Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 64. (Read 1019107 times)

legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Nigeria court is a mess,all they do is to give bad judgement against the citizens. The judges are corrupt and have been bribed. If not for these lectures that taught them will they be where they are now. Imagine judgement, let them go back to classroom,is this not stupid,then why did ASUU go on strike,the problem has not been solved meaning the court and the government are taking ASUU for granted. Only God will save us from this confused government that has nothing to offer to us

My brother, the judgment tayah me, if I be ASUU you think say I go happy? See as the government dey throw money anyhow and I dey reason dem to pay me then na Court dem come dey carry me go because e dey control am. Make we no support bad thing as if dem fit run ASUU dis kind scam who the ordinary man come be na?. Na so so financial support we dey give other African countries and dem dey better meanwhile our own nothing concern us. Na to dey do like our people no matta. Most university na dem dey take care of themselves that's why you dey see all those fees here and there because if dem wait for the government no be today something.

Me I dey believe the government dey delay this striker until election come make dem use one stone kill two bird, like dem go call them enta close room. Give dem better money and even extra if dem go side with them. We know say na university professor dem dey use for the election and if you fit get dem on your side, anything is possible. This country tayah me but we keep pushing small small. Una happy Sunday ohhh. How the weekend dey be na?
newbie
Activity: 8
Merit: 0

Nd with dat there will be a big problem in Nigeria education system.



No be say there will be a big problem in Nigeria Education system, the problem don already dey there..... Which result we wan expect from people wei no deeply dey involved for the system make dem come dey lead that system.... Na to spoil things naw. How you go appoint accountant as minister of education, no be him field be that naw, so he never feel the first hand of wetin the people wei really dey the education system dey go through, if na one lecturer now dem appoint for that office, him go understand. But this government, dem know wetin dem dey do, na why dem no go just do the right thing
member
Activity: 854
Merit: 13
  I blame FG  pass because just seat and negotiate aba imagine say them no pay them how them go feel this people to get family get children wey they go skul just look am say husband and wife na lecturer how do expect them to survive  FG  should just try abeg make people go back work.
Oga I no say federal government get fault too but na asuu dey prove strong head if no be say we students later no say dey dey fight for themselves not we. You say dey be family men or women wat about us wen must of our parents are local government work and dey dey hustle pay our school fees, rent, feeding, pocket money. Make asuu too look us with dat na. Dey should thank God dey are getting hundred of thousands naira monthly base. Everyone for nija no how local government salaries are. Make asuu know say dey are not beta than some of local government staff oooo,  so make dey no say na opportunity dey get, so make dey becareful.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
~snip~
I know that very soon in no distant time ASSU strike and whatever strike will be a thing of the past. The recent face-off between the lecturers, FG and court reminds me the proverbial saying that you can force a horse to the river but you cannot force it to drink water. Fingers crossed to see what happens  next.

We know say e go soon be something of the past, but how much longer our students go fit wait again. Dis matter tire even people wey no be students again o. With d way d matter dey go now, dem fit no call off until afta election. Dem no wan give ASUU money again and dem get money to do campaign around. It is well sha, I just believe say anyhow e be, naija go beta one day and I no lose hope for dat.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
I see no reason why some very vital positions in the country like the chief judge, commissioner of police, head personnel's of the arm forces, even vice chancellors and rectors of higher institutions and worst of all INEC CHAIRMAN be by appointment and we still expect fairness and transparency for the common man ?
No it wouldn't be easy if ever possible.
Person no dey bite the finger way feed am or na so them dey talk am but children dey bite if you leave hand for the mouth too long, why? Them no sabi nothing, the corruption never reach them. Na why we dey advocate for a more youthful leader on the seat of government. The bad thing be say, most persons don corrupt on the sideline and just dey fine chance to exhibit there in built talent.

My man, FG lawyers in the court come tok say, make asuu should go to class (resume) and teach. So pipo wey understand di mata dey tok say, if FG force asuu go class e no good. Make Dem settle ASUU Dan to force Dem go class.
Anything way them do with force no dey go well, we no go gree dey always follow body and that we no go gree get plenty leg way e fit carry come. All of which, na the student go suffer ram and e dey very painful to have them at the end of every action and inaction. Na so there fate just be and e dey very very sad.
ASUU kwa don too do bcus, government don try see reason with them but, them no wan dey flexible no more. No be so the life be, them don show there anger, make them cool temper small and count the time way students dey waste at home. There are other nations with less resource and still, them dey produce sound graduate. Abeg, make them push with watin we get. We no go use one step, jump once once archive.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
~snip~
I know that very soon in no distant time ASSU strike and whatever strike will be a thing of the past. The recent face-off between the lecturers, FG and court reminds me the proverbial saying that you can force a horse to the river but you cannot force it to drink water. Fingers crossed to see what happens  next.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Den 2. Di Lectures might call off di strike based on di court order 4 1 week or days and went back 2 anoda fresh strike again. Den everything would start 4rom di beginning. Strike would be starting all over again.

Na so the thing go be at the end the way I deh see am because one of them oga don even talk am say if government force to resume, they will resume for few days and then go back to strike. See how politician don yeye our schools finish. I no like how that shortman Ngige and Adamu deh act around this whole ASUU thing like say them no go school at all. If to say Buhari make am a law say anybody weh go take up appointment must have their children in Nigeria schools all this thing for don end long time ago. Buhari self no better. In short all of them na the same group them deh, no one better pass.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!

FG no talk say make dem just go class like that but they should suspend the strike while negotiation continues. So what's the big deal there? ASUU are just inconsiderate tbh. Talking about the benefit of what they are fighting for, I don't understand please. Na the revitalization wey FG say he go dey pay batch by batch abi the EEA wey FG say 2023 budget go cover or the increment of salary wey FG agreed to increase by 23% but ASUU insisted on 100%? Which other benefits are you talking about? If Na the backlog salary you dey talk about, who dey pay who no work? It's the constitution unless government overlook it.


My man, FG lawyers in the court come tok say, make asuu should go to class (resume) and teach. So pipo wey understand di mata dey tok say, if FG force asuu go class e no good. Make Dem settle ASUU Dan to force Dem go class.

Nd really if asuu go class now... Di classes e no go dey interesting bcos Dem no go teach di stdents with dia whole heart bt with anger. Nd with dat there will be a big problem in Nigeria education system. Pipo go graduate 4rom University bt can not spell something Adbitco's story.


As 4 me, I no like weti fg do, instead of dem to heal di wound but dem dey make di wound more painful.
hero member
Activity: 896
Merit: 612
The issue be say he no go work ordering the lecturers to go back just like the court should also consider the fact that them no pay this people for 7 months now the major problem is that does guys are just not ready to pay all waiting our politicians problem now na election wey they come which is very selfish of them , in fact waiting they vex me pass na say make federal government seat down negiociate na problem for them that's not fair, na so so private uni they open for everywhere majority of those skul no get accreditation I see one which day from skul of health he become university how comes? see what the system is turning into and sincerely public skul is good but the government not taking it as a priority is a problem and na why for this part  I blame FG  pass because just seat and negotiate aba imagine say them no pay them how them go feel this people to get family get children wey they go skul just look am say husband and wife na lecturer how do expect them to survive  FG  should just try abeg make people go back work.
You no fit just order pesin to do somtin e no wan do becos nah who go sufa am, na d students. Imagine wia lecturer go ask you to sort on top somtin e no teach properly becos time no dey or zeal no dey. How does ones wey no hold rabas go do?
 
 I just want wia d govt go do d ryt tin instead of to dey turn turn children upandan. As e be sef students don taya to dey ya say strike go soon dey called off. Person wey dey learn some skills don sabi am to an extent sef. Make government reason them sef.
sr. member
Activity: 700
Merit: 348
The Asuu strike don last for over 7 months, with several university students left out of schools. And all the court fit do or the government na to order lecturers back to the lecture hall, how that one take happen?
This lecturers has sacrificed their scheme/schedule for the semester, students has lost several months on the educational calendar and the government think say them fit just order them back to the classroom just like that. Without giving them the benefit of what they are fighting for all this while.

I am also affected by this strike and it is heartbreaking that even after protests by students the government can find a way to resolve this situation. One of the big reasons is that their children aren't schooling in Nigeria so it's quite understandable and shameful.
Boss no vex abeg but make una dey try follow up the update as e dey be. FG no talk say make dem just go class like that but they should suspend the strike while negotiation continues. So what's the big deal there? ASUU are just inconsiderate tbh. Talking about the benefit of what they are fighting for, I don't understand please. Na the revitalization wey FG say he go dey pay batch by batch abi the EEA wey FG say 2023 budget go cover or the increment of salary wey FG agreed to increase by 23% but ASUU insisted on 100%? Which other benefits are you talking about? If Na the backlog salary you dey talk about, who dey pay who no work? It's the constitution unless government overlook it. No work, no pay. Let be honest with ourselves, ASUU na selfish union couples with greedy leadership. And for una wey dey blame FG for not implementing the MoU remember say na so Nigeria govt dey do with each other. The incumbent administration go sign agreement wey no fit possible to implement and thereby causing inconveniences for the incoming government. Na wetin Buhari dey warn Ngige and Adamu be that say make dem no promise ASUU wetin no go fit possible to implement for this administration and the coming administration cux na wetin cause this strike be that. Na why the strike even long reach this time. Believe you me if Na somebody wey no care Buhari be ehh ASUU Don end the strike tey tey cux na fake promise dem go do them.

I'm not saying FG is not at fault but ASUU is more to be blamed on top this matter.
sr. member
Activity: 868
Merit: 383
Underestimate- nothing
The issue be say he no go work ordering the lecturers to go back just like the court should also consider the fact that them no pay this people for 7 months now the major problem is that does guys are just not ready to pay all waiting our politicians problem now na election wey they come which is very selfish of them , in fact waiting they vex me pass na say make federal government seat down negiociate na problem for them that's not fair, na so so private uni they open for everywhere majority of those skul no get accreditation I see one which day from skul of health he become university how comes? see what the system is turning into and sincerely public skul is good but the government not taking it as a priority is a problem and na why for this part  I blame FG  pass because just seat and negotiate aba imagine say them no pay them how them go feel this people to get family get children wey they go skul just look am say husband and wife na lecturer how do expect them to survive  FG  should just try abeg make people go back work.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
The Asuu strike don last for over 7 months, with several university students left out of schools. And all the court fit do or the government na to order lecturers back to the lecture hall, how that one take happen?
This lecturers has sacrificed their scheme/schedule for the semester, students has lost several months on the educational calendar and the government think say them fit just order them back to the classroom just like that. Without giving them the benefit of what they are fighting for all this while.

I am also affected by this strike and it is heartbreaking that even after protests by students the government can find a way to resolve this situation. One of the big reasons is that their children aren't schooling in Nigeria so it's quite understandable and shameful.

There are two things involved by ordering the lecturers to return to the classroom. 1. You can force the horse 2 di water bt u cannot force him to drink di water. Lecturers might go to di class bt there will be no knowledge that will be impacted to di students. Dat is di worst part in education. Den 2. Di Lectures might call off di strike based on di court order 4 1 week or days and went back 2 anoda fresh strike again. Den everything would start 4rom di beginning. Strike would be starting all over again. As I said before and will be saying again and again di major problem we have in Nigeria is di court. if di court r really gud nd not corrupt there would have known di best to settle asuu b4 telling dem 2 resume. ASUU IS ANGRY SO GOING BACK TO CLASS WITHOUT SETTLING THEIR GRIEVANCES IS THE HIGHEST DANGER TO NIGERIAN EDUCATIONAL SYSTEM.
With this some of Nigerian youths are still supporting the....

I've spoken about this issue previously and bitterly and it's a great pity that at the end of this whole thing either resolved or not, it will be just the students that will suffer all the pains from this strike directly. I'm not actually blaming just the government or ASUU and labour force but  also blaming the entire country because of its poor governance and electorate system. I see no reason why some very vital positions in the country like the chief judge, commissioner of police, head personnel's of the arm forces, even vice chancellors and rectors of higher institutions and worst of all INEC CHAIRMAN be by appointment and we still expect fairness and transparency for the common man ?
No it wouldn't be easy if ever possible.

I just pray the bad eggs are fished out not just by shouting amen but getting our PVCs and voting out the wrong leaders.
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139

Boss na where you dey see your update? Nothing like dem dey collect their pay. Na why the matter even long reach now cux na the first month of their strike FG stop their salary. If to say FG they pay them their salary since then and up to now me sef go talk say ASUU no get conscience. The truth be say ASUU Don buy wrong market this time. Both ASUU Chairman and minister of labor dey prove strong head con take the matter personal. If you watch their last meeting with HoR leadership you go relate wetin I dey try Yan. Both FG and ASUU get issue I swear down but the God we serve go fight for us wey be the victim of their selfish interests.
You go agree with me say, no matter how this matter later turn, these guys go still collect salary for all the time way them seatdown for house dey form strike. Abi no be so? If e be so, we go say them dey pay them abi them no dey pay them?
The students way dey house so, watin go be there compensation for the months way them don waste like this...! For those way go use there certificate work as Civil servants, na years to there retirement don dey count so o.

U correct, both FG and ASUU get issue, but the 95% of the issue na 4 d head of FG, useless government. How u go sign MoU con turn around say e no possible again, na who dey do dat? As I dey like dis, I support ASUU, make dem kuma fight d battle to finish as we no get better government. Persin no fit do a 4-year course 4 naija wey at least 2 major strike no go dey. I use 7 years 4 university 4 a 5-year course about 15 years ago and part of d issues den still dey ground till now. Na real nonsense, make dem trash wetin dey cause am once and for all.
The government bad o, them bad well well but, we no dey pity for them kwa. Na everytime ASUU go put knife for there throat to sign watin no dey there body to sign, las las whe the capacity to meet up no dey, them go crucify them say them been don agree before. Na just the students I dey pity for this whole matter as, na them dey pay pass and yet, nothing them go still benefit.
hero member
Activity: 952
Merit: 742
Nigeria court is a mess,all they do is to give bad judgement against the citizens. The judges are corrupt and have been bribed. If not for these lectures that taught them will they be where they are now. Imagine judgement, let them go back to classroom,is this not stupid,then why did ASUU go on strike,the problem has not been solved meaning the court and the government are taking ASUU for granted. Only God will save us from this confused government that has nothing to offer to us
D mata self funny me sha, both d ASUU and d court people, na Federal Government get dem, so I no surprise wit dir judgment, because I know, say dem most give dem instruction to resume classroom.
But d problem be say dos lecturers no go wan teach student well and e go be waste of time. E go better make Federal Government no use force drag dem go back class make dem try settle some of their issues even if dem no go give dem all dir needs.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
 Nigeria court is a mess,all they do is to give bad judgement against the citizens. The judges are corrupt and have been bribed. If not for these lectures that taught them will they be where they are now. Imagine judgement, let them go back to classroom,is this not stupid,then why did ASUU go on strike,the problem has not been solved meaning the court and the government are taking ASUU for granted. Only God will save us from this confused government that has nothing to offer to us
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
The Asuu strike don last for over 7 months, with several university students left out of schools. And all the court fit do or the government na to order lecturers back to the lecture hall, how that one take happen?
This lecturers has sacrificed their scheme/schedule for the semester, students has lost several months on the educational calendar and the government think say them fit just order them back to the classroom just like that. Without giving them the benefit of what they are fighting for all this while.

I am also affected by this strike and it is heartbreaking that even after protests by students the government can find a way to resolve this situation. One of the big reasons is that their children aren't schooling in Nigeria so it's quite understandable and shameful.

There are two things involved by ordering the lecturers to return to the classroom. 1. You can force the horse 2 di water bt u cannot force him to drink di water. Lecturers might go to di class bt there will be no knowledge that will be impacted to di students. Dat is di worst part in education. Den 2. Di Lectures might call off di strike based on di court order 4 1 week or days and went back 2 anoda fresh strike again. Den everything would start 4rom di beginning. Strike would be starting all over again. As I said before and will be saying again and again di major problem we have in Nigeria is di court. if di court r really gud nd not corrupt there would have known di best to settle asuu b4 telling dem 2 resume. ASUU IS ANGRY SO GOING BACK TO CLASS WITHOUT SETTLING THEIR GRIEVANCES IS THE HIGHEST DANGER TO NIGERIAN EDUCATIONAL SYSTEM.
With this some of Nigerian youths are still supporting the....
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
The Asuu strike don last for over 7 months, with several university students left out of schools. And all the court fit do or the government na to order lecturers back to the lecture hall, how that one take happen?
This lecturers has sacrificed their scheme/schedule for the semester, students has lost several months on the educational calendar and the government think say them fit just order them back to the classroom just like that. Without giving them the benefit of what they are fighting for all this while.

I am also affected by this strike and it is heartbreaking that even after protests by students the government can find a way to resolve this situation. One of the big reasons is that their children aren't schooling in Nigeria so it's quite understandable and shameful.
sr. member
Activity: 1960
Merit: 329
www.Artemis.co
Palm Tree. Palm Tree can produce more than 10 products (groundnut oil, broom, red oil, soap, engine oil, powder, body lotion that is body cream, hairs cream, nerve medicine, lubricant, to pursue mosquitoes etc), This is only for Palm tree, in those days the West was coming to buy this tree in Nigeria and plant it at their lands and used it to produce a lot of things. if you dont know how to produce any of the above mentioned, tell me I will give the expository analysis (write up) here.

Na true for the things weh you list but that groundnut oil own. For my place na Ororo them deh call am. That oil no deh good for health because of high cholesterol weh deh am. I deh avoid using it. Infact na because of am make me no deh eat anything fry fry outside my house because I no go know which kind oil them take fry am.

Which of the Presidential Candidate has mentioned any of the things I listed in their IDEOLOGY, BLUEPRINT, MANIFESTO? Non. There is a different between a leftest, a centrest, and a rightest. All Nigeria leaders that I know now are RIGHTEST. That is, they are not progressive but conservativist.

No mind them. All of them deh try play safe. Them no want talk or do anything weh go cost them their 2023 ambition, that is why they are sitting on the fence.
member
Activity: 854
Merit: 13

Dem go obey the court order?
Dey have to obey d order from court becos federal government dey wait for small mistake wen asuu go do to give than punishment. If you watch the meeting dey had with speaker you go think say na personal issues dem get btw asuu and Labour minister na him be my reason dat. Asuu no fit do strong head na. Na federal dey pay dem na.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
One truth to this matter be say, strike or no strike, these lecturers no run out of job and e no stop them from pursuing there individual career objectives. As them dey strike so, them still dey collect there pay, seating in there houses. The only thing way them dey miss be sorting money and small chippings them dey extort from students.

I doubt say ASUU dey supportive of students else, they for realise say, them too fit help government solve the matter with education if them feel say, government no dey try. I no go like discuss personal issue but I recall a laxity expressed by a lecturer in my time of just walking or driving down a 2kilometer distance to verify the state of a matter that has been pending for over 7months. The guy just banked on whatever excuse he had until he was ordered to and the list has been lying there for over that period of time, waiting to be picked up.

E go hard for us to dey get solution until these guys handling public office are affected by the deeds of there expenditure. There children needs to enroll and pay the price as well. The sacrifice no get to be one sided.
Students are loosing valuable working time. Person never work, e don dey retire. How can we be having year 1A, B and C cef, its unheard of.

ASUU don fail out 4rom appeal court.



Dem go obey the court order?
Pages:
Jump to: