CNB's Plan to Scrap ATM.
Make this our FG and CBN to take a chill pill abegy. Their wahala don d too much. Em remaining few months for their tenure to be over and them bring up irrelevant things wey no d important atal. Wey be sae d country get pressing issue at hand wey d suppose find means to get
a lasting solution for our economy, flooding, insecurity and unemployment.
Which one be scraping ATM cards to unveil National Domestic card scheme. Abegy make CBN and FG just park well before people go just vomit fire give them for this hardship wey dem don cause for this country so.
My brother I don laf tire the matter no clear waiting be their reasons to scrap ATM the thing don tire me I swear wey pressing issues they ground on our to improve the economy and see challenges wey people they face, I don know this present government I don know what their problem is no priority at all them they always do irrelevant things, make them do comot there time don they reach to comot for there, we need people with insight not some greedy folks that don’t know their jobs.
As in ehn, these guys go just wake up one morning with the most stupidest ideas just to fuck the country over more than they don do already. If this government really care about the people, they for don dey find solution to this flood issue wei dey at hand now, because e no dey just affect the life and properties of people. E dey affect the economy too. Just last week here I been wan go buy cement, na so dem knack me price say because road no dey for the trailer to bring their stocks over because of the flood.
E dey pain me o gaga,anytime I just hear or see nonsense mata wey old men dey come up with e dey vex me. Wetin concern ATM card with hardship and flood disaster wet try wrapper join am. Na for inside my ceiling I been dey sleep for almost 11 days because flood ravage my house and displace my family. Thank God say DAT mata son pass sha. I still thank our menthol and Boss of all bosses for here.
The problem be say from my understanding Nigeria too big for one man to rule because the country trouble and rumbles big pass one man small head wet be like onions. Imagine court pass other for the release of Nnamdi Kanu, one man wet say e na president no obey court order. This means say people dey Nigeria wey dey above the law,this also show say our leaders and we the people no even know the constitution wey we dey practice.
Nigeria dey practice Federal Constitution we say Supremacy of law i.e no one is above the law and the Supreme court is the highest power. This old men just dey do nonsense dey spoil these lovely country because of say dem no won give the government do another generation and nothing dey them head on way forward. These old pipu dey use old fashion lifestyle of 1970s dey rule us when then thief and evil politicians dey loot public funds.
Now these is the new era where every government dey after taking care of their citizens and building the country for competition in the global world but these same old men no understand these things. This na why dem dey behave like these because nothing dem get to offer. Imagine insecurity, kidnapping, unemployment,bribery and corruption,poor power supply, inflation,poverty,lack of country production, stealing by the government, Aboby, if I list dem e go pass two pages, dem never fit solve just one na mumu ATM wey no even affect anybody or help anybody condition na e dem dey talk.
Nigeria government are confused set of people is a pity say Buhari and him government na mess to the people