Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 63. (Read 1019120 times)

sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us. THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved
 
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?

This issue of oil theft e don they become problem for this our country you no fit pull this stuff with government not been swear , since the navy is in charge of fishing out illegal stuffs like this I don follow one security guy wey don work for delta tell me say all the security people get their own local refineries for there and government is loosing billions to oil theft, and na still them them they run this shit, be told president making is president making him self minister of petroleum  was a hudge mistake, and now people buys don reduce for oil since cars don they use light work or solar. So definitely there is something fishy about oil theft.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
THE MATTER NA THIS OIL THEFT.
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?

My brother, I dey reason dey go your side too oh. You see ehh even the illegal bursting of pipeline and refining self, government still follow. Make e no shock you say na dem dey buy most of the equipment needed for the referring and na force men dey guide those wey dey export to go sell so e no get how dem when tell me say their hands no follow for this one too. This country na just better cruise, how wetin dey give the country money no dey well safeguarded. That picture wey I dey see so, no be hand dem use run those connection na big machine, so how dem use transport am?

You even sure say dem no run am the very same day dem run those pipes because if cruel dey flow normally dem no go fit dey run this connection as e fit explode so either dem off am then run the bypassing or na follow come but anyone e be government dey aware.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?
You know eh, the thin wey dey pain pass for the whole matter be the way wey the same government dey come out come dey form ignorance just to insult our collective intelligence. I fit bet say even this one wey dem discover no be the only one wey dey. Probably, the person or persons nor gree settle na him make dem burst am. Time don reach wey dem suppose dey do public execution for corrupt public office holders wey dey collect bribe dey look another just to make this country spoil.
hero member
Activity: 924
Merit: 600
Leo is resting.
I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us. THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved
 
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?


This picture dey clear and e dey obvious say na men wey know the business weller dey run this kind illegal oil tapping for our naija here.
As person wey dey into oil business for naija here, I dom see tire but the business be say even when you catch the men dem wey dey do this illegal pipe drilling, tapping and smuggling, you no go fit make plenty noise because most of them get link to oga politicians them wey know men wey dey for the top so nothing fit happen to them even most of our politician's day into the business because na wetin dey give them better funds wey dem dey take dey oppress the youth dem for our country.


No way wey them go take pull this thing without the help of the government because every pipeline for naija get security way dey guide am and government dey get signal if anybody breaks any pipe to steal oil even the ship wey dem dey take move the product na move wey the ship dey move dem no dey fly.
sr. member
Activity: 630
Merit: 453
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
4 dis kind tin to de happen, government they involve because pesin we no de d government no fit get mind burst any pipeline because even if him bust am, them go catch am. All issue wey de hapn 4 dis 9ja, government de know, but dem fit no stop am because dem de get benefits 4rm dem
Bro no be  everything wen dey hapon government dey de involved, but I fit say na government the cause am becos if dey do tins well we no go dey behave like criminal.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
4 dis kind tin to de happen, government they involve because pesin we no de d government no fit get mind burst any pipeline because even if him bust am, them go catch am. All issue wey de hapn 4 dis 9ja, government de know, but dem fit no stop am because dem de get benefits 4rm dem

God go bless you my brother for dis talk weh you talk. Government with all its surveillance, equipment and personnel no go fit tell me say common citizens go still pass them. Anything weh deh happen whether good or bad the government deh aware. Ok, see the person weh government deh pay to safeguard the pipelines shebi na the same militant weh deh government wanted listed. Abeg, we never deh ready for this country at all. Na drama we deh act now, when we deh ready the world go know. Na all this things make the rest of the world no deh count us.
sr. member
Activity: 700
Merit: 348
4 dis kind tin to de happen, government they involve because pesin we no de d government no fit get mind burst any pipeline because even if him bust am, them go catch am. All issue wey de hapn 4 dis 9ja, government de know, but dem fit no stop am because dem de get benefits 4rm dem
Oga no talk like this abeg. No be every thing and every time we go dey blame government. For this particular one na we wey be citizens get fault here. How you go burst pipe fix another one for your own selfishness for God sake? What if the entire pipe cut in the process? Do you know the amount of lose it will cost the entire country? Honestly, we need to be responsible as a citizen and stop all these sort of criminality. Government does not have hand in this at all thou some security personnel might be their accomplice for chicken change. But with all honesty, na disgrace to this our nation as youths wey suppose make the country better don turn to day light criminals. The painful thing is that some people dey hail those criminals and finding this thing funny. Smh
member
Activity: 742
Merit: 30
I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us. THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved
 
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?

4 dis kind tin to de happen, government they involve because pesin we no de d government no fit get mind burst any pipeline because even if him bust am, them go catch am. All issue wey de hapn 4 dis 9ja, government de know, but dem fit no stop am because dem de get benefits 4rm dem
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
  Life no balance, the rich dey get richer and the poor dey get poorer. My vexation na way back wey Nigeria government go print 500 naira note and 1000 naira note so that make e easy for them to fit  thief big big money and you no go know. This na the first place wey dem fuck up our currency. Another one be say Nigeria fit produce and process so many things for the country into finished goods but instead,them prefer to buy from foreign country, e come be like say we no fit do without them becos of inefficient government for example Nigeria get refinery dey carry crude go foreign country go refine pay them money for there,then come still import the products back to Nigeria becos the people wey dey in charge of exporting the crude and bringing it back to we country na dem no want make our refinery work. Only crude oil get so many byproducts wey you go get not only kerosene,diesel, gas,petrol e.t.c because crude oil na hydrocarbon. I won ask what of other byproducts like bitumen,asphalt and the rest,meaning the exporters dey sell all these byproducts for foreign wey be another source of producing other goods wey dey useful to us.

 All these problems na e dey make our Naira dey depreciate everyday by day. We need government wey go support investing for Nigeria country than dey go invest for another man country, and also repair any Nigeria property wey don spoil, so that we no go do dey rely on foreign people. All these go add value to Nigeria currency and economy.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us. THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved
 
Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
The Devaluation Of The Nigerian Naira
Presently, the US dollar to the naira is #433.72 and the pound sterling is £480.84.

What then can we do to restore the naira before it goes to debasement?

Firstly, we need to stop to dey lie to ourselves abeg, foreigner wey read this your topic now go think say na wetin dollars be meanwhile men dey buy own #700+ for street. This dis dame things dey decieve our government, dem go dey give another value for something wey no be so for street. Even d banks no dey sell that amount you mention. The main cause of devaluation of currency na the economy and this one no be news again as the country economy no dey do well but the government no go come out talk the truth. Dem go dey lie say we dey improve meanwhile no be so.

If we fit get our economy up and running, borders get open and business return to as e been dey before I believe the Naira go quickly regain some value against dollar. The Naira dun fall to the extent we go need more than four years of good governance to get some strength to the Naira but e no dey impossible.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
What then can we do to restore the naira before it goes to debasement?
That one no really they our hands as citizens, i know say citizens they play their own part through microeconomics, but the main thing wey go get effect pass on the economy na macroeconomics, and the people wey they control that one na our government, based on how them make some of their economic policies, how them handle inflation, how them sort our production, import and export, etc, all of that they for government hand, and in the case of Nigeria so ehn, our government they renowned in making very bad decision, so i no know wetin be the fate of our currency/economy. Having said that, even before microeconomics go boom ehn, macroeconomics gats they okay, because na the effect go trickle down for the benefit of small and medium scale businesses (microeconomics).
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
But to my own perception both government and ASUU are responsible for deterioration of Nigerian education, owing to the fact that only in Nigeria that universities lecturers are paying by the government and strike is the only way for solving universities and lecturer's need.

The matter hard me to understand also. Universities abroad deh generate funds through patronage, aids and grants to take run themselves and not depend on any government for salaries and overhead costs. But Naija own must always deh different because some people want to cut from government. Na the same thing with our clubs for local league. Na state governments of various states deh supply them cash to keep them going.

The price for $1 don reach #725/720 oo

That one no be problem na for us weh deh here as I sabi say many of us here go want make exchange even enter N1k/$ today today so that pay go rise. Anybody weh want to deny this one deh lie to himself.
hero member
Activity: 896
Merit: 612

Another reason to be worried is that the naira was equivalent to the dollar and in close proximity with the pound sterling.
 

My guy the problem of the country na im dey affect naira and nothing else. No be magic go make naira improve. All those years back wey naira still make sense, the economy good and production dey go on but now ask yourself wetin dey go on for the country even you confirm say toothpick self ww dey import am. Okay make you check google and see how many companies dey run leave naija. Me I just check and drop these links. Even nairaland self, discussion dey there.

https://www.nairaland.com/2725494/list-multinationals-nigeria-crashing-under

https://tribuneonlineng.com/10-companies-shut-down-businesses-in-nigerias-food-beverages-industry-in-five-years/


Presently, the US dollar to the naira is #433.72 and the pound sterling is £480.84.


I hope you still dey with the current wave of price oo.lol no mind wetin dem dey put online. You know even sabi say the government pull down some site wey men dey take sabi the value for black market, dem close abokifx but you fit still take binance know price. The price for $1 don reach #725/720 oo
Dis price I give above nah according to bank rate and not black market o. Haba, I know say black market price don increase tey tey na. Ah, I still dey expect am to climb reach 750 or 800 sef
full member
Activity: 882
Merit: 207
~snip~
I know that very soon in no distant time ASUU strike and whatever strike will be a thing of the past. The recent face-off between the lecturers, FG and court reminds me the proverbial saying that you can force a horse to the river but you cannot force it to drink water. Fingers crossed to see what happens  next.
If FG forces lecturers and students back to school, who will teach, or grade their scripts? Handouts sale alone would be the means to survive as well as sorting, among other forms of money extortion methods known by these lecturers. Simply saying that, crime and other delinquencies are bound to suffice. The needful be done by FG
now, because whether we admit It or not, incoming government will find the Asuu issue difficult to effectually resolve.
hero member
Activity: 1022
Merit: 673
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The Devaluation Of The Nigerian Naira

 A weak currency according to Ross Perot is the sign of a weak economy and which in turn leads to a weak nation.
According to Audu Ogbeh, the past Minister for agriculture and rural development, the tragedy of Nigeria started in 1986 when the then President, Ibrahim Babangida introduced the Structural Adjustment Programme (SAP).
Pple go get dere own model shah nd I go gree say weak currenci way b d naira in our own mata ft mean weak contri bt dat one no mean say, we weak 4 evri wher. We naija stil remain top 4 militari power 4 we West Africa evn thou, we neva ft resolv d plenty katakata way dey wori we nation.

Na tru shah say, na we b our own wahala. Why, we naija right frm independence, we sort more for life way we no ft provide 4 ourselves. Despite d resource way we get, both natural nd human, na test of civilization way we never mature reach 2 get way hungry us. Na so we start to borro 2 buy cum, dey deal wth d devil way go chop our head nd now, na sinking sand we dey inside wth govment way no get e pple 4 mind. D naija mata no start today!
hero member
Activity: 2520
Merit: 624

Another reason to be worried is that the naira was equivalent to the dollar and in close proximity with the pound sterling.
 

My guy the problem of the country na im dey affect naira and nothing else. No be magic go make naira improve. All those years back wey naira still make sense, the economy good and production dey go on but now ask yourself wetin dey go on for the country even you confirm say toothpick self ww dey import am. Okay make you check google and see how many companies dey run leave naija. Me I just check and drop these links. Even nairaland self, discussion dey there.

https://www.nairaland.com/2725494/list-multinationals-nigeria-crashing-under

https://tribuneonlineng.com/10-companies-shut-down-businesses-in-nigerias-food-beverages-industry-in-five-years/


Presently, the US dollar to the naira is #433.72 and the pound sterling is £480.84.


I hope you still dey with the current wave of price oo.lol no mind wetin dem dey put online. You know even sabi say the government pull down some site wey men dey take sabi the value for black market, dem close abokifx but you fit still take binance know price. The price for $1 don reach #725/720 oo
hero member
Activity: 896
Merit: 612
The Devaluation Of The Nigerian Naira

 A weak currency according to Ross Perot is the sign of a weak economy and which in turn leads to a weak nation.
According to Audu Ogbeh, the past Minister for agriculture and rural development, the tragedy of Nigeria started in 1986 when the then President, Ibrahim Babangida introduced the Structural Adjustment Programme (SAP).

 The naira began it's downward descent when economists from Harvard advised it should be devalued, and sadly for virtually every week for 32 years the naira lost value. Another reason to be worried is that the naira was equivalent to the dollar and in close proximity with the pound sterling.
Presently, the US dollar to the naira is #433.72 and the pound sterling is £480.84.

 Nigeria has a problem of investing in local producers as a country, that is why you hear cases of the country spending $18m on toothpicks importation annually, $600m on fish annually and 5m eggs annually from South Africa. It actually makes no sense that a country which is richly blessed with natural resources and man power to produce and export is sorely dependent.

 What then can we do to restore the naira before it goes to debasement?
member
Activity: 756
Merit: 30
I observed one thing here most of the people commented here are doing it base on the political situation we are now in, some accused government just because they hate APC government and some accused ASUU because they are backing APC government.
But to my own perception both government and ASUU are responsible for deterioration of Nigerian education, owing to the fact that only in Nigeria that universities lecturers are paying by the government and strike is the only way for solving universities and lecturer's need. Is ASUU as a group of intellectuals can not find another alternative to press home their demands other than strike? What a shame!
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
  I blame FG  pass because just seat and negotiate aba imagine say them no pay them how them go feel this people to get family get children wey they go skul just look am say husband and wife na lecturer how do expect them to survive  FG  should just try abeg make people go back work.
Oga I no say federal government get fault too but na asuu dey prove strong head if no be say we students later no say dey dey fight for themselves not we. You say dey be family men or women wat about us wen must of our parents are local government work and dey dey hustle pay our school fees, rent, feeding, pocket money. Make asuu too look us with dat na. Dey should thank God dey are getting hundred of thousands naira monthly base. Everyone for nija no how local government salaries are. Make asuu know say dey are not beta than some of local government staff oooo,  so make dey no say na opportunity dey get, so make dey becareful.

My brother you talk very well here... if you check my last comment for this ASUU something, you go notice say I don dey neutral. Before now, I bin dey support ASUU, even when I be student under Jonathan regime weu de strike last for about 6months, I dey always support ASUU. But this time, I no support anybody again. ASUU na just association wey opposition dey use fight government wey dey for power. Which kind dialogue wey go reach 7 months but never yield results if it is done in a good fate.

Even students sef don tire to stay house and e don clear for their eyes say that ASUU hustle no go benefit them. Make dem resolve their matter amicably abeg.
Pages:
Jump to: