Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 221. (Read 1030740 times)

full member
Activity: 140
Merit: 128
Still on the matter of ban on BDC, imagine wetin our fellow Nigerians dey yarn in support for FG, na everyone dey open mouth talk him own oooo as it does not surprise me seeing this online.

Quote
|Manufacturers Association of Nigeria backs CBN on FX ban to BDCs. ... This was disclosed in a statement titled: “MAN's Perspective on the CBN's New Policy on Forex Allocation to BDCs,” signed by its Director-General, Mr Segun ... CBN Intervention Funds yet to achieve desired impact

For more details, pls click the link below
https://nairametrics.com/2021/08/02/manufacturers-association-of-nigeria-backs-cbn-on-fx-ban-to-bdcs/
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino

Also CBN no supply foreign currencies to BDC again Grin  If Buhari get the power to ban crypto finally, he go do ham, CBN governor would have advice him to do so. Although, Nigerians will turn to VPN but e no go easy, especially to access exchanges.

Malami talk say dey no tell Nigerians not to use Twitter  Roll Eyes  Person wey talk say anyone found will be prosecuted. CBN governor don talk before say cryptocurrencies are illegitimate  Roll Eyes  but na Naija Boko Haram, bandits and many other kidnappers dey collect as ransom. You see Buhari son's bridal gown? It is against Sharia way of dressing, Hisbah reacted to the gown worn, make dey go arrest her na, the law is for the poor in Nigeria.

E just dey sad say at this kind of time when nearly all countries are adopting new innovations and initiatives to improve their economies and the well being of their people, Nigeria dey below the perking order with too many backwards policies. The twitter ban few months ago dey completely unnecessary yet them do am. I just dey thankful say all those people wey them bribe to vote buhari in for two consecutive tenures dey follow us suffer all these things we dey suffer too. Maybe we go try get sense for the next election to pick a more better leader coz I never really see anything good wey this buhari government don do except for making it easier for the average joe to survive.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---snipped---
I like how United States no sell fighting jet for Nigerian government, the reason why US no sell the fighting jets na because of how Buhari government dey abuse citizens right. Nigeria is faulty from ground up, no good modern era foundation. No bill passed to ban crypto in Nigeria, which no dey possible, even if dey possible, the chance dey negligible, na CBN ban crypto, but Naija shine eyes, they turned to crypto P2P transaction.

When dat one nor work, na so dem ban Twitter to frustrate owa social life.
Also CBN no supply foreign currencies to BDC again Grin  If Buhari get the power to ban crypto finally, he go do ham, CBN governor would have advice him to do so. Although, Nigerians will turn to VPN but e no go easy, especially to access exchanges.

Malami talk say dey no tell Nigerians not to use Twitter  Roll Eyes  Person wey talk say anyone found will be prosecuted. CBN governor don talk before say cryptocurrencies are illegitimate  Roll Eyes  but na Naija Boko Haram, bandits and many other kidnappers dey collect as ransom. You see Buhari son's bridal gown? It is against Sharia way of dressing, Hisbah reacted to the gown worn, make dey go arrest her na, the law is for the poor in Nigeria.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
If we sabi whatsup na to ignore de rubbish wey CBN dey wan launch dey call am digital currency.
Anybodi weu dey believe CBN for dis kain matta dey try, i dey tell you! Me nor fit try am. Even when my mind sey make im agree small na serious warning my brain dey give mind oh. Hia! How anyone go believe an institution wey wan rubbish owa hustle. Nor be dem ban crypto so dem go fit cripple us financially? When dat one nor work, na so dem ban Twitter to frustrate owa social life. This present CBN under Godwin Emefiele and Naija under Bubu nor be am at all at all.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Username: EzeBitcoin2002
Gender: Male
Country/State Of Origin: Nigeria/Imo State
Skills: Graphics Designer and Nursing Student
Username: Joy_learns_crypto
Gender: Female
Country and State Of Origin: Nigeria/Imo State
Skills: Graphics designer, Web designer, Digital marketer
Username: dari-phil44
Gender: male
State of origin: Adamawa
Skills: cosmetology.
This one eh, no be only una waka come o, lol... As I see the way una take fall in we corner eh, e just be me like say, the them just dey form the thread abi thread author in the person of CryptopreneurBrainboss don ask for fresh intro!

Anyhow e be, una try to fine una way come here and una welcome wella. Na we corner for the bitcointalkband crypto space be this. After all the plenty English for the many boards way dey the forum, na here you fit come to free yourself, to speak pighin with your family and to feel at home. So, commot fear for your body but still, no carry say you dey house con violate rules shah. Some kind talk, you go code am, you know at in I mean na. Una dey welcome and I hope say, una go dey come dey with us anytime una dey online as na so e suppose be and na like that we dey carry know say, this person na family true-true.
Oya na, make una dey enjoy.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nobody should believe anything wey this yeye country dey talk about e-naira oo na just avenue to carry collect money put for pocket then abandon the project.
You mean say the country (Nigeria) no go lauch any CBDC, I no go against your opinion because the country no get bearing, any disappointment can happen. I still dey think how the country go lauch CBDC before the end of this year, 2021. I no go believe until it is done.

If we sabi whatsup na to ignore de rubbish wey CBN dey wan launch dey call am digital currency. dem dey just find way wey dey go fit dey monitor our money since dem see say we no wan let the whole crypto thing just die like dat.
Me no get issue with CBDC because e go dey almost similar to Fiat if privacy is the case. It is just like what is for Ceacer na still for Caeser. If we dey use Fiat, I no see CBDC different, but na we sabi say decentralized currencies (most especially Bitcoin) will give privacy, CBDC can not. Also, CBDC is inflationary, subjected to devaluation while Bitcoin is deflationary. But that no mean I can not have little amount of money in CBDC which go be only for spendings and nothing more, anything related to Nigeria currency can wreck someone's if kept for over long time.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
For it's part, the CBN has complemented it's regular arguments against crypto currencies with the now routine assurances that Nigeria will have it's own digital currency soon.
Bitcoinnews.com

If we sabi whatsup na to ignore de rubbish wey CBN dey wan launch dey call am digital currency. dem dey just find way wey dey go fit dey monitor our money since dem see say we no wan let the whole crypto thing just die like dat. The government been dey think say if they behave like dey wan punish people wey dey run the crypto package people go fear leave am but dey no realize say na anything wey dem say make we no reason do na him we dey always wan do.

The government wan control over money again and na wetin dat digital nonsense dey about, no go believe their rubbish oh. We don already win dem. Firstly their digital naira go be centralized and no be wetin the industry dey all about. We we dey advocate decentralization and we country no go fit allow us get am if not dem go lose everything.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Bitcoinnews.com
E no dey bad to include the direct clickable link.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
As some reports have shown, Nigeria's position as the biggest crypto currency market in Africa remains unchanged. For it's part, the CBN has complemented it's regular arguments against crypto currencies with the now routine assurances that Nigeria will have it's own digital currency soon.
Nobody should believe anything wey this yeye country dey talk about e-naira oo na just avenue to carry collect money put for pocket then abandon the project..besides other countries don drop that E-money project dey battle covid19 now...and Op abeg I no want shout but that your source wey you put dey wrong oo I just run test now and e show me where you carry some of your text soo try edit am before police go see you abeg.
newbie
Activity: 12
Merit: 1
It has been more than 6 months since the central bank of Nigeria CBN directed banks to stop serving customers from the crypto industry. While the measure appears to have succeeded in removing crypto entities from the banking ecosystem, the policy has however led to the growth of the peer to peer trading.
As some reports have shown, Nigeria's position as the biggest crypto currency market in Africa remains unchanged. For it's part, the CBN has complemented it's regular arguments against crypto currencies with the now routine assurances that Nigeria will have it's own digital currency soon.
Bitcoinnews.com
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
I say make I bring dis account buying something come here, I dey see plenty people wey dey reach out to me after their accounts dey banned am. Make una dey very careful, normally the forum dey against account buying so if you buy one and dey ban am for plagiarism, u no go fit even get am back. And make una also know say posts history dey always dey available meaning say no just dey para everywhere after u just get dat account if not people go identify you.

Make I welcome those our new forum 48 dem wey join us una well done to follow us sitdown for here, na this small apartment we dey sleep for now so make una mange with us for the moment as our chairman CB and other members dey hustle to give us big place to sleep.

 I give una 1 kurikuri each as I check una post history come see say una dey try I say make I dash to show una say if una continue we go help una... If you check other pages una go see say I dey share Kurikuri anytime I visit here to show my presence.

And as for wetin our CB talk about our men wey dey tighdy account come go lose guard abeg make we try dey on our widas ooo make pant no wear us [ hope say una dey understand PH slangs] for the forum everybody na smart thi3f every body dey use their head so make you try use your sense too.

My DM and telegram dey open 247 if you need help (nobe money oo cause I dey find too make una beg CB and CharlesTim  Grin) I dey available to assist I no get single pride I be cheap ashawo...
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
My people, market don go back up  but activity in Our community don reduce. I hope say everybody dey fine?

Wetin we dey lack here na topic to just use dey hold body. The topic supposed be sweat ones and dey informative too. Right now we need plenty talk to keep the thread active and dat kind talk go only fit come from gossipable talks wey people fit relate to. Of you get dat talk, no waste time bring am here. No be must e go be crypto something or Nigerian. Remember we just dey hangout here sonaoo mata una fit bring am out table make we discuss.

I say make I bring dis account buying something come here, I dey see plenty people wey dey reach out to me after their accounts dey banned am. Make una dey very careful, normally the forum dey against account buying so if you buy one and dey ban am for plagiarism, u no go fit even get am back. And make una also know say posts history dey always dey available meaning say no just dey para everywhere after u just get dat account if not people go identify you.

"In all they doings get sense abeg" make una no go dey stain the country reputation. We done try build am to dis level make una no gree greed spoil everything. I prefer building up alts wey u no go abuse any forum rule to rank am up then going to put your main account at risk as you no go fit know when you go mistakenly do something wey go expose both accounts identify. Make una know we no go fit defend una when abusing of the forum dey involved. I dey see plenty greed dey come up of recent, make una slow down abeg before una go regret am.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
My people, market don go back up  but activity in. Our community don reduce. I hope say everybody dey fine?
~Snipped

Na the coin be that oooh, anywhere wey you come across this project, run for your dear money, no let them trick you with their low supply bullshit, dev still dey mint new coins dey sell and many of their new investors no know.

Damn bro. Sorry about your loss. Na today I just come see your reply despite checking the thread a couple of times this week already. I no know about the project you mention but from wetin I don learn from this crypto space, na to put just a fraction of capital into relatively new projects because projects like that na basically gambling and only a few of them dey end up getting traction. Na why I no dey too patronize coins wey dey pancakeswap and other dex (or AMM) wey dey always list shitcoins.

For now, I just dey accumulate more NEAR, ICP (I been enter their airdrop early 2018) and BNB.



I want to take out time to welcome all new members to our community.  Smiley
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Una all wey be new members, I won say una welcome ooo to the forum and most especially, welcome to this our small(but soon become big) corner where we dey come together to reason wetin dey happen for our very own naija country and crypto currencies in general, I no be the chairman here, but I go still say make una feel very free to join every discussion wey come any body bring up here, if at all self una get anything wey una want us to chuck mouth on, make una no hesitate to bring it up here, we all dey grow oooh, and we have a lot to learn from each other, so make una feel free.
And welcome ones again.
newbie
Activity: 12
Merit: 1
Username: dari-phil44
Gender: male
State of origin: Adamawa
Skills: cosmetology.
 Good evening sir/ma. It's a pleasure to be part of this board. I just recently joined this forum and saw this Nigerian language board. So as a Nigerian I decided to see to myself how the board works and it's rules if applicable. I sincerely appreciate every one of you for being Nigerians and looking forward to be guided on the forums activities and the way to succeed in the forum. Thanks
jr. member
Activity: 37
Merit: 14
Username: Joy_learns_crypto
Gender: Female
Country and State Of Origin: Nigeria/Imo State
Skills: Graphics designer, Web designer, Digital marketer

I dey new to the forum and  i happy say i find board where i fit follow my people reason.
newbie
Activity: 6
Merit: 2
Username: EzeBitcoin2002
Gender: Male
Country/State Of Origin: Nigeria/Imo State
Skills: Graphics Designer and Nursing Student

I am still a Newbie in this forum and I am excited to discover this place, a place where I get to interact with my people.
Hope I am welcomed here
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
~snipe~
Na satin show say, you be man of plenty experience be this o, you dey able to determine the trick at play and e no do you two two plenty to run with your money. On like some people way be say, the hope say, e ho soon bounce back con favour them for make them stay. You do well kwa to come warn some of us here way be say, to trade dey the body or even cef, to buy and hodl because, with this thing you dey talk so eh, the coded minting of coin as e be so, na em be say, the coin no go ever go up. The price go just dey as e deay mean while, people dey chop there money dey go on the low. Plenty trick full this our business shah o.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Abeg which activities una dey take part in now apart from forum participation over here?
- Trading
- Farming
- Abi na IDO investing?
Holding and trading. Be like say Bitcoin price don get pass $40000, China fud and Elon Musk price manipulation don over. Me no know much about IDO or IEO or ICO. But as risky some dey be, I still get few people telling say such projects make sense, but risky o.
Bitcoin don fall back to below $40,000 usd now, all this dey give me feelings say that Saturday night pump na just manipulation and trap wey some rich fork set to take get some quick profit, this aside though.

Me na investing and small small trading I majorly dey into ooh, but last week na very bad week for me, as due to how I need money bad bad, I begin look for some altcoins wey I go invest in wey fit give me some quick profit, this thing make me go invest for one coin wey I see for coinmarketcap not knowing say na scam, the coin get only 21,000 as total supply and price was still very cheap, below $20 usd, and just listed on coinmarketcap, I got in at $19.87 usd, I come reason say when people discover the coin, the price fit go up sharply due to the low supply, I no know say the devs dey mint new coins secretly dey sell for pancakeswap without the investors knowing.... The long and short of the matter be say, the 40k naira wey I invest into this coin, na 8k naira I manage pull out, the rest gone with the wind.





Na the coin be that oooh, anywhere wey you come across this project, run for your dear money, no let them trick you with their low supply bullshit, dev still dey mint new coins dey sell and many of their new investors no know.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013

Nigerian government will always try to frustrate legitimate business. We wake up every morning to one bad news or the other. On the brighter side this will push people to embrace crypto. The value of naira is depreciating everyday. We might get to 560/$ at this rate. Save your money in stable coins.

Sometimes me i dey wonder the  Kind igbo our government dey smoke abi na just wicked wey dem just like to do normally, because the way dem take dey ban things back to back nor gel at all.

Finally na to cling to bitcoin ooo, make e for soft for you because bitcoin dun start to go up again. Na better time for us wey get bitcoin, nor allow 9ja loose guard you.
Jump to: