Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 39. (Read 1337222 times)

full member
Activity: 1414
Merit: 236
Catalog Websites
Quote
As we take the talk about   FXT matter make we no forget sae we get upcoming election for d country next year.

My brother and sister abegy make una look into the face of this children, make una check weda dey born them 1992






Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
I don't think, such thing will happen again come 2023, because the U.S government has given a sound warning to Nigeria leaders who used to come to their country to relax or do other business to far away from magomago in dis general election, that anyone find in general election ringing will be ban from their country and their family too. With dis warning, I believe INEC will not allow underage voting to happen in the North because there are many things dey will use to expose underage in dis general election 4 Nigeria citizens vote to count for future purpose.
hero member
Activity: 1036
Merit: 675
INEC don accept dia fault, as they don talk, we must continue to d help them. Go through the register, make claims and objections via our observation.


This is good but the timing the very short. Make we help validate the registered people as fast as possible
E no mata weda dem realize their mistakes or not, the question is will their be an absence of rigging? Even when INEC say them go punish doz involved in the registration of the under aged candidates, e go take a lot to ensure a free and fair election.
Watin me I go like talk b say, eida rigging or not, at least, dem don identify nd accept d wahala way dey d system as d complain com up. Watin we go hope b say, mak e no end 4 dere. At least dem gats punish dis pipo, giv dem wahala way go discourage future practices of dis manner.

Dem no dey use 1day solve dis kind mata way don sink deep inside we countri. So long as we beliv say e go better nd we no jst fold hand sey wait for d better to com, dat dey enouf to chnge smal tins till e go sure. Mak we jst hope say, votes try count 4 dis election nd we go see  som chnge.
legendary
Activity: 1106
Merit: 1372
INEC don accept dia fault, as they don talk, we must continue to d help them. Go through the register, make claims and objections via our observation.
(Snip di image)

This is good but the timing the very short. Make we help validate the registered people as fast as possible
I don't want to tok about Political issues again because I was called by name because of Political discussions. But let me put mouth on dis issue.
INEC is always be an INEC, me as a political scientist/Political Economist. Nigeria Government and INEC can't deceive me anymore. Di problem we dey face in 9ja e dey cause my 3 major personalities. The police, the court and INEC, but in these few years back (Like 3 or 4 years back) INEC is getting better but not really okay. Make we see what dey can do 2023. If court nd police dey do their best well in the country naija for don better since. Di Nigerian citizens are trying their best to make sure that Nigeria beta but the court and police dey frustrating di efforts of the citizens. Once dis two institutions are destroy and restructure dem back then Nigeria go better.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
INEC don accept dia fault, as they don talk, we must continue to d help them. Go through the register, make claims and objections via our observation.



This is good but the timing the very short. Make we help validate the registered people as fast as possible
E no mata weda dem realize their mistakes or not, the question is will their be an absence of rigging? Even when INEC say them go punish doz involved in the registration of the under aged candidates, e go take a lot to ensure a free and fair election. 
 INEC don say dem go still make use of BVAS wey fit help check if PVC dey valid but I feel say if we politicians wan play dia mago mago, e go still happen.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
INEC don accept dia fault, as they don talk, we must continue to d help them. Go through the register, make claims and objections via our observation.



This is good but the timing the very short. Make we help validate the registered people as fast as possible
sr. member
Activity: 966
Merit: 391
Underestimate- nothing
This election go rugged oh because manipulation go choke due some of the aspirants they desperate for that position people like Asiwaju wey talk say na him turn to rule

Pa Yekini Amoda Bola Tinubu sabi say Nigeria na cruise and nobody deh ready to tackle any corruption na him make am still deh struggle to enter Aso Rock. If not that one wetin concern man weh him hands and legs deh shake for election. Nothing about Tinubu weh deh genuine, from his fake name to schools he said he attended. Nothing at all.

God abeg  see faces and date of birth wey they put for them the thing no match at all, and if you look this matter now na from north na were problem they always they be that them they always they easy to manipulate due to high poverty make we see waiting go happen next year sha.

Na north all that one come from and na so them use am against Jonathan for 2015 election and Jonathan no fit talk. But wetin deh vex me be as no politician from other regions want probe and condemn that thing. All of them just deh keep quiet and things deh bad go.
The number of illiteracy plenty for their plus poverty once their educational system and poverty level is addressed problem go they be that and north will always be a problem because as it is now and does guys are very populated because if you look during election na were vote they plenty pass north na always problem if government wan address issue of insecurity na to start  from north na were most of our problems they be that make prayer remain for this country.
member
Activity: 421
Merit: 47

E go hard INEC and any other any of the state to do mago-mago for this election because the youths don swear to put body. Imagine the number of underage voters that were discovered today in Kano and the number that will be discovered in the coming weeks. People don start to dey study the voters register like textbook already. Exciting times ahead.

Nothing like go hard for inec lol; it has always been easy for inec to rig elections in nigeria; they have it confidently too easy; na why i happy as dem de suffer those asuu professor because na their idea and na them dem de us rig the election

I see one review for twitter today; e say for kano, same day election 1.5m personn vote for presidential candidate; while that same day only about 850k people vote for senate and house of rep; where inec see additional 700k vote from for presidential voteS?

The only thing wey fii stop inec for this presidential na our political elites in the senate and house of reps; put pressure on inec to invalidate all multiple and fake registration. on top of that shey u sabi the bigges gist? dem say inec de do home delivery of voters card up north; and we de suffer down south to even get hands on the cards hahaha
member
Activity: 742
Merit: 30


Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
Na dis underage voting dem de use rig election especially 4 villages wey be say some INEC officials no fit do anything. Wetting de vex me now be say, even as e don de publicize say dis kind tin de happen Government suppose do something to stop d printing of dos kin PVCs wey neva reach 18, but dem go print am because na dere d wuruwuru de come from. Make we de hope say dem go do something about dis mata.
legendary
Activity: 2184
Merit: 1302
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
Underage voting they happen for Nigeria well well, e no start today and you fit find am for every zone for Nigeria, but the thing be say the thing they too predominant for the Northern geopolitical zone, them too they register people wey never reach the legal age to vote, the thing they very bad as children go begin learn corrupt practices at a very young age, come imagine when them begin to grow up; quite a lot has to be done to stop this, i no know if INEC officials are being threatened into registering underage voters, or if they are doing it because them wan do am, but whichever it is ehn, this is 2022, Naija don suppose find way eradicate this kind nonsense from our electoral system.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
Dis tin no sopoz look new to you na. Haba, abi you no be naija brot up? Nah during the time of election you see the greatest kind of comedy and unseriousness. This one small na, during our dear bubu time, no be goats and cows wey dem use add number?
 Anoda tin wey dey off me na say doz officers wey dey count the number of votes, why machine no fit do am? Dis we contri corrupt level, nah only God go save us.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
I no kmw where u cari dis data frm bt, na reali INEC work 2 luk into dis illegal registration nd call both d agents and parent way carri out dis registration to order. Fine dem or tak some drastic majors.
E go hard INEC and any other any of the state to do mago-mago for this election because the youths don swear to put body. Imagine the number of underage voters that were discovered today in Kano and the number that will be discovered in the coming weeks. People don start to dey study the voters register like textbook already. Exciting times ahead.
hero member
Activity: 1036
Merit: 675
My brother and sister abegy make una look into the face of this children, make una check weda dey born them 1992

Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
Hahahahahaha, notin way we no go see 4 dis we countri o. No b new tin shah nd as funi as e b, no b mata 2 tak play shah. Na so dem dey do nd dem don start again.

I no kmw where u cari dis data frm bt, na reali INEC work 2 luk into dis illegal registration nd call both d agents and parent way carri out dis registration to order. Fine dem or tak some drastic majors.
No be onli dose people way dey kidnap nd kill pipo be enemy of d state o, dese pipo way dey do dis kind tin follow kwa. We dey try decide d futur of our countri 4 d nxt 4yrs nd dis at dey block road.
hero member
Activity: 1162
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
The matter of under age voting don dey tey tey, na the hand work of the people wey dey live for the Northern part of the country. One thing with INEC be say, the version of INEC wey dey for North different from the ones wey dey the South. For this voters register wey just conclude you go realise say millions of voters dey disqualified from the South part of the country but very small from the North. Day time robbery dey happen.


Abeg, make we try deh help ourselves for this our one thread. Those images wey stack wey Marykeller post, almost 4 people don quote the images full the thread. If you wan comment you fit cut the image commot make here for dey make sense for us.
full member
Activity: 980
Merit: 237
That ur idea is also gud but we are saying Port Harcourt because Lagos State is already congested with population and businesses, now we are trying to create another mega world class city in Nigeria. So bringing it to Port Harcourt is a gud idea. Abuja is already a capital of the country, Lagos is already well known capital city in the world Port Harcourt is a developing city in Nigeria so let place it there so that North - South, West - East can easily assess it.
I will want Boss to also poll this option after this present poll to know the location of the Bitcoin village. Brainboss you can create a poll for this matter after this present poll that is going on.
Nice spot for PH go make sense. It will sure redefine commerce and drive entrepreneurship. Although there is no saying how Lagos will take this, seeing there are tech companies with headquarters there. If there are criteria on deciding this, then it should include the aforementioned with regards to security inclusive.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
This election go rugged oh because manipulation go choke due some of the aspirants they desperate for that position people like Asiwaju wey talk say na him turn to rule

Pa Yekini Amoda Bola Tinubu sabi say Nigeria na cruise and nobody deh ready to tackle any corruption na him make am still deh struggle to enter Aso Rock. If not that one wetin concern man weh him hands and legs deh shake for election. Nothing about Tinubu weh deh genuine, from his fake name to schools he said he attended. Nothing at all.

God abeg  see faces and date of birth wey they put for them the thing no match at all, and if you look this matter now na from north na were problem they always they be that them they always they easy to manipulate due to high poverty make we see waiting go happen next year sha.

Na north all that one come from and na so them use am against Jonathan for 2015 election and Jonathan no fit talk. But wetin deh vex me be as no politician from other regions want probe and condemn that thing. All of them just deh keep quiet and things deh bad go.
sr. member
Activity: 966
Merit: 391
Underestimate- nothing
As we take the talk about   FXT matter make we no forget sae we get upcoming election for d country next year.

My brother and sister abegy make una look into the face of this children, make una check weda dey born them 1992






Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
This election go rugged oh because manipulation go choke due some of the aspirants they desperate for that position people like Asiwaju wey talk say na him turn to rule, God abeg  see faces and date of birth wey they put for them the thing no match at all, and if you look this matter now na from north na were problem they always they be that them they  always they easy to manipulate due to high poverty make we see waiting go happen next year sha.
hero member
Activity: 1008
Merit: 702
As we take the talk about   FXT matter make we no forget sae we get upcoming election for d country next year.

My brother and sister abegy make una look into the face of this children, make una check weda dey born them 1992

Dis one don dey happen for long because even me too I don see am happen long time ago, I think 2011 elections wey young boys wey I sabi there age dey do voters card for them and dey cast their votes. Young boys like dis that know nothing about politics are easily lured to be bribed and na dem dey easily fall for am because of wetin d society don turn too now, young boys dat don’t know their left from right fa. Make INEC do their part well make dem no allow all dis kind tin dey happen for transparent elections to happen.
hero member
Activity: 896
Merit: 586
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
As we take the talk about   FXT matter make we no forget sae we get upcoming election for d country next year.

My brother and sister abegy make una look into the face of this children, make una check weda dey born them 1992






Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
Why e b say na Naija tins na e different from other pple own,which country u don't see children dey cast their votes for election meaning say Naija dey take our right wet b election for child's play. All did tinz dey happen bcos say na wayo wayo politicians and criminal na e dey involve for our political platform.

I no just fit know when dis nonsense won stop becos e don tire me,this gang of thieves wey call dem self politician no just give us chance to benefit from our citizen rights instead them dey mess with our future.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
As we take the talk about   FXT matter make we no forget sae we get upcoming election for d country next year.

My brother and sister abegy make una look into the face of this children, make una check weda dey born them 1992






I no just understand why our countri like to joke over serious matter, e just be like say nah advert we want do next year instead of election wey go make us choose who go help us change this madness wey dy happen for our country.

Nah every time we go dy see all these things? Why Dem no fit just forget about to do mago mago make we face the future?
Abeg make e no be say nah new born small pikin wey we go see for PVC next oh...
My brothers and sisters maleria just hold me for this Yama yam I see wey dem call PVC...
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
As we take the talk about   FXT matter make we no forget sae we get upcoming election for d country next year.

My brother and sister abegy make una look into the face of this children, make una check weda dey born them 1992






Na this kind underage voting wey we go see again for 2023 election?. Something should be done to stop all this woroworo wey INEC d do from North. This kind thing no d acceptable this time macha
omo this we country na really cruise oo. Notin wey no dey possible for this we country. Just imagine the picture of 1992 and 1993 voters wey Nigeria dey show us. The act has been going on with the election process in Nigeria for a  long time now and nothing has been done in other to tackle this nonsense.. People boldly come out as they like and lie to we Nigerians on different sector of the country concerning things we ourselves can vividly see its a lie.

Omo owna go see drama na, for this upcoming election for this country
Pages:
Jump to: