Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 59. (Read 1018844 times)

hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
So guys the three main contenders in no particular order na
+ Atiku
+ Obi
+ Tinubu

So guys Nigeria is on a part to becoming a major player in crypto-currency but the government can also accelerate that goal.
 So guys with your knowledge so far on this three candidates who una feel fit boost the growth of crypto-currency in the country.

Based on personal observation, the only person wey I no wey fit get the youth of this country for mind and person wey fit do things wey go favour the youth to me na Peter Obi. Peter Obi na confirm businessman and base on the things wey dom come out from em mouth so far, that man go make naija crypto-friendly and as em dom understand already even as em dey go about dey campaign say majority of the people wey dey support em campaign project na youth and like 80℅ of dem dey into crypto I believe say that one alone go make am do things wey go make cryptocurrency grow and dey well known and recognize for our country Nigeria.


Atiku too na man wey sabi business well well because em na confirm investor for naija here and outside the country em too fit do something to make sure say naija become crypto-friendly but I no go want make that man become our next president because em go use em power privatize and buy everything wey belong to the government and our economy go sink more because if you calculate the amount of money wey that man dom waste since em begin to dey contest for president eeh my people till em go rule finish for 8 years we go still dey pay the money so for this reason I no fit support am.

Tinubu for try well well because em dom show working for lagos when em be governor for dia and em develop the state without allocation from federal government but that man no no anything about wetin go benefit the youth so asking him to make naija to be crypto-friendly is like asking Buhari to pay asuu 500 billion naira before em comot for seat I believe we know say that one no fit work.
Na person wey dey smart, person wey young wey get good agenda and wey sabi handle things about economy wey we need now and among the three candidate wey dey here na just one person get that quality.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501

My Vote na Atiku ( no be say I want am to win or na him my vote dey go to for the real election) but since na based on cryptocurency matter; I remember him publishings this back in 2018: Nigeria’s presidential Candidate Promises Cryptocurrency Regulation if elected ansd I been create that thread then so although I never know him stand now but based on exiting knowledge na him I believe go fit deliver we Cryptopreneurs.
I no sae all man get the right to vote any candidate of his choice for this coming election. We don see how the present government d against crypto. So any government wey go take over whether na Atiku, Tinubu or Obi go like support crypto in one way or the other. Them no go like do d mistake wey the present government do about crypto.

I no know why our politicians dey like bring up tribal mata anytime wey em d reach for election period. How can a presidential aspirant like Atiku go talk sae
Quote
Dont vote for a Yoruba or Igbo candidate, vote only a Northerner
Na wetin Atiku advice em fellow Northerners. Assuming na Obi talk this kind thing, em for the trend all over Twitter. It's time for us to face the real fact, sae na Nigeria as a whole needs a big change. Na about been sentiment for the matter. The better we vote right, d better for us. Have we ever try to imagine the accumulated debts wey this regime don accumulate for us? Wetin we just need na a working government wey d ready to serve. Not a government wey go d travel go Dubai to go stay or travel go London for medication
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Good evening guys, can be do a brief discussion for anyone wey one drop him own opinion.
My person, make I ask you 1 thing. Na only this three people dey contest for the office of the president for 9ja?

My Vote na Atiku ( no be say I want am to win or na him my vote dey go to for the real election) but since na based on cryptocurency matter; I remember him publishings this back in 2018: Nigeria’s presidential Candidate Promises Cryptocurrency Regulation if elected ansd I been create that thread then so although I never know him stand now but based on exiting knowledge na him I believe go fit deliver we Cryptopreneurs.

My leader you truly get four eyes and you dey see well, not just based on the past post but most people wey surround Atiku dey tech inclined and them dey really follow up with the recent happening as them also know say na crypto dey drive us go where we no know.

Me personally weda na the crypto industry or any other sector of the economy, I believe personally say Atiku go deliver and that man na person we dey ready to even invest him money to achieve any goal wey he don write or talk keep. So I go vote Atiku anytime.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Good evening guys, can be do a brief discussion for anyone wey one drop him own opinion.
My person, make I ask you 1 thing. Na only this three people dey contest for the office of the president for 9ja?

Leave political talk, u and me and everybody know say na only 3 candidate get a shot at winning this presidential seat. Before now na only two but as the youth dun side Obi side, we dun get three now. Before I drop my own view, I dun make a poll so everybody for go vote. Voting no get to do with who is liking to win the seat or who you want make him rule but the person you believe say for encouge cryptocurency activity and lead to the adoption for the country.

My Vote na Atiku ( no be say I want am to win or na him my vote dey go to for the real election) but since na based on cryptocurency matter; I remember him publishings this back in 2018: Nigeria’s presidential Candidate Promises Cryptocurrency Regulation if elected ansd I been create that thread then so although I never know him stand now but based on exiting knowledge na him I believe go fit deliver we Cryptopreneurs.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.

If your face strong or you get dred for head or you dress fancy or ... them plenty. E don get interpretation for law and we need to redefine these things. Na why we need leader way no go dey too traditional. Those other men them, e go hard them to change because, na the traditional bring them to fame but the case different with Obi and e fit make crypto get pass for we naija.

Chairman I don dey follow your matter for sometime now and I go talk say you dey really calm down talk your mind and you dey always try to dey avoid to dey one sided.
With regards to this very men, personally if na crypto and the country at large aswear I go everly dey obident because I don watch and read matter wey that man don talk and e dey sweet my Belle.
Me I dey always talk am say politics na game of personal interest and Atiku na one man wey I know say in time past, he don create so many jobs for we country through he logistics company (INTELs) especially the one for onne and I been witness wetin people been suffer wen the onne seaport been shot down as directives from federal government, and how that matter alone been increase rates of criminality. But I believe say if Atiku win this election, INTELs go resume work and employ so many people and them go commence work for the proposed cargo airport wey dey Eteo, Eleme, hence plenty people go dey gainfully employed and money go circulate well and people go get money to invest for crypto because na who don chop dey invest and from my little research one of the major set back for people wey wan enter crypto na money as the major thing you go hear na buy low and sell high, how you wan take buy low when you no get money?.

Congratulations @frankolala and I believe say more dey come for you, and I dey tap in your grace.
member
Activity: 854
Merit: 13
                          My full member rank

I greet everybody for this house,how the hustle? I won annouce my new rank to the house as God don help me reach full member rank yesterday,e no child's. I thank all of una for this local board for una love and care wey una dey show for the board make God bless all una handwork abundantly. My respect for our Big Boss Brainboss wey dey enlighten us and show us the right way as a good role model for the forum, make God shower you with endless blessing for there.I still use this opportunity congratulate Agbe wey come first for the month highest poster. I see you
Congratulations bro I wish you more success ahead. No be small journey be this as you enter this position no relas said you now na oga you be. I want to see you in Sr member very soon. Once again congratulation for this rank position.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Good evening guys, can be do a brief discussion for anyone wey one drop him own opinion.
No be new thing say the next general election na next year. And we all here are Crypto-currency enthusiast at least the curiousness to learn crypto brought us here

So guys the three main contenders in no particular order na
+ Atiku
+ Obi
+ Tinubu
My person, make I ask you 1 thing. Na only this three people dey contest for the office of the president for 9ja?
Because the last time I checked, we have 18 registered political parties as at 2020 electoral law by Inec, and out of this 18 political parties, 16 of them submitted the presidential candidates to Inec before the 2022 election candidates' submission deadline. Even say na, Peter Obi, Tinubu, and Atiku are the most popular candidates if we must make a vivid point devoured of sentiments and political interest we should also bring in all the other candidates and make a poll to see what every one of them has to offer, corrupt politicians have designed weak institutions that make political parties a tool in the hands of the politicians to seize power so there is no true federalism what we have is the concentration of power in central where other components are weak. That is why we can't hear of the other presidential candidates so even if we end up choosing the best among Tinubu, Peter obi, or Atiku there is a high percentage that we have not elected the right President for this country, take the last US election for example so many unpopular candidates won into the upper and lower Chambers of the legislative arm of US, and that is a reflection of the effectiveness of their electoral system but such can not happen in Nigeria 🇳🇬 before you contest for the office of the President, you must come from among the three regions of Nort, west or east and those regions, only two among the three have dominated the Central since Nigeria independent. This is how slow and weak our electoral system has been, this same thing will happen in the 2023 election and we should not expect anything new from this politician they have game plans so it will amount to a was of time trying to analyze Nigeria's politics.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
So guys the three main contenders in no particular order na
+ Atiku
+ Obi
+ Tinubu

 So guys with your knowledge so far on this three candidates who una feel fit boost the growth of crypto-currency in the country.

Without being told, you go know say na the man weh him name deh Bible there na. Lol. No be say I want to talk Bible or religion here. But the answer is clear. Among them, na Peter Obi be the only person weh fit do something there. In a country where most people deh remove sentiments and talk constructively, it is clear say somebody like that sick grandfather no suppose even open him mouth to say him want to contest. Tinubu na agbado man, he knows nothing about cryptocurrency and will not support it. Atiku deh clueless.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
So guys the three main contenders in no particular order na
+ Atiku
+ Obi
+ Tinubu
 So guys with your knowledge so far on this three candidates who una feel fit boost the growth of crypto-currency in the country.

Senior man, if you wake me for dream any time ask me this question, I go tell you say na Obi. Apart from say him don dey show sign, Peter Obi know say na youths dey push him agenda and crypto na youths something, him go like support the crypto something.  
Aside from the youth something shah, make e just do watin dey good and beneficial for the country. If we look am like youth something, na em  be say, e don dey go one sided be that and that na based on support.
If we dey try look into these men them way face show say, na between them way the last president go emerge and which one go favour crypto matter, Obi don already prove en stand over and over again say, na youths e dey for. Una fit recall that video way drop with Obi for plan, dey try tackle EFCC to allow boys use there laptop  in peace, although en no mean am as fraud shah but, e dey try make point say, youths no mean criminal because, na so the country don dey be.

If your face strong or you get dred for head or you dress fancy or ... them plenty. E don get interpretation for law and we need to redefine these things. Na why we need leader way no go dey too traditional. Those other men them, e go hard them to change because, na the traditional bring them to fame but the case different with Obi and e fit make crypto get pass for we naija.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
                          My full member rank

I greet everybody for this house,how the hustle? I won annouce my new rank to the house as God don help me reach full member rank yesterday,e no child's. I thank all of una for this local board for una love and care wey una dey show for the board make God bless all una handwork abundantly. My respect for our Big Boss Brainboss wey dey enlighten us and show us the right way as a good role model for the forum, make God shower you with endless blessing for there.I still use this opportunity congratulate Agbe wey come first for the month highest poster. I see you
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.


So guys the three main contenders in no particular order na
+ Atiku
+ Obi
+ Tinubu
 So guys with your knowledge so far on this three candidates who una feel fit boost the growth of crypto-currency in the country.

Senior man, if you wake me for dream any time ask me this question, I go tell you say na Obi. Apart from say him don dey show sign, Peter Obi know say na youths dey push him agenda and crypto na youths something, him go like support the crypto something.  For the 3 candidates you list, I go say na Peter Obi be the digital mindset person wey dey there and things wey him no understand, him dey research ask questions, no be to dey form oga at the top.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
Good evening guys, can be do a brief discussion for anyone wey one drop him own opinion.
No be new thing say the next general election na next year. And we all here are Crypto-currency enthusiast at least the curiousness to learn crypto brought us here

So guys the three main contenders in no particular order na
+ Atiku
+ Obi
+ Tinubu

So guys Nigeria is on a part to becoming a major player in crypto-currency but the government can also accelerate that goal.
 So guys with your knowledge so far on this three candidates who una feel fit boost the growth of crypto-currency in the country.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
At last dem call off dis strike. I dey very happy for Naija students o. But d painful part now be say almost everybody wey been don enta school during Covid-19 go add extra two years for school now. One from Covid-19 and now anoda one from ASUU, 4 years course don turn 6 years now and 5 years course don turn 7 years. Afta dem finish school now, dem go say job wey dey available na for 25 years and below afta you don suffer finish for school. Dis naija mata ehn, God go see us through. E go better one day.
E no go better one day, e go better when we join hands together vote out this evil men wey sit down on top the progress and development of our country, the time for us to put ourselves on the right part to all round development in our country is in 2023, i they fear say if we miss this opportunity, we fit no get am again.

If Nigeria never make you talk "omoh" reach 10 times in a day, then maybe you no be Nigerian, Grin sometimes after you talk "omoh" you go shake head join am, it is pitiful, i keep wondering how person get mind they campaign for Tinubu and Atiku, upon all the red flags wey they fly around their body, na wetin make me believe say Nigerians they inure to sufferings, and we can never look above tribal and religious differences to do the right thing.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
At last dem call off dis strike. I dey very happy for Naija students o. But d painful part now be say almost everybody wey been don enta school during Covid-19 go add extra two years for school now. One from Covid-19 and now anoda one from ASUU, 4 years course don turn 6 years now and 5 years course don turn 7 years. Afta dem finish school now, dem go say job wey dey available na for 25 years and below afta you don suffer finish for school. Dis naija mata ehn, God go see us through. E go better one day.
Na true you dey talk but make even pray say dey no go go strike for next year because person no fit predict 9ja ooo. Dey dey share money now as I dey talk direct from CBN and dey no get money to give asuu.
Naso them they always talk but before you know now they go start agreement matter, true this matter done actually waste people time for this wee country, see women self wey don plan there self for marriage and the strike don fuck there plans up, he come be like say planning for this country no they work o, is good to plan but as the thing be for this country now you go plan one obstacle go just comot from no were God go sha see us true for this country I swear , na good news sha as them call off.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Na true you dey talk but make even pray say dey no go go strike for next year because person no fit predict 9ja ooo. Dey dey share money now as I dey talk direct from CBN and dey no get money to give asuu.
Na d tin b dat, we get joy o bt, d fear say dem go go again stil dey as na dere lifestyle. Demands dey always dey nd evn if by any miracle, govmnt pay everything way dem promise ASUU, dem go get anode demand. Dem jst dey unfair 2 Nigerian students.

At last dem call off dis strike. I dey very happy for Naija students o. But d painful part now be say almost everybody wey been don enta school during Covid-19 go add extra two years for school now. One from Covid-19 and now anoda one from ASUU, 4 years course don turn 6 years now and 5 years course don turn 7 years. Afta dem finish school now, dem go say job wey dey available na for 25 years and below afta you don suffer finish for school. Dis naija mata ehn, God go see us through. E go better one day.
Na d reality of skulling 4 we naija b dat nd d wahala wth being a common man 4 we countri. Pple way dey put all dis schuls mata on hold no get pikin 4 public schuls nd plenty cef no evn get pikin way dey schul 4 d countri. Na hw dem dey tak stay ahead, while Nigerian students dey lose months nd yrs of schulling, der own dey finish in time 4 abroad wth job way dey wait 4 dem.
Only God nd wth pur small effort 2 mak beta ft sae us 4 dis we countri.
member
Activity: 854
Merit: 13
At last dem call off dis strike. I dey very happy for Naija students o. But d painful part now be say almost everybody wey been don enta school during Covid-19 go add extra two years for school now. One from Covid-19 and now anoda one from ASUU, 4 years course don turn 6 years now and 5 years course don turn 7 years. Afta dem finish school now, dem go say job wey dey available na for 25 years and below afta you don suffer finish for school. Dis naija mata ehn, God go see us through. E go better one day.
Na true you dey talk but make even pray say dey no go go strike for next year because person no fit predict 9ja ooo. Dey dey share money now as I dey talk direct from CBN and dey no get money to give asuu.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
ASUU DON CALL OFF ITS STRIKE
The academic staff union of universities has bowed to pressure, obey court order and suspended its 8 months strike. From the official release from ASUU, e dey clear say FG never settle them but court order don force them to suspend the strike. E dey painful as ASUU and FG just waste our academic session for a complete eight months without achieving anything. I for like Post the picture but I no know how to. So I go drop the link to the image of the official release. Thou na just part wey show say na court order make dem call off the strike I drop. the last paragraph of the release

At last dem call off dis strike. I dey very happy for Naija students o. But d painful part now be say almost everybody wey been don enta school during Covid-19 go add extra two years for school now. One from Covid-19 and now anoda one from ASUU, 4 years course don turn 6 years now and 5 years course don turn 7 years. Afta dem finish school now, dem go say job wey dey available na for 25 years and below afta you don suffer finish for school. Dis naija mata ehn, God go see us through. E go better one day.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
Asuu called off the strike and all of a Sunday Nnamdi Kanu won his court case against the government, honestly the matter never clear. The general elections are fast approaching and political party are bringing all their measures to ensure success for the elections.

I think Asuu calling of their strike is influenced by the incumbent political aspirations to regain hold of sit and so is the court discharge of Nnamdi Kanu.

This is nothing but deep wisdom from you. I think the APC-led administration has failed and will fail again in the 2023 general election if they think they can buy the conscience of angry Nigerians with the release of Mazi Nnamdi Kalu and the calling off Asuu strike that has lasted for about 8-9 months. Well, nothing person no go see for here again as e be say 100 people go die but our government go come out for news say nobody die I no sure say e get anything wey them no fit do again to make sure say power remain for thier hand.


Make we no panic and make we no jones too because na when we dom give up for the fight to end bad governance na the time them go take advantage of us especially the youth, once we no let them influence us through their seasonal grants and giveaways, I believe say no matter their plans we go bring change wey we need for our country 🇳🇬 
hero member
Activity: 896
Merit: 612
ASUU DON CALL OFF ITS STRIKE
The academic staff union of universities has bowed to pressure, obey court order and suspended its 8 months strike. From the official release from ASUU, e dey clear say FG never settle them but court order don force them to suspend the strike. E dey painful as ASUU and FG just waste our academic session for a complete eight months without achieving anything. I for like Post the picture but I no know how to. So I go drop the link to the image of the official release. Thou na just part wey show say na court order make dem call off the strike I drop. the last paragraph of the release
Hehehe, this news just dey bittersweet. For some, na beta news as students no fit wait to rush go back school, but wen dem remember exam wey dey wait, Dem go dey sad. If you ask me I go say dis strike wey dem call off nah for two tins; to use collect more money from students as I hear say many more still dey apply for this ASUU related universities and to avoid court wahala because if election start, sch fit go break. So wetin come b d point?

 I dey hear say beta wharfing of students wey no fit meet up go dey and like dis nah so dem go kiss dia sch fees too o. Chai, but why e be say our govt no fit consider the plight of the poor masses wey dey hustle just to get a degree?
full member
Activity: 798
Merit: 134
Asuu called off the strike and all of a Sunday Nnamdi Kanu won his court case against the government, honestly the matter never clear. The general elections are fast approaching and political party are bringing all their measures to ensure success for the elections.

I think Asuu calling of their strike is influenced by the incumbent political aspirations to regain hold of sit and so is the court discharge of Nnamdi Kanu.

Well make una pardon me for awhile i never show face here but i as lap in like this i come dey see ASUU mata and the rest.
make i chuck mouth small, una think say everi tin dey pure for this we country?
no nothing is pure because they knew that without the ASUU calling off strike no much votes for them especially universities are the most populated now in terms of youths, in school they are far much and they are the target souls to vote for them. They have no option than to call off strike, then about Nnamdi Kanu, well i don't think Peter Obi journey would be successful without that man being free, you all may say forget about him or that but believe me, Igbo's have sense and they can operates in any dimension.
Pages:
Jump to: