Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 250. (Read 1032746 times)

hero member
Activity: 2268
Merit: 579
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@charles wetin you suggest no bad at all too I don check other local board them the way den dey sama merits like water I know say na our merits fit bring pipo come here we don try money no way. I like your suggestion i support you for this motion. If all of us join hands we go Chieve better tins for here
You pipu don make a good point but no bi merit or kudi alone bi the koko and I think we nid to restrategiest carry everybody along no bi level wey someone go carry idea cum and we go delete ham though the idea may no work but the pesin dey try to make contribution and we go first respect hin opinion b4 we move, i dey say dis thin cus I don see someone wey comot 4 dey telegm group bcus of dis and if dey ran ham like dat it no go carry us go anywhere
Note : I bi busy type, I have 2 boys, a wife and other thin wey I have 2 do everyday so I may not involve in d chat as unah expect but I dey read unah talk telegm and for here
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
[igehhh if u believ we(few) can do it dan looking 4 multitudes dat will bring ethnicity into a peaceful home like dis, una dohhhh!
Omo you knw say to survive for here no be beans persin need crowd ooo we nofit do am alone you sabi say after dat our request for meta thymos dey stroll here steady dey check pipo wey been dey agitate for local board, as that post dey like dat him go just wake up comment him observation so at this point we need dis our pipo I no say 100 of dem still dey bounty world dem never know here.... Na only our oga brainboss fit drag dem come here as a manager but how him go take do am??? Na here be the wahala...dose guys want grow if dem see senior men here dem go gum body dey talk here I swear.


Omoh did one don pain you no be small dis one u just dey throwaway curse dem anyhow. Make we easy pressure oh because e get how you go miscap people go find you come your location lol. Anyways shai wee be one here and na weekly me love we go dey show 24/7.
Dem no dey fear Pitakwa boys I go chop their prick Grin baba me just dey para I swear...this your dash dash go make sense ooooh i for like make we do am for our chamber for de other room
full member
Activity: 756
Merit: 231
De tin be big pass Covid ni, dose doctors bad shiaaa dem no go check well b4 dey talk wetin dem see but tank God 4 his mercy. Doctors fit kill pensi nd i just confirm de tin.

Na so one operate my mumssy till today she never dey herself. Many of the university just dey graduate doctor wey sort their way out of School, dem no knows say dem dey put patients at risk of death due to human errors wey all thoes unqualified doctor fit cause.
Am so sorry 4 dat Boss, de tin no be small tin, dey will just dey form sey dem dey ontop of de game until de pensi just collapse, i collapse plenty times b4 dem fit get wat dem need, but tank God am still alive, baba God go heal mumsy IJN Amin. We get doc but dat guy dey smoke wella b4 em even go hospital, imagine if God no dey patient side?, bad result go stew everywhere 4 his patient nd die wit ordinary BP.   

The inactiveness no be lik normal something to me ooo ever since we apply 4 the local board na so so bad luck dey follow us for here, nobody set talk for here again even as I put my own money to give the most active nobody dey talk even all these our newbies wey no dey signature wet suppose use here get activities  point too dey lose guard. Every body just dey denial the group... Mumu wey dey denial him country if u lik claim Russian if u no get the required merit you no go still enter campaigns or rank up...una just dey mumu una self...
My broda igehhh b calming down small-small, life na je-je. dose pensi fit tell deir reasons is just 4 us to mak dem aware dat Home is still better than third class or second class citizen, dey will undastand. Most of dem na old gay/guy Grin nd dem no wan show sey dem be Naija. Also, remember sey our country too na jagajaga(no b me talk am shiaa ooo) since 2017 till now we neva dey hear gud news pass bad ones; i talk lie? NO SIR.
Mak we form our own country hia becus de one wey we have b like cursed 1 alredy nd some pensi follow join dis cursed. igehhh if u believ we(few) can do it dan looking 4 multitudes dat will bring ethnicity into a peaceful home like dis, una dohhhh!
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
De tin be big pass Covid ni, dose doctors bad shiaaa dem no go check well b4 dey talk wetin dem see but tank God 4 his mercy. Doctors fit kill pensi nd i just confirm de tin.

Ah that one no be today thing na but thank God you survive am this country doctors na wah wah for dem. Na so one operate my mumssy till today she never dey herself. Many of the university just dey graduate doctor wey sort their way out of School, dem no knows say dem dey put patients at risk of death due to human errors wey all thoes unqualified doctor fit cause.

The inactiveness no be lik normal something to me ooo ever since we apply 4 the local board na so so bad luck dey follow us for here, nobody set talk for here again even as I put my own money to give the most active nobody dey talk even all these our newbies wey no dey signature wet suppose use here get activities  point too dey lose guard. Every body just dey denial the group... Mumu wey dey denial him country if u lik claim Russian if u no get the required merit you no go still enter campaigns or rank up...una just dey mumu una self...

Omoh did one don pain you no be small dis one u just dey throwaway curse dem anyhow. Make we easy pressure oh because e get how you go miscap people go find you come your location lol. Anyways shai wee be one here and na weekly me love we go dey show 24/7.
full member
Activity: 756
Merit: 231
I greet una hia in de house, e don tail my peeps, no be small tin i battle wit life sickness seriously; i greet everyone for deir concerns nd prayers offered am back again. Mak God save us 4rm any form of sickness becus e no dey gud at-all, again una tank-u for keeping hia busy wit gud tori Cheesy
You survived Covid ni 🤔. Thank God as you show back here like showmax. The thing worry me small sha as we nor hear from you but the beta tory be sey you dey gidigbam now. Welucome back to earth.
De tin be big pass Covid ni, dose doctors bad shiaaa dem no go check well b4 dey talk wetin dem see but tank God 4 his mercy. Doctors fit kill pensi nd i just confirm de tin.

I greet una hia in de house, e don tail my peeps, no be small tin i battle wit life sickness seriously; i greet everyone for deir concerns nd prayers offered am back again. Mak God save us 4rm any form of sickness becus e no dey gud at-all, again una tank-u for keeping hia busy wit gud tori Cheesy
I greet you back my naija brother and you dey very welcomed back for our small corner. As e be now eh, we don shift for you make you seat down with the paddy them. We don dey wonder watin sup for your side since for the telegram level. E con be say, na sickness hold you hand. Sorry and thank God say, you don show back.
Yes oo, i tank God nd una prayers 2 4 me work, una tank-u plenty. I 4 don join de telegram group but my phone wey i dey use 4 dat was stolen, wen i get anoda i will show face abeg.
Quote
My people I hail una o. Mehn, I just fear myself now now oh, Jeez! I no fit believe say e happen like this o. Say person like me don dey 1 full week, no be half but 1 full week, I no talk anything for here... oh mehn,,, I dey fk o. Na waa o, e shock me just now. Make una forgive me abeg, I skip. How e dey happen na, watin dey sup...
Na so em dey be, somtimes de fingers dey pain but just spying hia should be our watch-world as we dey try build our own board. if we go fit make hia busy with topics den we go quick get de heaven we need. At least mak we mak am sey one post or more fit do 4 a week, we tank God sey we are all back again hia.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
@charles wetin you suggest no bad at all too I don check other local board them the way den dey sama merits like water I know say na our merits fit bring pipo come here we don try money no way. I like your suggestion i support you for this motion. If all of us join hands we go Chieve better tins for here
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Baba talk wetin dey your mind make we follow chuck mouth. I no know why here come dey dry like this just when we be don even dey close to get our board..we no fit just dey consistent for once
Waiting I think be say Brainboss get more power to get Naija attention for here, he go make good sense if merit giveaway dey for people wey dey bring quality topics and posts for this local thread. Although having like two merit source for better, but having one can still go a long way which fit make us progress having more merit source later.

Also, another thing wey I think be sey, many people among us no know the Kind topic wey they wan bring come, we should reiterate how the topic should look like until we all dey acquainted to it for here. Some people no even know sey this thread can contain topic. I remember when I search for something online, it took me to one of the topics I don create here on this local thread before. We should see this local thread as a board, it go help.

Also, I think Naija too dey relax, e go make sense if Brainboss concentrate merit on this local thread for Naija pass meriting there posts on other boards. Like as I see ham before, Brainboss they give merit like 99:1, or even the whole 100% to other threads. I mean for the forum, na 99% merits for Naija, and local thread na 1%. Na another reason people no dey concentrate for here.

For other local board, they get active users because they know say merit dey sure for local board, but not to be abused as only quality posts go worth ham. I think if Brainboss reduce the merit to 70:30 go make sense. Although, na Brainboss go comment about this one o, how it will go, na him go talk am how he go be. Mine na just way I think our local board can be achieved.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
<...>
Na true talk be that, but I still dey think we members wey get established account already, also wey dey active here can come up with something. Make we make suggestion as we think ham, me get some suggestions wey dey my mind, but e go make sense if Brainboss dey active for here so he no go miss any information about this suggestions. And people can oppose the suggestions or support, but waiting needed is to make the support or oppose constructive.
Baba talk wetin dey your mind make we follow chuck mouth. I no know why here come dey dry like this just when we be don even dey close to get our board..we no fit just dey consistent for once
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
Na true talk be that, but I still dey think we members wey get established account already, also wey dey active here can come up with something. Make we make suggestion as we think ham, me get some suggestions wey dey my mind, but e go make sense if Brainboss dey active for here so he no go miss any information about this suggestions. And people can oppose the suggestions or support, but waiting needed is to make the support or oppose constructive.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
The inactiveness no be lik normal something to me ooo ever since we apply 4 the local board na so so bad luck dey follow us for here, nobody set talk for here again even as I put my own money to give the most active nobody dey talk even all these our newbies wey no dey signature wet suppose use here get activities  point too dey lose guard. Every body just dey denial the group... Mumu wey dey denial him country if u lik claim Russian if u no get the required merit you no go still enter campaigns or rank up...una just dey mumu una self...
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
Na so, no be waiting we go force, even if we force ham nothing good go come up than not achieving waiting we want. But I dey think of waiting we can do to make Naija dey concentrate for here. Some dey get excuse say their campaign no count local board, and that one no be excuse like that, even if na 3 posts dey get for a week, at least it go count.

Also, I think like you implied as we no dey cooperate, we need to change this about us. Naija for this forum need to dey work together.

But, we wey dey active for here now, waiting we suggest go make this thread active? Because I know there would be ways this thread go dey active.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

No bi lie, me self done tayah, only 2 or 3 people no go fit do am alone. I remember when I dey very active here but the discouragement come dey show face small small na e make I no come dey active again but I like wetin I dey sweet here.

Make una try I go show face too also incase of next time make we no go rush apply again na collective decision and we all gas agree to am. When the thread down reach like 100 pages na e we go fit get say. I don do my research them and also thread get to dey look like we need broad to separate our discussion since e don dey congested.

Na small small mbahhh turn goat, make we just dey take am easy, no rushing if God say e go happen we just dey one dey here say Oga theymos don reason our matter.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
My people I hail una o. Mehn, I just fear myself now now oh, Jeez! I no fit believe say e happen like this o. Say person like me don dey 1 full week, no be half but 1 full week, I no talk anything for here... oh mehn,,, I dey fk o. Na waa o, e shock me just now. Make una forgive me abeg, I skip. How e dey happen na, watin dey sup...
The thing be say we Naija no dey dedicated to achieve a local baord for now. you self still dey try, and happy say you leave here for a week and accept say make others no vex, nobody go vex because say you still dey try if I no go lie. But we Naija need to try improve and post quality posts and increase the rate of posting for local thread, this go really help us achieve local board. As the fact for now, we dey far from having local board o. You are welcome back, I hope say I go dey see you around.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
I greet una hia in de house, e don tail my peeps, no be small tin i battle wit life sickness seriously; i greet everyone for deir concerns nd prayers offered am back again. Mak God save us 4rm any form of sickness becus e no dey gud at-all, again una tank-u for keeping hia busy wit gud tori Cheesy
I greet you back my naija brother and you dey very welcomed back for our small corner. As e be now eh, we don shift for you make you seat down with the paddy them. We don dey wonder watin sup for your side since for the telegram level. E con be say, na sickness hold you hand. Sorry and thank God say, you don show back.

My people I hail una o. Mehn, I just fear myself now now oh, Jeez! I no fit believe say e happen like this o. Say person like me don dey 1 full week, no be half but 1 full week, I no talk anything for here... oh mehn,,, I dey fk o. Na waa o, e shock me just now. Make una forgive me abeg, I skip. How e dey happen na, watin dey sup...
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
<...>
Waiting we know be say nothing can stop bitcoin, if CBN no gree, nothing go stop people to use p2p, p2p will also count too. Just make I talk about it directly, the CBN no know how the banks are benefiting from direct bank-crypto transactions, having no valid reason cryptocurrencies should be banned for the country. But, see the transactions from fiat to bitcoin alone, this is a very high amount.

I go like if you include the link so we can read about it in details.
Check coinmetrics.io you go see the statistics and e get plenty things you go read too edey helpfull somehow. When you dey failed state no dey too expect oo
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
I greet una hia in de house, e don tail my peeps, no be small tin i battle wit life sickness seriously; i greet everyone for deir concerns nd prayers offered am back again. Mak God save us 4rm any form of sickness becus e no dey gud at-all, again una tank-u for keeping hia busy wit gud tori Cheesy
You survived Covid ni 🤔. Thank God as you show back here like showmax. The thing worry me small sha as we nor hear from you but the beta tory be sey you dey gidigbam now. Welucome back to earth.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
So on average how much were person fit expect as return?
Like I have illustrated above, it depends on:

  • Deferential price
  • Accumulated fee gain


To understand more about it, you will really need to read the link I posted above, especially the one I post below again

https://pintail.medium.com/uniswap-a-good-deal-for-liquidity-providers-104c0b6816f2

But, to make it more understandable, if you stake ethereum and the price of ether increase, that means you are gaining already, but the main gain is from the accumulated fee, which is a certain gain that is fixed in percentage that you would have known before staking at all, but if the price of ethereum decrease, it will let the gain from the accumulated fee gain to decrease, and it can be to the extent it will take all the gain and also reduce the worth of your stake in dollars.

If you can stake little amount of money (I am not sure), you can try it out for you to understand it practically.
jr. member
Activity: 155
Merit: 7
The dream God is what I embody
Abeg e get anybody here were de provide liquidity poo
Nobody here can provide liquidity pool, only some kind of decentralized exchanges like Uniswap can provide liquidity pool in a way no need to make use of exchange order book which can lead to high transaction fee, this is common in exchanges that rely on gas fee in order to minimize the fee. Instead of such decentralized exchanges to rely on order book which will make the fee high, they rely on already deposited funds into smart contract as a form of pool which buyers can rely on for low fee.

I been think say risk no de for staking LP
Liquidity provider (LP) tokens, these are the tokens on Dex (decentralized exchanges) that are staked, these tokens are ETH and ERC20. Everything about cryptocurrencies are risky, but the risk can lead to potential gain or loss. Let me use some examples to illustrate:

Assuming you staked when ethereum price is $1000, and the price of ethereum decreases over time. Very possible for the LP to lose if his gain from the accumulated fee profit is not more than the amount lost from the price decrease of ethereum.

Assuming the LP have staked for some months and have gained from accumulated fee, if the price of ethereum decreased, he can lose. But later if the price increase back to the staked price ($1000), his gain will be from the stake profit from the accumulated fee.

But if there is a great fall of ethereum price, that means LP is losing already, if the loss is more than the gain from accumulated fee.

Which means the profit or loss depends on the accumulated fee gain and price deferential.

You can read this to know more about it:
https://pintail.medium.com/uniswap-a-good-deal-for-liquidity-providers-104c0b6816f2
https://uniswap.org/docs/v2/advanced-topics/understanding-returns/

I been ask unto say I been want gather more info...
So on average how much were person fit expect as return?
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
<...>
Waiting we know be say nothing can stop bitcoin, if CBN no gree, nothing go stop people to use p2p, p2p will also count too. Just make I talk about it directly, the CBN no know how the banks are benefiting from direct bank-crypto transactions, having no valid reason cryptocurrencies should be banned for the country. But, see the transactions from fiat to bitcoin alone, this is a very high amount.

I go like if you include the link so we can read about it in details.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
$4 Trillion Worth Of Bitcoin Transferred across The Globe Without Banks nor The Government

My pipo dis na de amount pipo don transfer bitcoin including u cos u too, u don transfer as ur hand reach so we add ur money kwa to dat one, I try put am for Naira my phone screen nearly go blank. Shebi now una don see why d government dey fight bitcoin for everywhere cos de little choppings wey bank dey give dem from transfer charges nodey too come as before again all de fees dey go miners hand now. And dos miners na pipo lik us nobe government so na wetin dey pain dem for mind be dat. As e be lik dis so bitcoin don gooo moon.
Jump to: