Ma people, how e dey be na, we don reach the last day for dis week and another one we dey enta like dis. I pray baba God go show una massive blessings this new week we dey enta, d blessing go choke but we go fit brett shay if not e no go make say to die leave all the hustle we don achieve for life. Una see wetin dey happen for Anambra, omehn I never see money spent for ordinary burial like dat. I hear say that cubana of a man don help plenty people wella na wetin make dem dey all show love for him mama burial.
This na the kind love I want us to get as community for this forum. Make we dey turn up to our people dem. Well I come make I ask una wetin we go do to bring about very active discussion for this thread, I noticed say we dey very behind oh. You don check out the pinned thread them, you don see replies and views they get. We go need catch up so if theymos wan add two or more locals our own go dey included based on activities.
If we way be omo naija no sabi anything eh e get place way be say eh, we no dull at all and that na the area of spending money and flaunting our wealth. Our neija people we too sabi that one. We make small, we spend a lot. No be small thing this guy and men them dey do for the Oba o. I no fit imagine burial way don trend like this so tay, people forget say yesterday cef na Wizkid birthday. Burial way them dey bounce person commot, e con be like say na club person been wan go.
All this one na to show say, for the life way we come, e good make you help people and chuck body for their matter o, na one hand dey watch the other. Another thing to note from this burial na 'In this life eh, make money o'. David been talk am since but, na now way person really dey grow enter the talk. So my people, anyhow e be, no forget people way dey around you and even cef, if them no dey around you and you get chance to help, just help. E count for your front.
I dey see say, we don dey put head here small small, una well done o. I clap for una.
On wayin go boom here small, na the coolele water be one vital factor. Even if na just 1 cef but then, e no mean say, you go give am anyhow normally.