Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 238. (Read 1031926 times)

legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
The reason wey dey make alts dem dey crash pass be sey people nor too trust dem. Nothing more. We sabi sey Bitcoin must eva rise back by fia by force once im craze touch naked wire.

On the cash matta, I flow with Brainboss. Make all man send the cash wey dey dem hand directly to owa brother widow. Na decentralisation we dey preach here so.

All those wey dey involved for this transaction stuff and wey dey keep owa money, I twale for una commitment. Una do well. And those wey don pay up, una pockets nor go dey deep for nothing. For those wey neva show us love, abeg make una try pay up. Deadline na deadline.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Make e no shock you say only bitcoin move oh. E din happen before after a crash, alts go come in later sha
For the recent crash, bitcoin crash for $40000 to $30000, that na 1.33X crash o. Altcoins at the time don crash 2x or more if not say the price don they increase back. And to waiting you talk, you dey right, crash they affect Altcoins pass.

Make we continue give our opinion about how the money will be sent o. I agree with decentralization, as far as transparency dey.
hero member
Activity: 2184
Merit: 798
Top Crypto Casino
  • either the money in naira will be transferred to Charles-Tim, while Charles-Tim go transfer the money to Becky666 family.
  • or Smartvirus, Igehhh and Charles-Tim go individually transfer the fund to Becky666 family.

In my opinion, I go prefer if all funds go dey sent from one central account rather than having it sent from different sources. I dey talk this one base on say e go dey much more easier for accountability purposes if need be. Option 2 still make sense too since everybody go still come give account of how them use disburse the funds. Just that I dey like make processes dey dey simplified. No need to make a simple process get complicated. Similar to how @CryptopreneurBrainboss been handle that covid-19 project last year.  I go like hear the opinion of other community members think about am coz both options dey alright just that I prefer option 1.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
  • either the money in naira will be transferred to Charles-Tim, while Charles-Tim go transfer the money to Becky666 family.
  • or Smartvirus, Igehhh and Charles-Tim go individually transfer the fund to Becky666 family.

I go with option two just as I talk before, make we comot mind for centralization. Make we defi the donation in the sense dat all those wey recieve go forward to the women account details when I get them. That way everything go dey open if not I for just say make everyone send me the donations I forward to the woman but I no wan make doubt begin they come inside the picture.

Make we allow the three different individual to forward to the woman that way truly we go know say she recieve am. The small small 50 naira wey go comot for charge no be anything. E better we scarified am then we regret giving one person d money something beyond our control come happen.

Make e no shock you say only bitcoin move oh. E din happen before after a crash, alts go come in later sha
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Snipe
I dey with una and I hold una funds still.  I go still talk am again, aside from Rollbit, I never receive any funds in BTC from anybody.
This na to talk say, if you get claim say you pay and your name never pop up, abeg, present your claim.

Meanwhile, fir we way never pay, we get till 12pm Nigerian time to show our support in monetary form. Make we try set compass to meet up with anything way we been don or carry for mind say we go do. I know say the life hard but, we still get see our brother way don journey to the fatherland family people through.

About the matter way Charlie bring come so, na watin we don touch light but, we never been agree finish so, e go good make we agree. Any option una want make we do this thing, we go do am then drop proof.

I thank una.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
No be chaise, my money don lock, the crash hold all. If I sell now eh I fit pack go village so I just lock up maybe if Darkster_ reason me dat loan wey I don apply I fit hold body small and maybe buy one or two coins wey don fall badly in anticipation say dis bear no go last long as stori for town be say the bull never end.
Omoh wetin to pay plenty na money to use am now be the problem e get plenty altcoin I suppose put the least $200-300 each now hold am for like 3 years, na altcoin market money dey now some people wey buy during pre sales dey catch out like $5000- 20000 in two to there years ooo.

Even if Bitcoin fall go $20k the money no dey to buy and na wetin dey make me vex pass be dat. I just dey look BNB if e village people affect am e reach $100 nothing go make me no buy.
If Bitcoin like make him enter $5000 I no go buy am I don lose interest for bitcoin market now I dey focus on altcoin this period as na there oil money plenty now.. Omo BNB don fall from $600 to $300 see opportunity ooo na money come spoil am if e reach $100 I must gredie buy 2 or 1 hodl am for 5 years.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Smartvirus
BTC: bc1q8mvnr3actrxn97v3pxn28tly9yu0yw5mpvxhts

igehhh
USDT (TRC20): TP4kLhXxQwy1MppaSSQPyi2vyeeK1YC83p (TRC20)

Charles-Tim bank account details
GTBank (please, make sure it is Guarantee Trust Bank)
0049732936
PM me (Charles-Tim) if you think the account name is necessary.

Bitcoin
1. Rollbit team: 0.01058000 BTC



USDT (TRC20)
1. posi: 18.57 + 12 (30.57)  USDT
2. Mpamaegbu: $12
3. Anonymous: 300 USDT

Naira
1. Josefjix: 9,900 naira
2. Lordhermes: 6,000 naira
3. nelson4lov: 10,000 naira
4. Charles-Tim: 10,000 naira
5. Igehh: 6,000 naira
6. Gozie51: 5,000 naira
7. CryptopreneurBrainboss: 12,000 naira

Updated. Good morning all, final update will be at 12:00 AM GMT +1. That is 13 hours from now. Immediately I finally do the last update, I will send message to Smartvirus and Igehhh. They go both convert the coins with them to Naira.

To make this official, please you people should express your opinion about how the transfer go be. It can be in two ways which we already don talk about.

  • either the money in naira will be transferred to Charles-Tim, while Charles-Tim go transfer the money to Becky666 family.
  • or Smartvirus, Igehhh and Charles-Tim go individually transfer the fund to Becky666 family.

In my opinion, I will go with option two because we fit paste the transaction receipt for here as an evidence that we don transfer the money. While the three of us (smartvirus, Igehhh and Charles-Tim) go send to the same bank account number owned by Becky666 family member (most probably his widowed wife).
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
This crash done affect me madly, my hopes self for campaign to pay me for my management no come work.  They run me street. Even to post this days no be here. Mehn e come be say na only dis one I get.
Omoh the crash affect me like mad too e get some of bitcoin I suppose tether wey I no tether on time before the crash I just dey thank babGod say I no panic rush go tether during the crash if not I for lose jagajaga I no lie you bro.

No be chaise, my money don lock, the crash hold all. If I sell now eh I fit pack go village so I just lock up maybe if Darkster_ reason me dat loan wey I don apply I fit hold body small and maybe buy one or two coins wey don fall badly in anticipation say dis bear no go last long as stori for town be say the bull never end.

Many people dem still dey believe this na just initial gra grab wey go maintain very so. No be my first market crash be dis so I no dey panic but dis one eh come unexpectedly as others I dey get reverse wey I dey fall back to but this one nothing dey.

Even if Bitcoin fall go $20k the money no dey to buy and na wetin dey make me vex pass be dat. I just dey look BNB if e village people affect am e reach $100 nothing go make me no buy. I fit sell myself self just to buy am. I no know why I believe those people die but my village people useless me last time I miss am, e no go happen again if e fall to my target.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Smartvirus
BTC: bc1q8mvnr3actrxn97v3pxn28tly9yu0yw5mpvxhts

igehhh
USDT (TRC20): TP4kLhXxQwy1MppaSSQPyi2vyeeK1YC83p (TRC20)

Charles-Tim bank account details
GTBank (please, make sure it is Guarantee Trust Bank)
0049732936
PM me (Charles-Tim) if you think the account name is necessary.

Bitcoin
1. Rollbit team: 0.01058000 BTC



USDT (TRC20)
1. posi: 18.57 + 12 (30.57)  USDT
2. Mpamaegbu: $12
3. Anonymous: 300 USDT

Naira
1. Josefjix: 9,900 naira
2. Lordhermes: 6,000 naira
3. nelson4lov: 10,000 naira
4. Charles-Tim: 10,000 naira
5. Igehh: 6,000 naira
6. Gozie51: 5,000 naira

No update. 22nd (this coming Sunday) is the deadline. Two days remaining. Let us be expecting the final update on Monday (23rd) morning.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
This crash done affect me madly, my hopes self for campaign to pay me for my management no come work.  They run me street. Even to post this days no be here. Mehn e come be say na only dis one I get.
Omoh the crash affect me like mad too e get some of bitcoin I suppose tether wey I no tether on time before the crash I just dey thank babGod say I no panic rush go tether during the crash if not I for lose jagajaga I no lie you bro.you see as the forum dey like this sometimes to post dey tire me but when I check wetin dey enter pocket weekly use compare my monthly salary , my monthly sig payment of $200 big pass my fiat salary for now I no lie you so na this motivation I dey use post, women dey too wey man suppose visit one or twice weekly to test weda your tin still dey work. So anyhow ebe make una no lose concentration oooo....
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
Na real matter you talk so o because, no be say we no dey get info on time but, the matter most times dey be say, we no sabi be our brothers keeper. We dey reserve almost everything for our cartel men them and if e con happen say our cartel men no go benefit from the info, we go just short down forgetting say, other people way fit jellof from the matter dey the community too. This one for be benefit to the people way dey active for this our corner and e go make sense as, e fit encourage more participation just the way merit be and clicks for the page.

Charlie, you don dey try since, I dey see am and e go well say, you don clear our eyes and call us to join body make we for carry our people up and e go well. Another thing be say, we gat make sure say, the updates on this one go be relevant one and make we use colour or font decorate am so, e go easy to site tip tap.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
E no go make sense make we get another thread for Altcoin discussion? I just dey suggest ooo so we fit dey talk about altcoins.
The thing go make sense, the reason I created that campaign discussion thread be say I notice we Naija dey miss some campaigns as a result of not applying in time, and as we never get local board, we go just dey get ham for mind to post recent one wey never dey here, e go help others. About altcoin, me self being dey think ham since the last altcoin season, I notice say some of us miss out because say we no get information, and na this forum the best information we can share to dey easily accessible. We should know that any of these kind info are welcome here so far e go help we Naija that dey here.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
(Pidgin) Bounties discussion thread
How e should be
If you know say there is any new signature or bounty (altcoin) campaign posted on this forum, e go make sense to post ham for here with its link so other people among us go see ham easily.
This is a welcome development as information is very vital, wetin you talk make sense I think most of us dey try dey give updates on bounties and sig campaigns for our official telegram group but e go make more sense if we dey talk am here too as most of us node the group. dey current situation for we country no easy so e go make
sense to be our brothers keeper, anywhere you see any good bounty you tell us make others benefit too, and make we try channel help to our Junior members too
E no go make sense make we get another thread for Altcoin discussion? I just dey suggest ooo so we fit dey talk about altcoins.


legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

How e should be
If you know say there is any new signature or bounty (altcoin) campaign posted on this forum, e go make sense to post ham for here with its link so other people among us go see ham easily.

Better idea, me I dey very interested, abeg if una see better bounty make una info me oh, if I see say e go well I fit comot here wey I dey as I don tire for here. That $100 wey dey come ba small money now oh, bills done plenty only my wifi fee self don chop half of all that money talk more or fueling or transportation self and worst part all this rubbish investment just they chop e own share small small.

This crash done affect me madly, my hopes self for campaign to pay me for my management no come work.  They run me street. Even to post this days no be here. Mehn e come be say na only dis one I get.

For donations matter, make una sorry say my name never reflect there but I dey very rough time although I go find some cash give Charles before 22nd end since na d dday. Una well done for una cooperation.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
(Pidgin) Bounties discussion thread

I believe I no need to dey explain waiting bounties be, but I wan make some clarification before I proceed into the real matter, we get two types of bounties on this forum, Bitcointalk. The first one be the one wey we know as signature which participants in the campaign are paid in Bitcoin. The other one na bounties (altcoins) in which participants are paid in altcoins. I dey believe say there go be many signature and altcoin bounties some of us go dey miss due to lack of information, some of us no get the way we can see all bounty posts for this forum without missing some. This na the reason I think we should have this discussion thread which go dey solely for campaigns on this forum.

How e should be
If you know say there is any new signature or bounty (altcoin) campaign posted on this forum, e go make sense to post ham for here with its link so other people among us go see ham easily.

If you know say new participate dey needed for the campaign you dey, you can easily come here to post ham with the link needed. But, this no dey limited to only campaign you dey, if you know any other campaign you know say relevant information never posted here or new participants dey needed, e go better to also post ham here.

There will be discussion of campaigns on this forum for here, discussions like 'how long the campaign fit be', 'reason not to join a certain campaign' and other discussions you know say go dey relevant.

Rules of posting
  • all discussions go be in Pidgin or English, but Pigin dey highly recommended
  • no other discussion other than signature and bounty (altcoin) campaigns on this forum for here. Any campaign wey no dey this forum no dey included
  • strictly following the rules of this forum while posting

Nigeria Local Thread: Naija never get official local thread for this forum, but we dey work to achieve this, and we believe say one day we go get ham, which go dey helpful to get access to more information about cryptocurrencies matters for Naija. But as of now, we get local thread we dey reason together about crypto matter for Naija, you can also be active on the thread. Anything you wan ask, you fit ask ham there if dey related to crypto in Naija or any other related matter. You fit also see something you think go dey benefitial, also go make sense to post ham there. You can use the below link to access our local thread, or go to main page, scroll down, click on 'other languages/locations' and look for our local thread created by Cryptopreneurbrainboss.

Nigeria Local Board {Official language, Pidgin}
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
For we, yes we I no go commot myself, especially the people way be say, we dey campaign con dey chop small small something for here and our name never come up for that list abeg, make e be say, we get time wa we don plan to throwaway the something. Even as e be like that, make we use eye dey watch our time because like this eh, time don dey finish. Na only 3dqys remain like this as deadline na 11:59pm and no be forum time o, our own time. So, make we try comply. All the option of payment way we need don advocate for come board like this. I bin hear bitcoin payment complaints and yet, na only bitcoin payment from Rollbit i don receive since abi na because of them we create that option? Nothing spoil shah so long as, we try drop something.  Na our fellow left behind we dey try help like this becuase, this stage for wife way be say, husband been be major source of chop chop for house and pikin wahala, e no dey easy o.

For una way don drop something, una do well and I clap for una while, for us way never do anything, na small time dey. Make we do as our power carry so, Becky666 anywhere way e dey, e go know say, en people for this side identify with am.

I greet una.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Smartvirus
BTC: bc1q8mvnr3actrxn97v3pxn28tly9yu0yw5mpvxhts

igehhh
USDT (TRC20): TP4kLhXxQwy1MppaSSQPyi2vyeeK1YC83p (TRC20)

Charles-Tim bank account details
GTBank (please, make sure it is Guarantee Trust Bank)
0049732936
PM me (Charles-Tim) if you think the account name is necessary.

Bitcoin
1. Rollbit team: 0.01058000 BTC



USDT (TRC20)
1. posi: 18.57 + 12 (30.57)  USDT
2. Mpamaegbu: $12
3. Anonymous: 300 USDT

Naira
1. Josefjix: 9,900 naira
2. Lordhermes: 6,000 naira
3. nelson4lov: 10,000 naira
4. Charles-Tim: 10,000 naira
5. Igehh: 6,000 naira
6. Gozie51: 5,000 naira

Updated. 22nd (this coming Saturday) is the deadline. Two days remaining. Let us be expecting the final update on Monday (24th) morning.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I read some pages on twitter today where people been dey talk about Elon posting shit posts about bitcoin and manipulating the market price him come talk say Tesla never sell any of the bitcoin wey den been buy even when the thing been dey drop say him still believe in bitcoin.
Elon Musk na clown. His mission na to make bitcoin price fall. The man wey talk say Tesla no go accept Bitcoin again because e too dey consume electricity, saying the coin wey Tesla go accept go dey use less than 1% of bitcoin electricity usage for mining. So he also tweeted later that he is working with Doge develpers to improve system transaction efficiency. Even if Tesla no later accept doge Doge payment, he want people to fomo so they can buy Doge, all his plans is for doge to take the place of Bitcoin.

          

https://mobile.twitter.com/elonmusk

See how the guy lie to the world making them believing Bitcoin consumes more of fossel fuel for energy of which na lie, Bitcoin 74% mining electricity consumption comes from renewable sources which are not fossit fuel.


My people how una dey see the market? Any bullrun go dey before next month?
The market is not easy to predict for now, as Bitcoin increased back, that no mean say the bear market is over, or the $40000 resistance go strong for now. I remember say Bitcoin dey $38000 when Elon Musk bought $1.5 billion worth of bitcoin, very possible the price can be around that level for now. But na just guess o.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Bitcoin fall $10000 dip and hit $10,000 rise the same day

Bitcoin been dey on a long time dip for the past few days now but today get as e be oo e been hit $10k dip and just when people thought it would go down to 28k Bitcoin took them by surprise with another $10k pump in price, this kind thing never happen before, I just dey imagine people wey buy major at $38k dip before the $10k pump, the gain
No be  here too.

I read some pages on twitter today where people been dey talk about Elon posting shit posts about bitcoin and manipulating the market price him come talk say Tesla never sell any of the bitcoin wey den been buy even when the thing been dey drop say him still believe in bitcoin. My people how una dey see the market? Any bullrun go dey before next month?
member
Activity: 672
Merit: 29
Smartvirus
BTC: bc1q8mvnr3actrxn97v3pxn28tly9yu0yw5mpvxhts

igehhh
USDT (TRC20): TP4kLhXxQwy1MppaSSQPyi2vyeeK1YC83p (TRC20)

Charles-Tim bank account details
GTBank (please, make sure it is Guarantee Trust Bank)
0049732936
PM me (Charles-Tim) if you think the account name is necessary.

Bitcoin
1. Rollbit team: 0.01058000 BTC



USDT (TRC20)
1. posi: 18.57 + 12 (30.57)  USDT
2. Mpamaegbu: $12
3. Anonymous: 300 USDT

Naira
1. Josefjix: 9,900 naira
2. Lordhermes: 6,000 naira
3. nelson4lov: 10,000 naira
4. Charles-Tim: 10,000 naira
5. Igehh: 6,000 naira
6. Gozie51: 5,000 naira

Updated. 22nd (this coming Sunday) is the deadline.
Am so much happy for our brothers and sisters wey don contribute so far, it's not easy cos level no pure for all man side. All the same a job well done for people wey in one way or other to raise funds for the burial of our Naija brother. May God bless unah.
At least the money go a long way for the family
Jump to: