Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 58. (Read 1018844 times)

hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
{~}

As e be like dis ehn everitin don cast. Atiku dey plan 2 sell di national assets which di Northern elites kicked against im in di 2015 nd 2019 election. Bcos di Northern elites r di major beneficiaries of di national assets in we kontri. Atiku na businessman so im go bring businesses wey go benefit everyone bt Atiku e no like di youths as well, Atiku also support di elite to elite wealth, nai make he dey give money 4 di elites well.

Obi go sure pass because im go carry along di youths, Tinubu wey used di youth fight against di youths e no go ever good 4 di position of di president.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Buhari government no steal money wey this people dem steal. Buhari been get good mind but clueless and this people dun spoil the palace before him come, I just wish who ever go enta dat seat go fit do something meaningful make we the ordinary person fit chop as dem dey chop.

Yes na true, i no sure say dem fit compare with dem at all.
make i no lie, chop na chop o, all those billion wey we dey hear say we presido carry go clean him ear no be beans oo. Those money wey him go borrow for China no small money oo, wetin him carry those money dem do. See my brother no body be saint for the seat nomatta wetin dem swear or take anything as oat once dem enta there forget their characters changes.

I just hope dem no go boycott the election like the last tym. Make Nnamdi calm down make election finish before him resume the struggle so obi fit get enough support/no excuse make this election sweet abeg.

Him no go make noise again na because Obi na igbo man and him been dey fight since make power at least enter Igbo for once make we change the country narratives, him major annoyance be say na only one people get everything for we country.
for instance;
Presidential seat: North
Chief of army staff: North
and many more to be called, so tell me why some people no go panic abi dem accompanied northan come 9ja to come watch them?
NO because yet na dem poor pass, na dem beg pass, na dem sick pass, yet dem no fit change we country for good, cattles inside city, na which developed country you see dem with that kind thing dey happen?

Omo plenty thing dey happen this country we need to fix, oya make we talk about GEJ him na successor of Yaradua and na cartel control the man despite say him president yet na still this same northan people dey control am, na wetin make as Obi jase out from his party go join Labour party him don consider say if him enter there nobody fit control am and him go be 001 there, na wetin make him get full support nation wide, and Nnamdi Kanu no fit caugh again so if him see say power no come to Igbo's na there you go see revolution of Biafra.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Wayin Atiku do that year shock even him way be the president and e dey imagine watin Atiku fit do if e take over power as president for the kontri. E go cast... we no fit talk finish shah!

I hear this rumour too because dem never hold am guilty. Him hiding dis kind thing that time says alot about who OBJ is, him wan look good meanwhile the country unda his watch dey die. What else did he hide because na him destroy this country. Buhari government no steal money wey this people dem steal. Buhari been get good mind but clueless and this people dun spoil the palace before him come, I just wish who ever go enta dat seat go fit do something meaningful make we the ordinary person fit chop as dem dey chop.

Anyways I hear say Nnamdi kunu dun commot prison, what a perfect timing, APC dun drop one strong distraction for the East. I just hope dem no go boycott the election like the last tym. Make Nnamdi calm down make election finish before him resume the struggle so obi fit get enough support/no excuse make this election sweet abeg.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
But why Obasanjo nor like Atiku and e dey openly talk against am? I don't think anyone knows Atiku better than OBJ, and if e dey talk say Atiku nor good, I believe am.

But wait oh, among everyone to believe na OBJ of all person? Obj wey bring down Jonathan to put Buhari wey dun keep this country like a his?  Same person wey work against Atiku to keep buhari for office to destroy the country finish, that same OBJ? I dun even hear one political rumour like that say obj no want any executive to renter that side again make nobody serve pass am. I even hear say that was the main reason behind that Jonathan betrayal say only am go serve for eight years and if Jonathan been return, him own go be 10 that's plus the 2yeaea of the previous president.
Omo I no too angry with these reasons way you put out like this. E no too get weight like that via the issue with the presidency. I no fit talk for the GEJ or our Buhari matter bit I fit tell you say, Atiku matter with OBJ na via fraud way Atiku run when e been dey serve as vice for OBJ. News way I hear one time like that carry say, Atiku and en wife been launder money through wire transfer go abroad and the matter later cast. Him kwa been OBJ follow for reasons why, them no fit arrest Atiku for the issue that year via say, na en vice and e go make en government look bad so, e cover the matter. Con no allow them extradite Atiku go abroad on the allegations against am na why, e dey openly kick against Atiku as president.

Wayin Atiku do that year shock even him way be the president and e dey imagine watin Atiku fit do if e take over power as president for the kontri. E go cast... we no fit talk finish shah!
member
Activity: 421
Merit: 47
But why Obasanjo nor like Atiku and e dey openly talk against am? I don't think anyone knows Atiku better than OBJ, and if e dey talk say Atiku nor good, I believe am.

But wait oh, among everyone to believe na OBJ of all person? Obj wey bring down Jonathan to put Buhari wey dun keep this country like a his?  Same person wey work against Atiku to keep buhari for office to destroy the country finish, that same OBJ? I dun even hear one political rumour like that say obj no want any executive to renter that side again make nobody serve pass am. I even hear say that was the main reason behind that Jonathan betrayal say only am go serve for eight years and if Jonathan been return, him own go be 10 that's plus the 2yeaea of the previous president.

Obj no supposed follow for people we go take their advice for this country as him get selfish interest. Dem follow among the reason wey this country dey like this. Infact all three aspirants follow for this country problem as none did well when they were in office. Make una no dey believe any of this political stories dem dey display. If dem all been do well, Nigeria no for dey were we today.

One thing wey ah don learn for politics be say na about interest; as citizens, we must push for contestants that their views work in line our interest. Obj endorse or no endorse has little relevance. AS i de so, na party wey go pursure my own interest with their policy ah de follow
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
But why Obasanjo nor like Atiku and e dey openly talk against am? I don't think anyone knows Atiku better than OBJ, and if e dey talk say Atiku nor good, I believe am.

But wait oh, among everyone to believe na OBJ of all person? Obj wey bring down Jonathan to put Buhari wey dun keep this country like a his?  Same person wey work against Atiku to keep buhari for office to destroy the country finish, that same OBJ? I dun even hear one political rumour like that say obj no want any executive to renter that side again make nobody serve pass am. I even hear say that was the main reason behind that Jonathan betrayal say only am go serve for eight years and if Jonathan been return, him own go be 10 that's plus the 2yeaea of the previous president.

Obj no supposed follow for people we go take their advice for this country as him get selfish interest. Dem follow among the reason wey this country dey like this. Infact all three aspirants follow for this country problem as none did well when they were in office. Make una no dey believe any of this political stories dem dey display. If dem all been do well, Nigeria no for dey were we today.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I have always been curious as to what the FG, EFCC always do with the monies, cars and properties seized from internet fraudsters. Does any one have any idea?
According to wetin I been hear one time, dem say any money wey EFCC seize either from cybercriminals or politicians dey enter one account pending investigation...but my people we know how this country be, that money fit dey enter one side, e dey possible say na story dem just dey tell us.

+ Atiku - Atiku been lead the most successful recovery for Nigeria in time past, when him and obasanjo been de control the affairs of the nation
But why Obasanjo nor like Atiku and e dey openly talk against am? I don't think anyone knows Atiku better than OBJ, and if e dey talk say Atiku nor good, I believe am.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
I have always been curious as to what the FG, EFCC always do with the monies, cars and properties seized from internet fraudsters. Does any one have any idea?

Na d same fraudulent act dem dey do na, dem go take all this things share wetin demselves for those branches government/people eye no too dey and others dem go auction am to demselves as the average man no fit enter buy those things at the low price dem dey auction am. My experience for those people office make me understand say wetin dey trend online say this EFCC dem be thief no be lie. You see the way people dey profile any young guy wey get iPhone as fraudster, wetin we go come talk about this officers wey get cars of all sharp and using expensive phones in their office, mostly iphone and majority na still young girls.

You dey see this corruption wey dey this country, no be small something as in the places you think say things for dey alright small na their the corrupt full. Make e no shock you say dem fit dun set that guy up. A typical yahoo boy dey avoid all this court cases as dem dey find way to settle the matter off court wey be say him go benefits especially those ones wey commit crime to outsiders. I hear say dem supposed return any recovered money to the rightful owner but how dem wan take know this owners which means dem dey pocket the recover funds unless na local scam wey person fit come claim am. Shaa if true true the guy na yahoo boy then another win for the good but what will happen to the recovered funds.
Boss u don use di hammer hit di nail. Na so di tin bi. Di former efcc boss was also accused of money fraud. I don't know whether im don clear imself 4 di allegation. And na Dem bi di pipo wey dey fight corruption oo. Oh Nigeria..di money wey snake swallow where Dem carry am go. Dem share am among demselves.


Bt if u luk well if to say dis Yahoo boys dey scam government only me I 4 like am bcoz na dia money wey e dey government hand nai Dem dey collect but whereby Dem come dey collect 4rom Oda pipo wey dey work hard to save to do won ton to another 2 beta dia life nai dem dey scam. Dat won 2 bad. From 2016 2 2018 I really suffer 4 dis boys hands. Dem used different Ponzi scheme 2 scam me well. Den 2021 was di last year dem scam me ND I no believe say dem go still scam me again.
hero member
Activity: 812
Merit: 927
I have always been curious as to what the FG, EFCC always do with the monies, cars and properties seized from internet fraudsters. Does any one have any idea?

all this looted funds na still loot dem dey loot am again na
Senior man if we wan reason all this things person go just ment. Imagine the 80 billion Naira wey dem collect with accountant general Malami and all those dem Abacha loots wey dem recover with some Paris refund. Even world Bank talk say dem don give this bail out money to FG for education and Agriculture oo and ASUU bin go entire 8 months strike and some people dey here dey talk say na ASUU get problem. We self na our problem wey be oo because once we begin dey ask government for all this money na that time things go begin dey soft oo. If you look 80% of people wey collect that yeye National Award wey Buhari share last week suppose dey jail but we dey applaud them come even honour them with national award.

The only difference with Yahoo boys and Politicians na Internet and biro. Yahoo boys dey use Internet scam oyibo people while politicians dey use biro scam us citizens
member
Activity: 421
Merit: 47

+ Atiku
+ Obi
+ Tinubu 

By comparing antecedents; i go list my views on the 3 candidature below.

+ Atiku - Atiku been lead the most successful recovery for nigeria in time past, when him and obasanjo been de control the affairs of the nation, Atiku focused more on opening the country to more opportunities back then and also widened nigeria tax bracket.

With this in view, we can talk say, atiku go epp tech and crypto, as he believes in allow multiple streams of forex enter come the nation, also citizens go worry less about crypto tax cos atiku believes in economy recovery plan while enabling citizens survive

i say 8/10, using antecedents.


+ Obi - after about 4 years as anambra governor; thanks to numerous impeachment and election troubles he faced; the antecedents for obi de comparable to atiku; obi also believes in allowing more forex into the country; but with wetin e do for anambra; e show say e struggled to improve the common living standard in the state as e de unable to get his house in order to complete the numerous ideas weh hin get

Also, na wetin lead obi to de save money be that. That aside, Obi will definitely support tech and crypto currency; also, obi is known as a taxer (just like tinubu). so i would say with Obi, you should prepare to pay crypto tax well well, obi no go let you rest; and e no go fit improve common man living standards too (just as e happen for anambra). na core reason why people prefer ngige be this. (no SHADES)

6/10

+ Tinubu  - I DE SORRY, i de very bias for anything wey concern tinubu. Why be say, tinubu and acn are advocate for povery in nigeria, from increasing tax, to passing laws that makes life difficult for the common man na their way of life.

If tinubu enter, na only God go save tech and crypto traders because case go be like baboon de work, monkey de chop; also there will be developments just as the case for obi and atiku; there will be numerous thuggery too.

like i do tell my padi, a vote for tinubu is a threat to my life haha.

On the contrary, i just want a president that will open up the economy and let us be, just like jonathan and obasanjo did. Tinubu and apc does believe in that.
cheers guys
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
When I reached di bank. I told di customer care service provider and he told me dat I would give him 10k and I said oga I am not a Yahoo boy.

You can imagine the boldness of thieves. Them go deh act like say them no know the real people weh be Yahoo boys. E deh clear say most of the account scams weh deh happen for people bank accounts na those thieves weh pretend to be bankers deh do am. I believe them no panic you much anyway and they later release your cash without long talk. Even those weh deh around us for compound self go deh take eye look some of us when no get any other offline job as Yahoo boys because as we deh stay house and flex well.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341

 Does any one have any idea?


All of Dem dey do di same thing. All di moni wey efcc don collect 4rom pipo where dem dey? All do loots di government don collect since 2015 till date where dem dey? All r one. Bt 4 di Yahoo boys and girls weti dem dey do e no good at all. Other pipo go work hard 2 get moni dem go dey house dey scam dem. Dat one na veri bad thing. Me I no dey see weti efcc dey do dis boys oo. Dis boys dey give Moni 2 efcc dey pass do weti dem wan do. Imagine, one day I went to bank to withdraw my Moni and bank blocked my account because of the amount has passed the limit but na small Moni oo. Just 110k. When I reached di bank. I told di customer care service provider and he told me dat I would give him 10k and I said oga I am not a Yahoo boy. I wan use di moni buy electric outside di bank. Imagine how much dem dey collect from dis boys. If Nigerian Police, efcc, banks courts nd any other agents dey do dia work well, I believed Yahoo 4 don go down well well.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I have always been curious as to what the FG, EFCC always do with the monies, cars and properties seized from internet fraudsters. Does any one have any idea?

Na d same fraudulent act dem dey do na, dem go take all this things share wetin demselves for those branches government/people eye no too dey and others dem go auction am to demselves as the average man no fit enter buy those things at the low price dem dey auction am. My experience for those people office make me understand say wetin dey trend online say this EFCC dem be thief no be lie. You see the way people dey profile any young guy wey get iPhone as fraudster, wetin we go come talk about this officers wey get cars of all sharp and using expensive phones in their office, mostly iphone and majority na still young girls.

You dey see this corruption wey dey this country, no be small something as in the places you think say things for dey alright small na their the corrupt full. Make e no shock you say dem fit dun set that guy up. A typical yahoo boy dey avoid all this court cases as dem dey find way to settle the matter off court wey be say him go benefits especially those ones wey commit crime to outsiders. I hear say dem supposed return any recovered money to the rightful owner but how dem wan take know this owners which means dem dey pocket the recover funds unless na local scam wey person fit come claim am. Shaa if true true the guy na yahoo boy then another win for the good but what will happen to the recovered funds.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
NEW TOPIC: Court forfeits ‘Yahoo Boy’s’ N40m Bitcoin to FG

Crime doesn't pay and never will. Money wey go give peace of mind even if na one naira better pass 40 million naira wey you go get wey you not go fit drink water drop cup. I go give una the summary of the gist wey I read for The Nation online newspaper

  • The Federal High Court in Lagos has ordered the forfeiture of 1.982, 022, 84 units of Bitcoin worth N40million, to the Federal Government.
  • The cryptocurrency, according to the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), belongs to one Alkali Naziru Tanimu, suspected of involvement in internet fraud, locally known as Yahoo Yahoo.
  • Justice Nicholas Oweibo, who made the order, also forfeited to the government an iPhone 12 Pro Max; iPhone 7, and all funds found in account numbers 0301510085 and 2174982616, domiciled in Guaranty Trust Bank Plc and UBA Plc, respectively, said to belong to Tanimu.
  • Investigation suggested that the suspect was into dating scams where he poses as, and used the picture an Arab woman to defraud unsuspecting victims on the internet.

Now imagine the sleepless night wey this person don pass through to collect the N40m. I have always been curious as to what the FG, EFCC always do with the monies, cars and properties seized from internet fraudsters. Does any one have any idea?
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
~snip~
We nor fit tell which of the candidate dey crypto friendly. Not even the youth's favourite. But one thing we I dey sure be say the man go get listening ear to look into am.

As per people wey dey affected by the flood directly and for us wey dey affected indirectly, I just want make you know say no situation dey permanent. This one go pass too. But my question be say which measure wey our countri don put in place to ensure say next time even if Niger Repulbic, Benin Republic and Cameroon release the water wey dey their dam e nor go swallow us?

See the passport for one hand and PVC for another hand na two-factor authentication be that as one person talk for twitter. 
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Not a government wey go d travel go Dubai to go stay or travel go London for medication

We no come here come drag politics, the question na which of the candidate go make Nigeria cryptocurency friendly for better adoption. Every politician get their own strategy, say one dey favor you no mean say the other no know wetin him dey do. As you talk so you no outline why you believe this candidate go fit well for cryptocurency progress for the country or not. Abeg as we dey discussion make una understand say, we no dey drag who go win or not abi who dey carry everybody along or only their brothers, the question our chairman raised na which one go recognize we the crypto community and na wetin we dey discuss now.

Again make I remind everybody say I dun point am for pinned post so everybody for vote. Also my condolences to those wey dun lose love ones to this flood wey dey disturb we country and for anybody wey e dun affect indirectly or directly, I dey sympathize with you. One day we go celebrate a better Nigeria, just hold on.

PS: I hear say RichKid dey secure Visa while we dey secure PVC, chai what a life lol.
sr. member
Activity: 700
Merit: 348
After observing and going through the discussion so far, I Don notice two things here. One be say sentiment don lead most of una and the other way be say some people dey fear to talk their minds base on say dem go collect from some people. Everyone just dey talk about Obi this Obi that ehhh una don forget how we take hail Buhari? And see where we are today. Obi is never a Saint moreover, he dey among the bad leaders wey help spoil this country. All of them na bird of the same feathers abeg. In my own opinion Tinubu is the most suitable among the contender but age no go allow him perform well. We saw and heard about his performance in Lagos state. I'm sure he (Tinubu) go get him own lapses as a human but he dey more qualify than Obi if we are to fair with ourselves but sentiment no go allow us see that. All we dey after is na igbo turn to be president and nothing more na why 95% of his supporters dey east. The earlier we stop talking about zoning, the better for us a country. Let go for the fair candidate (since all of them are the same thing) kwankwaso is least talk about but he's not bad. Talking about Obi, What has done during his days as a governor? Threatening to sack the VC while ASUU went on strike or the doctors that went on strike for several months without attention abi the state money he use to invest in family business una dey call achievements? Na wa ooo but sha let keep our fingers crossed and be watching as things unfold ahead of 2023 election.
 
I no dey campaign for Tinubu or any candidate but saying the truth wey dey my mind.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
My Vote na Atiku ( no be say I want am to win or na him my vote dey go to for the real election) but since na based on cryptocurency matter; I remember him publishings this back in 2018: Nigeria’s presidential Candidate Promises Cryptocurrency Regulation if elected ansd I been create that thread then so although I never know him stand now but based on exiting knowledge na him I believe go fit deliver we Cryptopreneurs.
I voted Tinubu because of his previous leadership experience. I agree that a country like Nigeria needs someone who is young and healthy to run the country's affairs, but I won't be upset if Atiku or OBO win. They are all the same. Since 1999, the Southeast has had no good leadership, which is why all of the southeast states are underdeveloped.( I may be wrong)

Floods have devastated half of the country, and none of these candidates have proposed a long-term solution; all they have done is send condolences and donations. Meanwhile, all we need to do is build dams in each of these states and, for God's sake, stop depending on the Cameron Dam!! We can also generate electricity and put an end to flooding with these Dams. Our leaders would rather send donations to gain more RT on social media... Hypocrites.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
So guys Nigeria is on a part to becoming a major player in crypto-currency but the government can also accelerate that goal.
 So guys with your knowledge so far on this three candidates who una feel fit boost the growth of crypto-currency in the country.
Tbh with you i do not know about that, Peter Obi is the youngest of the three and imo he seems to be the one that clicks quite well with the youths and all, so he prolly might be more receptive to change in the aspect of cryptocurrencies in Nigeria, mind you again that i am saying all of that based on a hypothetical situation, i do not know what will happen in respect to crpto if any of them gets to the seat of power.

Having said that, what i do know is that cryptocurrencies are the least of our problem as a country, my brother we have a plethora of problems that needs good leadership to address it, and Peter Obi is the better person in that respect, he is a purposeful leader and he has in him what is necessary to set Nigeria on the right part, we have poverty to address, unemployment, economic collapse, corruption, nepotism, bigotry, favoritism, inflation, and to put in a general term: a failed nation, now do you still think "which of the candidates can boost cryptocurrencies" should or is our problem heading into the 2023 general elections.
member
Activity: 854
Merit: 13
Good evening guys, can be do a brief discussion for anyone wey one drop him own opinion.
No be new thing say the next general election na next year. And we all here are Crypto-currency enthusiast at least the curiousness to learn crypto brought us here

So guys the three main contenders in no particular order na
+ Atiku
+ Obi
+ Tinubu

So guys Nigeria is on a part to becoming a major player in crypto-currency but the government can also accelerate that goal.
 So guys with your knowledge so far on this three candidates who una feel fit boost the growth of crypto-currency in the country.
Me I dey reason ATIKU because him get properties for dubai and dubai now want tune into cryptocurrency nation so I dey suspect say him go done sabi the cryptocurrency well, I go even boost out say ATIKU dey connected to cryptocurrency. If ATIKU be our president we go transact freely wit digital crypto.
Pages:
Jump to: