Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 40. (Read 1013002 times)

hero member
Activity: 686
Merit: 987
Give all before death
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤
You no say if you talk of any thing for Naija now the first thing people go reason na security. Nobody wan go place wey you go dey run dey fall or sharp guys go just collect you wototo. But the yarn now bi say no area for Naija dey safe. Make we say Lagos dey sef but apart from people wey go enter plane, omo kidnappers full road. And Lagos dey too polluted and overcrowded. But if na for infrastructures and other menemenes, gidis come board. Rivers State for make sense because our governor like show and him for fit sponsor the conference so that him fit show him new dance step and the state get good roads but soot don caste the ama. Cross River State na the place I go like make the conference hold. Na true say the present government don gbolo the state but in terms of cleanliness and welcoming environment the place make sense. No forget say bitcoin dey move towards clean and green energy and Calabar go really fit that target. And all the single people like Oluwa-btc wey come for the conference go fit get wife for Calabar Grin.  
member
Activity: 742
Merit: 30


Wetin happen don teach us one very important lesson again say, "one person, company nor suppose get too much power so tey e fit influence, affect or impact the whole industry and world either negatively or positively". I just dey wonder whether say at any time the CEO of this Nestcoin ever feel say this kind thing go fit happen to their investment. Make una shook mouth for the matter.

Me and u know say d way crypto dey dump e no de tell any bodi, but I reason am say why den go do dat kind big investment for just FTX? Dem for split their capital for plenty stable coins because I believe Dem see wetin Luna do last time and now FTX. Make d CEO take heart, but him suppose know how e de be for crypto, but as him wan sack some staffs na I'm be d koko. I been see post for Beginners board wey talk say make we no fully rely on cryptocurrency, and na true, make we sha de very careful because dis market now me I no understand am.


FTX downfall na sometin wey neva dey expected, even d CEO himself no go eva imagine say dis tin go sup afta how big dey don grow for cryptocurrency world and their assets at ground. Nestcoin themself would neva imagine dis could happen to dem too, but dis will serve as a lesson dat nothing is beyond falling if cautious is not well taken. I sympathize with dos staffs dat will lose their job as a result of dis, it is not easy in naija and losing a job at a critical time like dis is very painful. Dis na lesson wey we don learn from all and go dey more careful further in dis cryptocurrency world.
Na so e d happen, but I expect say as a big company wey don grow well, dem no suppose put all investment for only FTX because of wetin happen to Luna. Dis kind tings dey come unexpected and I de sure say e go take d company plenty time to recover because d market self no d move wella.
legendary
Activity: 854
Merit: 1246
Nigerian crypto startup, Nestcoin, will lay off workers after losing assets to FTX crash
The whole FTX issue don touch everybody for the crypto world whether directly or indirect. As I read now, this Nigerian crypto company, Nestcoin go drop some of their staff sake of say the company put plenty of their stablecoin investment for the FTX Exchange and as e be now e go dey easy to collect yam from goat mouth than for them to recover their money. See the summary of the gist for bullet point.

  • Last year, Nestcoin raised capital from a range of investors, including Alameda Research. For context, Alameda’s equity is less than 1%. We used the closely-associated exchange, FTX, as a custodian to store a significant proportion of the stablecoin investment we raised – 1.e. Our day-to-day operational budget.
  • However, last week’s events have had an impact on us, as we held our assets (cash and stablecoins) at FTX to manage our operational expenses. We were not undertaking any trading, but simply custodied our assets on the FTX exchange.
  • While there are uncertainties including the outcome of our assets held at FTX, we as a company have to adjust our plans, rethink our strategy and take steps to better position ourselves for the future. Unfortunately, this means saying goodbye to some of our very talented Nesters

Wetin happen don teach us one very important lesson again say, "one person, company nor suppose get too much power so tey e fit influence, affect or impact the whole industry and world either negatively or positively". I just dey wonder whether say at any time the CEO of this Nestcoin ever feel say this kind thing go fit happen to their investment. Make una shook mouth for the matter.

Day is how di business chain always be. One company's disaster affect other ones. What to happen FXT e no supposed affect Nestcoin company if di management was good. Because Nestcoin supposed know dat crypto ecosystem system is not stable so dealing with such have to be careful but they were negligent of the ecosystem. Remember those of us dat did not invest were not affected but if binance fold up then it would affect us so with this knowledge of losing out funds or coin have created di second alternative to move all our coins from exchange platforms to wallet. Even binance I don't trust them, Ramitano is some how preferable. What Happened in the industry should be a good guide to us.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
FTX downfall na sometin wey neva dey expected, even d CEO himself no go eva imagine say dis tin go sup afta how big dey don grow for cryptocurrency world and their assets at ground. Nestcoin themself would neva imagine dis could happen to dem too, but dis will serve as a lesson dat nothing is beyond falling if cautious is not well taken. I sympathize with dos staffs dat will lose their job as a result of dis, it is not easy in naija and losing a job at a critical time like dis is very painful. Dis na lesson wey we don learn from all and go dey more careful further in dis cryptocurrency world.

Why FTX CEO no go expect wetin happen to him. Hope say you don read one or two sagas wey don play as the cause of the bankruptcy. When exchange big and the fund wey dey flow in the exchange also big, the CEOs dey always forget say na people money. Because dem go wake up see plenty money wey dey their fund dem go think say na their own and begin to use it anyhow. This Oyibo people too take risk and dem too like competition sha.
But one thing I know is that the CEO no fall with FTX, na only FTX and investors lose. The young guy go start up something else with another person identity and e go still blossom.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nigerian crypto startup, Nestcoin, will lay off workers after losing assets to FTX crash

Wetin happen don teach us one very important lesson again say, "one person, company nor suppose get too much power so tey e fit influence, affect or impact the whole industry and world either negatively or positively". I just dey wonder whether say at any time the CEO of this Nestcoin ever feel say this kind thing go fit happen to their investment.
I don follow up this FTX saga for some time now, and i feel so sorry for those wey their money dey trapped in, mostly the CEO of Nestcoin, as at this moment.
E no also dey easy to survive with salary these days, and to come lose the salary work without  other means of getting cash is the worst.  To the staff wey lose their jobs, maybe na even bliss in disguise, because if them understand the crypto means of trade and investments, and other opportunities wet dey involved, then they will survive while waiting for another job.
This FTX crash na big thing e spoil for the crypto space o becos e come make cryptocurrency price come down since pple dey fear dey sell their coins and some pple own even crash with FTX. Those pple were lose their coins for this crash na dem I pity for pass come join this hardship. I know think say the CEO of NestCoin know say this kind thing go happen if not e for don withdraw all their asset who go see fire go put hand inside?

Imagine where d crash go affect na pple job becos funds don lose somebody must pay the price by loosing e job. This crash I go say e come add more suffer to the hardship for crypto users,how did pple wey NestCoin won lay off to take start their life again with good job for this naija wey to get work na India film. Make God help all of us say we no go be victim to any problem to go affect our financial source.
full member
Activity: 882
Merit: 207
Nigerian crypto startup, Nestcoin, will lay off workers after losing assets to FTX crash

Wetin happen don teach us one very important lesson again say, "one person, company nor suppose get too much power so tey e fit influence, affect or impact the whole industry and world either negatively or positively". I just dey wonder whether say at any time the CEO of this Nestcoin ever feel say this kind thing go fit happen to their investment.
I don follow up this FTX saga for some time now, and i feel so sorry for those wey their money dey trapped in, mostly the CEO of Nestcoin, as at this moment.
E no also dey easy to survive with salary these days, and to come lose the salary work without  other means of getting cash is the worst.  To the staff wey lose their jobs, maybe na even bliss in disguise, because if them understand the crypto means of trade and investments, and other opportunities wet dey involved, then they will survive while waiting for another job.
full member
Activity: 1274
Merit: 175
Catalog Websites
Quote
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤
D topic make sense well well, I guess Lagos state will be d best 4 Bitcoin village because is the Most developed State that occupied the highest industries in Nigeria.  Nigeria are 100% capable to host Africa Bitcoin conference in Nigeria becos dey have many people who are exposed in crypto some years ago, and they will have something good to offer to people in Africa so that Africa can also enjoy what other countries are enjoying from Bitcoin.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
FTX downfall na sometin wey neva dey expected, even d CEO himself no go eva imagine say dis tin go sup afta how big dey don grow for cryptocurrency world and their assets at ground. Nestcoin themself would neva imagine dis could happen to dem too, but dis will serve as a lesson dat nothing is beyond falling if cautious is not well taken. I sympathize with dos staffs dat will lose their job as a result of dis, it is not easy in naija and losing a job at a critical time like dis is very painful. Dis na lesson wey we don learn from all and go dey more careful further in dis cryptocurrency world.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Nigerian crypto startup, Nestcoin, will lay off workers after losing assets to FTX crash
The whole FTX issue don touch everybody for the crypto world whether directly or indirect. As I read now, this Nigerian crypto company, Nestcoin go drop some of their staff sake of say the company put plenty of their stablecoin investment for the FTX Exchange and as e be now e go dey easy to collect yam from goat mouth than for them to recover their money. See the summary of the gist for bullet point.

  • Last year, Nestcoin raised capital from a range of investors, including Alameda Research. For context, Alameda’s equity is less than 1%. We used the closely-associated exchange, FTX, as a custodian to store a significant proportion of the stablecoin investment we raised – 1.e. Our day-to-day operational budget.
  • However, last week’s events have had an impact on us, as we held our assets (cash and stablecoins) at FTX to manage our operational expenses. We were not undertaking any trading, but simply custodied our assets on the FTX exchange.
  • While there are uncertainties including the outcome of our assets held at FTX, we as a company have to adjust our plans, rethink our strategy and take steps to better position ourselves for the future. Unfortunately, this means saying goodbye to some of our very talented Nesters

Wetin happen don teach us one very important lesson again say, "one person, company nor suppose get too much power so tey e fit influence, affect or impact the whole industry and world either negatively or positively". I just dey wonder whether say at any time the CEO of this Nestcoin ever feel say this kind thing go fit happen to their investment. Make una shook mouth for the matter.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Before posting this, I have messaged and obtained permission from the able moderator, Crypto Brainboss who was very kind and sympathetic to my condition.

Don't mistake this for an endorsement of this appeal, this is a open thread and I can't restrict what is been posted here neither I can stop anybody from trying to ask for financial help even though it's prohibited on the forum. You can try and if the community is or isn't okay and they come to a collective decision to ignore or help you so be the case. For users not okay with posts like this and aren't comfortable asking for it to be deleted openly then you can use the report opportunity for moderators to do the needful. Like I always say, we all be hustlers here. If you get problem no expect anything from anybody and try utilized the opportunity the forum dun offer to hustle your own.

Thanks for the suggestions. For me, I go personally suggest Calabar. That city too sweet, clean, quiet, and powerful serenity. I believe Calabar is heavily under utilized. I don't know much about internet access there though.

Calabar been also dey my mind to mention but e no dey as exposed as Port Harcourt. Calabar get their own kind doing wey no dey like place wey fit this discussion wey we dey on although na just my own opinion. I think to get the full value of this we go need place wey dey already active in the crypto businesses and so far after those other states wey I mentioned na PH be next best option.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Yeah ph better pass lag e no too good to carry am go their as you talk already ABJ go well e dey very accessible than lag issues. Although ph city too na very busy area for companies and d tin a very calm and cool place just like ABJ but no land there as well to build a crypto city so laslas na ph get space to build that kind of tin.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤
That will be lovely I swear the thing go make sense but choosing Lagos  nah I been do small research on El Salvador bitcoin beach omo the place no bad oh I tell you, Nigeria is gaining lots of ground on crypto currency’s we self suppose run am oh, running it we suppose avoid any kind wahala from Nigeria government, I see boss they suggest pH  Grin make we bring am come north he go sweet for their or rather make we vote towns wey people done suggest make we drop vote smiles.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤
Em get thoughts wey d come for mind when dem wan do a bitcoin village in a state. They start by how lovely state be and how accommodating em go be for visitors wey wan show for the state. We all fit choose Lagos, but we don consider how noisy and holdup's wey full for Lagos road, na all visitors go fit accept and enjoy am?

I support wetin our brother Agbe talk. Na PH sure pass due to how lovely the state be. The place d good for lookout, visitors no go experience katata for road, noise free, everywhere for state d friendly and accommodating compare to Lagos state. By the way, PH don host and organize so many crypto seminars for the state, and people all over the world show on board for the state.

If there is anything like bitcoin Village go happen in the future, na for PH em go land
member
Activity: 163
Merit: 65
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤

Guys Lagos dey too congested and somehow localish to become our Bitcoin village, if this na something wey the government dey endorse then I go say make e be Abuja, Abuja dey look like place we go easily get development if Nigeria wan tune maga citys with mighty structures as dem Dubai dem etc. But if na wetin d government no dey support and na men wan run am demselves then make dem come use PH. Port Harcourt dey very convenient as after Lagos for tech kind of things I think na Port Harcourt be next. Like since Lagos dun dey conquered already any tech related businesses dey like find their way come PH since na dem be oga for this south south side.

And make dem no worry Wike go help fight the government for them If them gree give am him own share lol. And if na land to use build a whole Bitcoin village from scratch like wetin Akon been dey try do to him home country, dat one no be issue lands full PH die. I just dey wonder why real estate companies never come take better full advantage of this opportunity. I just dey wait for when Port Harcourt go open like lagos because the potential dey there.

Thanks for the suggestions. For me, I go personally suggest Calabar. That city too sweet, clean, quiet, and powerful serenity. I believe Calabar is heavily under utilized. I don't know much about internet access there though.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤

Guys Lagos dey too congested and somehow localish to become our Bitcoin village, if this na something wey the government dey endorse then I go say make e be Abuja, Abuja dey look like place we go easily get development if Nigeria wan tune maga citys with mighty structures as dem Dubai dem etc. But if na wetin d government no dey support and na men wan run am demselves then make dem come use PH. Port Harcourt dey very convenient as after Lagos for tech kind of things I think na Port Harcourt be next. Like since Lagos dun dey conquered already any tech related businesses dey like find their way come PH since na dem be oga for this south south side.

And make dem no worry Wike go help fight the government for them If them gree give am him own share lol. And if na land to use build a whole Bitcoin village from scratch like wetin Akon been dey try do to him home country, dat one no be issue lands full PH die. I just dey wonder why real estate companies never come take better full advantage of this opportunity. I just dey wait for when Port Harcourt go open like lagos because the potential dey there.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤

Dis one no be matter to reason na broda. Na Lagos go be d main hub for dis kind event to take place. If no be Lagos where e go come be again for dis naija. I know say e fit boom for oda states like PH and Abuja but na Lagos be the sure place for dis. Lagos no be small name for Africa o, and anybody wey plan come and na Lagos dem arrange am ba, e go anticipate to participate more. Naija na big name for Africa, Lagos come be and a big city for Africa.
As far as I know, Lagos already has a high population density and at that Lagos no go make sense for Bitcoin hubs since we will need a good environmental climate with a low population and cooler weather since we know that Bitcoin activities that will be taking place in the such environment include and not limited to mining and we all know how the proof of stake Bitcoin mining machines generate a lot of heat and this may not be suitable for a highly populated place like Bitcoin.
I don't think Nigeria have any suitable city for a Bitcoin hub unless some Bitcoin activities will not be taking place in such cities, and one of the major factors that will limit Bitcoin city in Nigeria is the unstable electricity supply.
Based on weather climate issues and heat wey normally Bitcoin mining na something wey no really dey friendly to the environment as far as depletion and green environment is concern, and on top all of these over population na one Lagos problem again , so @wiwo  me I agree with ur argument u bring.

And I go like to add say place like Bayelsa no go be a bad place based on the criteria aligned above.cause normally bayelsa no get population, and the environment alone fit withstand Bitcoin mining impact based on the fresh and green natural ambient wey surround am both in waters and land. As for security ,me I believe say any where wey any government wan security and electricity to dey it go dey cos government na government and nobody big pass am.

Make we no dey always jam-pack development for  one place na wetin  make NAIJA never fit develop widely and talking of decentralization wey one core tin wey  Bitcoin is known for.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤
For dis kind matter na Rivers or  Delta nai go gud.. creating Bitcoin city in naija na better thing, let it be dat di major city go be Rivers den all di states go get their branches. Just like phone villages in all di states. Make im be like dat. So dat everybody go dey do things in their various Bitcoin villages but major events go dey do am 4 main city which is Rivers State. Na so me I see am. Though everyone get their own side of di matter, but Rivers nai gud well.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
This our broken don dey sweet me wella, na em be de only thing wey dey tell me say na our board be this.

Na so e supposed be my brother. Our own na our own. Them own na them own. Na why a Chinese no fit twist mouth say him want to follow you speak English. Na you go force yourself to understand am by the time weh him begin speak him chichayoou chanyou.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Quote
Are you in support of a monthly merit reward for the top contributors of this thread?
12 people don contribute so far and all vote in favour. E make sense.
I for like make this kind of poll dem wey be say external people hit the thread their eyes go fast catch, we for dey put am for our pigin.

Something like this;
You support say make merit dey follow people wey their hand clap pass for this thread every month?

This our broken don dey sweet me wella, na em be de only thing wey dey tell me say na our board be this. Apart from the pigin, another thing na the names of these Polithiefians we dey mention here. Especially those old ones wey don dey contest since when I dey 2years.
legendary
Activity: 854
Merit: 1246
TOPIC: WHICH STATE GO DEY BEST FOR BITCOIN VILLAGE ( HUB )4 WE 9JA AND WHY ?

 Fvck! I raise this topic one time like that, but d e be like e no make Sense bah ? Me say make I bring am up again. I done see the Elsalvador Bitcoin City and e sexy cum still sharp, still done read bout UK Dem make arrangements for them own tooo.
I know say many people choose Lagos Tor! But make we try reason am sha, weh be say if Bitcoin Conference wan go on for Africa Nigeria fit dey capable of the organization and coordination. Make we put mouth caprison.   Make we dey on Guard at all times, avoid trouble at all cost Ornah Merry Christmas in advance.   Cheesy🖤
We dey do Nigeria meeting here and u dey speak oyinbo r us " Fvck" abe enai aguke reyo (take ur time). Well di best state to adopt as BTC village in Nigeria is PH. And di reason be say, Lagos is already commercial city with different businesses and activities. And we need another place to be a commencial city and also, there criteria that needed to a BTC village, and such, steady light, Strong network. Etc and pH have all dis things, so pH go sure pass. There should be division of wealth location, we should not keep everything in one place.

pH has good hotels to even host local Bitcoin conference before the mega.
Pages:
Jump to: