Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 251. (Read 1334805 times)

hero member
Activity: 2268
Merit: 579
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
You pipu don make a good point but no bi merit or kudi alone bi the koko and I think we nid to restrategiest carry everybody along no bi level wey someone go carry idea cum and we go delete ham though the idea may no work but the pesin dey try to make contribution and we go first respect hin opinion b4 we move, i dey say dis thin cus I don see someone wey comot 4 dey telegm group bcus of dis and if dey ran ham like dat it no go carry us go anywhere
I dey get your point as I dey read ham, and valid things dey there well well. I believe say kudi may no do it, but the merit things feel work, so far na topics and posts wey worth ham people go merit. This go take time, but e go make good threads dey here wey go let us improve our posting quality for here, posting about Bitcoin and other crypto matter.

Make we post good for here, get merit, telling others to check and join. It may take time, but I believe e go work in a positive feedback manner.

E go make sense if we all still make suggestions, about how we fit get local board.

Note : I bi busy type, I have 2 boys, a wife and other thin wey I have 2 do everyday so I may not involve in d chat as unah expect but I dey read unah talk telegm and for here
I dey get the point too, which means sey some people busy, school work for now self na hard for some of our reputed members here. But, there are times time go dey, the good-post-merit-thing may encourage them to post for local board when they no busy, rather than having time but not posting here because sey here no dey active.
You correct my broda and dey thing bi say make we also follow some broda wey we know say Nah Naija talk about dis thread make dem join the movement but if we won achieve the local our posts numb never reach any.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Some of una really advance for this matter o. To say una sabi navigate or understand all these things them way still dey confuse person. I know say na time be the matter shah but then, this altcoin thing, how person wan carry dey follow am up ecf because, e no easy to fully dey focus on the altcoin them when Bitcoin way be the coco still dey boom.
Anyhow e dey be, una dey try for the hustle and to dey keep this corner heated up. Omo, this campaign thing no easy kwa o, na really push to dey active and I dey feel am now way be say i don join campaign. Na just how to meet up dey my head.
Brother man, na with time you go dey alright. As @Charles-Tim dey always Yan me, Wisdom and learning no dey ever finish. Just try and be learning this thing everyday. Our people talk say "Ant wey stand for him legs fit do wetin elephant no fit do when him lie down."  Consistency is where the whole thing lies.
hero member
Activity: 1036
Merit: 675
Hope people gather BNB and Una dey chop all these small small airdrops wey dey happen for discord?
Btw, who among us Sabi accelerate bitcoin transactions? Sometimes to spend unnecessarily on gas too expensive.
Some of una really advance for this matter o. To say una sabi navigate or understand all these things them way still dey confuse person. I know say na time be the matter shah but then, this altcoin thing, how person wan carry dey follow am up ecf because, e no easy to fully dey focus on the altcoin them when Bitcoin way be the coco still dey boom.
Anyhow e dey be, una dey try for the hustle and to dey keep this corner heated up. Omo, this campaign thing no easy kwa o, na really push to dey active and I dey feel am now way be say i don join campaign. Na just how to meet up dey my head.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
My pipo my pipo. How dey crypto hustle? We are pushing forward for ds btt board. Very soon everything go align for our good for this forum by getting our own board. Am happy see unah lovely post and comment for this local board. Make we keep it up
Chairman how you dey na I never too see you for the area oo you dey the telegram group so? Abeg try join make we yarn wella. The thing be say most of our newbies don give up for the forum maybe dem feel say for the local board nothing dey come out for them to rank up. Most of our pipo dey prefer Oyibo and e no make sense that way...

If una dey expect person to drop topic before una go share awuf give person e no go work, give dem for der comment move.....nodey dey hold person for shirt...russian board sef one comment line you go see like 23merits... All this quality post talk no go work for here as we no get board so.
member
Activity: 672
Merit: 29
My pipo my pipo. How dey crypto hustle? We are pushing forward for ds btt board. Very soon everything go align for our good for this forum by getting our own board. Am happy see unah lovely post and comment for this local board. Make we keep it up
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Hope people gather BNB and Una dey chop all these small small airdrops wey dey happen for discord?
Binance coin dey increase big time recently, but me dey think sey selling go good for now, but no mind my opinion, I am not good in trading that much.

Can you tell me more about the discord airdrop? I no too sabi airdrop things

Sometimes to spend unnecessarily on gas too expensive.
Ethereum and ERC20 tokens dey use gas, but nothing like that dey for bitcoin payment.

Btw, who among us Sabi accelerate bitcoin transactions?
To accelerate Bitcoin transaction, you can make use of free acceleratators but may not work at times, you can try https://www.viabtc.com/tools/txaccelerator, but try to make use of it at early time of an hour because it it can only contain 100 transactions per hour.  You can also make use of it as paid accelerators, https://www.viabtc.com/tools/txaccelerator also provide such service, but not advisable because of expensive fee that will be needed.

So, to know ways to unstuck transaction go make sense. In case of next time, if you dey make use of noncustododial wallet like electrum, you can enable the replace-by-fee. If you pay low fee, you go get the benefit to still be able to pump the fee higher, which will increase the chance of getting the transaction in a block by a miner. But, if na exchanges you dey use, the fee dey high already, and the transaction will be confirmed earlier.

Lastly, as to a question you asked earlier before asking this one above, bitcoin transaction can be 1 minute or even 30 minutes, but the normal algorithm used na to make bitcoin transaction take 10 minutes on average if high fee is used. So, if you pay high fee, expect the transaction confirmed around 10 minutes.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 305
yes
Hope people gather BNB and Una dey chop all these small small airdrops wey dey happen for discord?
Btw, who among us Sabi accelerate bitcoin transactions? Sometimes to spend unnecessarily on gas too expensive.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
You pipu don make a good point but no bi merit or kudi alone bi the koko and I think we nid to restrategiest carry everybody along no bi level wey someone go carry idea cum and we go delete ham though the idea may no work but the pesin dey try to make contribution and we go first respect hin opinion b4 we move, i dey say dis thin cus I don see someone wey comot 4 dey telegm group bcus of dis and if dey ran ham like dat it no go carry us go anywhere
I dey get your point as I dey read ham, and valid things dey there well well. I believe say kudi may no do it, but the merit things feel work, so far na topics and posts wey worth ham people go merit. This go take time, but e go make good threads dey here wey go let us improve our posting quality for here, posting about Bitcoin and other crypto matter.

Make we post good for here, get merit, telling others to check and join. It may take time, but I believe e go work in a positive feedback manner.

E go make sense if we all still make suggestions, about how we fit get local board.

Note : I bi busy type, I have 2 boys, a wife and other thin wey I have 2 do everyday so I may not involve in d chat as unah expect but I dey read unah talk telegm and for here
I dey get the point too, which means sey some people busy, school work for now self na hard for some of our reputed members here. But, there are times time go dey, the good-post-merit-thing may encourage them to post for local board when they no busy, rather than having time but not posting here because sey here no dey active.
hero member
Activity: 2268
Merit: 579
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
@charles wetin you suggest no bad at all too I don check other local board them the way den dey sama merits like water I know say na our merits fit bring pipo come here we don try money no way. I like your suggestion i support you for this motion. If all of us join hands we go Chieve better tins for here
You pipu don make a good point but no bi merit or kudi alone bi the koko and I think we nid to restrategiest carry everybody along no bi level wey someone go carry idea cum and we go delete ham though the idea may no work but the pesin dey try to make contribution and we go first respect hin opinion b4 we move, i dey say dis thin cus I don see someone wey comot 4 dey telegm group bcus of dis and if dey ran ham like dat it no go carry us go anywhere
Note : I bi busy type, I have 2 boys, a wife and other thin wey I have 2 do everyday so I may not involve in d chat as unah expect but I dey read unah talk telegm and for here
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
[igehhh if u believ we(few) can do it dan looking 4 multitudes dat will bring ethnicity into a peaceful home like dis, una dohhhh!
Omo you knw say to survive for here no be beans persin need crowd ooo we nofit do am alone you sabi say after dat our request for meta thymos dey stroll here steady dey check pipo wey been dey agitate for local board, as that post dey like dat him go just wake up comment him observation so at this point we need dis our pipo I no say 100 of dem still dey bounty world dem never know here.... Na only our oga brainboss fit drag dem come here as a manager but how him go take do am??? Na here be the wahala...dose guys want grow if dem see senior men here dem go gum body dey talk here I swear.


Omoh did one don pain you no be small dis one u just dey throwaway curse dem anyhow. Make we easy pressure oh because e get how you go miscap people go find you come your location lol. Anyways shai wee be one here and na weekly me love we go dey show 24/7.
Dem no dey fear Pitakwa boys I go chop their prick Grin baba me just dey para I swear...this your dash dash go make sense ooooh i for like make we do am for our chamber for de other room
full member
Activity: 756
Merit: 231
De tin be big pass Covid ni, dose doctors bad shiaaa dem no go check well b4 dey talk wetin dem see but tank God 4 his mercy. Doctors fit kill pensi nd i just confirm de tin.

Na so one operate my mumssy till today she never dey herself. Many of the university just dey graduate doctor wey sort their way out of School, dem no knows say dem dey put patients at risk of death due to human errors wey all thoes unqualified doctor fit cause.
Am so sorry 4 dat Boss, de tin no be small tin, dey will just dey form sey dem dey ontop of de game until de pensi just collapse, i collapse plenty times b4 dem fit get wat dem need, but tank God am still alive, baba God go heal mumsy IJN Amin. We get doc but dat guy dey smoke wella b4 em even go hospital, imagine if God no dey patient side?, bad result go stew everywhere 4 his patient nd die wit ordinary BP.   

The inactiveness no be lik normal something to me ooo ever since we apply 4 the local board na so so bad luck dey follow us for here, nobody set talk for here again even as I put my own money to give the most active nobody dey talk even all these our newbies wey no dey signature wet suppose use here get activities  point too dey lose guard. Every body just dey denial the group... Mumu wey dey denial him country if u lik claim Russian if u no get the required merit you no go still enter campaigns or rank up...una just dey mumu una self...
My broda igehhh b calming down small-small, life na je-je. dose pensi fit tell deir reasons is just 4 us to mak dem aware dat Home is still better than third class or second class citizen, dey will undastand. Most of dem na old gay/guy Grin nd dem no wan show sey dem be Naija. Also, remember sey our country too na jagajaga(no b me talk am shiaa ooo) since 2017 till now we neva dey hear gud news pass bad ones; i talk lie? NO SIR.
Mak we form our own country hia becus de one wey we have b like cursed 1 alredy nd some pensi follow join dis cursed. igehhh if u believ we(few) can do it dan looking 4 multitudes dat will bring ethnicity into a peaceful home like dis, una dohhhh!
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
De tin be big pass Covid ni, dose doctors bad shiaaa dem no go check well b4 dey talk wetin dem see but tank God 4 his mercy. Doctors fit kill pensi nd i just confirm de tin.

Ah that one no be today thing na but thank God you survive am this country doctors na wah wah for dem. Na so one operate my mumssy till today she never dey herself. Many of the university just dey graduate doctor wey sort their way out of School, dem no knows say dem dey put patients at risk of death due to human errors wey all thoes unqualified doctor fit cause.

The inactiveness no be lik normal something to me ooo ever since we apply 4 the local board na so so bad luck dey follow us for here, nobody set talk for here again even as I put my own money to give the most active nobody dey talk even all these our newbies wey no dey signature wet suppose use here get activities  point too dey lose guard. Every body just dey denial the group... Mumu wey dey denial him country if u lik claim Russian if u no get the required merit you no go still enter campaigns or rank up...una just dey mumu una self...

Omoh did one don pain you no be small dis one u just dey throwaway curse dem anyhow. Make we easy pressure oh because e get how you go miscap people go find you come your location lol. Anyways shai wee be one here and na weekly me love we go dey show 24/7.
full member
Activity: 756
Merit: 231
I greet una hia in de house, e don tail my peeps, no be small tin i battle wit life sickness seriously; i greet everyone for deir concerns nd prayers offered am back again. Mak God save us 4rm any form of sickness becus e no dey gud at-all, again una tank-u for keeping hia busy wit gud tori Cheesy
You survived Covid ni 🤔. Thank God as you show back here like showmax. The thing worry me small sha as we nor hear from you but the beta tory be sey you dey gidigbam now. Welucome back to earth.
De tin be big pass Covid ni, dose doctors bad shiaaa dem no go check well b4 dey talk wetin dem see but tank God 4 his mercy. Doctors fit kill pensi nd i just confirm de tin.

I greet una hia in de house, e don tail my peeps, no be small tin i battle wit life sickness seriously; i greet everyone for deir concerns nd prayers offered am back again. Mak God save us 4rm any form of sickness becus e no dey gud at-all, again una tank-u for keeping hia busy wit gud tori Cheesy
I greet you back my naija brother and you dey very welcomed back for our small corner. As e be now eh, we don shift for you make you seat down with the paddy them. We don dey wonder watin sup for your side since for the telegram level. E con be say, na sickness hold you hand. Sorry and thank God say, you don show back.
Yes oo, i tank God nd una prayers 2 4 me work, una tank-u plenty. I 4 don join de telegram group but my phone wey i dey use 4 dat was stolen, wen i get anoda i will show face abeg.
Quote
My people I hail una o. Mehn, I just fear myself now now oh, Jeez! I no fit believe say e happen like this o. Say person like me don dey 1 full week, no be half but 1 full week, I no talk anything for here... oh mehn,,, I dey fk o. Na waa o, e shock me just now. Make una forgive me abeg, I skip. How e dey happen na, watin dey sup...
Na so em dey be, somtimes de fingers dey pain but just spying hia should be our watch-world as we dey try build our own board. if we go fit make hia busy with topics den we go quick get de heaven we need. At least mak we mak am sey one post or more fit do 4 a week, we tank God sey we are all back again hia.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
@charles wetin you suggest no bad at all too I don check other local board them the way den dey sama merits like water I know say na our merits fit bring pipo come here we don try money no way. I like your suggestion i support you for this motion. If all of us join hands we go Chieve better tins for here
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Baba talk wetin dey your mind make we follow chuck mouth. I no know why here come dey dry like this just when we be don even dey close to get our board..we no fit just dey consistent for once
Waiting I think be say Brainboss get more power to get Naija attention for here, he go make good sense if merit giveaway dey for people wey dey bring quality topics and posts for this local thread. Although having like two merit source for better, but having one can still go a long way which fit make us progress having more merit source later.

Also, another thing wey I think be sey, many people among us no know the Kind topic wey they wan bring come, we should reiterate how the topic should look like until we all dey acquainted to it for here. Some people no even know sey this thread can contain topic. I remember when I search for something online, it took me to one of the topics I don create here on this local thread before. We should see this local thread as a board, it go help.

Also, I think Naija too dey relax, e go make sense if Brainboss concentrate merit on this local thread for Naija pass meriting there posts on other boards. Like as I see ham before, Brainboss they give merit like 99:1, or even the whole 100% to other threads. I mean for the forum, na 99% merits for Naija, and local thread na 1%. Na another reason people no dey concentrate for here.

For other local board, they get active users because they know say merit dey sure for local board, but not to be abused as only quality posts go worth ham. I think if Brainboss reduce the merit to 70:30 go make sense. Although, na Brainboss go comment about this one o, how it will go, na him go talk am how he go be. Mine na just way I think our local board can be achieved.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
<...>
Na true talk be that, but I still dey think we members wey get established account already, also wey dey active here can come up with something. Make we make suggestion as we think ham, me get some suggestions wey dey my mind, but e go make sense if Brainboss dey active for here so he no go miss any information about this suggestions. And people can oppose the suggestions or support, but waiting needed is to make the support or oppose constructive.
Baba talk wetin dey your mind make we follow chuck mouth. I no know why here come dey dry like this just when we be don even dey close to get our board..we no fit just dey consistent for once
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
Na true talk be that, but I still dey think we members wey get established account already, also wey dey active here can come up with something. Make we make suggestion as we think ham, me get some suggestions wey dey my mind, but e go make sense if Brainboss dey active for here so he no go miss any information about this suggestions. And people can oppose the suggestions or support, but waiting needed is to make the support or oppose constructive.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
The inactiveness no be lik normal something to me ooo ever since we apply 4 the local board na so so bad luck dey follow us for here, nobody set talk for here again even as I put my own money to give the most active nobody dey talk even all these our newbies wey no dey signature wet suppose use here get activities  point too dey lose guard. Every body just dey denial the group... Mumu wey dey denial him country if u lik claim Russian if u no get the required merit you no go still enter campaigns or rank up...una just dey mumu una self...
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
Na so, no be waiting we go force, even if we force ham nothing good go come up than not achieving waiting we want. But I dey think of waiting we can do to make Naija dey concentrate for here. Some dey get excuse say their campaign no count local board, and that one no be excuse like that, even if na 3 posts dey get for a week, at least it go count.

Also, I think like you implied as we no dey cooperate, we need to change this about us. Naija for this forum need to dey work together.

But, we wey dey active for here now, waiting we suggest go make this thread active? Because I know there would be ways this thread go dey active.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

No bi lie, me self done tayah, only 2 or 3 people no go fit do am alone. I remember when I dey very active here but the discouragement come dey show face small small na e make I no come dey active again but I like wetin I dey sweet here.

Make una try I go show face too also incase of next time make we no go rush apply again na collective decision and we all gas agree to am. When the thread down reach like 100 pages na e we go fit get say. I don do my research them and also thread get to dey look like we need broad to separate our discussion since e don dey congested.

Na small small mbahhh turn goat, make we just dey take am easy, no rushing if God say e go happen we just dey one dey here say Oga theymos don reason our matter.
Jump to: