Chairman e belike you no know wetin those northern state get for natural resources oh. No be only crude oil be national resources oh there are multiple been hoard by those state and anything wey make the country divide na dem go benefits pass and I no go surprise if them dey thief the crude dey store for them states self.
Kogi state becomes first northern oil producing state, receives oil allocationAs we dey argue on which region to survive after Nigeria break up which we no pray make happen, southern people dey boast of producing oil wey make dem advantageous over Northern people. For some time now northern people Don discover oil too for dem regions but adequate machinery never dey in place to make the oil dey useful. But today the report Don scatter for internet as kogi state Don officially becomes oil producing state for northern region. I believe say na the beginning be this because other states dey road dey do surveillance. Na double win for Northerners now as an oil producing states and food producing too. You go like read more about the update? Oya na the link be this
kogi become first Northern oil producing stateLastly why is it that is only Peter Obi showing concerned about the flood affected victims in the country?
Lets us discusse peacefully.
please not hates words
First of all, make I ask you this question. Has Peter Obi officially kick off his campaign? Make I still help you answer. The answer is capital NO! So why you con use the word suspend for the title of your writing? Obviously for propaganda I guess. We know say PO visit the flood victims but don't relate it with campaign just to blackmail other candidates. Apart from Atiku and PDP wey don kick off their campaign officially, other parties never start. So how you go suspend wetin dem never start? Secondly, you don justify my assertion wey I talk say this your write up na just for propaganda by saying other candidates no show concern about the flood affected victims. So you no hear say both Atiku and Tinubu donated millions of naira to flood victims? The earlier you realize that all these acts na campaign strategies, the better for you my brother. To even make am obvious, na labour party attire he wear go there. No trust any politician after all they all have the same agenda. And finally, you said no hate words while you indirectly portray hatred to others in your write up. Abeg we need to wise up biko
CAN SHARING OF MONEY ERADICATE POVERTY FROM NIGERIA.
This mata dey disturb me, I dey see say 9ja government dey confused on hw dey go eradicate poverty for the country, but d way dey dey do am I no think say the problem go solve. CBN share money last weekend me too get the money my own na 4k but can this solve our problems. Pls house watin government go do to eradicate poverty now.
The money no be wetin una dey think am sha. Na agricultural support fund from FG through CBN. Now make I answer your question. Poverty na natural phenomenon. No any government can eradicate it but can only be reduced by a meager percent and the only way to reduce it na to provide citizens with jobs both skills and unskills. You remember covid 19 loan? 500k to 1m but it was misused by the most of the beneficiaries. Some time government is not at fault but we the citizens tbh.