Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 47. (Read 1017615 times)

hero member
Activity: 686
Merit: 987
Give all before death

Boss na this one deh tire person for here. Sometimes e deh discourage me too. Our people go read better thread weh you start and throw eye go another side, that is if them no even go there to drag you. But if na other people open am you go see them rushing to show love. Love weh deh one sided, na love be that? Those weh deh do am think say na better thing them deh do. Make them continue. One day all man go level up. Na so e be for life.

Thank God say Satoprincess deh ok and continue for the new better campaign weh him just enter.
Each time I carry my local Naija dog dey strow for my street people go dey laugh me. Them dey laugh me because I no carry Western dog wey dem feel say better pass our Naija breed. I just dey laff them because that my local dog even get sense pass some of them. Africans no like their own because oyibo people don brainwash us. Sometimes the way our people dey correct ourselves for here dey make me fear. Even if you feel say your brother no talk well for thread, correct am with love no bi to give am the first attack. All these attacks and attention seeking no go give you wetin you dey expect, instead eh go dey open your yansh more more Cry.

And sometimes too no bi say we no want comment for thread wey Naija members they knack, but we no get much knowledge about the topic and we no want fall our hands.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
A typical Nigerians looks for validation from the whites because we have been trained to see them as superior and better than us. Its been encrypted into our memories that nothing good can come out of a black community as such we tend to unconsciously favor the foreigners over our own but on the other hand, this is a forum that's different from the general world. Your hard work does pay off here so instead of our people looking for handout, put head for ground hustle and when you blow outside, na your people go even they beg for your attention instead of you begging for theirs.

No take correction as attack although I believe we should be less aggressive toward one another even though na wetin the forum dey understand better, show love to each other, correct with love as we all were ones newbies before we reach were we dey today. Na small small things go fall in place. If person write you wetin you no like, no feel intimidated, questions am.

Allow me to use this word "It's a natural disease" that has ravaged and savaged the  mind of Nigerian most especially the black in the midst of white, i can't go beyond this words bcus we are still from one place, i could remembered then how it was where people were working collectively to make sure things flawlessly works normal without any discrimination or limitations. Yes of a true we were all ones a newbie but being that we have located ourselves and have a meeting place this should showed that we are one family in a forum where to care and show love to one another because i still believe this forum may not be our ends, i mean we most definitely meet outside the forum via working in same office, organization or any other pressure group which we might likely found ourselves in one of this. So anything we are doing we should try all our best to remain clean from any stain or tag.

It's only me who understand the Joy in me when i sighted to see you people over there was like " i feels like governor Wike" seeing your cartel meeting with you, lets say if we continue with this level what will it be?
I think its a thing of catering and caring for brothers and sisters, so let us learn to forgive and move forward, also help one another just like the case of Satoprincess and i never knew how the case went through.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
Na so me bin dey run for one thing wey encourage me be say as i com put eyes for another people local thread i cum see dey wey dem dey coperate and dey help each grow for d industry cun give me courage to come back here at least to dey relate with my pipo normal normal, yes e be like say we no want make people no our identity but if asked how much we get to dey hide ourself like that, nothing dey dia afterall everybodi dey hustle and we know say here na one major place wey dey put food for our table and i believe say we no fit jonse onto say we don get names well and i dey strongly against anyone who go cum put sand sand for our garri wey dey try drink like this.

My brother you don talk everything complete. Nothing much to add to the correct talk weh you give us there. Those people we say in unity we stand and divided we fall no deh foolish. Na wiseman talk be that. Our people just deh hide hide here and I no know their reason. To associate with others for here deh hard them but if you open discussion for thread na so some of them go rush to pick out errors and faults instead of them to gently correct you for pm. No, they must use your post shine and collect post count. All this things no deh good. E dey follow discourage some of our low ranked members. Abeg people weh deh do am, make them stop. No try run another person down to grow. Nemesis go catch you one day. Anybody still don hear about Satoprincess? Abi nobody here get how to reach am? His friends should tell us wetin deh with am.
Just like the saying "we left home to take care of home", all of us here for the forum na one purpose cari us cum here, to make life beta for we self and family members through the opportunities wey dey here.
And another sweet thing inside this forum be say the opportunities plenty to go round despite the number of pipo involved.

Na person wey no inow road the ask questions, and for him to ask questions him must have to see person along that road him the tread so him fit ask questions but when pipo we supposed ask questions cum the hide then na loss wey we wey no know road go just loss thereby making mistakes, and doing certain tins wey go just put them for trouble and Dem go just end up discouraged cum leave the forum kpatakpata.

Me personally as I dey inside this forum I just be like man wey find him sef inside big sea with no map to guide am, but I still the crawl small small the go. Na so life just be, . I remember the map wey inkita (native dog) like us been the use see road for this forum. Aswr dat map really be of great benefits to men like me but since them tear that map, pipo like me just dey like who na the ocean waves dey show road.

So like this SNR men them na beg I dey beg make una try create that map again. Men like me need am to the get infos, updates and be able to the asked certain questions for wer I don loss. I dey talk about the Bitcoin discussion Whatsapp group wey been dey before and based on say certain circumstances emerged the group com end till today.
I no want call names but the bosses Dem abeg make una tender justice with mercy and do the needful , country hard and I no want thief.  Lips sealed
full member
Activity: 798
Merit: 134
Our people go read better thread weh you start and throw eye go another side, that is if them no even go there to drag you. But if na other people open am you go see them rushing to show love. Love weh deh one sided, na love be that? Those weh deh do am think say na better thing them deh do. Make them continue. One day all man go level up. Na so e be for life.

Na dis one tire me pass self most at times dem go see you like say you no get better information or wetin you post no even follow for the matter but ones anoda pesin post na so e go full like say tomorrow no dey. anyhow e no touch because even those people wey dem dey run dey as well remove cap for us onto say dem believe say 9ja na hustlers and dem no dey carry last for the industry.
wetin i just want na one love make we hustle get our local board and i believe better go come one, and lastly.. Our 001, na beg me dey beg you like, you don already start the walker so no lose hope say we no go achieve am one day, we dey closer already so i believe say very soon e go enter, even some of the oyibo dem dey help us fasten things so make you no feel bad and i really love your efforts and supports.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Breaking News: ASUU Strike Looming Again

What I have said it's about to happen.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Our people go read better thread weh you start and throw eye go another side, that is if them no even go there to drag you. But if na other people open am you go see them rushing to show love.

A typical Nigerians looks for validation from the whites because we have been trained to see them as superior and better than us. Its been encrypted into our memories that nothing good can come out of a black community as such we tend to unconsciously favor the foreigners over our own but on the other hand, this is a forum that's different from the general world. Your hard work does pay off here so instead of our people looking for handout, put head for ground hustle and when you blow outside, na your people go even they beg for your attention instead of you begging for theirs.

No take correction as attack although I believe we should be less aggressive toward one another even though na wetin the forum dey understand better, show love to each other, correct with love as we all were ones newbies before we reach were we dey today. Na small small things go fall in place. If person write you wetin you no like, no feel intimidated, questions am.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
From the dept of my heart joined with my wife.
I want to use this medium to say a very big thank you to those who humbly honored my invitation to my just concluded wedding today. It was an awesome one, although It was an easy task and stressed coupled with the rain and holdup, many were stocked on their way coming to the venue but due to some physical challenge they ended up meeting us at the reception and yet they volunteer their selves to dance and merry with us.
Specifically my thanks goes to these wonderful house for their regular check up, chat and wishes that was sent to me from;
1. Brainboss
2. Igehh
3. Bruchiman
4. John George
And many more, please if I don't list your name doesn't mean your are not recognize.

Thank you all for making my marriage a blissful one., Same God who did it for me will also do it for you all, most especially to those singles brothers and sisters in our midst.

Thank you all
Adbitco cares.
Congratulation my Senior man. E no easy to marry for this period, make I no lie you becos the stress wey dey involved no be ya. And make I follow you thank the others wey stand behind you like to rock for this forum. Happy married life.

Ehen, to the mata wey dey for ground. The news about the naira wey don rise to 855 against the dollar no be somtin wey sopoz shock us. Before my guy here dey predict say e go soon reach 1000, I don already dey yarn give my guys say e go climb up as at the time e bin dey 700.
 As to this mata, how we govt go take solve am? Nah to rebrand or them get beta plan to reduce am becos as e dey we fit wake one morning find say we no get any Fiat.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Anyways I also noticed her reduced engagement on the local thread but you no fit blame her. When he needed our help, we couldn't come to her rescue and If she's taking some time off the board no hard feelings, I would had done the same as well if people I called my own couldn't trust me to help push for an assistant I needed.

Boss na this one deh tire person for here. Sometimes e deh discourage me too. Our people go read better thread weh you start and throw eye go another side, that is if them no even go there to drag you. But if na other people open am you go see them rushing to show love. Love weh deh one sided, na love be that? Those weh deh do am think say na better thing them deh do. Make them continue. One day all man go level up. Na so e be for life.

Thank God say Satoprincess deh ok and continue for the new better campaign weh him just enter.
full member
Activity: 882
Merit: 207
Naira falls to 855 per dollar
Quote
despite the Economic and Financial Crimes officials’ crackdown on Bureau D Change operators in Abuja on Tuesday, the value of Nigeria’s naira deteriorated further against the dollar at the parallel market. The naira traded at N855 per dollar as of Wednesday afternoon. The naira’s free fall could reach N1,000 per dollar in a matter of weeks despite government’s frantic jackboot

Day by day commodities d dey high for price because dollar rate against naira don increase wella. Alot of business don d fold up, Business don d crash, debt here and there. And the dollar no wan reduce for price against naira. Speculation don d go on sae naira fit increase to 1000naira per dollar before next year. if you no d careful for collecting contract without due diligence of the product price em go fit amount to extra ordinary expenses give you. Make God save us for this country. This no be the 1naira equal to 1dollar wey APC government promise us oohh

Na the thing be that as dollar they high every other thing they increase and the kind thing no Favour civil servant at all how much them they earn that will meet up with the price hike, if you carry 10k go market my brother I don’t need to talk much what you will get from that amount will be very little, imagine having family and children and schools too are already increasing there school fees already, brother no be lie the way dollar they go he fit enter 1k sha.
The matter tire everi body. E tire some people to the extent say, if you mention this news, den fit remove slippers pursue you. So dollar dey try tell us say the 1$ wey make Naira climb over the years to watin e be now, no do again, now na 1000naira to 1$ Dem want. Haba, how is the crime rate supposed to reduce, how is security supposed to be paid for with this maddening rate. Other than a functionless E-naira, what other reasonable ideas has the federal government adopted to aid citizens increase or maintain a decent lifestyle, mostly for those who earn online or are Internet savvy?
 The Philippines Unionbank now offers business, commerce, trade and other cryptocurrency services to aid it masses and improve its economy at large. Still decentralized, but regulated to an extent.
Naija need to shine eye wella, because e get as e go be, na Chinese Yen we go adopt o.
full member
Activity: 798
Merit: 134
Anybody still don hear about Satoprincess? Abi nobody here get how to reach am? His friends should tell us wetin deh with am.

I think wit the way i see things our 001 fit her control so make wait small see weda him fit come up with sometin or Igehh go even relate with them.
Like on a serious note, i don walker well well for dis place but wetin my eyes there and here no be same thing and this things make most of us no dey near here the first time self me com dis corner e be like omo you too na 9ja, i cum say Yes but due we names na.

She dey active now as I just see her comment for one thread wey I just comment finish.

Thank you sir, i been no read this part of your comment before i post.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Where SatoPrinces?
My people, I greet una abeg I notice say satoprincess have not been online since 27th of last month, and you know as that user dey active before for the forum. Please anyone close to Satoprincess should please put call through and check on that user.

She dey active now as I just see her comment for one thread wey I just comment finish. And also she was recently accepted in one of the well paying campaign so I doubt she's having any challenges maybe just took a day or two to rest. Anyways I also noticed her reduced engagement on the local thread but you no fit blame her. When he needed our help, we couldn't come to her rescue and If she's taking some time off the board no hard feelings, I would had done the same as well if people I called my own couldn't trust me to help push for an assistant I needed.

I understand we all are hustlers here because if country been better I doubt many of us for dey here. The forum is very time consuming and not to talk of all the headache and eye problem wey follow for been constantly on your phone/laptop screen. Anyways I love the concern showed here. We should keep it up and check up on one another aways, depression dey everywhere and people are passing through alot. I hope we all come out stronger & successful one day to look back at this times and smile.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
Naira falls to 855 per dollar
Quote
despite the Economic and Financial Crimes officials’ crackdown on Bureau D Change operators in Abuja on Tuesday, the value of Nigeria’s naira deteriorated further against the dollar at the parallel market. The naira traded at N855 per dollar as of Wednesday afternoon. The naira’s free fall could reach N1,000 per dollar in a matter of weeks despite government’s frantic jackboot

Day by day commodities d dey high for price because dollar rate against naira don increase wella. Alot of business don d fold up, Business don d crash, debt here and there. And the dollar no wan reduce for price against naira. Speculation don d go on sae naira fit increase to 1000naira per dollar before next year. if you no d careful for collecting contract without due diligence of the product price em go fit amount to extra ordinary expenses give you. Make God save us for this country. This no be the 1naira equal to 1dollar wey APC government promise us oohh

Na the thing be that as dollar they high every other thing they increase and the kind thing no Favour civil servant at all how much them they earn that will meet up with the price hike, if you carry 10k go market my brother I don’t need to talk much what you will get from that amount will be very little, imagine having family and children and schools too are already increasing there school fees already, brother no be lie the way dollar they go he fit enter 1k sha.
full member
Activity: 1274
Merit: 175
Catalog Websites
Quote
From the dept of my heart joined with my wife.
I want to use this medium to say a very big thank you to those who humbly honored my invitation to my just concluded wedding today. It was an awesome one, although It was an easy task and stressed coupled with the rain and holdup, many were stocked on their way coming to the venue but due to some physical challenge they ended up meeting us at the reception and yet they volunteer their selves to dance and merry with us.
Specifically my thanks goes to these wonderful house for their regular check up, chat and wishes that was sent to me from;
1. Brainboss
2. Igehh
3. Bruchiman
4. John George
And many more, please if I don't list your name doesn't mean your are not recognize.

Thank you all for making my marriage a blissful one., Same God who did it for me will also do it for you all, most especially to those singles brothers and sisters in our midst.

Thank you all
Adbitco cares.
A big congratulations to you brother from another mother, your new home is blessed.  Dis is the type of good news we are expecting from our single brothers and sisters in this house so that other people will no dat we belong to a solid community. Am so happy 4 u Adbitco for ur bold step in dis hardship season we found ourselves in Naija, infant u have challenge many single people in dis house so, because I never believe say person will bring such huge amount of money to do wedding in dis hardship, say bear market open well na dis 4 person to plan well ahead of bull tin, infant I celebrate you again brother from another mother.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Na so me bin dey run for one thing wey encourage me be say as i com put eyes for another people local thread i cum see dey wey dem dey coperate and dey help each grow for d industry cun give me courage to come back here at least to dey relate with my pipo normal normal, yes e be like say we no want make people no our identity but if asked how much we get to dey hide ourself like that, nothing dey dia afterall everybodi dey hustle and we know say here na one major place wey dey put food for our table and i believe say we no fit jonse onto say we don get names well and i dey strongly against anyone who go cum put sand sand for our garri wey dey try drink like this.

My brother you don talk everything complete. Nothing much to add to the correct talk weh you give us there. Those people we say in unity we stand and divided we fall no deh foolish. Na wiseman talk be that. Our people just deh hide hide here and I no know their reason. To associate with others for here deh hard them but if you open discussion for thread na so some of them go rush to pick out errors and faults instead of them to gently correct you for pm. No, they must use your post shine and collect post count. All this things no deh good. E dey follow discourage some of our low ranked members. Abeg people weh deh do am, make them stop. No try run another person down to grow. Nemesis go catch you one day. Anybody still don hear about Satoprincess? Abi nobody here get how to reach am? His friends should tell us wetin deh with am.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
From the dept of my heart joined with my wife.
I want to use this medium to say a very big thank you to those who humbly honored my invitation to my just concluded wedding today. It was an awesome one, although It was an easy task and stressed coupled with the rain and holdup, many were stocked on their way coming to the venue but due to some physical challenge they ended up meeting us at the reception and yet they volunteer their selves to dance and merry with us.
Specifically my thanks goes to these wonderful house for their regular check up, chat and wishes that was sent to me from;
1. Brainboss
2. Igehh
3. Bruchiman
4. John George
And many more, please if I don't list your name doesn't mean your are not recognize.

Thank you all for making my marriage a blissful one., Same God who did it for me will also do it for you all, most especially to those singles brothers and sisters in our midst.

Thank you all
Adbitco cares.

Congratulations senior on your wedding. Sorry it's coming late but I pray that the blessings of marriage and wedding dwell with you and your family,
Also know that marriage is a beautiful thing and always remember that for a union to work perfectly, there must be one person who is willing to take the blame and ready to make things work.
There is an adage in my place that says " THE MAN IS THE HEAD AND THE NECK(WIFE) CONTROLS THE HEAD".
please don't get it wrong but always try to confine almost everything in your wife and always make her feel relevant.

NA WHO WEAR SHOE, KNOW WHERE E DEY PAIN AM. no let person interfere with your marriage and anything you dey do, try no forget home.

ONE LOVE CHIEF.
full member
Activity: 798
Merit: 134

brother make i tell you, yes we know say forum na individual race but you know say here we dey like one belle so if one pesin no dey sound na we responsibility to check on the pesin or even though fuckup reach d pesin na we go still fight for am to make sur say everywhere good. Na so me bin dey run for one thing wey encourage me be say as i com put eyes for another people local thread i cum see dey wey dem dey coperate and dey help each grow for d industry cun give me courage to come back here at least to dey relate with my pipo normal normal, yes e be like say we no want make people no our identity but if asked how much we get to dey hide ourself like that, nothing dey dia afterall everybodi dey hustle and we know say here na one major place wey dey put food for our table and i believe say we no fit jonse onto say we don get names well and i dey strongly against anyone who go cum put sand sand for our garri wey dey try drink like this.

If for say our Brother Adbitco hide himself e get anytime him for come appreciate those people wey him cum thank here?

No becus him dey free to invite pipo wey him feel like say dem good to invite and finally nothing happened and those Oga them honored him invitation and go there celebrate with am just like that na good thing and na another way to show love be that my brother, so remove personal race here make we care for each others.
Just take time visit other people thread make you see wetin dey happen there.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Naira falls to 855 per dollar
Quote
despite the Economic and Financial Crimes officials’ crackdown on Bureau D Change operators in Abuja on Tuesday, the value of Nigeria’s naira deteriorated further against the dollar at the parallel market. The naira traded at N855 per dollar as of Wednesday afternoon. The naira’s free fall could reach N1,000 per dollar in a matter of weeks despite government’s frantic jackboot

Day by day commodities d dey high for price because dollar rate against naira don increase wella. Alot of business don d fold up, Business don d crash, debt here and there. And the dollar no wan reduce for price against naira. Speculation don d go on sae naira fit increase to 1000naira per dollar before next year. if you no d careful for collecting contract without due diligence of the product price em go fit amount to extra ordinary expenses give you. Make God save us for this country. This no be the 1naira equal to 1dollar wey APC government promise us oohh
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
New Topic : One of the Major Problem in Nigeria is the Unequal Distribution Formula.
For the past one month, Nigerians citizens were battling with man made flood from the wicked hands of the devil, and the region that suffered most is Bayelsa because Bayelsa has low land mass. The land in bayelsa is below the sea level. So they suffer most in flood period. The hardship of the flood is untold.
We are all happy that the flood is going down gradually to it root and the worst again comes from government.

Donations
The former president Jonathan local government plus his house were flooded and he became an IDP and as a former leader in the federal republic of Nigeria, donations were coming in to his account from all corners in the world. From world bank, USA, uk, un au, even bayelsa stte government etc. As far as bayelsa is concerned everyone was affected and donators brought billions and million, governments official, individuals and international bodies brought millions to share to the flood affected people but the money that was brought to my resident community to share make she'd tears. The money people gave to Bayelsans because of the flood are more than the population of bayelsa x10 but 600k was given to the community IDP camp then those who are badly affected by flood and were not in the IDP were carved out.

I am not interested in the money but I want everyone to get it except me. Those who slept in their houses on the flood were not given bcuz there are not in the IDP.

God should kill all these politicians and bring up New ones.
Nor be today wey yansh dey back. This one na the wise words of out forefathers. What we have in Nigeria interms of greed, corruption and man's inhumanity to man is more than witchcraft. I weep sadly because this goes even outside of the political offices and we know it. I wonder how people who divert public funds are able to sleep at night. It is so sad. We need to do better as Nigerians.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Where SatoPrinces?
My people, I greet una abeg I notice say satoprincess have not been online since 27th of last month, and you know as that user dey active before for the forum. Please anyone close to Satoprincess should please put call through and check on that user.


I think princess na pesin wey we suppose dey check up to know how she dey do, from the previous develop on W-group that was closed made us to lose contact and not knowing how everyone is so i suggest anyone who every every control should put call to know how we are doing. A warn reach out to our brothers and sisters who are not active would be greatly valued although I m not always active in this section of our thread but i strongly believe from today i will be putting eyes gradually to know how far and latest update from our people.
Yes na, ani body wey dey here well well (active) nd he no come dey here like dat, we need 2 call dat pesen 2 kno how im dey faring.  But she (princess) sef e no dey try... bcuz of wat happened in di defunct group, she no dey come here sef dey participate, though forum na individual race but we still dey care 4 one another. Ani how Bossman go get her number nd im go tanana her kapa, then he go come update us weti happen wey she no dey come online and also participate in di campaign dey selected her. Anoda pesen sef fit call her 2 kno her wereabout.
As she no dey tok ani thing 4 here pipo sef e no go discuss di mata again. I kno say nothing go happened but quietness in dis place is bad.

Nd another thing again make we dey try w help pipo in a small small way in dis local thread.0.0001 e no go kill u if u dey campaign. Na so I see am. Make una call and give feedback.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
From the dept of my heart joined with my wife.
I want to use this medium to say a very big thank you to those who humbly honored my invitation to my just concluded wedding today. It was an awesome one, although It was an easy task and stressed coupled with the rain and holdup, many were stocked on their way coming to the venue but due to some physical challenge they ended up meeting us at the reception and yet they volunteer their selves to dance and merry with us.
Specifically my thanks goes to these wonderful house for their regular check up, chat and wishes that was sent to me from;
1. Brainboss
2. Igehh
3. Bruchiman
4. John George
And many more, please if I don't list your name doesn't mean your are not recognize.

Thank you all for making my marriage a blissful one., Same God who did it for me will also do it for you all, most especially to those singles brothers and sisters in our midst.

Thank you all
Adbitco cares.
One swt tin way dey b say, d smal tin way we start 4 here dey grow 2 b major somtin nd e dey mak meaning 4 us awtside. Dat na very gud sign say, no b play we con play 4 here nd our hangout dey unit us mor dan we knw.

Congratulobia 2 u my bro. Dem say persn way fine wife, e fine good tin. My prayer 4 u b say, mak dat good tin manifest 4 ur life nd d resources 2 tak pull family thru fine u com as u dey fine am go.

I go stil end am say, pple way try attend frm d forum, evn if na base on individual as we no bin get any arrangement, una too do well. Una don giv dis group meaning. I tank una plenty.

Congrats Mr & Mrs Adbitco.
Pages:
Jump to: