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Me na bounty make sense pass, because one sure bounty fit give u rabbas were three years signature campaign no fit give u.
E depends sha if you get big account you go sure benefit from any job because ur payment go make sense but small account like us, na to dey hustle to rank up be our own for now.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
August is a month of challenge for us to improve our performances here and be a regular active and functioning member, yes we can!
Pls what's our respective opinions?

We gaz try our very best. E no easy I understand but we need put effort to make sure the thread dey active. Bring discussion come I sure mehn dem go reason your mata. Nobody go recieve free package via account reviewing from me anymore. If you wan get dat thing we go help you grow den show working. Make we dey post atleast ones daily for the thread.

We dey try make I talk truth, we no plenty here like other local board them. Our people just the hustle for the bounties dem. I dey meet plenty of dem steadily and they no dey even reason all this been a good forum users we dey reason, there own na just how to make the money go their way.

Now to new topic: Between bounty and signature which one you feel dey profitable pass. Asin which one fit give you better rubbers. Make we discuss to pass time, no forget to give better reasons oh.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Kuda Bank Is Blocking Accounts; Attention To P2P Traders




The restrictions are still very active


Na only God fit deliver this country and her citizens from all this wicked, greedy and corrupt old men wey call themselves our leaders, e tire me say our leaders no fit provide jobs for the youths of we country, but they are quick to bring frustration to those wey decide to hustle hard and legitimately to earn their daily bread, if this our government people get sense at all, they suppose dey thank Satoshi for investing bitcoin wey in turn give birth to crypto currency, this really don help millions of our youths become something for their life, if not for crypto currency, I wonder how many more for carry gun dey street, but our useless government people no dey realize this.
full member
Activity: 140
Merit: 128
I just saw an update chart for monthly performances of each local board and threads and saw how some have been performing well in leading the table in the month of July,
I believe sey na this thread https://bitcointalksearch.org/topic/m.57685837 you dey refer to, ba? Well, the thing even sweet my belle sey dem tag owa hangout as one of d boards wey dey for local. Dat thread go even drag theymos attention enta there. Make we continue wetin we dey do. In d voice Mr Macaroni "We are doing well!"

Exactly my brother, that's the thread, we are on track!
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I just saw an update chart for monthly performances of each local board and threads and saw how some have been performing well in leading the table in the month of July,
I believe sey na this thread https://bitcointalksearch.org/topic/m.57685837 you dey refer to, ba? Well, the thing even sweet my belle sey dem tag owa hangout as one of d boards wey dey for local. Dat thread go even drag theymos attention enta there. Make we continue wetin we dey do. In d voice Mr Macaroni "We are doing well!"
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Pls what's our respective opinions?
Keep it up, I don dey track your account since and see how good you are, just keep it up, I believe say you go rank to full member very soon.

You dey right very well, we should continue to post for here, but waiting dey reasonable and quality. We supposed dey discuss many matter about Nigeria for here, especially the ones that dey related to bitcoin and waiting bitcoin users dey use. I am out of smerit, you really deserve to be given merit, but I will look into this one day.

Also, e go make sense to discuss anything that dey related to cryptocurrencies in general in Pidgin, nothing bad about that too, so far we dey our local board.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Una good evening my fellow naija brother's, today am here to charge us on our performances on the platform and how active we do appear in making it lively here, I just saw an update chart for monthly performances of each local board and threads and saw how some have been performing well in leading the table in the month of July, we can also do better, let's bring in naija spirit of "we can" and be among the best, August is a month of challenge for us to improve our performances here and be a regular active and functioning member, yes we can!
Pls what's our respective opinions?
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
How many of una get that memo from owa darling Binance? E come be sey na every week Binance dey create one change or the other.

If na for change ehh binance no dey dull, well be no dey use website access my account, i dey roll with d app so for now no update ourselves to my knowledge although the system been dey update since morning as based on the notification wey i get as i wake up.
Quote from: Binance Announcements
The spot trading system upgrade, which is scheduled to complete at 2021-08-13 06:00 AM (UTC), will be extended by approximately 30 minutes to an hour. We apologize for any inconvenience caused.

Binance Spot Trading System Upgrade Complete (2021-08-13)
https://www.binance.com/en/support/announcement/3ef1861772a44c67acc2c9f5ec9f87e4

Well this update wey you update us on no too bad abi i no dey understand am well. Belike fear dey catch dem, dey don dey hide their peer2peer doings lol.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!


How many of una get that memo from owa darling Binance? E come be sey na every week Binance dey create one change or the other.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Twitter ban to be lifted soon ― FG
My country people, hear wetin our naija govt yarn about Twitter ban lift, giving it a condition to establish a legal presence in the country and to register as a naija company with an address, wetin una see.

Dem dey find wetin dey go control. Dey don use regulations spoil everything for the country dey think say twitter CEO na mumu. Abi dem forget says e never too tay twitter leave Nigerian go Ghana go mouth? Wetin Nigerian get na just population, every other thing dey broken. Business no get protection for her, infact only the cost of running business fit make you bankrupt in just months wey you start.

See wetin dey happen to kuda na, dat bank na online based why e come dey dey get all these issue now. Nigerian just they misbehave, make the government no wrong we go leave the country for them to run am themself since na wetin dem dey find with all this rubbish dem dey call regulation.

See bank wey me just register and been dey wait for one or two to verify an wells so I fit enter dis peer2peer business wella but dey don spoi am.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Twitter ban to be lifted soon ― FG
My country people, hear wetin our naija govt yarn about Twitter ban lift, giving it a condition to establish a legal presence in the country and to register as a naija company with an address, wetin una see.

Quote
The Federal Government on Wednesday said that the Twitter ban in Nigeria will be lifted soon.

The Minister of Information and Culture, Alhaji Lai Mohammed stated this while briefing State House correspondents at the end of the virtual Federal Executive Council, FEC, meeting presided over by Vice President Yemi Osinbajo at the First Lady’s Conference room, Presidential Villa, Abuja.

The Minister who was asked to give an update on the Twitter ban in Nigeria and the interface with the company said, “The end for amicable resolution is very much in sight.

‘We appreciate the patience of Nigerians. I want to assure you that we have made very tremendous progress. We have met with Twitter both physically and in writing. We are actually almost there.

” The engagement has been extremely positive without any acrimony. We have made it clear what we want from Twitter.”

Alhaji Mohammed stated that some of the conditions made by the Federal Government for Twitter operations to resume in Nigeria include that Twitter should establish a legal presence in the country, register as a Nigerian company with an address.

It should also have a Country Representative that will serve as a liaison and must register with relevant regulatory agencies including the NCC.
Source link:
https://www.vanguardngr.com/2021/08/twitter-ban-to-be-lifted-soon-%E2%80%95-fg/amp/
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

Na waa o, the p2p way we been dey use run matters, way dey make me feel like say crypto don win election na em you dey talk this one for. E bad o, e bad well well. Though, e be like na via high transactions them dey put eye, abi no be so?

Yes na high transactions dem dey really put eyes, make e no exceed N5M daily limit once you exceed this limit den go ask you to show proof of business or work wey you dey do to dey make that kind big money transactions, even with the proof den still dey block people accounts.

I dey feel for those merchant wey dey make almost N10M + daily or more dey use survive, the country dey really piss up person the government just dey do anyhow, nothing come out for the country. Make everyone just dey on widas
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Kuda Bank Is Blocking Accounts; Attention To P2P Traders




The restrictions are still very active


This info vital die. I never confirm am but, coming from my kontry man, I no need any verification on the matter.
Omo, I dey use those men them run shits once once o. This konrty and the government policy eh, na just decoration them decorate some kind talk them make e no look too bad until them carry your matter. Na that time you go sabi the stakes way involve.

Na waa o, the p2p way we been dey use run matters, way dey make me feel like say crypto don win election na em you dey talk this one for. E bad o, e bad well well. Though, e be like na via high transactions them dey put eye, abi no be so?
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Kuda Bank Is Blocking Accounts; Attention To P2P Traders

Please those using Kuda bank for P2P or any heavy transactions please you need use your head as jungle don red, the bank don put daily transactions limit on their inflow and outflow, one of my guys fall victim a few weeks ago, my guy account was blocked and ask to provide a legitimate business registration, the government is still fighting cryptocurrency with all their power nobody should decide you with any E-naira shit. We live in a country where the government want to track everything meaningful to her citizens but can not track bandicts and terrorists making lives unbearable at the Northern part of the country.


The restrictions are still very active


Jump to: