Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 54. (Read 1018434 times)

hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
While we focus on the forth coming general elections do we have to neglect the current situations of the country.
Who else is noticing that the major interest in the country right now is the general election.
Even though the country is going through
1. Flooding
2. Global recession
3. Naira currency inflation
4. Insecurities
5. Educational issues.

The main issues now has become election, how to we cope before the election, the present administration has always been lackluster in performing their duties but now it has even gotten worse.

No be today we no say all the politicians and the parties dem wey dem dey represent dey against us wey be the people wey dem dey claim say dem dey represent. Before the Flood matter hit some state for our country now, Flood dom happen before for 2012 and 2018 I still remember the one wey happen during the tenure of our before presidoo oga Jonathan I been dey Bayelsa state that time dey hustle for school runs but las las nothing dem do to stop the flooding from happening again and this year now, after all the hardship and hunger wey 90% Nigerians dey go through flood come join dey pursue plenty people for house wey dem dey manage drink water with an empty stomach sleep and our politicians get mind still dey buga around dey campaign eeh e no go better for some of them, especially the evildoers.

I no even wam talk about the other issues wey you list here because the matter dom tire me but the only thing wey I think say we fit do now to survive before the election na to assist in any little way wey we fit do to contribute funds to help the flood victims and to raise our voice to tell them to vote for the right candidate wey fit get human sympathy for us and deliver good governance.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
While we focus on the forth coming general elections do we have to neglect the current situations of the country.
Who else is noticing that the major interest in the country right now is the general election.
Even though the country is going through
1. Flooding
2. Global recession
3. Naira currency inflation
4. Insecurities
5. Educational issues.

The main issues now has become election, how to we cope before the election, the present administration has always been lackluster in performing their duties but now it has even gotten worse.

We no neglect am, just dat di election nai go determine di rest things but as 4 now na di flood nai bi major thing. Peter Obi stopped his campaign bcos of di flood nd he come visit Bayelsa State on di 22 of October, 2022 and I hear say he gave 5m to di Govnor of do state to give to Internally Displaced Persons (IDP). Bayelsa State na di worst place wey di flood affact pipo but di correct government APC and Atiku still dey on their campaign train but PO whom Dem say na d stingy man nai show di highest sympathy 4 di victims. Now if u luk wella. U go know say dis disasters and ill-treayment of institutions r caused my bad governt. Because good govet can control and channel di flood 2 sea. But bad governt e no go do am.
If dis no be neglect, den I no sabi watin b neglect again. I no fit imagine hw selfish way our Nigerian politicians b. Say dem no fit dey turn up 4 pipo way dem wan lead. E dey very bad nd I hope say d pipo of Bayelsa dey carri eye see nd my Nigerian pipo too. Becus na frm here we go dey knw persn way dey 4 us nd peesn way no dey o.
No b watin b say, na election time, pipo go con dey print demselves on top bag of rice. Na watin go last we need, persn way mind go dey wth d pipo nd so far, d ruling party don fail.

I sori 4 d pipo of Bayelsa nd I hope say, we go dey try dey stay off water ways kwa  becus, dis one follo to dey mak matter worst.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
While we focus on the forth coming general elections do we have to neglect the current situations of the country.
Who else is noticing that the major interest in the country right now is the general election.
Even though the country is going through
1. Flooding
2. Global recession
3. Naira currency inflation
4. Insecurities
5. Educational issues.

The main issues now has become election, how to we cope before the election, the present administration has always been lackluster in performing their duties but now it has even gotten worse.

We no neglect am, just dat di election nai go determine di rest things but as 4 now na di flood nai bi major thing. Peter Obi stopped his campaign bcos of di flood nd he come visit Bayelsa State on di 22 of October, 2022 and I hear say he gave 5m to di Govnor of do state to give to Internally Displaced Persons (IDP). Bayelsa State na di worst place wey di flood affact pipo but di correct government APC and Atiku still dey on their campaign train but PO whom Dem say na d stingy man nai show di highest sympathy 4 di victims. Now if u luk wella. U go know say dis disasters and ill-treayment of institutions r caused my bad governt. Because good govet can control and channel di flood 2 sea. But bad governt e no go do am.
So as we dey tok about di election we dey also discussed how we go select good person 4 di persident position.  Even di naira devalue na di govt cause am.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
While we focus on the forth coming general elections do we have to neglect the current situations of the country.

The main issues now has become election, how to we cope before the election, the present administration has always been lackluster in performing their duties but now it has even gotten worse.

Well, the issue be say, na bad government dey cause everything wey you list so and unlike before wey we dey solved dem one after the other, this tym around Nigeria dun wise up and dem wan solve the problem from the root wey be who go lead Nigeria. If we get am wrong this time again as we dey do before then come next four/eight years we go dey here to discuss this same issue you dey mention above. But when we get am right, then many issue go dey resolved and Nigeria go go forward. Now to the flood matter, we all know wetin dey cause am say na dam and the solution but our mumu government no go build that shock absorber dam wey Cameroon advice dem to build.

Naira currency inflation na because the country no dey productive but only consuming here and there. If a better government been enter, by now we for dun get many working refinery and dey run our own fuel production plus other goodies wey dey follow but no mumu government only know how to borrow money and flex, dey pay allowances for all the people wey join hand keep them for the top.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Anybody wey wan vex make e vex, all the politicians for Nigeria na thieves and na their personal interest dem dey after, but one thing be say, among all the theives wey come out this time, na Peter Obi be my own choice, na him I want make we try thus time around. Anybody wey wan mention him own candidate dey free to mention. Anybody wey wan vex because we call politicians name, make him huge transformer. E go tell me weda as Nigeria dey deh sweet him.

My brother your talk sweet me well well. Make everybody feel free to fly them candidates but na that billboard and poster display we supposed avoid because e deh take space. I talk am say all politicians na thieves but e get some weh never too thief thief like others. And na there PO deh. I deh proud to support PO and I believe any well meaning Nigeria deh behind PO. Those supporting that sick old man make them too show them face. E go good make everybody declare where them deh self so that we go know who predict well after the 2023 elections.

Una deh see the warning weh America don issue of attack weh go happen for Abuja now abi? Na so this useless government go still fold hand until e happen and innocent people go die. And someone go still deh somewhere deh root for this Buhari government or make Tinubu succeed am? Abeg, I no deh like selfish human beings. Somebody go deh support this government because of small coins weh him go get but forget say na blood money him deh collect. I no want to swear for anybody o but I deh para like this. See as inflation want to kill us.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The main issues now has become election, how to we cope before the election, the present administration has always been lackluster in performing their duties but now it has even gotten worse.
Na truth u dey talk so Oga BIT-BENDER becus if u check am, na partisan govmnt we don run 4 d naija nd wth d mentality way we politicians get, evrytin na there selfish interest way only ft materialise 4 inside party. Anytin way no b party no dey work 4 dem nd lik dis, d kind arise way pple don get, na to mak sure say, dem party stil enta dat seat b dere wahala. Any other gbegeh way dey d naija no concern dem. Na y tins just dey fly anyhow.

Nobody go talk say them no know say Buhari/Osibanjo administration was a complete disaster, every Nigerian knows that, some of them go pretend like say them no know, maybe because them they benefit from this administration in one way or another, but the fact wey they there be say for this eight years, baba Buhari no try at all.
E no try at all. Dis 1 no b watin dem go say, pple spoil wn govmnt. Does element dey always day in evry govmnt. Na hw u cari mak am na em go mak, package am na em go mak ur tenure beta. Dis govmnt, e bad no b small.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
The main issues now has become election, how to we cope before the election, the present administration has always been lackluster in performing their duties but now it has even gotten worse.
Nobody go talk say them no know say Buhari/Osibanjo administration was a complete disaster, every Nigerian knows that, some of them go pretend like say them no know, maybe because them they benefit from this administration in one way or another, but the fact wey they there be say for this eight years, baba Buhari no try at all.

Having said that, despite everything wey they go on, the fact remains that the election preparations have to go on, that one na sure thing, to prepare for election no easy, so no matter wetin they happen the nation has to prepare for its election to make sure say e go on successfully. E be like say some candidates don suspend their rallies sha, so that them to fit help the flood victims, and it is good to see. No forget too say we want make this election come fast, so we go see if better government go enter power, make we begin enjoy the resources of our nation.
hero member
Activity: 812
Merit: 927
Me I feel say we fit still dey do discussion of politics here but abeg make we know how we go take they canvas for our candidates for here. If you dey feel say Obi na the best no mean say make we everybody accept am. Na y na democracy we run. The best thing na to find ways convince come your side.

I also observe another discussion been wan come up here which is the issue of division of south and north. Me personally ah no like make we dey do that kind discussion here


The last thing be say bitcoin discussions no too much for here and I feel say na him suppose the main thing for here.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

I think maybe why he said we should reduce political discussion is about everybody choice of candidate. You fit dey support person now and person wey you dey portray for here anoda person no like am, maybe him dey see the person as political criminal. Calling name of political candidate of your choice make him remain within you, and make you no dey call other people candidate with vulgar names because dem no go like am. Dis fit bring hatred within people for here. And dis our local board na unity and progress we need within ourselves. If to say we get our own board as you said, dis matter fit remain for d child board, but for now make e no come spoil the real motive of this our local thread now.

Big man, your talk sweet o for anybody wey read am, but if you look am well, e no too make sha, e come be say we wan come limit ourselves for here or wetin na? Why person go dey hide to mention the particular person him dey support for election make another person no for vex?

Anybody wey wan vex make e vex, all the politicians for Nigeria na thieves and na their personal interest dem dey after, but one thing be say, among all the theives wey come out this time, na Peter Obi be my own choice, na him I want make we try thus time around. Anybody wey wan mention him own candidate dey free to mention. Anybody wey wan vex because we call politicians name, make him huge transformer. E go tell me weda as Nigeria dey deh sweet him.

Wetin Igehhh talk be say, as we dey discuss politics and economy, make we try chip in some bitcoin discussion too and make two people no raise two topics for the same page.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
Can we limit some political discussion?

This one go hard to do because na election deh face us so. We gat to talk about am na. It is like asking people not to talk about football during the world cup. The only thing be say make we no come they post pictures and campaign posters for here so e no go be like anybody deh promote those thieves for here. All politicians na thieves them be but some thief pass others. Una see that man for Lagos? That one worst pass them all. I no mention anybody name o. But if to say we get board already na to move everything politics to the childboard so here go come deh neat for eye.

I think maybe why he said we should reduce political discussion is about everybody choice of candidate. You fit dey support person now and person wey you dey portray for here anoda person no like am, maybe him dey see the person as political criminal. Calling name of political candidate of your choice make him remain within you, and make you no dey call other people candidate with vulgar names because dem no go like am. Dis fit bring hatred within people for here. And dis our local board na unity and progress we need within ourselves. If to say we get our own board as you said, dis matter fit remain for d child board, but for now make e no come spoil the real motive of this our local thread now.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Can we limit some political discussion?

This one go hard to do because na election deh face us so. We gat to talk about am na. It is like asking people not to talk about football during the world cup. The only thing be say make we no come they post pictures and campaign posters for here so e no go be like anybody deh promote those thieves for here. All politicians na thieves them be but some thief pass others. Una see that man for Lagos? That one worst pass them all. I no mention anybody name o. But if to say we get board already na to move everything politics to the childboard so here go come deh neat for eye.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
E get as d matta b shah on the seize campaign something. I lik watin Peter Obi dey try do bt, dis one in itself na stil campaign for ram nd being d first persn way call out don mak am d baba 4 d pple. If Tinubu nd Atiku con dance to en drum wch is unavoidably, all elements 2 d success go still fall back to PO.

You don tok am finish say d action of PO nah just a packaged way of campaigning but I no go lie, dis method tight. Pipo dey say e be man wey dey cap careless according to supporters of  Atiku and Tinubu but as d mata b, even if dis act dey one kine, e still make sense as e demonstrate one tin: there will be no people to give your beautiful manifestos if flood washes them away. So him gats pause am.
 These our politicians eh. Biko nah who go change the contri we need o
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
While we focus on the forth coming general elections do we have to neglect the current situations of the country.
Who else is noticing that the major interest in the country right now is the general election.
Even though the country is going through
1. Flooding
2. Global recession
3. Naira currency inflation
4. Insecurities
5. Educational issues.

The main issues now has become election, how to we cope before the election, the present administration has always been lackluster in performing their duties but now it has even gotten worse.
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Whatever those ones get na for small quantity them deh. You no go fit compare am with wetin crude deh give na. And oil touch everybody. No be everybody deh like wear gold but na everybody deh use petrol. Even if you no use kerosene or gas or any other crude oil produce, you must use petrol.

Na true talk wey you talk. Petrol na wetin every naija dey use and even the oyibo pepo self wey dey build electric cars never fit abandon petrol cars, this one na to show us how important petrol and the byproducts dey and to shop how the world take dey trapped on top petrol matter. Despite say solar this and that dey come out but petrol still never comot for market. For naija now, to run confederation system like as e dey before no go dey easy where every politician eye now dey for oil. Abi na aboki go want go back to kolanut era abi na Yoruba go want begin cultivate cocoa. Every of them fit sell their house make dem just enter there.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛

Can we limit some political discussion? This is a bitcoin forum, it's hurt that there is no single bitcoin or altcoin discussion or news for Godknows when now, this is not going to help us achieve our local board if all we do here is talk about politics and crack jokes.

Abeg another important matter be say if you get a topic to create, always check and make sure there is no double topic on each page ( every page should have maximum 1 topic

N/b we do really give a damn about Atiku campaign table on the thread, same thing goes to other party members too.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

Governor Soludo Bans Bet9ja, Nairabet, Other Gambling Services, Casinos In Anambra.


Abeg how legit this news be and watin una see about this new development by the governor

Na this news don dey trend for social media since yesterday. Major news paper for online don carry the news but I never see link to the governor's speech wey ban the gambling. Me, I wan see the link read by myself. Media sabi misinterprete things, e fit be say na regulation the man put for the gambling or the man ban it for open places or one or two things. But I go like see the link read by myself.

Even if the man ban it completely, na just agents wey rent shop dey do the business e go affect because individual gamblers go enter online full, open account and continue to dey gamble dey go.
hero member
Activity: 952
Merit: 742

Am touched see person wey get good regardless of been a presidential aspirant this guy na good guy imagine calling other aspirants to support to seek solution to current flood issue wey they ground now, na this kind people we need, flood this year deal with people especially states like kogi, Niger, Lagos e.t.c  even kill people join  and made many people homeless and is not a priority to the present government the matter don tire me but never the less we just have to support one another as it now in this country.destitut
 Peter Obi don see say the people wey flood ravage dey suffer and them need help from these politicians,since the dey claim say them care for the citizens of the country. To know who go work dey very easy at this moment na the flood victims na e dey pass through frustration and government need to render help. If I tell you say presently nothing has been done for the flood victims by FG only private donors dey help. Nigeria government won say Cameroon no give them money for the damage wey this flood cause to Nigerians. So make Tinubu and Atiku start to show say no be our money dem dey come thief say na good mind na e dem won use rule the country by providing for victims who flood have turned homeless presently.
Peter Obi na very good man, him de qualified to rule Nija, because him get good heart.
Nigerian Government go come to d issue den just de wait for people wey go bring more support so dat dem use dat one cash out b4 dem live office again. We really need to change dis people because nothing de work for this country.😬
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
New Topic: Peter Obi suspends all campaign



From the information above, Peter Obi decided to suspend all campaign calling on other presidential aspirants in the person's of Atiku, Tinubu to ceased on their political race.
Peso wey get human feeling suppose know sae this no be the time to move around from one to state to another for political campaign wey be sae the country wey you d inside the experience flooding. I hear sae Atiku, Tinubu don give out huge amount of money to states affected by the flood. It's a good thing sae we get leaders wey get human sympathy.

I believe sae with kind of plea by Peter Obi, other Presidential candidate go like reschedule and reconsider their campaign dates around the country

PDP TIMETABLE: Atiku's presidential campaign around the country



hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
CAN SHARING OF MONEY ERADICATE POVERTY FROM NIGERIA.

This mata dey disturb me, I dey see say 9ja government dey confused on hw dey go eradicate poverty for the country, but d way dey dey do am I no think say the problem go solve. CBN share money last weekend me too get the money my own na 4k but can this solve our problems. Pls house watin government go do to eradicate poverty now.
The money wey CBN release no be childs amount but see wetin reach you. Ma guy, if govt like make dem remove all f Moni wey dy CBN, doz corrupt pipo go fes collect dia share and if dis tin continue e go com become means wey dem go use flenjo.
 To eradicate poverty dey simple. Provide jobs and put pipo wey merit am inside, avoid nepotism and greed. Or you stop to go outside dey import tins, make doz wey get skill run am and you go see say poverty go use style jakpa
Na only incompetent government wey no get focus and sense on wetin to do to eradicate poverty because of their old stealing brain,na e go feel say to share money na the best thing to do for this kind country wey dem don scatter. Them must think say na to share money so that them too go benefit inside the money.
 Mr A get Nigeria funds of 1M,he go come announce say e won share money to Nigerians, because say na him b boss so e no go fit share am,so e go give Mr B wey be next to am 800k to share whereas Mr A don corner side 200k.Mr B go also cut him own share give Mr C,na so the corruption go dey circulate till he go reach the final person wey go share am to pipo.

This final sharers go come form processing things,if na 500 pipu them need,for Naija like 500M pipu to apply,at the end theses final disbursters go only give 250 pipu,then put their family pipu and friends,wey go come benefit the remaining 250 persons own,or sometimes dem fit even enter agreement say u go still find them small thing from that your own becos say na dem put your name. All these sharing money thing na device wey dey enhance corruption for the society. Na did make dem also dey share money for elections because dem know say na to deceive you,which is a corrupt known as election malpractice (selling of votes)
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Make una avoid multiple topics creation at a tym. E dey make the thread messy, no forget say na only here we get to discuss so try dey avoid disorganizing the place or e go results to deleting. Some topics wey una dey create no worth e own topic so just comment am as normal reply and those wey get interest go respond to your reply. No be every election headline we go make topic here. This thread is more that just discussing Nigeria election. Other reasonable discussion are welcomed.

Secondly, if you drop topic, try make one or two comment with your own view for that matter, this go help others to respond more. No just drop one line topic and leave am like that, it could be considered spamming. Make we dey help discussion here dey high quality, e go help your account as well. Local boards din dey get better voice, make we make our own small thread stand out as well. Una happy weekend.
Pages:
Jump to: