Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 225. (Read 1031033 times)

legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Ma people, how e dey be na, we don reach the last day for dis week and another one we dey enta like dis. I pray baba God go show una massive blessings this new week we dey enta, d blessing go choke but we go fit brett shay if not e no go make say to die leave all the hustle we don achieve for life. Una see wetin dey happen for Anambra, omehn I never see money spent for ordinary burial like dat. I hear say that cubana of a man don help plenty people wella na wetin make dem dey all show love for him mama burial.

This na the kind love I want us to get as community for this forum. Make we dey turn up to our people dem. Well I come make I ask una wetin we go do to bring about very active discussion for this thread, I noticed say we dey very behind oh. You don check out the pinned thread them, you don see replies and views they get. We go need catch up so if theymos wan add two or more locals our own go dey included based on activities.

Una weldon, I dey see everybody dey work but we need more force. Wetin we go talk. Anybody get stori? D one wey talk plenty oh no be the one wey we go dey crack brain. Now we need quantity first because na wetin go enta people eye but make spam no dey I trust una nah, everybody dey e own side they perform excellently, make una carry on.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
You can make your opinion on the thread but I want to ask question here which is more about Nigerian matter which na we Nigerians that can provide valid information about, especially from people that read Nigerian news often. Is there a case in which the ransom demanded for is in Bitcoin? Altcoin? Or totally Naira or other fiat?

I no think say these bandits and kidnappers dey sophisticated enough to use crypto as their pipeline for operation. Most likely it's done in naira but might not be straight to their bank account to avoid tracing. Also all the kidnapping stories I've been reading on channels tv and the punch, them never mention say kidnappers request for crypto but only make mention of the requested amount in naira. That's as far as their news dey always go. But e go dey interesting to know their exact method for handling funds because most people don dey talk say bitcoin go be tool for this kind of situations so I go like know if true true situations like that exist.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Them no born those bandits well to use Bitcoin na. With there low level of education cef! Where the. Wan from learn a. Kwanu,,, University graduate cef na em never grasp watin blockchain tech really dey about na em herdsmen way only know how to whistle for cows to behave wan can dey reason blockchain tech. Even the Iman cef eh, them no still born a well. Bitcoin  no be Quoran o. I sure say, religion supersede the bitcoin matter but then, for easily understood matter, bitcoin no be chaise too and bandits no fit get this iead at all.

maybe they discover say some individuals dey into human trafficking  and na through bitcoin/crypto na im them dey transact to avoid tracing, this countries or government wey dey against crypto, ne them dey first come out come tell the world say "una see am, this na why we ban crypto as e no good for the system, e don give criminals ability to operate without being tracked or traced" but this countries or government forget say even before crypto come out, far back as in 19God/knows/when, all this criminal activities don dey happen and some of the perpetrators of this act, they never fit catch them till date, now, they won come dey pretend like say na crypto na im make this crimes still dey exist.
No be small o my brother. The way them go talk the matter for we naija eh, e go dey like say, na bitcoin bring abduction for we country. Fortunately for us, them never reason go that side and them no fit too.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Hi guys, please anyone here can lend my 30 usd in ether please, I need it very urgently to claim an airdrop, I will pay back 32 usd plus the transaction fee spent to send it on or before 9 pm tonight please???

UPDATE - Sorted myself out, thanks guys.
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Me self dey think like that but you enlightened me more about this, if Bitcoin or any other crypto is used for ransom, Nigerian government would have disclosed this since, but if na fiat that is used, nothing will they comment about fiat.
See my brother, no be for only Nigeria this one dey happen oooh, this same thing dey happen for any other country wey they ban or dey against crypto, any bad thing wey happen for crypto, like as we dey talk, if criminal kidnap person come demand Ransome for bitcoin, or maybe they discover say some individuals dey into human trafficking  and na through bitcoin/crypto na im them dey transact to avoid tracing, this countries or government wey dey against crypto, ne them dey first come out come tell the world say "una see am, this na why we ban crypto as e no good for the system, e don give criminals ability to operate without being tracked or traced" but this countries or government forget say even before crypto come out, far back as in 19God/knows/when, all this criminal activities don dey happen and some of the perpetrators of this act, they never fit catch them till date, now, they won come dey pretend like say na crypto na im make this crimes still dey exist.

And guys, also check this thread out, https://bitcointalksearch.org/topic/end-round2-weekly-bitgesell-bgl-4-prizes-5-15-30-50-july-18-5348853

place your bet now, just 2 days left for the final draw, cost absolutely nothing to bet.

2 important rules are

1. Accounts with newbie rank are not accepted.
2. You must have received at least 1 merit in the last 120 days.
And also make sure to pick a number that's not been picked.

That's all.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Is there a case in which the ransom demanded for is in Bitcoin? Altcoin? Or totally Naira or other fiat?
Omo, criminal activity na one big business for we country now o. If e easy cef, government for dey collect tax for there hand and e for turn up plenty money. Money way be say eh, the revenue go add weight and the economy go swell well, lol. Unfortunately,  that no fit happen but the matter still remain say, e don too rampant. With your least strategy cef eh and I mean, plan way be say you no take time arrange am well, you go crime for the country, collect ransom and then, nobody go reason your matter pass 1week. The thing just bad anyhow and na big fk.

Luckily for everybody, bitcoin na anonymous something and anybody fit claim say, e no get or e no sabi but, criminal way mean business, e ready teach you the whole thing till you sabi finish to buy and arrange payment. Watin just dey pause this system be say, people way sabi dey focused on there G-money so, them no get time for kidnapping matter. The kidnappers na normal bandits, herdsmen way still get time for there cattle but dey carry that one as side hustle else, the matter eh, e no for get where e touch reach. Na once government for hunt every body way get bitcoin. This one way SARS been dey check phones for be like joke na, armed force men for dey check people phones scatter
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
@igehhh, check my post na and respond to it. Abi you nor wan deal again? I don ask for your account numba but you neva respond.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Why you no use remitano, or maybe you no won pay withdrawal fee, cus If you buy from remitano, you go still pay blockchain fee to withdraw the bitcoin to your personal wallet or exchange.
Some people no like to buy Bitcoin on centralized platforms to maintain privacy, buying from Remitano will lead to privacy deprivation. To protect privacy while using bitcoin, buying from someone directly like on this forum is safe which no require kyc. It is just like you asking why is he maintaing privacy and freedom while using bitcoin.

---Snipped---
Me self dey think like that but you enlightened me more about this, if Bitcoin or any other crypto is used for ransom, Nigerian government would have disclosed this since, but if na fiat that is used, nothing will they comment about fiat.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Is there a case in which the ransom demanded for is in Bitcoin? Altcoin? Or totally Naira or other fiat?
From wetin I know and for the ones wey don showcase for medium these bundits get communicator wey dey act as third parties between them and the government and most of these middle men na Iman of a mosque, each state wey bunduts dey terrorize get their own Iman wey dey stand for them, they act as negotiators, when this people kidnap na this Iman dey collect money from government give to this people. Most of them na Illiterate I no sure say den den use crypto to make transactions

Anyways, guys, I no know how many of una here wey the use remitano, if you the use remitano, probably you go don know about this latest development, Remitano announce say they are launching their own coin wey they call RENEC, and the distribution of this coin na free for everyone wey fit participate for their airdrop mining program wey don already dey on.
I've been mining the coin for days now I have over 1.6RENEC so far, my mining hash is just x2 daily, the mining power depends on your level of KYC on the site, and you go download the app before you begin mine...
legendary
Activity: 2380
Merit: 1082
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
Why you no use remitano, or maybe you no won pay withdrawal fee, cus If you buy from remitano, you go still pay blockchain fee to withdraw the bitcoin to your personal wallet or exchange.

Anyways, guys, I no know how many of una here wey the use remitano, if you the use remitano, probably you go don know about this latest development, Remitano announce say they are launching their own coin wey they call RENEC, and the distribution of this coin na free for everyone wey fit participate for their airdrop mining program wey don already dey on.

For more details on how you fit participate, abeg, see my article on medium https://link.medium.com/1ggqarKRIhb

And anybody wey dey register newly for this exchange, abeg help me use my link ooh, make I for fit get small percentage abeg, the link dey for the medium  article wey I don't paste above.

Thank you.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I just posted a topic on Bitcoin discussion like an hour ago, it is about the 2021 first half abduction in Nigeria. We all know that Nigeria no dey safe like before, abduction is now common and has become job. Boko Haram but now especially bandits and normal kidnappers are kidnaping for ransom, abducting kings no be new thing for Nigeria (Naija) again.  The reason I posted the thread na because of people wey dey go against Bitcoin, but if na fiat, nothing will be said.

You can make your opinion on the thread but I want to ask question here which is more about Nigerian matter which na we Nigerians that can provide valid information about, especially from people that read Nigerian news often. Is there a case in which the ransom demanded for is in Bitcoin? Altcoin? Or totally Naira or other fiat?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
You be real business person, I noticed the buying price always dey higher than the selling price. I just checked right away, the buying price dey $514 while the selling price na $505 or a price around that in relation to Bitcoin price. What I wan just pinpoint na say buying and selling price are not the same.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
@Smartvirus, you funny die! Where you see the hodl na. I just want put am for an investment wey require BTC funding. Nothing much oh. You sabi sey everybody gat to dey invest now before the brutality of tomorrow.

@igehhh, abeg make you check your inbox here and get back to me bro.
Baba no vex I no dey stable for here again the work wey dey real life dey stress me up so my attention no dey my inbox, baba that your value nodey enter eye ooo the least I fit go an N513 make I kuku know say nothing com out my side na just help. Abeg any investment wey you put head wey pay abeg try give us update too biko, na money all of us dey find we no com life come suffer.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
@Smartvirus, you funny die! Where you see the hodl na. I just want put am for an investment wey require BTC funding. Nothing much oh. You sabi sey everybody gat to dey invest now before the brutality of tomorrow.

@igehhh, abeg make you check your inbox here and get back to me bro.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
N515 rate if you get interest make I know make we transact.
N505, make we run the parole.

@Brainboss, nobody chat me up. Any how. I still dey game. Anybody wey dey interested make im run me the stuff. Na direct. I go send you first.
See hodler way get plans. Watin you d9n see na my  senior man, show me o make I follow you see o. Make you no con tune millionaire alone then, I go con dey worry you to pay my bills o. You cef know say e no go sure o but then, na so e just be shah. Anybody way hole am stand and ready to sell, make e throw way am for the investor. We dey together,, na so e just be.

How e dey be na my people? How things for that una area because, here way I dey eh, na everybody wan use my head o. People eye just tire for money here and as e con be say, na new environment I enter, them don chop me tire and I no fit cry for help, lol...
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
N515 rate if you get interest make I know make we transact.
N505, make we run the parole.

@Brainboss, nobody chat me up. Any how. I still dey game. Anybody wey dey interested make im run me the stuff. Na direct. I go send you first.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.

I see ur 1st message but I think say person go don chat u up already. Well e go depend for rate oh. Me I dey available but e go depend on d price you wan offer me. Make we talk na, sha u get my contact details.

That said, I hope say una enjoy the Italy vs England match? E no too make sense like Copa American finals between Brazil vs Argentina but at least, e still go well especially since Italy fight very hard to equalize after England score very early.

Southgate abi wetin be e name na mumu, how u go use small boys go dey play penalties. E no see as Italy use mature man dem to make sure dey win. Worst part e no play Chelsea boys dem or even give them opposite to play the penalty. I Know my boys dem, dey no for disappoint until some clubs boys dem (lol, make I no call name be4 dey come attack me).

Finally Messi don win international trophy na, he can now be called a goat in my eyes. Before na only one goat I been know, d other one na mbahhh but now d two na GOAT.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
N515 rate if you get interest make I know make we transact.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
1.@Charles-Tim even if we change our name to Jesus Christ alaye Juda go still cash out for our head so abeg the name aspect no mean anything , people dem wey get local board today be no do as we don do ooo.

2. Me I nodey like people wey too dey make noise for back oo my fada talk say any wise man wey dey were foolish people dey dey suffer well well we don bump that local board request thread nobody don go talk there make e dey top of Meta for like one week make theymos dey see am.. Una keep quiet finish.... Anybody wey bring local board discussion here wey no go that thread to express him frustrations me and that person go fight for here.. Our people talk say na prick wey stand dey enter toto we need stand up and seek theymos attention because nobody go do am for us.

3. I no too cap here last week via say work full my hand here and for some time I been node too get time for forum I even miss last week payment via say I no meet up post, hopefully I go focus on the forum this week.
Jump to: