Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 224. (Read 1031029 times)

legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Dat Reno talk nor miss road at all!

Make him garrat, sha true true we get problem with money spending and you know why but before we enta dat matta why e go use this opportunity the talk e come belike bad belle, why e no talk am since abeg make them free our OBA doers oh. Ok back to the spending matta, which dey I just sit-down the calculated how much I don make from just posting on the forum I no add my other earning join like campaign management etc. Me self I surprised say I no get any of those money or know where dem go like if I been dey keep all ehh ahhhh I for don retire since na.

But a normal Nigeria get many problem for money to do them. Na we they provide our own light, transportation, data, water etc guy the problem plenty for you to just wake up to say we no dey spend money well when we no dey even make enough self. If na the government e talk then no problem. No bi you go tell the normal man how e go spend e money. E no owe anything to the public ahhh we no follow am make money now e wan spend am na we go tell am how to spend am, you reason am na.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139

Dat Reno talk nor miss road at all!
Hahahahahahahaha, this one just tire me just now! But, na true o baba. If you use eye check oyibo then check us, especially when e con be say, na occasion you wan use compare. You go see say eh, we naija people them, we weaked wella with watin we dey use money do. Imagine kontry way people dey cry say, things hard, things hard but yet, you go still see people way dey ball anyhow. Where the matter cast reach na even when poor man cef eh, dey measure showder with Rickman via who whats sup pass... this kontry sweet me I tell you. The only way to enjoy am na to just get money.

Assistant Jesus weldone
Use your main and stop acting like a frightened dog by hiding under an alt with your kurukere moves. Although, I already suspect who you be because your word usage exposed you. Again, dat someone disagrees with your point of view nor mean sey dem nor use dem head or make you any wiser than d person. There's something called expression and liberty of it. People dey entitled to dem opinion. Grow up and grow some balls so dat next time when someone else nor agree with you you no go run enter ya alt to attack d persin.
Bless you my person. As you dey talk, na maturity I just dey see inside the talk and e sweet me for body say man like you na fellow naija person like me. Na men like you dey sweet me share space with. Oil dey your head, no worry. You too much.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino

Dat Reno talk nor miss road at all!

This reno own na to dey pump fire steadily on twitter. Nigeria dey the way e dey now because of bad and nonsense government. E go shock me if EFCC or any other criminal related organisation go track the biggest spenders and big boys wey attend Obi Cubana momsy burial and ask about the source of their wealth. Complete nonsense especially when them fit devote that energy to figure out a way to get majority of the masses out of poverty. In every country, no matter how poor the economy is, we go still get the rich, poor and middle class (neither rich or poor, just in between). For everyone wey head dey burst unto this obi Cubana burial stuff, no forget say those men no even dey top 10 richest men in Nigeria list. Lol.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---snipped---
We dey the same country wey some people dey help, check the punch news I read like two days:

I’ve forgiven dad for abandoning me since childhood –Lagos amputee water hawker turned landlady
PICTORIAL: Lagos amputee hawker holds housewarming ceremony

make the government nodey chook eyes for people pocket they should do the needful, unBan cryptocurrency and make the market dey open again then growth go increase.
Our leaders seem to have primitive brain, they no know what it takes to move the country forward. They all dey go for selfish ambitions.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
The thing be say African parents can raise N1million for your burial but nogo fit raise 100k send you to school the thing be say we value the death more than the living in Africa.
This no dey true. Nigeria get different culture. People are most ready to help when someone is sick and people support when someone's father or mother died by sending money to the person.
No this is 100% true if you want test your family members ask them for N5k say you need am for personal reason nobody go send you at all den go tell you say eno dey but make you try enter police trouble those same family members fit raise N3m bail you out of trouble but na the same people wey no fit give you 5k wey you been ask. I don see plenty poor member wey die wey their family member contribute big money do burial for ham but when that man been dey alive nobody send am even the least 1k.

We don see plenty celebrities wey die cause say no money for operation, their friends no send them but na the same friends dey contribute for the burial pass. Omoh Charles you no dey this country at all.

The problem Nigeria get no be how to spend money, na how to increase the country's GDP.
make the government nodey chook eyes for people pocket they should do the needful, unBan cryptocurrency and make the market dey open again then growth go increase.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Assistant Jesus weldone
Use your main and stop acting like a frightened dog by hiding under an alt with your kurukere moves. Although, I already suspect who you be because your word usage exposed you. Again, dat someone disagrees with your point of view nor mean sey dem nor use dem head or make you any wiser than d person. There's something called expression and liberty of it. People dey entitled to dem opinion. Grow up and grow some balls so dat next time when someone else nor agree with you you no go run enter ya alt to attack d persin.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Wetin Reno talk na confirm tori especially the West and Eastern part of the country if you see the level of lavishing on burial
Waiting him talk no true, no just generalize I'm Western part which I think na south west you meant, Muslims also still plenty for South West, na Muslims full North (although Christian plenty for certain parts for North). Muslims no dey celebrate burial. And how is this true and related to economy help? I still try to fathom waiting that words meant, but I got not meaning to it yet as many Nigerians still dey poor. The money wey Western nations dey give, you think they just give ham, na for purpose and lack of sufficiency that cause ham. Still Nigeria dey borrow money.

...and marriages you go wonder how some people dey use make money for this country wey people dey cry
Na Nigeria be that, na human nature, if you get you go spend. People dey too poor for Nigeria to the extent external and internal help no dey sufficient.

The thing be say African parents can raise N1million for your burial but nogo fit raise 100k send you to school the thing be say we value the death more than the living in Africa.
This no dey true. Nigeria get different culture. People are most ready to help when someone is sick and people support when someone's father or mother died by sending money to the person, although, some still dey connected to the poor only and never get enough help. For our side, we no dey celebrate young that died, the young celebrate the old that grow hold and died, likewise many tribes for Nigeria no dey celebrate someone's death, only just few part in Nigeria dey do that. About school, my tribe dey try, my state has one of the highest Nigerian professors in the world, na north no dey care.

You dey talk say them dey spend, if people for country no spend, how will sellers be existing, all celebration na even to help the community. How burial even relate to the need of a country? No be rich people him dey refer to? If him reason the rich people's ways, him suppose reason poor people's ways too, that neutralized the talk.

To problem Nigeria get no be how to spend money, na how to increase the country's GDP.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Dat Reno talk nor miss road at all!
I done unfollow this guy since him dey mis yan, baba use your head before another person use ammm for you oooo. Rano tender for Ethiopia since 2015 but dey cause trouble on social media for 9ja. Abeg make we hustle make burial no switch off your birthday.
What kain of comment is dat you just put out there now? If you disagree with someone, you nor need to be disrespectful to express your own side. Wise up. BTW, his name is Reno not Rano.
Assistant Jesus weldone
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Dat Reno talk nor miss road at all!
Wetin Reno talk na confirm tori especially the West and Eastern part of the country if you see the level of lavishing on burial and marriages you go wonder how some people dey use make money for this country wey people dey cry. My own be say anybody get the right to choose the way him wan spend him money as far say him make am happy. The thing be say African parents can raise N1million for your burial but nogo fit raise 100k send you to school the thing be say we value the death more than the living in Africa.

The major thing Obi cubana teach us be say make you try dey give your friends compass so when e be una go jolly together too, all those people wey spray money na Obi cubana boys wey him been show road.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Dat Reno talk nor miss road at all!
I done unfollow this guy since him dey mis yan, baba use your head before another person use ammm for you oooo. Rano tender for Ethiopia since 2015 but dey cause trouble on social media for 9ja. Abeg make we hustle make burial no switch off your birthday.
What kain of comment is dat you just put out there now? If you disagree with someone, you nor need to be disrespectful to express your own side. Wise up. BTW, his name is Reno not Rano.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino

Dat Reno talk nor miss road at all!
I done unfollow this guy since him dey mis yan, baba use your head before another person use ammm for you oooo. Rano tender for Ethiopia since 2015 but dey cause trouble on social media for 9ja. Abeg make we hustle make burial no switch off your birthday.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
You fit take out time explain wetin you talk there as me I see am as a paradox. You can't be poor and not be poor-like-dat at the same time na .
The poor people for Nigeria surpass the rich and average, but no be say rich people no dey. The problem Nigeria get na say no good leadership. Naija people dey suffer, poverty na home to many Nigerians.

Besides, no country wey poor people nor dey. Not even in Israel that is God's own chosen.
Good economy dey unlike in Nigeria.

I sabi sey na a small percent of owa people dey rich but wetin Reno try talk there na about misplacement of priority, not even about the money itself if you got the drift.
Any Nigerian have one of the most expensive car, jet, yacht ect? E dey people's nature to chop life if the privilege dey. White go do expensive burial in a expensive place and yet buying flowers annually as na waiting dey respect.

Naija only failed to understand how they need to focus on internal production rather than importing, our leaders failed us.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Dat Reno talk nor miss road at all!
Nigeria is a poor country. No be say Nigeria poor like that,
You fit take out time explain wetin you talk there as me I see am as a paradox. You can't be poor and not be poor-like-dat at the same time na 🤷.

Besides, no country wey poor people nor dey. Not even in Israel that is God's own chosen. I sabi sey na a small percent of owa people dey rich but wetin Reno try talk there na about misplacement of priority, not even about the money itself if you got the drift.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Dat Reno talk nor miss road at all!
This is not correct in my opinion by centering this on just rich people. If I no go lie you, na even obvious truth, Nigeria is a poor country. No be say Nigeria poor like that, many rich people dey, but the wealth divided by people (people that have the wealth) is low compared to people wey dey suffer. E no talk of plenty people that go borrow money because of burial, or people that are not rich at all, him dey center this on richness but not on the truth (truth which is the standard if living in Nigeria).
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!

Dat Reno talk nor miss road at all!
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Ah na Wizkid birthday nobi burial oh abi you wan our star boy to die lol
😆😆😆... He was thinking too much about that Oba burial come dey see burial burial as im dey type go na. But Wizkid go die one day sef na. One of my friends sey since T. B. Joshua die, im don believe sey nobody wey nor fit die 😏
Na this one show say, we dey read wella for the forum, e goes well. Anyhow shah, e dey happen normally, na mistake e be and i don correct o, lol. Sometimes cef eh, the hand dey fast pass the brain. Before you even think or talk am finish cef, the hand don type am finish but, that na for men plenty typing something. Una know as e dey be, eh heh.
I swear eh, this burial matter don make that village go viral for we naija. Person way for never hear or no for know a thing about that village don sabi the name finish. E don turn trend cef, I do  dey hear people dey talk 'Do Oba for me'. E con mean say, make you dash or spray me better/plenty money. Omo, make person do Oba for me o, I need am. I greet una my people.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Ma people, how e dey be na, we don reach the last day for dis week and another one we dey enta like dis. I pray baba God go show una massive blessings this new week we dey enta, d blessing go choke but we go fit brett shay if not e no go make say to die leave all the hustle we don achieve for life. Una see wetin dey happen for Anambra, omehn I never see money spent for ordinary burial like dat. I hear say that cubana of a man don help plenty people wella na wetin make dem dey all show love for him mama burial.

This na the kind love I want us to get as community for this forum. Make we dey turn up to our people dem. Well I come make I ask una wetin we go do to bring about very active discussion for this thread, I noticed say we dey very behind oh. You don check out the pinned thread them, you don see replies and views they get. We go need catch up so if theymos wan add two or more locals our own go dey included based on activities.
If we way be omo naija no sabi anything eh  e get place way be say eh, we no dull at all and that na the area of spending money and flaunting our wealth. Our neija people we too sabi that one. We make small, we spend a lot. No be small thing this guy and men them dey do for the Oba o. I no fit imagine burial way don trend like this so tay, people forget say yesterday cef na Wizkid burial. Burial way them dey bounce person commot, e con be like say na club person been wan go.

All this one na to show say, for the life way we come, e good make you help people and chuck body for their matter o, na one hand dey watch the other. Another thing to note from this burial na 'In this life eh, make money out. David been talk am since but, na now way person really dey grow enter the talk. So my people, anyhow e be, no forget people way dey around you and even cef, if them no dey around you and you get chance to help, just help. E count for your front.

I dey see say, we don dey put head here small small, una well done o. I clap for una.
On wayin go boom here small, na the coolele water be one vital factor. Even if na just 1 cef but then, e no mean say, you go give am anyhow normally.

All the money wey dem spray for that burial na the one wey we see oooo, we neva even start to talk the one wey dem privately send to am... and your know say normally, e get the kind money wey person go get, if you want make e acknowledge you or feel your weight, na better block na you go tear enter e account.

Like this sef 9ja, naija nor need to go dey borrow money from outside again...make dem just go meet igbo business men Grin
But if i wan talk real matter so, e clear for every body eye say Big man Obi na person wey dey show love and carry e friends along, and na very good thing be that...even apart from e friends, For that village wey e go so, you go surprise how many people life wey e dun change with money. Na good man e be.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Ah na Wizkid birthday nobi burial oh abi you wan our star boy to die lol
😆😆😆... He was thinking too much about that Oba burial come dey see burial burial as im dey type go na. But Wizkid go die one day sef na. One of my friends sey since T. B. Joshua die, im don believe sey nobody wey nor fit die 😏
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
If we way be omo naija no sabi anything eh  e get place way be say eh, we no dull at all and that na the area of spending money and flaunting our wealth. Our neija people we too sabi that one. We make small, we spend a lot. No be small thing this guy and men them dey do for the Oba o. I no fit imagine burial way don trend like this so tay, people forget say yesterday cef na Wizkid birthday. Burial way them dey bounce person commot, e con be like say na club person been wan go.

Ah na Wizkid birthday nobi burial oh abi you wan our star boy to die lol, I don correct am go run am sharply. Omoh dat burial mahd. if na me be d mumda I fit vex small asin some kind things no go well. I been dey enjoy all the videos I dey see for people WhatsApp status and twitter concerning the parole but where I come vex na wen I see strippers for the burial asin e get time we gals naked come dance for people to spray dem and women self follow the spray, dat one no go well na.

We supposed respect the dead but apart from dat time eh, every other thing been mad. I here say billions was spent on just the burial. I hope d mama enjoy pass like dat when she dey alive oh. Abeg make we dey try show our people love when dey dey alive.

In regards to the showing road and love, u no see wetin we do for our brother Becky, na pure love be dat and I believe e full dis community. Everybody dey chop and e make sense like dat. Make we just dey carry go and no bad energy. One love to everybody.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Ma people, how e dey be na, we don reach the last day for dis week and another one we dey enta like dis. I pray baba God go show una massive blessings this new week we dey enta, d blessing go choke but we go fit brett shay if not e no go make say to die leave all the hustle we don achieve for life. Una see wetin dey happen for Anambra, omehn I never see money spent for ordinary burial like dat. I hear say that cubana of a man don help plenty people wella na wetin make dem dey all show love for him mama burial.

This na the kind love I want us to get as community for this forum. Make we dey turn up to our people dem. Well I come make I ask una wetin we go do to bring about very active discussion for this thread, I noticed say we dey very behind oh. You don check out the pinned thread them, you don see replies and views they get. We go need catch up so if theymos wan add two or more locals our own go dey included based on activities.
If we way be omo naija no sabi anything eh  e get place way be say eh, we no dull at all and that na the area of spending money and flaunting our wealth. Our neija people we too sabi that one. We make small, we spend a lot. No be small thing this guy and men them dey do for the Oba o. I no fit imagine burial way don trend like this so tay, people forget say yesterday cef na Wizkid birthday. Burial way them dey bounce person commot, e con be like say na club person been wan go.

All this one na to show say, for the life way we come, e good make you help people and chuck body for their matter o, na one hand dey watch the other. Another thing to note from this burial na 'In this life eh, make money o'. David been talk am since but, na now way person really dey grow enter the talk. So my people, anyhow e be, no forget people way dey around you and even cef, if them no dey around you and you get chance to help, just help. E count for your front.

Jump to: