Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 222. (Read 1030740 times)

legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---snipped---
No be say I no go for bull run, but I no go for bull run at that time, I dey use Bitcoin price history for my prediction. There will be bull and bear run, but the thing be say the all-time-high no dey certain again until next halving when more companies go start to dey invest. You know say some institutions don dey wait for that time, they know people like to fomo some weeks and some months after halving, they also use the opportunity to pump the price go up. I may not be totally right, but in accordance to Bitcoin price prediction.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
I go advise say you just put your mind into am and try allocate time for am. 1-2hrs daily no bad to learn trading concepts and 30 minutes to 1hr for trading analysis.
I understand, thanks boss, but e no easy sha cause of say enough things dey to do too, buh anyhw I go still try dey dedicate small time for am.

Anyhow my people una happy new month oh, I pray say jolly go dey enough for us this month 👐, make market pump back to $64k make everywhere stew for boys, how una see the market sef, this one everything don dey green back again, abi the bull run wan continue oh?   E for nice sha.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
Holding and trading. Be like say Bitcoin price don get pass $40000, China fud and Elon Musk price manipulation don over. Me no know much about IDO or IEO or ICO. But as risky some dey be, I still get few people telling say such projects make sense, but risky o.

I been think say you been don take your foot off the gas on top trading matter after market crash since may? Well, e dey good to see say you don get back in the business regardless of anything wey happen. Walaha only dey for person wey give up.  As for the market, I dey happy as market don improve a bit. At least, e don pump my bags small. Plenty risks dey for all the token sale projects whether na ICO/IDO/IEO - but na someone we go have to live with considering the fact say everything about investment always involve substantial amount of risk. IDOs dey do well but that's if you invest for the ones wey blow. otherwise, na to take the L.

Aside from forum participation one thing way I really wan learn na be trading oh, but lately e come bae as if 24hrs per day no dey enough for me again oh, omo the stress no be here sha, anyhow the way d market dey recover now is like na good time to just buy hold, since China fud don finally finish, IDO investing dey hard to dey whitelisted oh,since the competition for that one spot no be here, me no get strength to go dey drag with who get $100k🤣🤣.

I go advise say you just put your mind into am and try allocate time for am. 1-2hrs daily no bad to learn trading concepts and 30 minutes to 1hr for trading analysis.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
My people, I dey hail oh ,sorry say I dey inactive here oh, when market been bad your boy just lay low, but now I don show back now Smiley.
I dey happy to see say activity on this thread don increase lately. It dey good say we never give up yet on our long term goals yet for this community. That said, I hope say all of una dey do well, especially now wey the market don dey rise up back slowly towards the previous all time high?

Abeg which activities una dey take part in now apart from forum participation over here?
- Trading
- Farming
- Abi na IDO investing?
Aside from forum participation one thing way I really wan learn na be trading oh, but lately e come bae as if 24hrs per day no dey enough for me again oh, omo the stress no be here sha, anyhow the way d market dey recover now is like na good time to just buy hold, since China fud don finally finish, IDO investing dey hard to dey whitelisted oh,since the competition for that one spot no be here, me no get strength to go dey drag with who get $100k🤣🤣.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Abeg which activities una dey take part in now apart from forum participation over here?
- Trading
- Farming
- Abi na IDO investing?
Holding and trading. Be like say Bitcoin price don get pass $40000, China fud and Elon Musk price manipulation don over. Me no know much about IDO or IEO or ICO. But as risky some dey be, I still get few people telling say such projects make sense, but risky o.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
I dey happy to see say activity on this thread don increase lately. It dey good say we never give up yet on our long term goals yet for this community. That said, I hope say all of una dey do well, especially now wey the market don dey rise up back slowly towards the previous all time high?

Abeg which activities una dey take part in now apart from forum participation over here?
- Trading
- Farming
- Abi na IDO investing?
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
~snipe~
The king is here. Omo, you and me relate die I no go lie you, as I see your user eh, na so the name just sweet me for body. E sure scatter! Anyhow shah @Nathrixxx, them no dey carry post them join body the way you dey run am. Na fk and forost place them, e go count as spamming. Na only here way be say, them no dey reason am like that. The more reason way be say eh, you and others for dey come to faji freedom. Still on still, avoid make your post dey follow each other for yansh inside one thread instead, edit the one way dey un top then, you add the post with am so, e go big. Na small small, with time, you go dey okay.
hero member
Activity: 854
Merit: 506
signature that I mean na to dey write and promote campaign, am just a newbie here and will appreciate your kind gesture towards my growth on the platform
Just a correction. You no even dey campaign yet, even if you dey campaign, never seen ham as job, na just reward to quality contents posted on this forum. You dey try I think (as a beginner), just keep on posting good, likely you go rank up to member asap, but no see signature as job.

Also, no dey post repeatedly on a thread, it is against the rules of this forum.

Na true talk my brother, you know say na only here him fit do that kind thing but for another thread them fit wipe all the post wey him make, so some fit result to ban from the forum. we really get some moderator wey no dey pity person atall so make him try avoid some say them say.
hero member
Activity: 854
Merit: 506

I throw salute give you, e good say you get this kind good skills maybe if you build your account well you fit dey do managerial work for here, na only for altcoin discussion I dey see you, I know say you be omoh naija since but I been dey wait make you come around thank God you did you try make men and you cap for telegram e get wet in we go chok mouth for.
 
Like this eh, I don run go apply the next round way you post o, I go encourage other Nigerians way dey here to go do the same. Make we for dey collect dey go. You do well bro.
I applied last round but I no see result of the winning numbers at all make them dey try dey make the process transparent any which way I go still apply again try luck.

Correct!
thank you man, i sight you from far too.. like this now i done follow the telegram group but e be like say the group no too dey active for people to dey reply. person been dey ask about community manager so i won sabi the type of community manager wey him they find for the group, if na to do moderator and the rest then make him cap me well for our group there make we see e go be.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Partner with Sam Zuga to grow E-Naira Digital currency, FG told.
Our greedy leaders don't have the mindset to focus on growing the economy rather than looting and corruption, the power of partnership in business goes along way only if FG can invest and partners with innovative minds like Zuga who has something to offer, as a developing country, our first priory is to boost the economy to stability through divers means of partnership, this is when a  country is in full responsibility of it's citizen's creativity and development, hear the ideology of many who could voice out.

Quote
|Some Nigerians Wednesday urged the Federal Government to partner with Professor Archbishop Sam Zuga who has successfully raised his currency Zugacoin to the most expensive and popular coin in Africa.

“Now that they have decided to go into Cryptocurrency, it would be very patriotic for them to officially involve the leader of Cryptocurrency in Africa who happens to be from Nigeria. It is also very important for them to do this because, eventually, the E-NAIRA must run on a blockchain platform, that being the case, if they partner with the CEO of Sam Zuga, they will even be given a cheaper access fee compared to the ones they might use that would be from the western world.

The access fee they will pay into the foreign economy they would use their Blockchain platform for E-NAIRA would leave our economy, thereby amounting to capital flight. But if they use Sam Zuga’s Blockchain Main Net which is indigenous, that money will stay within our financial ecosystem thereby boosting our economy. The Buhari administration have to do everything to use home grown technology for this Cryptocurrency they are planning. By so doing, they will mitigate against foreign manipulation and control of E-NAIRA.

I am optimistic that this little piece of information would inevitably get to the appropriate authority, one way or the other. I just came up with this as a concerned Nigeria,” Austin Ntukogu stated.

It should also be noted that ZUGACOIN is now on 3 different Blockchains, Ethereum, Binance and Samzuga Blockchain
This is also coming after the first Blockchain Main Net in Africa was successfully Launched by the first professor of Digital Economy in the world, Archbishop Sam Zuga.
Source:
https://www.vanguardngr.com/2021/07/partner-with-sam-zuga-to-grow-e-naira-cryptocurrency-fg-told/amp/
full member
Activity: 140
Merit: 128

Nigerian government will always try to frustrate legitimate business. We wake up every morning to one bad news or the other. On the brighter side this will push people to embrace crypto. The value of naira is depreciating everyday. We might get to 560/$ at this rate. Save your money in stable coins.

Naira falls after CBN stops forex sales to BDC
Wonder shall never end in this era of change, regarding placing a ban on BDC, I think the service stand as a decentralized third party exchange having their own special role they play in terms of any currency circulation for exchanges, which is the same role crypto operates, the question is that does placing a ban on BDC has a positive impact on the Nigeria's economy and Naira value to Dollar?...

Quote
|Naira fell marginally against the U.S dollar at the parallel market on Tuesday, after the Central Bank of Nigeria (CBN) announced that it has ended the sales of forex to Bureau De Change operators.
Link:
https://www.premiumtimesng.com/news/top-news/476061-naira-falls-after-cbn-stops-forex-sales-to-bdcs.html

I think we need a reset on our economy and a reform on how naira can begin to gain value against dollar than placing a ban on what contribute to the economy.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
signature that I mean na to dey write and promote campaign, am just a newbie here and will appreciate your kind gesture towards my growth on the platform
Na  now I grab watiin you been dey try mean. E go well shah but, the person way orientate you just miss small detail. The work way most persons dey do for signature and the forum na our normal talk talk via writing. E dey needed o, that one na real matter but, we no dey really see am as skill for herevia say, people way sabi write plenty. When we dey talk skill, na like management of campaign, Web design, Ann thread creation, campaign service thread creation, NFT designs and other shits like that. Somethi6way be say, many people no sabi and na watin you fit do online or deliver online. Na so e just be.

Anyhow shah, you no make mistake, na learn you come learn so, you go try put eye for ground but for now, commot mind for plenty money make you dey try push yourself up. Whe  the money time reach, you cef, you go confirm am buy mind you, money and pushing account up no dey tally well.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
signature that I mean na to dey write and promote campaign, am just a newbie here and will appreciate your kind gesture towards my growth on the platform
Just a correction. You no even dey campaign yet, even if you dey campaign, never seen ham as job, na just reward to quality contents posted on this forum. You dey try I think (as a beginner), just keep on posting good, likely you go rank up to member asap, but no see signature as job.

Also, no dey post repeatedly on a thread, it is against the rules of this forum.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Username: Nathrixxx
Gender: Male
Country: Nigeria
Skills: Signature and Trading
You na strong hands o, Newbie way get skills for signature and trading. No worry, you be better pikin. You dey very welcome to both the forum and our small corner way we dey take manage life. Here way you don come so, na among brothers you dey be this and for anything way we dey do, we dey try carry ourselve along before we go hope say, them Oyibo and other people them go carry us join body. So, we don know you now, you too go try put eye make you for know your people them finish so that, we no go con dey Jons ourselves for some kind matter.
Abeg eh, try keep to the rules and another important thing be say, you go try dey show face for this area, we need am. You do well.

Its a pleasure once again, the signature indicated earlier no be coding but na to do campaign and promote am, I still remain your newbie and maintain been loyal to you all, thank you.
full member
Activity: 140
Merit: 128
Skills: Signature and Trading

Welcome to the forum, I use the opportunity welcome odas wey post their introduction before you and you too. I just dey very interested in your skills, when you say signature wetin you mean. Like you Sabi run signature codes, abi you dey mean to dey write dey promote campaign through signature participations. If na dar one you mean then dat one no be skills oh everybody fit run dat one na, abeg clear us.

Una good morning oh, how last week be na, market don dey green again oh, I hope una done secure the bags already so as things dey go up una go follow benefit. In all dey getting, get BNB na one altcoin I dey sure go do well if market favour altcoins. Already dey don burn their quarterly burnings na for bull to come now carry price go three digits.

Its a pleasure to be on this our Nigeria local thread, there's nothing more like to feel at home when you're been welcomed, signature that I mean na to dey write and promote campaign, am just a newbie here and will appreciate your kind gesture towards my growth on the platform
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---snipped---
Try include link next time for us to enjoy the full reading. You never known that recent government like wonders, na another one be that.

The value of naira is depreciating everyday. We might get to 560/$ at this rate. Save your money in stable coins.
Why you no leave some for Bitcoin, so you go enjoy the deflationary/appreciative nature of Bitcoin.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555

Nigerian government will always try to frustrate legitimate business. We wake up every morning to one bad news or the other. On the brighter side this will push people to embrace crypto. The value of naira is depreciating everyday. We might get to 560/$ at this rate. Save your money in stable coins.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
For other Nigerians, Incase you refer person to the forum and they no fit register, you fit show them this thread - https://bitcointalksearch.org/topic/m.57505657
They fit get whitelisted for free, but they go need prove say they be true new members, my own email dey there too.
The matta nor dey easy like dat oh. Na so dem nearly take questions wan stress out my guy wey I bring enta this forum to the point wey I use vex tell my guy sey make im nor worry I go pay the fee for am. The person wey im dey yan with sey make im do video evidence of im IP to show sey nor be me dey run the parole. I scatter laugh as the thing weak me. I tell the veteran member sey the suspicion dey unnecessary. So, if I wan run another parole I nor go come sabi how to pay the fee ni or what? Na so I ask am. How you go tell person to expose im IP because you wan pay one shikini money for am? And I sure na so many genuine newbies go face dat same frustration if dem nor get Satoshi to pay by dem selves or someone to pay for dem.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Username: Nathrixxx
Gender: Male
Country: Nigeria
Skills: Signature and Trading
You na strong hands o, Newbie way get skills for signature and trading. No worry, you be better pikin. You dey very welcome to both the forum and our small corner way we dey take manage life. Here way you don come so, na among brothers you dey be this and for anything way we dey do, we dey try carry ourselve along before we go hope say, them Oyibo and other people them go carry us join body. So, we don know you now, you too go try put eye make you for know your people them finish so that, we no go con dey Jons ourselves for some kind matter.
Abeg eh, try keep to the rules and another important thing be say, you go try dey show face for this area, we need am. You do well.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

Jump to: