Yes, d news de legit because I don see am b4, na just confirmation I never get na why I no fit share am here, but as be now it is confirmed.
NITDA self de try with all dis kind programs just be say dis one dem talk say dem go train plenty people na why I been doubt am b4, but I personally know say NITDA de run some kind programs wey de help Nigerian youths even though some of them de be on a low ki. Back den in 2021, de run digital satellite training program 4 some limited number of people and dem try provide some basic equipment for dem after d training; so dis one to go de very legit but how person wan take participate na im be d main wahala now, because as dem don talk am if u no know anybody we fit just come see news again say dem don finish d training.
Na were naija issue dey be this, no be say initiatives or innovations no dey wey government implement oo but na selection be the wahala, Nepotism go always take place na some of this innovations dey die before he even come to light. Look at that partnership wey dem bin wan do with Binance similar to this one, nobody gree hear anything again oo abi anybody get info about am.
Concerning Crypto related issues for here I feel say na una senior men like Brainboss, Igehhh, CharlesTim dem suppose start am. Make una bring up better topic make new people like myself sabi. You look around technical area of this forum we no planty wey dey engage there and that wan fit influence the board wey we they look for.
What are the direct effect of the Naira with Bitcoin as the Naira has been devalued drastically?
Nigerian Naira is Drastically Devalued and news came that it is because of the redesigning of the Naira by CBN and those who had stored a lot of money in their houses are depositing the money in the bank and transfering or converting it to dollar for safety.
Will the devaluation of the Naira have bad effect in the Bitcoin exchange market?
Na straight up something people dey with plenty naira wey dem don hoard for long. And now them dey look for stable currency to put them in so exchanging it will bitcoin will devalue and also will increase dollar to naira ratio. Making it hard for people to buy bitcoin now at a cheaper. But one thing I observe be say once this re design don finish naira go begin get value and we fit but Btc back