Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 43. (Read 1016467 times)

hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
Petrol can't sell lower than 510naira: NNPC

NNPC don yarn sae petrol can't sell lower than 510naira. They no fit continue with 170naira price again.
Link to information: https://gazettengr.com/petrol-cant-sell-lower-than-n510-nnpc/
Quote
The Nigerian National Petroleum Company Limited has revealed that premium motor spirit (petrol) cannot sell lower than N510 per litre as the President Muhammadu Buhari regime gears towards the phase-out of the fuel subsidy era.
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo

They done start again we are producing oil but look at the price we are buying fuel this government is just after to ruin us how them go sell fuel for us 500 naira, anything wey affect fuel price to everything go start cost, the thing done tire me I swear now wey Christmas done near they want to start drama, the thing they pain me, see the way line for fuel long for every were some people done already hide fuel for their filling station as the thing done cost they go start sell abeg na life be this.
As the country be like dis the only way forward na for all man to make sure say him get PVC cos all this talk we dey talk here go only be like sounds of empty komkom wey d make noise if all man no even get PVC to use make choice of the kind of leaders we need for we country.
Sometimes it dey baffle me as some people wey dey suffer under this same government na still Dem d support th e same government for another election 2023. Some other group of persons get this mentality say your vote no go count so no need to go out go vote , but the question be say if your vote, my vote, our vote no go count, then why politicians the lobby to buy electorate their voter's card? Na because them know say our vote get power in numbers and it count but them no want us to know this secret.

Abeg this country situation if it really don tire u as it tire me, then join body com out for election day at least make we try our best vote better people put for we government make tins for get better small.
See bag of rice price, see fuel price abi na gas own we want talk about or na transportation abi na the unemployment rate.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
Petrol can't sell lower than 510naira: NNPC

NNPC don yarn sae petrol can't sell lower than 510naira. They no fit continue with 170naira price again.
Link to information: https://gazettengr.com/petrol-cant-sell-lower-than-n510-nnpc/
Quote
The Nigerian National Petroleum Company Limited has revealed that premium motor spirit (petrol) cannot sell lower than N510 per litre as the President Muhammadu Buhari regime gears towards the phase-out of the fuel subsidy era.
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo

This our oga bubu sef funi o. How e go say dis increment go help solve economic problem? As Dec don dey near, tins don dey go up. Why him no dis wan since or abi nah now wey naira start to climb?
 When dis we govt go bring up idea wey go make sense sef?🤔 In the space of one month, Dem introduce e-naira and rebranding of currency. How all dis ones go help the economy grow? This go just make the poor masses suffer.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo

Nothing dey surprise me for dis naija again, everything just dey hike dey go and cost of living no dey favourable to the local man hustling to just survive and not to gather riches like dem top politicians. Na dem get the money and na dem dey regulate everything and na dem go still dey enjoy the result of it. As e be now, na prayers we just need to dey do now, I hope say my fatherland go better one day with or without me been alive then to witness it.

We gats dey alive to witness the positive change our country go get in the future.
I went to ABA last week Friday from port Harcourt, meh I wept and I come dey hear say the governor of Abia dey use the money dey faji widows, asin he dey run package with widows
I tire oo and didn't say a word in the bus but you should know that there is an atom of truth in every lies an rumors.
Most times we citizens no dey even ask for much but good road and power supply even if say we go pay no issues.
I just hope the Almighty Creator forgive us our transgressions and come to our aids
hero member
Activity: 910
Merit: 686
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo

Nothing dey surprise me for dis naija again, everything just dey hike dey go and cost of living no dey favourable to the local man hustling to just survive and not to gather riches like dem top politicians. Na dem get the money and na dem dey regulate everything and na dem go still dey enjoy the result of it. As e be now, na prayers we just need to dey do now, I hope say my fatherland go better one day with or without me been alive then to witness it.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
I only used forum rank for first and second place. BTW, that was the only month we had two members with the same post count in first and second place. Isn't that a reasonable criterion?

What of if the two weh come first come be the same rank, wetin them go take differentiate them?

As for the discussion on reward, poll dun dey up as usual for everyone to cast their vote while staying anonymous. E belike people no wan contribute as e go belike dem be bad belle if dem no support the motion so to make things easier, make we see where the majority stand.

Am not sure na the reason of who them support go make them no vote there. After all shebi two people voted the shaky shaky hand man of agbado kingdom with poisoned holy communion. The thing go fit be say people no deh aware say poll deh up there. So e go good to they remind members from time to time like this weh you do am now. Thank you.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Bola Tinubu make promise to Nigerians to provide 1million jobs in his first tenure,
Make nobody deceive u oo. U know how many jobs Buhari promised wen im been dey come. All  dis toks na to deceive us. All job promise Buhari made. No one job was implemented.

Brainboss Tinubu still dey 4 di poll again...me I no understand the Tinubu part oo
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I only used forum rank for first and second place. BTW, that was the only month we had two members with the same post count in first and second place. Isn't that a reasonable criterion?

Nope e goes well, I just wan make e clear make everyone knows how first place are been determined in this case. As for the discussion on reward, poll dun dey up as usual for everyone to cast their vote while staying anonymous. E belike people no wan contribute as e go belike dem be bad belle if dem no support the motion so to make things easier, make we see where the majority stand.

The poll go dey pinned up until the end of the month and when the chart analysis come out, we go follow wetin the poll they talk. If yes get majority vote then we go share the merits as Uchegod been suggeste of merits been shared within the first three position instead of just the first position. Everyone will be welcome to participate in the rewarding of the users.

For the new comers, una welcome. Feel free to ask questions and contribute to the activeness of the thread. Also do well to read the forum rules make we no go dey beg for you on Meta.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Petrol can't sell lower than 510naira: NNPC

NNPC don yarn sae petrol can't sell lower than 510naira. They no fit continue with 170naira price again.
Link to information: https://gazettengr.com/petrol-cant-sell-lower-than-n510-nnpc/
Quote
The Nigerian National Petroleum Company Limited has revealed that premium motor spirit (petrol) cannot sell lower than N510 per litre as the President Muhammadu Buhari regime gears towards the phase-out of the fuel subsidy era.
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo

Why e con be like say this government just dey punish e citizens for watin them no just understand. As though not understanding is the crime! Why the APC lead government qan turn set back on all qe bin dey enjoy for we country. As if, the hardship way we Nigerians dey suffer never too much, them wan come remove subsidy.
Why we dey even dey sell raw materials only to buy it's by products at a higher price when, we get the tools them for this country, to use refine and better our life.
We still dey kneels deep into our colonial era of trades and its not helping. Watin dey really stop them from putting the refineries in order and get those Chambers working! I no just understand!!!
full member
Activity: 882
Merit: 207
Una well done o, I been just dey listen to FM today wey been dey play inside moto wey I dey, I come hear wen presidential aspirant, Bola Tinubu make promise to Nigerians to provide 1million jobs in his first tenure, if elected president.
 I come calculate how out of let's say 70million Nigerians right now, no get better earnings to survive on. I understand him agenda, but e go really make sense if instead of making a promise wey no go better everybody or do little with this current Nigerian ressession standings; why e no better for some of us wey don see light for this bitcoin matter to flood social media or create physical campaigns wey go help sensitize youths on how to earn by investing their time and money in trading crypto, instead of to sell off their votes for promise wey be political yarn. Also, if person fit make these politicians dey involved as to make them aware of how them fit take help the unemployed so as to beat the 1million count and more as APC presidential aspirant yarn, e go make sense wella.
Naija need to find better and more innovative ways to improve the economy, because as e be like so, tins are really falling apart.
Watin Una think?
hero member
Activity: 784
Merit: 568
Petrol can't sell lower than 510naira: NNPC

NNPC don yarn sae petrol can't sell lower than 510naira. They no fit continue with 170naira price again.
Link to information: https://gazettengr.com/petrol-cant-sell-lower-than-n510-nnpc/
Quote
The Nigerian National Petroleum Company Limited has revealed that premium motor spirit (petrol) cannot sell lower than N510 per litre as the President Muhammadu Buhari regime gears towards the phase-out of the fuel subsidy era.
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo


Wahala no dey finish 4 dis country ooo, I dey tired with dis heavy shock news very day ooo. My main problem sai all dis  naija government workers not kon dey receive beta money as salary earner and price of things dey increase par yearly but government no kon dey do minimum wage yearly. Now wen NNPC wen increases price of fuel from 170naira to 510naira.how person go dey survive now? bcus price of things go dey increase too . I no understand  again ooo sai we no dey get crude oil again neh abi wat?
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
Petrol can't sell lower than 510naira: NNPC

NNPC don yarn sae petrol can't sell lower than 510naira. They no fit continue with 170naira price again.
Link to information: https://gazettengr.com/petrol-cant-sell-lower-than-n510-nnpc/
Quote
The Nigerian National Petroleum Company Limited has revealed that premium motor spirit (petrol) cannot sell lower than N510 per litre as the President Muhammadu Buhari regime gears towards the phase-out of the fuel subsidy era.
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo

They done start again we are producing oil but look at the price we are buying fuel this government is just after to ruin us how them go sell fuel for us 500 naira, anything wey affect fuel price to everything go start cost, the thing done tire me I swear now wey Christmas done near they want to start drama, the thing they pain me, see the way line for fuel long for every were some people done already hide fuel for their filling station as the thing done cost they go start sell abeg na life be this.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo
Na for all man to set him compass to cut him coat according to him size for this December. The thing wey dey worry me pass na the rate of insecurity. People dey fear to even travel because as e be now person no know who the next person be. Brothers dey gang up dey kidnap fellow brother. In another news $1 = N700 at least this one don go down.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Petrol can't sell lower than 510naira: NNPC

NNPC don yarn sae petrol can't sell lower than 510naira. They no fit continue with 170naira price again.
Link to information: https://gazettengr.com/petrol-cant-sell-lower-than-n510-nnpc/
Quote
The Nigerian National Petroleum Company Limited has revealed that premium motor spirit (petrol) cannot sell lower than N510 per litre as the President Muhammadu Buhari regime gears towards the phase-out of the fuel subsidy era.
How are we going to handle this, now wey festive season d around the corner? Everything for this country just d increase at the wrong time. Are we going to survive the cost of living and transportation this time around? What's the way forward our country pipo
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Well-done, na as you drop your analysis I come dey see something wey my eye no be catch before, I no know say Agbe and me tie. Abeg Igehh wetin you dey use do the ranking when more than one persons get same value. You dey use alphabetical order or based on forum rank? I go like make we know and maybe we dey tie the position when people get same number of posts. Na just suggestion I dey drop so.
I only used forum rank for first and second place. BTW, that was the only month we had two members with the same post count in first and second place. Isn't that a reasonable criterion?

Also how una go feel if we put small reward for this monthly stats so, like only the first position gets a reward? Like $10 or 10Merit
or both kind of encouragement. Wetin una think, e go increase quality engagement on the thread or e just increasing spamming.  Why only the first position (some might ask). Make we no make am much of a tournament but just like a little encouragement something wey go dey low key. What's your takes on this?

It's a good idea, and I hope it works out well; I tried to set up a monthly campaign last season, but it didn't work out. Personally, I think the 10 merits is a good price to pay for a quality post. Only crypto post.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co



That N800+ per dollar weh them put for Emefiele head supposed enter N1k+ before next year. That man na the worst among past CBN governors. No be worst because of how the naira take fall yakata but because of how him take allow politicians dey use am. You can imagine a sitting governor of the central bank running for a political election as presido. The old man no get shame at all. Him be wetin we deh call agbaya oloriburuku.

Also how una go feel if we put small reward for this monthly stats so, like only the first position gets a reward? Like $10 or 10Merit or both kind of encouragement.

Your suggestion deh good. To prevent spamming weh fit enter am, the cash reward go deh cancelled. Make e bi only something like merit and the merit go be through post review. And the review no go be on just posts weh the person make for this thread. Infact make e no even concern posts here. But na who want to deh put the merit self since na only one merit source we get for here?
full member
Activity: 1274
Merit: 175
Catalog Websites
Quote
Username : daNNy001
Gender.      : male
State of residence : Bayelsa state
Skill : am a plumber and also a teacher

Well I dey happy 2day bcoz I Don see this Nigerian group wey I fit gist wit ma people  dem wella
OK my experience for the forum e dey good  although say I still be new comma and I still dey learn but everywhere gud sha ..
At least from this forum  I Don start to understand about bitcoin and crypto currency  well well
Welcome to the best family in the whole world, I believe, u will never regret to be part of this potential movement to promote cryptocurrency in the land. D most important tin here is to try ur possible best to obey the rules and regulations that guided the group to enable u to understand so many things in the group that will make u to have more interest on what is going on here. Once again welcome to progressive community that stand 4 the progress of humanity.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341

Also how una go feel if we put small reward for this monthly stats so, like only the first position gets a reward? Like $10 or 10Merit
or both kind of encouragement. Wetin una think, e go increase quality engagement on the thread or e just increasing spamming.  Why only the first position (some might ask). Make we no make am much of a tournament but just like a little encouragement something wey go dey low key. What's your takes on this?

If you go set aside like 10merits monthly for the reward and spread it across the top 3. Make e for spread. Like number one person go recieve 5merits, number two 3merits and number three go recieve 2merits. By this even if na you carry first, the rest of us go fit rally 5 merits drop for you make e for dey sustainable.

Me no support say make we dey give any incentive for dis our house here not even merit because e go too lead to spamming especially both from senior men and the lower accts abeg make we avoid am so we no go just put ourselves into trouble. Make anybody wey want post for here post instead of looking at price or reward for posting. The monthly update of guys wey post here dey okay.
Well na different opinions na go come out but di thing na gud idea bcoz di thread na self moderated won, so anyone wey Spam di thread im no go see im comment 4 di next seconds. Me and uchegod-21  we still dey do am like di tilapia way. Normal normal we no dey shake. We were looking 4 more pipo 2 join us and now dat Boss come suggest dis won, me I really like am very well. Di thin go even motivate quality post.
U Kno say, dat general monthly statistics local boards review in Meta board also dey review merits sent in each local board monthly? And Naija dey take 8-10 some times. So dis idea e gud. Make we run am see first 4 dis month nd next month 2 know di out come!

Igehhh my man no reason am....ooo. I been dey try 2 say make u no leave us bcos ur contributions dey make sense well.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
NIGERIAN LOCAL BOARD THREAD ACTIVITY UPDATE FOR OCTOBER, 2022.

My people I greet una specially. I don come with our hardwork result for the month of October. E come somehow late because of plenty activities wey full head. But here dey important very well. Happy New month everyone.

Top 30 active users October 2022
Code:
1. CryptopreneurBrainboss [28]
2. Agbe [28]
3. Maestro75 [22]
4. RockBell [19]
5. uchegod-21 [19]
6. Majestic-milf [18]
7. Marykeller [18]
8. Coyster [16]
9. knowngunman [16]
10. Frankolala [15]
11. Davidvictorson [14]
12. Mate2237 [13]
13. Obari [10]
14. Asiska02 [9]
15. Awwal08 [9]
16. Chilwell [9]
17. Mr.right85 [9]
18. Adbitco [8]
19. Cryptomultiplier [8]
20. Smartvirus [8]
21. Wiwo [8]
22. GiftedMAN [7]
23. Rruchi man [7]
24. Zaguru12 [7]
25. BIT-BENDER [6]
26. Hyphen(-) [6]
27. Ragdoll_3.0 [6]
28. igehhh [6]
29. EarnOnVictor [4]
30. Oluwa-btc [4]

Total posts: 396 posts
Total poster: 52 users

Comments/Observations
  • Boss CryptopreneurBrainboss don shock everybody for this month. Last month we been dey reason how em face no show, but this month, em face over show. E from championship go carry champions league straight.  Congratulations Boss
  • Agbe still dey gidigba for top 4, him get same post count with CryptopreneurBrainboss, but big man name gas dey number 1 for sure.
  • Maestro75 wey no show face last month from nowhere enter 3rd position. Him don pick form again o....this time around dem don finally knock Uchegod-21 out for top 3, carry him dey go the place him no know . Sorry bro, naso life be
  • This month eh, plenty senior men face no show for up o. Even BIT-BENDER wey dey follow Coyster dey drag for up, just decide to follow igehhh this time dey drag bottom
  • New faces don full and dem do well. RockBell from far last month don contest fine. Obari made his first appearance in a big way. Ragdoll_3.0,  Zaguru12 una face show wella./li]
    • Oluwa-btc carry this key go house, na you go open this place for December (Christmas) meeting.


    My people I no lie una, we dey try for here and the whole community dey fully aware say we dey exist and we dey too active. One love my people!

    Advice:
    December dey close, people wey wan ride motor no remember to hustle from January. Na this November dem go remember their goals and begin do yamayam things to show off for village. Make we try avoid issues and illegal things wey fit put us for trouble. One man for my community talk say, "Na person wey dey alive carry first"

    Congratulations CryptopreneurBrainboss, leadership by example!

    The data wey I use for this topic come from here.
    Nigeria Local Board Update

I too happy to see my name for this very list
I never expected it because I still new for here and even despite the fact say I no really dey active as expected, I still enter list and e dey sweet my Belle Wella
My thanks goods to the boss of the bosses @brainboss God go bless you for all that you do and no worry you no go lack and your good no go ever swallow you Amen.
Big thanks to @uche for finding me worthy.
We'll do more come December and we go thrive because i no think say to go back follow for my options at all.[/list]
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Username : daNNy001
Gender.      : male
State of residence : Bayelsa state
Skill : am a plumber and also a teacher

Well I dey happy 2day bcoz I Don see this Nigerian group wey I fit gist wit ma people  dem wella
OK my experience for the forum e dey good  although say I still be new comma and I still dey learn but everywhere gud sha ..
At least from this forum  I Don start to understand about bitcoin and crypto currency  well well
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
South Africa Retailer Pick n Pay Now Accepts Payment in Bitcoin at 39 Outlets

Small small, companies wey dey South Africa e don dey accept Bitcoin as we dey tok. One of di thing wey dey spread Bitcoin very fast to all corners na retail companies. Because dem dey sell goods and give services so their spread of di currency is very fast. Like now if retailers accept Bitcoin in any country den dat country e don accept Bitcoin bi dat.

There is this company in South Africa Pick n Pay wey dey carry goods dey go give pipo e don tok say dem dey accept Bitcoin 4 39 of dia branches in di kontri. Wen I see the news I like very well bcoz na weti I need in my locality.
Pages:
Jump to: