Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 227. (Read 1339036 times)

staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
@Smartvirus, you funny die! Where you see the hodl na. I just want put am for an investment wey require BTC funding. Nothing much oh. You sabi sey everybody gat to dey invest now before the brutality of tomorrow.

@igehhh, abeg make you check your inbox here and get back to me bro.
Baba no vex I no dey stable for here again the work wey dey real life dey stress me up so my attention no dey my inbox, baba that your value nodey enter eye ooo the least I fit go an N513 make I kuku know say nothing com out my side na just help. Abeg any investment wey you put head wey pay abeg try give us update too biko, na money all of us dey find we no com life come suffer.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
@Smartvirus, you funny die! Where you see the hodl na. I just want put am for an investment wey require BTC funding. Nothing much oh. You sabi sey everybody gat to dey invest now before the brutality of tomorrow.

@igehhh, abeg make you check your inbox here and get back to me bro.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
N515 rate if you get interest make I know make we transact.
N505, make we run the parole.

@Brainboss, nobody chat me up. Any how. I still dey game. Anybody wey dey interested make im run me the stuff. Na direct. I go send you first.
See hodler way get plans. Watin you d9n see na my  senior man, show me o make I follow you see o. Make you no con tune millionaire alone then, I go con dey worry you to pay my bills o. You cef know say e no go sure o but then, na so e just be shah. Anybody way hole am stand and ready to sell, make e throw way am for the investor. We dey together,, na so e just be.

How e dey be na my people? How things for that una area because, here way I dey eh, na everybody wan use my head o. People eye just tire for money here and as e con be say, na new environment I enter, them don chop me tire and I no fit cry for help, lol...
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
N515 rate if you get interest make I know make we transact.
N505, make we run the parole.

@Brainboss, nobody chat me up. Any how. I still dey game. Anybody wey dey interested make im run me the stuff. Na direct. I go send you first.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.

I see ur 1st message but I think say person go don chat u up already. Well e go depend for rate oh. Me I dey available but e go depend on d price you wan offer me. Make we talk na, sha u get my contact details.

That said, I hope say una enjoy the Italy vs England match? E no too make sense like Copa American finals between Brazil vs Argentina but at least, e still go well especially since Italy fight very hard to equalize after England score very early.

Southgate abi wetin be e name na mumu, how u go use small boys go dey play penalties. E no see as Italy use mature man dem to make sure dey win. Worst part e no play Chelsea boys dem or even give them opposite to play the penalty. I Know my boys dem, dey no for disappoint until some clubs boys dem (lol, make I no call name be4 dey come attack me).

Finally Messi don win international trophy na, he can now be called a goat in my eyes. Before na only one goat I been know, d other one na mbahhh but now d two na GOAT.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
N515 rate if you get interest make I know make we transact.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
1.@Charles-Tim even if we change our name to Jesus Christ alaye Juda go still cash out for our head so abeg the name aspect no mean anything , people dem wey get local board today be no do as we don do ooo.

2. Me I nodey like people wey too dey make noise for back oo my fada talk say any wise man wey dey were foolish people dey dey suffer well well we don bump that local board request thread nobody don go talk there make e dey top of Meta for like one week make theymos dey see am.. Una keep quiet finish.... Anybody wey bring local board discussion here wey no go that thread to express him frustrations me and that person go fight for here.. Our people talk say na prick wey stand dey enter toto we need stand up and seek theymos attention because nobody go do am for us.

3. I no too cap here last week via say work full my hand here and for some time I been node too get time for forum I even miss last week payment via say I no meet up post, hopefully I go focus on the forum this week.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
---Snipped---
An active thread dey on bitcoin speculation board about this too, you fit read through ham, I gained from replies on the thread. I still dey noticed that the Bitcoin price still not increasing as I dey expect. Although, the price increased at the point of posting this from around $31000 to over $34000. This fit be an indication but other some other information must be considered before making the conclusion that I made.

---Snipped---
I noticed many posts that supposed to be here dey telegram, I too no dey active for telegram again, but I am still correcting if anyone make such post there to bring ham here.

---Snipped---
I get your point, we were even more active here when we dey telegram group, but we no need to make telegram as necessary as that, if we go get local board, we go get ham, it can be slow, but e no matter.

I have a suggestion, waiting you think if this local thread title is changed to 'Nigeria'. Me dey think e go make sense like that so people no go dey think we dey rush things to happen quickly. I dey think we should let our posts do this thing and we no need to rush.

Please, make we also engage ourselves more in Bitcoin and altcoin discussion, especially bitcoin discussion, like speculating about the price, and the recent crypto news in Nigeria. Did you know the last thread I reported for deletion on local board other languages about Nigerian digital currency was marked as bad report (that I should not have reported it for deletion), just make we involved ourselves more on crypto related discussion as it dey more valid and counts towards recognition.

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
The deep once way be say eh, e take kontry man way be guyman cef to understand and so long as, you no talk watin forum no support, everything still set.
... Na waffi and AJ underground pidgin you dey refer to here na. Na dem be d koko na. Area! I hail all man. Abeg, no matta wetin wey dey do here make we nor eva lose owa dignity. Make we keep owa heads straight. Naija, we nor dey carry last. Na we be the koko, the Toyota wey dey for cars na im we be na. Make we learn to be owa brodas keepers. If persin do you good here, make you rob im back too.

Edited: Abeg who get BTC for sale. I need $250 worth.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
The thing be say anything wey get disadvantage also get advantage, that telegram group don help us oo without that telegram group we for no fit achieve the donations to becky666, the plan na for the telegram e start, and for their still end. Before the telegram this place was not even dey busy as edey now, the telegram no get any thing to do with wetin dey happen for the thread. The thing be say you no fit carry chat app compare with forum cus edeu more easy and simple to just drop one liner comment but here u must make it more quality at least. Every local board dey discord or telegram group for private conversation, no be everything den dey share for forum... Gossip, mango mango business, p2p for telegram e make sense.
Mehn, the issue here be say, when e con be say, the advantage for one side dey suppress the other one way be say eh, we for benefit pass, the one way drag all of us here together, the one way dey make the kori for we kontry no dey too worry us. When the disadvantage con dey hit this side way be the forum, that one no sure o. Because say eh, e go hard for us to know our upcoming kontry man and to help them cef go be wahala.

So, we for dey try bring that our talk-talk come here. I know say normally,  we go dey fear say, people way no from this side go dey put eye once-once, that one dey! But, the real matter be say, you fit use main or inside pighin, no be even this one I dey talk cef. The deep once way be say eh, e take kontry man way be guyman cef to understand and so long as, you no talk watin forum no support, everything still set.

Here no be where them dey do quality, na local board e be. You fit drop your one or two lone something and everything go still dey alright. So long as na language you use cap. Like that eh, nobody go fit really tell if na spamming or not. To note cef, sometimes, we dey drop post, especially for the naija proverb side way be say, instead of to edit old post, we go post fresh one and e go con be say, our names go dey come under each other. The same name for that matter way be say, on a normal, e for be spamming but via say na local board something, nobody dey reason am. Na so e just be. Make we dey try!
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
As we dey hustle money, make we try keep time for entertainment and enjoy life small regardless coz even rich folks dey die frequently too.
Na true! And we gat to be closer to God (in good deeds & faith) as we dey move closer to owa graves every year. About the local board, make we just dey do owa thing dey go like sey the board thing nor be big deal. Before long we go get am. I don check other boards, most of them nor even dey active like us. Make una leave theymos, one day I go frighten am for dream like Pilate and im go panic give us the board by fia by mountain 😆.
hero member
Activity: 2212
Merit: 805
Top Crypto Casino
Whether telegram involvement or market cause inactivity for this thread, no need to play blame game. That said, I hope say una enjoy the Italy vs England match? E no too make sense like Copa American finals between Brazil vs Argentina but at least, e still go well especially since Italy fight very hard to equalize after England score very early. As we dey hustle money, make we try keep time for entertainment and enjoy life small regardless coz even rich folks dey die frequently too.

~Snipped
We all dey dis struggle together and we go celebration nomata d small small argument (disagreement) we dey get, e normal. na wetin show say we want d best for the community.

All of us here get one common goal wey go benefit us all if we achieve am in the end. So no worries. I believe say activity go return back to the thread. Small small.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
No fear to comment even though na just one line for here, nobody go delete am especially no be me. Na unless wetin you comment turns out to be spam na wen I sure men dem here go report am to moderator to delete. Just know telegram or no telegram the donations for still hold. I no just carry am for head as then I get so many worries and dey low on cash if not me myself I get plans for our brother but even now self rubbers no dey last for person hand, so I just decide make e just dey as e dey.

Nobi the first time we don do donation for forum, my covid doings make plenty donations come forum account wey dem no been dey receive before. If I been ready say make we promote the donations, we for fit even turn Becky wife into millionaire but I just decide make e be as e be. This forum na sense e need, eye don too dey my account I just decide to no show body much before I begin enta people bad book na even wetin make me no required for local board myself. You need see my mata for other local board as dem dey discuss me, especially dat voting time.

I want fresh person so I happy for Charles bold steps although was too early and no mobilization and igehhh you talk better, abeg make we dey bump am atleast biweekly so e go dey pepper theymos eye. Dat guy too get stubborn head, who get jazzy make we lock am hahaha. Anyways na him be boss make we dey hope e hear our cry. I dun bump am (I go delete bump pen down bettee sometime again when person posts after me).

We all dey dis struggle together and we go celebration nomata d small small argument (disagreement) we dey get, e normal. na wetin show say we want d best for the community.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
The thing be say anything wey get disadvantage also get advantage, that telegram group don help us oo without that telegram group we for no fit achieve the donations to becky666, the plan na for the telegram e start, and for their still end. Before the telegram this place was not even dey busy as edey now, the telegram no get any thing to do with wetin dey happen for the thread. The thing be say you no fit carry chat app compare with forum cus edeu more easy and simple to just drop one liner comment but here u must make it more quality at least. Every local board dey discord or telegram group for private conversation, no be everything den dey share for forum... Gossip, mango mango business, p2p for telegram e make sense.

If you delete the telegram group here go still dey like dessert so why not leave it? We need people, activity no matter if you no get back up for here ooo. If we like make we get 100 pages if we no get connection for here theymos no go still reason us..

Make we go bump that Charles Tim thread for Meta abeg.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Na d reason wey make me comot telegram, d only reason dat group still dey active na because no be me create am if not I for don delete am since. Telegram dey distract us and d sooner we begin dey see am as e be nahh dis thread go dey active weller.
Na real matter be this o because eh, someday cef, I go just wake check my Telegram group and the message way go dey come off the we naija hangout alone eh, e go dey read that kind 200+. Via say, me no dey too wan yarn for there except say I must.
The idea of the Telegram group no bad o, I like am via say, I fit use am pass coded capping to those of us way be we-we but then, when e con be say the thing wan dey at the expense of the forum, na that one no sure.

We fit still dey talk dey laff for here na, na hangout e be o. The way we dey carry am torchlight issues way concern us via how e vital reach, we fit still use am talk dey laff for our pighin dey go. Na why e be hangout. E pass the local board something, na our land be this for the forum for now, until people way dey make am official run am official for us.

Anyhow e be, we for dey branch here dey drop one or two, e go sure.
newbie
Activity: 12
Merit: 0
Bitcoin ratio of supply on exchanges don hit 6 months low

https://twitter.com/santimentfeed/status/1411971284448202755

I don create this thread for Bitcoin discussion, but I dey think some people can learn from this, while good posters among fit make good reply.

Na like this e be, Bitcoin exchange inflow for exchanges means Bitcoin users are moving their Bitcoin go exchanges, e get no two main reasons while Bitcoin users dey do this, it is because they want to sell their Bitcoin. If the Bitcoin is sold, the price plummet.

On the other hand, Bitcoin exchange outflow means that Bitcoin users dey send Bitcoin into wallet from exchanges, the main reason holders go do this is because they want to hold for that time period. I remembered many bull run occured like this, miners are holding while Bitcoin users are sending their Bitcoin to wallet from exchanges leading to bitcoin exchange outflow and later resulted to increase in Bitcoin price.

Waiting you people thing about this? Me dey think the bear market for now is over, but Bitcoin no dey go far if the price increase. $64000 no fit dey attainable until the next halving in my opinion, but this can result to bull run that can drive the price of bitcoin go above $40000, or even if the price decrease due to traders, e no fit decrease pass $30000 as the support level. Waiting you think go happen?

The thing you talk na the koko, right now i think hodlers dey carry dia bitcoin go keep for wallet, and the others way keep dia own foe exchange(some they convert to stable coin and others they sell) the true matter be say, transactions don reduced wella for exchanged as many they plan for future inside this crypto like this.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
The matter for here don dey too cast o, I swear. Watin sup na?
I dey wonder me say, our corner for we Telegram even soft pass here cef, here way be say na the main thing way bring us together, way be say the Telegram matter cef, na to set pass way suppose make this side soft but instead, Telegram con soft pass this side.

Na d reason wey make me comot telegram, d only reason dat group still dey active na because no be me create am if not I for don delete am since. Telegram dey distract us and d sooner we begin dey see am as e be nahh dis thread go dey active weller.

If u get better topics bring am here, u no go tell me you go write better thing your people no go dash u small merits. I understand d merit no much among us but still we need scarified one or two post even though dey no go pay you for d thread to dey active.

Onli one or two person no go fit dey keep d thread active as dem go easily tayah but if we plenty dey talk, tori go plenty na. Fine discussion wey go encourage normal discussion like say we just dey talk and the thread go dey active. The educational posts dem go come later, make we just tori for now, to keep thread active, I wish girls dey among d hustle, gossip for plenty but as na men we bi, all our mindset na money money lol.
hero member
Activity: 2212
Merit: 805
Top Crypto Casino
The matter for here don dey too cast o, I swear. Watin sup na?
I dey wonder me say, our corner for we Telegram even soft pass here cef, here way be say na the main thing way bring us together, way be say the Telegram matter cef, na to set pass way suppose make this side soft but instead, Telegram con soft pass this side. E no go well na! Make una check am na!! The last time way person post something here na like 4days way don pass us finish, that kind thing. Na fk na.

~Snipped

Na wetin I realize be that. Telegram make am very easy to stay in touch quickly and most of the discussion wey suppose dey this thread wey go boost engagement and other things, we dey do am on telegram. I no talk say telegram community been be bad idea but at least we suppose try to stop by once once. But I dey feel say some of us don tire for the local board hustle. I mean, the journey don dey daunting and tiresome already. Month in, month out and still no update or at least acknowledgement say them don take our request into consideration.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
The matter for here don dey too cast o, I swear. Watin sup na?
I dey wonder me say, our corner for we Telegram even soft pass here cef, here way be say na the main thing way bring us together, way be say the Telegram matter cef, na to set pass way suppose make this side soft but instead, Telegram con soft pass this side. E no go well na! Make una check am na!! The last time way person post something here na like 4days way don pass us finish, that kind thing. Na fk na.

Abeg, how e dey be, all these my people way been dey try and those way just run intro way never too tay. How e dey happen, na so we don forget here? Abi na to tell us say, we no dey carry our kontry men along for watin we dey do... becuase, e just tire me just now I swear. I dey take style dey watch if person go throwaway something here for days now and nobody wan reason we corner matter.

Even with the plenty talk-talk some kind men don yarn via how we for carry get people to look we corner say we dey try then, them for reason give us watin we dey fine. Make we try dey lap abeg. Make we con laff and talk the talk here abeg, make we Telegram dey be where we go use set pass way be say, if we talk am here, e go cast matter via say, we forum no go get joy for the kind talk. If not, na so here go take cast finish o. E don dey cast like this ready but, we no gat gree.
I greet una.
Jump to: