Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 62. (Read 1019097 times)

sr. member
Activity: 700
Merit: 348

Lol first of all with or without IPPIS people go still steal and the ASUU UTAS is not immune of corruption. FG agree to include all they've been asking for in IPPIS but ASUU still kicked against so dem go continue with their fraud. Talking about jumping from one Uni to another, no be me and your chance dem dey block so? The money wey FG dey spent on revitalization before, you see any changes for your school? FG secondary schools are still in good condition make I clear your doubt bro. Wetin FG tell them na true thou if dem wan compare their pay with politicians they should better go and start farming. Shey dem say teachers reward is in heaven. Talking about buying cars and spending on neighboring countries is a must for the survival of Nigeria in the midst of francophone countries surrounding our borders. You go know better of what I dey try talk if you Sabi Nigeria foreign policy.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
THE MATTER NA THIS OIL THEFT.
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?

My brother, I dey reason dey go your side too oh. You see ehh even the illegal bursting of pipeline and refining self, government still follow.

Na the true position of wetin deh happen be that. Government get hand for all this bunkering thing. Otherwise wetin go make them rush burn every vessel weh them say them catch for bunkering. They should be keeping the vessels as evidence so they can prosecute those thieves weh them say them catch if they weh be government no get anything to cover up. Another thing be, why police or the army weh deh catch those vessels no deh parade them for media like them deh parade common criminals? Na them them deh run am. This country don cast well well for a long time now. Abeg make China or Russia come buy this country make everybody rest.
hero member
Activity: 812
Merit: 927
ASUU don try to be a good negotiator for this their fight for the betterment of our educational system. After every fight, negotiation supposed dey. Both parties don finally to agreement.

Na good thing sae ASUU don agreed to call off the strike finally after the magnanimous behaviour of the FG. Make ASUU lecturers no worry, na gradual process, wey the FG go take met all their demands
Oga ASUU no try anything dem no just get options again. Nothing change except the arrears wey FG agreed to pay in tranches the rest na same promise wey dem dey reject before. Na court just humble them but dey Wan use HoR intervention cover up. The ASUU Chairman sef lack everything called manner.
Senior Man I Don notice your replies he be like u dey vex with ASUU more than government me I no know y oo. If we look this thing wella although ASUU dey fight for dem pockets too but don look there demand and how much government don waste since then. Make I list them,
1. IPPIS: ASUU talk say them no wan gree am because he no reflect there allowances. Sincerely that one no be lie because even people wey dey thing most importantly NASU and SSANU don dey complain. ASUU come talk again say irregularities dey that thing and he be like say God vindicate them because Former Accountant General Malami bin embezzled 90bn using thesame IPPIS. Concerning lecturers wey no go fit teach for more than one university, see even oyibo people wey we dey copy dey do shifts so we no fit stop am. The last thing again be say why government go promise them UTAS and come back on there promise after dem say he pass there assessment test?

2. Rivatalization: bros abeg u fit check our secondary schools how them don useless because of lack of funding. I sabi say only government no fit fund uni but y una go reduce there budget money compare to last administration own. Government come even get mind talk say make dem Increase tuition fee that one self they try tell us say dem no want make common man pikin attend school be that. Painful part be say some of them for that government na free scholarship dem take use do school finish oo.

3. Still on top school funding! You Don ever notice why Nigeria no dey compete for Nobel prize in science but na only literature own wey dey win. Because no equipped labs to work in. Almost all chemicals na imported ones and dem dey expensive. Na this lecturers sometimes dey pay by there Money oo that thing dey discouraging na

4. You talk say ASUU chairman dey arrogant but u don see watin all this yeye ministers dem tell them. I remember minister of state for education dey even tell them say make them go Farm if them want more money!! Imagine the talk bros.

Since February wey ASUU go strike federal government don waste Billions on top nonsense like the cars wey dem buy Give Niger Republic
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
Coyster face show well well.
My face no only show oh, my Nike shoe shine too, i no go lie you oh, our local thread really improve well well oh, this burst of activities wey you they see here so ehn, no be by luck e take come oh, people don they enjoy to comment for here, the discussions carry better quality and na so contructive posters they drop their comments one after the other, e make sense wella oh, and na to continue in the same way na im remain.

Having said that, abeg make we maintain the standard wey we they set for here, too much talk about merit/merit begging no they welcomed for here abeg, and even outside of here too; if you make quality posts merit go come, that one na sure thing. Well Done my brothers, i believe say sooner or later we go get our own local board.
sr. member
Activity: 700
Merit: 348
ASUU don try to be a good negotiator for this their fight for the betterment of our educational system. After every fight, negotiation supposed dey. Both parties don finally to agreement.

Na good thing sae ASUU don agreed to call off the strike finally after the magnanimous behaviour of the FG. Make ASUU lecturers no worry, na gradual process, wey the FG go take met all their demands
Oga ASUU no try anything dem no just get options again. Nothing change except the arrears wey FG agreed to pay in tranches the rest na same promise wey dem dey reject before. Na court just humble them but dey Wan use HoR intervention cover up. The ASUU Chairman sef lack everything called manner.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.

 Las las govt don agree to dia demands wey dem for do since.

No bi 2 agree but 2 give dem nai bi di wahala. No bi promised dem been dey promised dem b4. Fg sef e no dey sincere, na dem dey cause all dis yamayama.


I don talk this matter about ASUU tire and e no dey ever give me joy because both government and ASUU no try at all. Before I been dey hail ASUU say Dem try and make them strong leg make we end this strikes matter once and for all, because I see no reason wey government go cut education allocation comot and come dey owe worker, this matter no pure.

And one of the major challenge we dey face na the fact say some major position of government na by appointment rather than election, because I never see how e go easy for person to come bite finger wey feed am, e no  go easy except na sabotage wey he dey plan.
And this matter be like say this two bodies dey use students play very seriously and e no suppose be so because at the end of the day wether ASUU gree or not, students go suffer am directly. Because if government accept to pay any money, then them also suppose pay students some compensation as well.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
 I get somtin wey dy gimme stomach pain and I say make I bring am hia make we put mouth.
E consan d flood wey dy wori us for some parts of the contri, especially 4 Rivers State, ogbaland.

 Dis mata don hapn be4 for 2012, and nah Lagbo dam for Cameroon and now, my annoyance be say e be like we govt just fold hand dey look as katakata dey burse. Why dis kind tin wey dey quik turn national problem no one get solution? Abi na becos e neva enta Aso Rock?

 85% of di blame sopoz go Cameroon becos lai dis business, lives, livestock go dey affected and prices go go up. Imagine, nah 20 communities don dey affected. Bridges, farms and school no de left out.
As e b, even our senior man, @Agbe dey affected by the flood for Bayelsa.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
Make una see dis matter. I see am 4rom whatsapp o.
Quote
NOTICE OF SUSPENSION OF ASUU IDENFINATE STRIKE OF ALL MEMBERS UNIVERSITIES ACROSS NIGERIA

The Academic staff Union of Universities, following an order by Industrial Court and Court of Appeal on 7th October, 2022 sequel to Memorandum agreed sign by Federal Government has on Tuesday 11th October, 2022. The Strike which embarked starting from 14th February, 2022 Temporary suspended. Hence, all schools are urge to resume full activities from Monday 17th October, 2022 while announcing the suspension of strike, our Union will not hesitate to review its position should Government reneged on the signed Memorandum of action.

The union apologize for all inconvenience caused to students and parents alike.

 ASUU President
una don see am b4?
ASUU don try to be a good negotiator for this their fight for the betterment of our educational system. After every fight, negotiation supposed dey. Both parties don finally to agreement.

Na good thing sae ASUU don agreed to call off the strike finally after the magnanimous behaviour of the FG. Make ASUU lecturers no worry, na gradual process, wey the FG go take met all their demands
hero member
Activity: 798
Merit: 635
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform

Quote
NOTICE OF SUSPENSION OF ASUU IDENFINATE STRIKE OF ALL MEMBERS UNIVERSITIES ACROSS NIGERIA

The Academic staff Union of Universities, following an order by Industrial Court and Court of Appeal on 7th October, 2022 sequel to Memorandum agreed sign by Federal Government has on Tuesday 11th October, 2022. The Strike which embarked starting from 14th February, 2022 Temporary suspended. Hence, all schools are urge to resume full activities from Monday 17th October, 2022 while announcing the suspension of strike, our Union will not hesitate to review its position should Government reneged on the signed Memorandum of action.

The union apologize for all inconvenience caused to students and parents alike.

 ASUU President
una don see am b4?

No mind dem jare, ASUU neva suspend any strike, dem just say dem don see light 4 d end of d tunnel. Na their lawyer first talk before other news con dey join am. General stakeholder meeting and vote go happen 4 Thursday and Friday, na after den we go know wetin dey sup. E be like say dem go call d strike off bcos shame don dey enta their camp small small. I 4 prefer make dem fight dis fight till last but wisdom go dey appreciated 4 dis kind tight situation dem dey.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341

 Las las govt don agree to dia demands wey dem for do since.

No bi 2 agree but 2 give dem nai bi di wahala. No bi promised dem been dey promised dem b4. Fg sef e no dey sincere, na dem dey cause all dis yamayama.

Flood disaster in Bayelsa
Di flood dey increase everi second. Nd making pipo 4 homeless. As it is now in Yenagoa, e don dey around my house, nd I no no where 2 park go sef. nd like dis, dis thing fit affect me 4 coming 2 forum.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us. THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved
 
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?

4 dis kind tin to de happen, government they involve because pesin we no de d government no fit get mind burst any pipeline because even if him bust am, them go catch am. All issue wey de hapn 4 dis 9ja, government de know, but dem fit no stop am because dem de get benefits 4rm dem

You know lie. Na di true be dat. 4rom which sea port did oil theft dey carry di oil go abroad dey sell if di govt no follow? Di big pipo in di govet nai dey send dis boys dey do all dis things, nai make anti-theft square e no dey catch dem any day. If any pesin wey no bi 4rom di group go nd tif oil dem go catch dat pesin dat day dat day. Nd tell di world say na im dey do all di oil theft nd jail im den continue dia work again.



Make una see dis matter. I see am 4rom whatsapp o.
Quote
NOTICE OF SUSPENSION OF ASUU IDENFINATE STRIKE OF ALL MEMBERS UNIVERSITIES ACROSS NIGERIA

The Academic staff Union of Universities, following an order by Industrial Court and Court of Appeal on 7th October, 2022 sequel to Memorandum agreed sign by Federal Government has on Tuesday 11th October, 2022. The Strike which embarked starting from 14th February, 2022 Temporary suspended. Hence, all schools are urge to resume full activities from Monday 17th October, 2022 while announcing the suspension of strike, our Union will not hesitate to review its position should Government reneged on the signed Memorandum of action.

The union apologize for all inconvenience caused to students and parents alike.

 ASUU President
una don see am b4?
I hear of the fact say dem wan call off the strike becos even d president of ASUU don gree to call of the strike after dem meet wit House of Assembly and tok say dem go call am off after some days. E also say d government don resin to add #470bn for dem budget to help meet ASUU demands.

 Las las govt don agree to dia demands wey dem for do since.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341

bearly 50+ source merits dun beg tayah no response.

,_how I no go dey this list even commo 5 for the whole month Abeg check again my blood dey hot.

Jesus Christ of Nigeria, na 50 naira nai theymos dey give u. Abeg 4give mi I no no. Nd 98 percent of di pipo e no no, if 2 say I no make dat comment wey u come reply, boss we no go lie most of us think say na di same Merits source nai all of una dey collect. As u don tok am, no wa. Bt I no dey beg 4 merit just dat I like charity work nd wen I dey see pipo make nice comments nd I no get am 2 give, di tin been dey worry me but as u don tok am I don hear. Make our bosses no vex. Me 2 I dey try 2 make sure say pipo come hear dey make comments by encouraging dem. Bt as e bi now make una no dey worry boss again im don explain everything so make una lie low. Any how we go am twele twele dey go. Boss I salute u
4 di list, me 2 I surprised 4 not seen boss name even igehh name is not on di list. Boss was making comments very well last month as well as igehhh who was making comments on di Market prediction was not found in di list. Probably, it was a mistake.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
I also hereby beg our bosses 2 empower me 2 empower low rank pipo. 10 or 20 merits giving 2 me by our bosses will also help me 2 help low rank pipo dat makes reasonable comments nd dis list.

Chairman, this one na merit begging wey go Harvard. Why give you 10/20 merits just to get less spendable merits when we can easily merits the newbie quality comment that you're taking about ourselves? Just highlight dem and if they're merit worthy they'll be encouraged by anybody with smerits also no dey compare my source merits with those oga at the top. Those men dey get 500+ source merits and yet still dey ask for more meanwhile people like me wey get bearly 50+ source merits dun beg tayah no response. If you observe those oga merits amount you go understand say the source merits plenty and earned smerits as well so no expect same treatment wey dem dey give una for me to do the same that way I'll run out of smerits within days.

Understand this is just a thread and not yet a board we don't have merit source allocated to this thread, anything you see here na from Good heart and your quality and never an obligation so don't see it as a must for you to merit anyone here. Anyways were this can stats come from, how I no go dey this list even commo 5 for the whole month Abeg check again my blood dey hot.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
NIGERIAN LOCAL BOARD THREAD ACTIVITY UPDATE FOR SEPTEMBER, 2022.

Before I go continue I wan make one important Announcement:

1. Igehhh don add poll for Nigeria Local Board Update for Meta. Make we try go vote for there. Nobody know how this local board wan take come, make we try utilize every opportunity we create.

Top 30 active users September 2022
Code:
1. Agbe [21]
2. uchegod-21 [20]
3. Davidvictorson [18]
4. Coyster [17]
5. Gozie51 [17]
6. Awwal08 [14]
7. Cryptomultiplier [14]
8. Yawa2020 [14]
9. Frankolala [11]
10. EarnOnVictor [10]
11. Marykeller [10]
12. Mate2237 [10]
13. Rruchi man [10]
14. Adbitco [9]
15. igehhh [9]
16. Mr.right85 [8]
17. Asiska02 [7]
18. Hyphen(-) [7]
19. cryptalogic [7]
20. Detritus [6]
21. Majestic-milf [6]
22. RockBell [6]
23. Wiwo [5]
24. Anguwa [4]
25. BIT-BENDER [4]
26. GiftedMAN [4]
27. NdaMk [4]
28. Oluwa-btc [4]
29. Smartvirus [4]
30. knowngunman [4]


Total posts: 311 posts
Total poster: 49 users


Comments/Observations
  • Agbe don top this table for second time consecutively. And if you observe well, na so so quality posts him dey drop. Congratulations Agbe and keep it up
  • Uchegod-21 don swear say if him no fit dey first, atleast him go remain for top3 dey go. Adbitco and Gozie51 don slide commot for top4 for the league.  Dem don carry Wiwo my man dey go the play em no know  Grin
  • Davidvictorson don climb 3rd position, make we clap for him. Him go enjoy wetin Agbe and Uchegod-21 dey enjoy
  • Coyster face show well well. I dey wait when other senior men dem like BIT-BENDER,  igehhh,  Charles-Tim, Mpamaegbu and others go fit top this table again.
  • Abi na my eyes dey pain me? CryptopreneurBrainboss no dey dis list so. All those things wey him dey post here, na for dream???
  • New faces for the month na Dentritus, NdaMk, cryptalogic and knowngunman.  I welcome all of una and wish una smooth growth for here
  • Finally, after Charles-Tim close the door, lock the gate last month, e don handover the key to unknowngunman  ;DMake everybody behave well till next month, make una observe who hold key o


Advice:

Make we dey careful for our real life, as December don dey reach and election dey by the corner, many yamayama things dey happen for the country. Make we try keep our hands clean as people wey don dey enlightened.
Agbe comment for your merit.
Thank you @all.





I was not really expecting myself to be the first or on top of the list but you. Well I congratulate myself. As for the merit I promised the user that would make for the quality comments here only on crytocurrencies and igehhh was the one and I believed, I dropped a merit 4 dat promised 4 this list I would really like to give merits to the first, second and third position every months but I am not a merit source so I am restricted to that, therefore as The Pharmacist begged theymos 2 top up his allocations 2 help low rank pipo I also hereby beg our bosses 2 empower me 2 empower low rank pipo. 10 or 20 merits giving 2 me by our bosses will also help me 2 help low rank pipo dat makes reasonable comments nd dis list. CryptopreneurBrainboss, BIT-BENDER,  igehhh,  Charles-Tim, Mpamaegbu etc. Giving me 3, 4, 5, 6 7 etc merits can help me 2 help quality posts here, u can give me in oda place but I must come here 2 help our active users, make una look into di matter. As we dey house (home) na we know ourselves. I really like to help. Egberifa. Ado,ooo
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us. THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved
 
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?

4 dis kind tin to de happen, government they involve because pesin we no de d government no fit get mind burst any pipeline because even if him bust am, them go catch am. All issue wey de hapn 4 dis 9ja, government de know, but dem fit no stop am because dem de get benefits 4rm dem

You know lie. Na di true be dat. 4rom which sea port did oil theft dey carry di oil go abroad dey sell if di govt no follow? Di big pipo in di govet nai dey send dis boys dey do all dis things, nai make anti-theft square e no dey catch dem any day. If any pesin wey no bi 4rom di group go nd tif oil dem go catch dat pesin dat day dat day. Nd tell di world say na im dey do all di oil theft nd jail im den continue dia work again.



Make una see dis matter. I see am 4rom whatsapp o.
Quote
NOTICE OF SUSPENSION OF ASUU IDENFINATE STRIKE OF ALL MEMBERS UNIVERSITIES ACROSS NIGERIA

The Academic staff Union of Universities, following an order by Industrial Court and Court of Appeal on 7th October, 2022 sequel to Memorandum agreed sign by Federal Government has on Tuesday 11th October, 2022. The Strike which embarked starting from 14th February, 2022 Temporary suspended. Hence, all schools are urge to resume full activities from Monday 17th October, 2022 while announcing the suspension of strike, our Union will not hesitate to review its position should Government reneged on the signed Memorandum of action.

The union apologize for all inconvenience caused to students and parents alike.

 ASUU President
una don see am b4?
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
NIGERIAN LOCAL BOARD THREAD ACTIVITY UPDATE FOR SEPTEMBER, 2022.

Before I go continue I wan make one important Announcement:

1. Igehhh don add poll for Nigeria Local Board Update for Meta. Make we try go vote for there. Nobody know how this local board wan take come, make we try utilize every opportunity we create.

Top 30 active users September 2022
Code:
1. Agbe [21]
2. uchegod-21 [20]
3. Davidvictorson [18]
4. Coyster [17]
5. Gozie51 [17]
6. Awwal08 [14]
7. Cryptomultiplier [14]
8. Yawa2020 [14]
9. Frankolala [11]
10. EarnOnVictor [10]
11. Marykeller [10]
12. Mate2237 [10]
13. Rruchi man [10]
14. Adbitco [9]
15. igehhh [9]
16. Mr.right85 [8]
17. Asiska02 [7]
18. Hyphen(-) [7]
19. cryptalogic [7]
20. Detritus [6]
21. Majestic-milf [6]
22. RockBell [6]
23. Wiwo [5]
24. Anguwa [4]
25. BIT-BENDER [4]
26. GiftedMAN [4]
27. NdaMk [4]
28. Oluwa-btc [4]
29. Smartvirus [4]
30. knowngunman [4]


Total posts: 311 posts
Total poster: 49 users


Comments/Observations
  • Agbe don top this table for second time consecutively. And if you observe well, na so so quality posts him dey drop. Congratulations Agbe and keep it up
  • Uchegod-21 don swear say if him no fit dey first, atleast him go remain for top3 dey go. Adbitco and Gozie51 don slide commot for top4 for the league.  Dem don carry Wiwo my man dey go the play em no know  Grin
  • Davidvictorson don climb 3rd position, make we clap for him. Him go enjoy wetin Agbe and Uchegod-21 dey enjoy
  • Coyster face show well well. I dey wait when other senior men dem like BIT-BENDER,  igehhh,  Charles-Tim, Mpamaegbu and others go fit top this table again.
  • Abi na my eyes dey pain me? CryptopreneurBrainboss no dey dis list so. All those things wey him dey post here, na for dream???
  • New faces for the month na Dentritus, NdaMk, cryptalogic and knowngunman.  I welcome all of una and wish una smooth growth for here
  • Finally, after Charles-Tim close the door, lock the gate last month, e don handover the key to unknowngunman  ;DMake everybody behave well till next month, make una observe who hold key o


Advice:

Make we dey careful for our real life, as December don dey reach and election dey by the corner, many yamayama things dey happen for the country. Make we try keep our hands clean as people wey don dey enlightened.
Agbe comment for your merit.
Thank you @all.



sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
The Devaluation Of The Nigerian Naira

 A weak currency according to Ross Perot is the sign of a weak economy and which in turn leads to a weak nation.
According to Audu Ogbeh, the past Minister for agriculture and rural development, the tragedy of Nigeria started in 1986 when the then President, Ibrahim Babangida introduced the Structural Adjustment Programme (SAP).
Pple go get dere own model shah nd I go gree say weak currenci way b d naira in our own mata ft mean weak contri bt dat one no mean say, we weak 4 evri wher. We naija stil remain top 4 militari power 4 we West Africa evn thou, we neva ft resolv d plenty katakata way dey wori we nation.

Na tru shah say, na we b our own wahala. Why, we naija right frm independence, we sort more for life way we no ft provide 4 ourselves. Despite d resource way we get, both natural nd human, na test of civilization way we never mature reach 2 get way hungry us. Na so we start to borro 2 buy cum, dey deal wth d devil way go chop our head nd now, na sinking sand we dey inside wth govment way no get e pple 4 mind. D naija mata no start today!
Another thing be say we they give value to dollar pass our currency and most of the things wey we they use either make he be electronic etc na dollar we they use buy am the thing come tire me o, once dollar increase na so everything they increase for market both food wey we they plant naso the thing they go up which day person they complain say him buy local rice naso stone full am base on the foreign rice to cost , I come latter find out say them they intentionally no wan comot the stone say the quantity they reduce, see say no be only government get amendment  we self gats fix our selfs as citizen.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us. THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved
 
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?


I go give you real life and first hand information from wetin I done see no be Dem say Dem say! This nah first hand information as a waterside Bwoy I be. For the Okrika side, this pipe them Dem no dey inside ground for some areas, I for share pictures but I no dey okrika currently. E dey sup without Government notice even Nnpc no dey know for like one month.

For my secondary school days, I dey always dey duty post as prefect, so I witnessed army pipu and NNPC officials come around my school coz e dey near swamp area, niggas tap pipe from those pipe to that our school side, them say ( NNPC) say them dey get shortage and them come use them check to see if nah true and indeed nah him. Pipu weh do chemistry go know say this pipe get wetin Dem dey use check flow of the oil, ( I done forget the name, I go edit am immediately I remember ).

So nah so them cramp about ten to fifteen niggers, some done return from prison Sha, some still dey. Government no dey know, this days them dey even use bad boys dey catch other bad boy's. Na real cap I drop, I go drop pictures if person I tell to share me pictures drop am.
Them get tool's Dem deybuse run am and nah for zero zero hour's ( 2AM ) them dey move matters ( oil )
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Snip

See my brother let me tell you something about this oil theft or any other illegal theft happening around the country Nigeria, Know it and have Peace there is no any illegal connection, pipeline vandalization, killing and kidnapping that does not have a linked with at least one or two of the top rank politician that won't be involved. Do you think such operation would happen in that community without the Youth leader, King of the village, Local government chairman being involved?
The answer is simply No because such a heavy synchronization can't go on in that village (Zone) without those body's being among So if they want to investigates they should also hold all the above body's accountable for such compromisation in that pipeline.

We are talking of corruption this is how it all started, if all these can't stop how then do we have a good and restructured country, we have to do our best as Good citizens of country to make sure we the body's stay away from all mal activities let the blames go to Governments itself.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us. THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved
 
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?

I wan ask, wetin then the Nigerian Navy d do since? We get Joint Patrol Task Force for there. Now be sae all these thing d come out, wetin the so called Mr. President d do about am? Em no supposed to d carry out serious disciplinary action against these people starting from the Naval Chief? We no d help ourselves for this country of ours.

Buhari don give Tompolo free hand. The security agencies no fit touch am, NNPC cabal for use security agencies go after am. These things an inside jobs. No external person anywhere wey d steal the crude. Those militants boys in the creeks wey them d accuse just d collect only a pinch of wetin the cabal d take
Pages:
Jump to: