Curious Question about using Local P2P VS Exchange in-app P2P service.
My pipo I greet una. Abeg I wan ask this question wey dey my mind. Between our local P2P(the one wey we dey run with our paddy wey we know dey into buying and selling of biticon and other cryptocurrency) and using the P2P trade option for Binance, Remitano or Paxful, or any other exchange which one we feel say dey better? In terms of convenience, security and assurance, user experience?
Avoid see finish, Nigeria no safe, even though na your paddy wey be say you believe am die say him no go fit do you bad, avoid transacting big amount wey be say you know say even though na you wey person begin dey transact that kind amount, you go wan know how far for sake of him showing you wey so you fit dey cash out that amount too for extra income. Make I tell you story, e get person wey been dey trade just $100 with me like weekly on a constant level and the campaign him dey no dey pay reach that amount. Without any harmful reason me self gaz ask am how far (and na two reasons bring that question come out) firstly I need know the business wey dey generate such cash flow on a weekly so I go sure no be street him dey scam and na me dey trade am.
Trading for street guys frequently can put you in the shoes of a picker and secondly me been wan just find extra income to use body. But this one na me I no get any bad intentions na imagine if na person wey get bad intentions, you dun go out your head for trouble. Even the big platforms for peer2peer, I dey hardly trade with one person more than ones as I know say those platforms dey secure and nothing fit happen to my funds on some level unless na me use my hand release am when I never verify receiving the money. Make we just dey careful, crime committed towards you, infomat no dey far from you.
You no dey out of context as it concerns the level of trust wey we suppose accord to persons wey dey close to us or per P2P transactions. The truth be say, some fraudulent individuals dey use this P2P take siphon illegal money, and person wey get sense suppose by all means necessary to avoid getting involved in such.
This cautionary story follow for watin make government of most nations dey try employ the services of online security agencies, so as to put eye for misleading P2P transactions.
One get to dey extra careful so as not to fall victim by being implicated as an accomplice or something else not legally defined.
Shine your eye well well mostly for online transactions and use trusted agent like Paxful on binance wey dey recognized and mostly used for this side of Africa.