Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 67. (Read 1019366 times)

sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.

 Bros you dey welcome for we naija board. We use our two hands embrace you,my small advice for you be say you need to try make you grow for the forum,any question wet you won know about bitcoin we get professionals for here like our Big man Brainboss,people like igeehhh and many more we go give you perfect answer.life dey easy na just how you understand am.

You too much chief. "LIFE DEY EASY, NA JUST HOW YOU UNDERSTAND AM." This your talk really touch me for body, and I thank all my people wey welcome me for the platform because I don hear plenty beta tins about una and I believe say e no go reach my turn come change.
I still dey believe say wetin we no know pass us and I no even believe say place wey legit like say and you dey see reward for effort and hardwork.
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Curious Question about using Local P2P VS Exchange in-app P2P service.

My pipo I greet una. Abeg I wan ask this question wey dey my mind. Between our local P2P(the one wey we dey run with our paddy wey we know dey into buying and selling of biticon and other cryptocurrency) and using the P2P trade option for Binance, Remitano or Paxful, or any other exchange which one we feel say dey better? In terms of convenience, security and assurance, user experience?

Avoid see finish, Nigeria no safe, even though na your paddy wey be say you believe am die say him no go fit do you bad, avoid transacting big amount wey be say you know say even though na you wey person begin dey transact that kind amount, you go wan know how far for sake of him showing you wey so you fit dey cash out that amount too for extra income. Make I tell you story, e get person wey been dey trade just $100 with me like weekly on a constant level and the campaign him dey no dey pay reach that amount. Without any harmful reason me self gaz ask am how far (and na two reasons bring that question come out) firstly I need know the business wey dey generate such cash flow on a weekly so I go sure no be street him dey scam and na me dey trade am.

Trading for street guys frequently can put you in the shoes of a picker and secondly me been wan just find extra income to use body. But this one na me I no get any bad intentions na imagine if na person wey get bad intentions, you dun go out your head for trouble. Even the big platforms for peer2peer, I dey hardly trade with one person more than ones as I know say those platforms dey secure and nothing fit happen to my funds on some level unless na me use my hand release am when I never verify receiving the money. Make we just dey careful, crime committed towards you, infomat no dey far from you.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Curious Question about using Local P2P VS Exchange in-app P2P service

Well for me using our local p2p is more better since is trusted and reliable compared with Binance p2p, for Binance p2p as a beginner you really need a guilder someone who would help you know how to make used of it. but local p2p you don't need any since we have some trusted service  provider like our 001, then i was actually using his p2p service before i understand how to handle Binance p2p., Most times is a matter of price change and service fees that makes me use Binance p2p.
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Curious Question about using Local P2P VS Exchange in-app P2P service

My pipo I greet una. Abeg I wan ask this question wey dey my mind. Between our local P2P(the one wey we dey run with our paddy wey we know dey into buying and selling of biticon and other cryptocurrency) and using the P2P trade option for Binance, Remitano or Paxful, or any other exchange which one we feel say dey better? In terms of convenience, security and assurance, user experience?


As 4 me oo, di local won nai sure pass base on say, u know di guy and imself know u. bt di problem bi say na di price wey dem dey carry buy am nai bi di wahala we dey face so. 4 my experience on dis few days wey I don hustle small. Oboy Binance beta pass ramitano and paxful. But Binance dey delay well well if di buy e no dey online na so u go dey wait oooo some di time frame wey dem give sef go finished nd wen di time wey dem give 4 di trading period come finished nd di vendor neva pay di money dem go return d coin back 2 ur wallet. nd 4 ramitano ta!!! no go area, na won kind yeye app. But all dis thins e no go happen 4 local p2p of buying and selling. But all depend on di person wey won buy or sell. many pipo dey run 4rom local p2p bcos di price. If not i like it locally.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

3)Anonymity/privacy, submitting KYC documents on exchanges is a no-no for some people, so if you are that person who doesn't want to do that, you should stick with your local P2P vendor, at least chatting the person over TG or Whatsapp somewhat protects your identity, or else you decide to reveal it to the vendor, so in this case, i guess you local vendor might be a much better option in terms of privacy/anonymity.

I been think say e get wetin you for chiping for here about the privacy something but I no see am.
For example, CryptopreneurBrainboss dey run exchange, so since wey I exchange 5 BTC finish with him, I dey fear to go him area make e no for set me up because him don sabi say I over hole the bar. You get my point now. That one na another reason why some people dey consider run their transactions for p2p exchange where person no go sabi who dem be and person go hardly trace them.
So, the privacy something just dey in two ways, e just depend on the one you wish to sacrifice.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
My pipo I greet una. Abeg I wan ask this question wey dey my mind. Between our local P2P(the one wey we dey run with our paddy wey we know dey into buying and selling of biticon and other cryptocurrency) and using the P2P trade option for Binance, Remitano or Paxful, or any other exchange which one we feel say dey better? In terms of convenience, security and assurance, user experience?
It depends on you the user, many things are to be put into consideration, things like anonymity, security, rates, speed and a lot of other things, you can even use the both of them, what i mean is, you can trade with a local P2P vendor on some days and use an exchange P2P option on some other days, depending on your mood that day and what you are actually looking for.

Having said that, the first thing is if the vendor is trusted (the issue of security), that is only when the comparison can start, thus if you have a trusted local vendor you can decide between using either of the option based on some reasons like:
1)Rates, i think exchange p2p option offers better rates that most local P2P vendors, i stand to be corrected, but from my experience i think i am correct.
2)Speed, on this very one, i still think exchange P2P option is as well faster, most times you can reach out to your local vendor either on whatsapp or whatever platform you communicate in, and they are either busy with something else and cannot attend to you at the moment. Or for some of them that aren't so big, you'll have to wait some minutes for them to trade what you sent to them, before you either get your cash or crypto, because they do not always have it regularly available.
3)Anonymity/privacy, submitting KYC documents on exchanges is a no-no for some people, so if you are that person who doesn't want to do that, you should stick with your local P2P vendor, at least chatting the person over TG or Whatsapp somewhat protects your identity, or else you decide to reveal it to the vendor, so in this case, i guess you local vendor might be a much better option in terms of privacy/anonymity.
4)Supporting a friend or brothers business, if your friend or colleague prolly sells and buys cryptocurrency, you can look above all the cons and stick with trading with them, afterall them they talk say we rise by lifting others.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
BTW; I run local P2P services.

I need $198 BTC for my $200 MATIC
I would like this deal but, still wish for us to negotiate some more slash if possible. How about we handle this in the pm or which ever means of communication available and okay with you, I would like that. Mak we run this matter, na part of the advantage way we get between us to from and dey use the same local board. I dey with you brotherly.
Check your telegram I sent you DM
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
BTW; I run local P2P services.

I need $198 BTC for my $200 MATIC
I would like this deal but, still wish for us to negotiate some more slash if possible. How about we handle this in the pm or which ever means of communication available and okay with you, I would like that. Mak we run this matter, na part of the advantage way we get between us to from and dey use the same local board. I dey with you brotherly.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1104
Bitcoin Casino Est. 2013
Curious Question about using Local P2P VS Exchange in-app P2P service
which one we feel say dey better? In terms of convenience, security and assurance, user experience?
They are both good but just do the one that is convenient for you. For instance say you cannot trade yet personally on all those trusted P2P apps and you don't have a guide to help you, no need to do a trial by error method with your coins, you can just contact some trusted members here in our small community that run exchange services for people, like cryptopreneurbrainboss, pokapoka etc... they can help you exchange your coins safely without you needing to try something you do not understand first.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Curious Question about using Local P2P VS Exchange in-app P2P service

My pipo I greet una. Abeg I wan ask this question wey dey my mind. Between our local P2P(the one wey we dey run with our paddy wey we know dey into buying and selling of biticon and other cryptocurrency) and using the P2P trade option for Binance, Remitano or Paxful, or any other exchange which one we feel say dey better? In terms of convenience, security and assurance, user experience?


If you need decentralization use in person p2p it's more safer if the dealer is trustworthy since there is third party  but if you value your identity then you need P2P platform or Exchange in-app. The only disadvantage of using in-person p2p is that you likely going to get robbed by your business partners since he knows more about your finance



BTW; I run local P2P services.

I need $198 BTC for my $200 MATIC
member
Activity: 421
Merit: 47
Curious Question about using Local P2P VS Exchange in-app P2P service

My pipo I greet una. Abeg I wan ask this question wey dey my mind. Between our local P2P(the one wey we dey run with our paddy wey we know dey into buying and selling of biticon and other cryptocurrency) and using the P2P trade option for Binance, Remitano or Paxful, or any other exchange which one we feel say dey better? In terms of convenience, security and assurance, user experience?


i no sabi why i just hate paxful hehe, i no de like am since very beginning. Local p2p don cast too, the level of trust wey de town don diminish and everybodi wan avoid stories that touch the heart na why binance remains the king sha.

For p2p trade, i go remember binance, remitano, okx, paxful, kucoin in that order. As per nigerian wey ah be, ah don get fav accounts to do p2p with on binance already on a soft level
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Curious Question about using Local P2P VS Exchange in-app P2P service

My pipo I greet una. Abeg I wan ask this question wey dey my mind. Between our local P2P(the one wey we dey run with our paddy wey we know dey into buying and selling of biticon and other cryptocurrency) and using the P2P trade option for Binance, Remitano or Paxful, or any other exchange which one we feel say dey better? In terms of convenience, security and assurance, user experience?
legendary
Activity: 2380
Merit: 4265
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
My people I dey hail oo una brother dey here. I dey thank God say our boss don make things easier say we fit dey relate for here without others to choke mouth an I dey hail am and give am salute for this very effort. And I wan use this medium to say make una try accept me with open heart as na the hustle we dey for here. I say make I raise two hands up for una as I go do my best to dey drop better things. Uma do well.

Welcome my brother, no worry too much if you no get any digital skills yet, the Nigeria system no be favors skills so our parents no be too focus there, na now dem dey see say that way na the way forward now, like if you want survive you need get one or two digital skills that help you push through. I welcome you to the forum and to this our small hideout spot wey we dey use hold body they reason one or two things wey dey our mind. We dun beg forum tayah e come belike we get other things to do but hopefully one day we go celebrate our local baord just as we been dey celebrate Nigeria independent some days back.

Abeg as people dun cap you, no forget to read and understand the rules and regulations of this forum as e no dey make self when one of our brother give up due to some stupid mistakes wey dey very avoided. U get men dem here and they ready to help you, no feel shy to ask questions and dey ready to learn before you dey reason the bread side you f the he forum. I welcome you to the board and forum in general, goodluck.
hero member
Activity: 910
Merit: 574
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
           Smiley FUN FACT'S

     
    YESTERDAY MANCHESTER CITY BEEN WAN FOLLOW CELEBRATE NIGERIAN INDEPENDENCE DAY BY WINNING 6-2 BUT ANTONIO MARTIAL NO GREE! NA SO E HANG PENALTY TO MAKE AM 6-3  Wink

       Decent day ahead Y'all. Make we go try take our PVC and Vote wisely.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Username: Obari
Gender: male
State of resident (optional): Port Harcourt
Bros you dey welcome for we naija board. We use our two hands embrace you,my small advice for you be say you need to try make you grow for the forum,any question wet you won know about bitcoin we get professionals for here like our Big man Brainboss,people like igeehhh and many more we go give you perfect answer.life dey easy na just how you understand am.
member
Activity: 854
Merit: 13
Username: Obari
Gender: male
State of resident (optional): Port Harcourt
Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend.: For now I never acquire any skill but before two leg go dey ground for here I go don acquire one or two skills.

My people I dey hail oo una brother dey here. I dey thank God say our boss don make things easier say we fit dey relate for here without others to choke mouth an I dey hail am and give am salute for this very effort. And I wan use this medium to say make una try accept me with open heart as na the hustle we dey for here. I say make I raise two hands up for una as I go do my best to dey drop better things. Uma do well.

My brother I dey welcome you to the home of knowledge becos here wen you dey see so goes beyond watin u dey think. U are free here na wewe but dey careful in some tin because na here we dey other boards dey, dey no dey collect rush thing so l dey beg u make you dey careful with those places. Once you are welcome.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
~snip~
Bro you dey very welcome to the forum and e make sense say you don choose to identify with the Nigerian community here, nothing do you. Dem talk say, if you go market go dance, nobody go stop you. Na so e be for this forum. You fit share information, ask questions, talk am as e dey do you for mind nobody to beat you. However, the unforgiveable sin for the forum na PLAIGIARISM. Dem nor dey forgive this one. So if you copy something from the internet make you put the link were you get am from too. No forget this one. Welcome once again.
legendary
Activity: 2058
Merit: 1270
Play Poker on Telegram
<...>
You they highly welcome for this thread bro and for the forum generally, na open hands and heart we they always use welcome new users wey identify with us for here, so your own case no go they different. Una notice say we come they see plenty new Nigerian users, and most of them make sense wella, them they make constructive posts, and in the long term them i sure say them go be quality posters for this forum and for this our thread too (or board by then). Well Done @Obari, just go for meta read the rules, as long as you follow the rules wahala no go they; we they look forward to your contributions bro.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Username: Obari
Gender: male
State of resident (optional): Port Harcourt
Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend.: For now I never acquire any skill but before two leg go dey ground for here I go don acquire one or two skills.

My people I dey hail oo una brother dey here. I dey thank God say our boss don make things easier say we fit dey relate for here without others to choke mouth an I dey hail am and give am salute for this very effort. And I wan use this medium to say make una try accept me with open heart as na the hustle we dey for here. I say make I raise two hands up for una as I go do my best to dey drop better things. Uma do well.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
Which crypto exchange is the most popular in Nigeria?
The most popular crypto exchange in Nigeria is obviously Binance
Yeah that's correct! Luno comes second it's one of the most used Nigeria in Nigeria since users can be able to deposit and withdraw local fiat Naira using coupons.

What's the preferred exchange method?
If you do not know, our government has banned our commercial banks from facilitating cryptocurrency transactions directly from exchanges, so our most preferred method of exchange is P2P.
And to add it up the most used P2P platforms are Paxful, Remitano with zero deposit fees.

What are the FEEs they are taking from you?
Since we use P2P we do not pay any fees for it.
Yes buyer do not pay any fees but Binance P2P platform charges sellers 1% fees on each transaction
Pages:
Jump to: