Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 37. (Read 998825 times)

hero member
Activity: 1064
Merit: 501
I greet everyone  This evening. Guys end of the year don they reach and we a grateful for a year it's been, but still a lot can still happen for us and knowledge dem talk sey e be power.

Although this year hasn't been the best year for Crypto-currency. Things just they move from one dip to another we understand sey the market Dey volatile so we no go give us. That said I one know which coin una Dey hopeful on right now as the market Dey low and with reason make we exchange knowledge.

I go with Dogecoin. As we all know Dogecoin has had relationship with Elon musk wen him throw weight for them. Now he is in the news again with his acquisition of Twitter and the aftermath to come, I believe Dogecoin go collect some PR from this.
Make this year pass abegy. This year no be wetin peso need to talk about crypto. Anyway, thank God for keeping us alive despite all the ups and down of our crypto investment gone wrong. We need to thank for all that.

Anything like investment na till next year for my side. Make peso absorb the shock of luna finish till em go begin to the reason of another crypto investment to invest. Dogecoin go go well to invest sha, my eyes d on am. Make we see how em go be sha.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
The year never end yet but, we don dey very close to cross over so, I go like say thank God for the many protections way e dey give us and we never see even as we dey try dulge some of the wahala way for find us come kwa. Inside all these close to 2023 and thank God,I go still say, make we still look our front and back and dey slow in this time. Now na time way people dey like deu rush to meet up plenty and to make area soft but, this rush dey bring people close to wahala.  Make we try slow down eh... make life no end.

Mean while @BIT-BENDER, this altcoin matter eh, e always get as e dey be. No be lie say, Musk dry Dogecoin back and inside all these katakata bear market, Dogecoin still try do well small. If you look am for coin market, e push front ahead of the likes of Solana and Polkadot. That was encouraging but, I no realy see how Musk buying twitter go really be added advantage.  Musk don deu talk from yomeabd nothing go really change from the things e don talk except, e go place embargo on other promotions of other projects which is very unlikely.
legendary
Activity: 854
Merit: 1246
I greet everyone  This evening. Guys end of the year don they reach and we a grateful for a year it's been, but still a lot can still happen for us and knowledge dem talk sey e be power.

Although this year hasn't been the best year for Crypto-currency. Things just they move from one dip to another we understand sey the market Dey volatile so we no go give us. That said I one know which coin una Dey hopeful on right now as the market Dey low and with reason make we exchange knowledge.

I go with Dogecoin. As we all know Dogecoin has had relationship with Elon musk wen him throw weight for them. Now he is in the news again with his acquisition of Twitter and the aftermath to come, I believe Dogecoin go collect some PR from this.
Yes. God has power over everything and everyone, nothing go happen, everyone go enter next year and enjoy the bull market. Dem say experience is di original teacher.

Although, na dis year I really involved myself in cryptocurrency, and enter wen do market was 42$ nd as of March be dat. Nd from April nai di market just dey come down till now, tai!! Di small experience wey I don get for dis crypto world e no dey easy at all. Di coins I bought now no way to sell nd hungry wan kill pesin here.

Well Dogecoin is also good but one thing I came to understand is that bitcoin in any how im come down nai still dey high pass in di crypto world. 1 Dogecoin even in dis bear market of Bitcoin can't compare to 1 BTC.
member
Activity: 742
Merit: 30
I greet everyone  This evening. Guys end of the year don they reach and we a grateful for a year it's been, but still a lot can still happen for us and knowledge dem talk sey e be power.

Although this year hasn't been the best year for Crypto-currency. Things just they move from one dip to another we understand sey the market Dey volatile so we no go give us. That said I one know which coin una Dey hopeful on right now as the market Dey low and with reason make we exchange knowledge.
You no lie sir, dis year get as e be especially cryptocurrency wise. We just de move 4rm one bad news to another and crypto market no wan de stable so te some people dey give up for d crypto self, because d kin orientation wey we get be say d market go beta before d year end, but as we de see am now na maybe till next year again oo, I hope say e go beta next year.



Quote
I go with Dogecoin. As we all know Dogecoin has had relationship with Elon musk wen him throw weight for them. Now he is in the news again with his acquisition of Twitter and the aftermath to come, I believe Dogecoin go collect some PR from this.
I de wounder which coin self person go fit buy, as u mentioned dogecoin I get small hope say una go share us some good analysis on some kind coins wey we fit use dis bear market opportunity buy so dat we go enjoy d gain leta.
Maybe our senior men dem go reason and provide us good knowledge and analysis make we use dem make our decisions to buy our coins.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Although this year hasn't been the best year for Crypto-currency. Things just they move from one dip to another we understand sey the market Dey volatile so we no go give us. That said I one know which coin una Dey hopeful on right now as the market Dey low and with reason make we exchange knowledge.

God this year was my worst year in cryptocurency and yes I was around the last bear market in 2018 bit not as heavily invested as I was this year. You know wetin pain me pass, I know say the bear go come so was prepared but as things look now, belike na fake preparations I do because I dey heavily at lost and no be chaise. All the monitoring I do nothing come out, you see before the Luna crash na when me enta back market heavily and I dey already 80% down. Well that one na small challenges as we go smile again.

As we dey world cup season, my eye been dey look ALGORAND say e go do well as dem sign partnership deals with FIFA but e come dey look like say nothing come out as that coin dun fall massively. Well aside Bitcoin I think BNB for be good pick as now dem dun take over full control of the exchange market as their second in command dun fall down wey be FTX.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
I go with Dogecoin. As we all know Dogecoin has had relationship with Elon musk wen him throw weight for them. Now he is in the news again with his acquisition of Twitter and the aftermath to come, I believe Dogecoin go collect some PR from this.

This thing wey you talk now na wetin I bin reason one of my colleagues fod work place today. Elon na person wey fit do anything anytime and na lover of dodge coin. As me and you reason am, e mean say plenty people don reason am for the industry too. Me no be lover of altcoins though, but the risk make sense to take.
But my question now be say, shebi the target na next bull run, abi you think say Elon go fit push dodge to bull even when bull time never reach?
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
I greet everyone  This evening. Guys end of the year don they reach and we a grateful for a year it's been, but still a lot can still happen for us and knowledge dem talk sey e be power.

Although this year hasn't been the best year for Crypto-currency. Things just they move from one dip to another we understand sey the market Dey volatile so we no go give us. That said I one know which coin una Dey hopeful on right now as the market Dey low and with reason make we exchange knowledge.

I go with Dogecoin. As we all know Dogecoin has had relationship with Elon musk wen him throw weight for them. Now he is in the news again with his acquisition of Twitter and the aftermath to come, I believe Dogecoin go collect some PR from this.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I don't think, such thing will happen again come 2023, because the U.S government has given a sound warning to Nigeria leaders who used to come to their country to do business
Bros I beg no dey talk like say u no dey this country na USA won come stop this desperate politicians dem not to rig election, is like u dey forget say rigging of election na only wetin Nigeria don dey practice since no be free and fair election. USA just dey talk make e b say as world power them talk.

Even me too deh shocked when Zanab247 talk that thing say America go intervene for our election. That one no fit happen because America too know wetin sovereignty means. Except during war that they can rush in, without that every country deh respect the other sovereignty o. The highest thing weh America fit do na to send election observers and then write bad report if them think say e no go well free and fair. Our election na our own. We no supposed slack or rely on America or any foreign bodies to help us control bad leadership in Naija.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Quote


Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something shou
I don't think, such thing will happen again come 2023, because the U.S government has given a sound warning to Nigeria leaders who used to come to their country to do business
Bros I beg no dey talk like say u no dey this country na USA won come stop this desperate politicians dem not to rig election, is like u dey forget say rigging of election na only wetin Nigeria don dey practice since no be free and fair election. USA just dey talk make e b say as world power them talk.

Previous elections US no dey send observes come the country to observed election why dem no stop the mago mago then na now story for the gods. These our leaders na same people na e still dey there and because of greed na e make dem go still rig this election, if dem don bribe INEC wetin remain no be for INEC to come announce say na free,fair and credible election. All this yan wet INEC and US dey talk na for facility but I for happy if say na true.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Wetin happen don teach us one very important lesson again say, "one person, company nor suppose get too much power so tey e fit influence, affect or impact the whole industry and world either negatively or positively". I just dey wonder whether say at any time the CEO of this Nestcoin ever feel say this kind thing go fit happen to their investment. Make una shook mouth for the matter.

Dem no get sense, make dem use people wey dey cryptocurency join body so dem go dey give dem advise  but no na just so so professional wey no get any experience for crypto dem go dey use. Anybody wey dey cryptocurency for a very long time know say exchange aren't to be trusted, even as big as binace dey self, no keep your money for their exchange or use any of their investment products as if your money dey d exchange and e go down. Them fit just run away and nothing you go fit do. The industry dey unregulated and only few with the right information they wins this guys for court when something like this happen.

Make we just dey careful as this effect never do anything yet. I see plenty project going down soon and all go be because of this FTX issues. You see projects like Solana, FTX been get plenty hand for the project and we dun dey see already the project dey take a major hit as this thing happen. E go take God for that project not to go down. I just dey pity those wey go lose their jobs because of this.
The matter don tie rapper oooo, as e dey be so many things are getting effected by this whole FTX crisis more than what we thought the result of the crisis will be from the beginning, so many business will still face a lot from tho whole FTX crisis, but losing jobs at this point is very unfortunate for the project employees. One thing I will like us to understand is that, losing money in the cryptocurrency space are an unavoidable thing, we all must lose something at some point since the cryptocurrency industry is new and a lot need to be learned. The only thing we can do is to try as much as possible to minimize our risk level by holding our assets in a private wallet and never trusting any third party to the point of leaving large amounts of our money with them. And also we need to be more calculating in our approach to investment and we should also take all cryptocurrency projects aside from Bitcoin as none custodial investments since the project CEO or regulators' decisions can affect everything at whatever point without the investors having the chance to do anything about their money.
full member
Activity: 1274
Merit: 175
Catalog Websites
Quote
As we take the talk about   FXT matter make we no forget sae we get upcoming election for d country next year.

My brother and sister abegy make una look into the face of this children, make una check weda dey born them 1992






Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
I don't think, such thing will happen again come 2023, because the U.S government has given a sound warning to Nigeria leaders who used to come to their country to relax or do other business to far away from magomago in dis general election, that anyone find in general election ringing will be ban from their country and their family too. With dis warning, I believe INEC will not allow underage voting to happen in the North because there are many things dey will use to expose underage in dis general election 4 Nigeria citizens vote to count for future purpose.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
INEC don accept dia fault, as they don talk, we must continue to d help them. Go through the register, make claims and objections via our observation.


This is good but the timing the very short. Make we help validate the registered people as fast as possible
E no mata weda dem realize their mistakes or not, the question is will their be an absence of rigging? Even when INEC say them go punish doz involved in the registration of the under aged candidates, e go take a lot to ensure a free and fair election.
Watin me I go like talk b say, eida rigging or not, at least, dem don identify nd accept d wahala way dey d system as d complain com up. Watin we go hope b say, mak e no end 4 dere. At least dem gats punish dis pipo, giv dem wahala way go discourage future practices of dis manner.

Dem no dey use 1day solve dis kind mata way don sink deep inside we countri. So long as we beliv say e go better nd we no jst fold hand sey wait for d better to com, dat dey enouf to chnge smal tins till e go sure. Mak we jst hope say, votes try count 4 dis election nd we go see  som chnge.
legendary
Activity: 854
Merit: 1246
INEC don accept dia fault, as they don talk, we must continue to d help them. Go through the register, make claims and objections via our observation.
(Snip di image)

This is good but the timing the very short. Make we help validate the registered people as fast as possible
I don't want to tok about Political issues again because I was called by name because of Political discussions. But let me put mouth on dis issue.
INEC is always be an INEC, me as a political scientist/Political Economist. Nigeria Government and INEC can't deceive me anymore. Di problem we dey face in 9ja e dey cause my 3 major personalities. The police, the court and INEC, but in these few years back (Like 3 or 4 years back) INEC is getting better but not really okay. Make we see what dey can do 2023. If court nd police dey do their best well in the country naija for don better since. Di Nigerian citizens are trying their best to make sure that Nigeria beta but the court and police dey frustrating di efforts of the citizens. Once dis two institutions are destroy and restructure dem back then Nigeria go better.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
INEC don accept dia fault, as they don talk, we must continue to d help them. Go through the register, make claims and objections via our observation.



This is good but the timing the very short. Make we help validate the registered people as fast as possible
E no mata weda dem realize their mistakes or not, the question is will their be an absence of rigging? Even when INEC say them go punish doz involved in the registration of the under aged candidates, e go take a lot to ensure a free and fair election. 
 INEC don say dem go still make use of BVAS wey fit help check if PVC dey valid but I feel say if we politicians wan play dia mago mago, e go still happen.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
INEC don accept dia fault, as they don talk, we must continue to d help them. Go through the register, make claims and objections via our observation.



This is good but the timing the very short. Make we help validate the registered people as fast as possible
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
This election go rugged oh because manipulation go choke due some of the aspirants they desperate for that position people like Asiwaju wey talk say na him turn to rule

Pa Yekini Amoda Bola Tinubu sabi say Nigeria na cruise and nobody deh ready to tackle any corruption na him make am still deh struggle to enter Aso Rock. If not that one wetin concern man weh him hands and legs deh shake for election. Nothing about Tinubu weh deh genuine, from his fake name to schools he said he attended. Nothing at all.

God abeg  see faces and date of birth wey they put for them the thing no match at all, and if you look this matter now na from north na were problem they always they be that them they always they easy to manipulate due to high poverty make we see waiting go happen next year sha.

Na north all that one come from and na so them use am against Jonathan for 2015 election and Jonathan no fit talk. But wetin deh vex me be as no politician from other regions want probe and condemn that thing. All of them just deh keep quiet and things deh bad go.
The number of illiteracy plenty for their plus poverty once their educational system and poverty level is addressed problem go they be that and north will always be a problem because as it is now and does guys are very populated because if you look during election na were vote they plenty pass north na always problem if government wan address issue of insecurity na to start  from north na were most of our problems they be that make prayer remain for this country.
member
Activity: 421
Merit: 47

E go hard INEC and any other any of the state to do mago-mago for this election because the youths don swear to put body. Imagine the number of underage voters that were discovered today in Kano and the number that will be discovered in the coming weeks. People don start to dey study the voters register like textbook already. Exciting times ahead.

Nothing like go hard for inec lol; it has always been easy for inec to rig elections in nigeria; they have it confidently too easy; na why i happy as dem de suffer those asuu professor because na their idea and na them dem de us rig the election

I see one review for twitter today; e say for kano, same day election 1.5m personn vote for presidential candidate; while that same day only about 850k people vote for senate and house of rep; where inec see additional 700k vote from for presidential voteS?

The only thing wey fii stop inec for this presidential na our political elites in the senate and house of reps; put pressure on inec to invalidate all multiple and fake registration. on top of that shey u sabi the bigges gist? dem say inec de do home delivery of voters card up north; and we de suffer down south to even get hands on the cards hahaha
member
Activity: 742
Merit: 30


Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
Na dis underage voting dem de use rig election especially 4 villages wey be say some INEC officials no fit do anything. Wetting de vex me now be say, even as e don de publicize say dis kind tin de happen Government suppose do something to stop d printing of dos kin PVCs wey neva reach 18, but dem go print am because na dere d wuruwuru de come from. Make we de hope say dem go do something about dis mata.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
Underage voting they happen for Nigeria well well, e no start today and you fit find am for every zone for Nigeria, but the thing be say the thing they too predominant for the Northern geopolitical zone, them too they register people wey never reach the legal age to vote, the thing they very bad as children go begin learn corrupt practices at a very young age, come imagine when them begin to grow up; quite a lot has to be done to stop this, i no know if INEC officials are being threatened into registering underage voters, or if they are doing it because them wan do am, but whichever it is ehn, this is 2022, Naija don suppose find way eradicate this kind nonsense from our electoral system.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
Dis tin no sopoz look new to you na. Haba, abi you no be naija brot up? Nah during the time of election you see the greatest kind of comedy and unseriousness. This one small na, during our dear bubu time, no be goats and cows wey dem use add number?
 Anoda tin wey dey off me na say doz officers wey dey count the number of votes, why machine no fit do am? Dis we contri corrupt level, nah only God go save us.
Pages:
Jump to: