Pages:
Author

Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. - page 71. (Read 1019643 times)

hero member
Activity: 2520
Merit: 624
Senior man, make I no lie you, I give Nigerians just this last election, if nothing happen, I go commot my hand and mind for anything wey concern government and politicians. See I no go even read or listen political news again. I go just dey totally apolitical.

You say ?.... Grin

My guy forget naija matter. Na wrong leader we don dey get since shortly after republic and,  the time after coup wey come lead to biafran war. For Nigeria history, no be today wey ynash don dey back na. In fact since wey dem take discover oil for naija, na im every unit begin fight to dey on top and if Nigeria still dey operate this system of monidemocracy, na the same thing go still dey happen. Those our old musicians song na about the ills in Nigerian government na, so no be today wey the matter don be like this oo.
jr. member
Activity: 43
Merit: 1
Make i fes greet my oga dem for here, i no too sabi say naija get forum for here, i say make i do forum search with the keyword naija, na so i take land for here..

When i be come here newly i no sabi road for here, everywhere just de look like something weh i no understand, na so i take leave here ooo, but thank God say i don see my ppl for here.

Hope una go accept me for here
jr. member
Activity: 43
Merit: 1
Senior man, make I no lie you, I give Nigerians just this last election, if nothing happen, I go commot my hand and mind for anything wey concern government and politicians. See I no go even read or listen political news again. I go just dey totally apolitical.

This one don pass enough is enough. Year in year out people like Atiku, Wike, Tinubu go dey use dollars dey buy and bribe their way out and yet nobody go dey prosecuted. Just few days ago Wike talk how PDP chairman collect bribe for billion. You know wetin be billion abi? We don commot for million bribing and corruption.  Na for millions of dollars or zillions of Naira. Chei we don finish o...
Urchman no be only dey this boat like this o. All the younglings wey dey we naija wey don comot body for this election feel this way too, I nor go lie you. Shey you see the crowd wey show face for Abuja for Peter ObI 1 Million march nor be say dem nor get wetin to do but dem don put body. And if anything sup wey be say na baba emilokan, or Baba Atiku come win I nor go fit even fathom wetin go happen. But until then sha, we must keep hope alive.

Right now sef the small thing wey dey bother me be say -  nor be to follow do 1 million march o. Shey the 1 million "marchers" don collect PVC?

True true the 1million march ppl fit no get pvc at all, na just street carnival dem de do so where you fit get fresh banny
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Senior man, make I no lie you, I give Nigerians just this last election, if nothing happen, I go commot my hand and mind for anything wey concern government and politicians. See I no go even read or listen political news again. I go just dey totally apolitical.

This one don pass enough is enough. Year in year out people like Atiku, Wike, Tinubu go dey use dollars dey buy and bribe their way out and yet nobody go dey prosecuted. Just few days ago Wike talk how PDP chairman collect bribe for billion. You know wetin be billion abi? We don commot for million bribing and corruption.  Na for millions of dollars or zillions of Naira. Chei we don finish o...
You no go too blame them shah, Davido na em don open their eye with en constant noise of 30BG. E don make the sound common and we naija boys them don too dey collect million for the street way be say, the money nor get weight again, lol... No mind me shah, I just dey talk but, na real matter you dey talk shah.

The thing be say, you no fit live for the naija and you still nor reason the political matter. The voltage this 2023 too much and e go dey very disappointing if e turn out say, na the formal system still playout.

Right now sef the small thing wey dey bother me be say -  nor be to follow do 1 million march o. Shey the 1 million "marchers" don collect PVC?
This one funny me but, na the legit you yarn like this so o. Because, na where all the difference go come. You know say, nobody dey worry anybody during rallies and political campaigns matter but na for the election ground way be say, we dey see some kind kartakarta but, the matter be say, betta no go waka con find you for your house, na you go come out to con change things.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
Senior man, make I no lie you, I give Nigerians just this last election, if nothing happen, I go commot my hand and mind for anything wey concern government and politicians. See I no go even read or listen political news again. I go just dey totally apolitical.

This one don pass enough is enough. Year in year out people like Atiku, Wike, Tinubu go dey use dollars dey buy and bribe their way out and yet nobody go dey prosecuted. Just few days ago Wike talk how PDP chairman collect bribe for billion. You know wetin be billion abi? We don commot for million bribing and corruption.  Na for millions of dollars or zillions of Naira. Chei we don finish o...
Urchman no be only dey this boat like this o. All the younglings wey dey we naija wey don comot body for this election feel this way too, I nor go lie you. Shey you see the crowd wey show face for Abuja for Peter ObI 1 Million march nor be say dem nor get wetin to do but dem don put body. And if anything sup wey be say na baba emilokan, or Baba Atiku come win I nor go fit even fathom wetin go happen. But until then sha, we must keep hope alive.

Right now sef the small thing wey dey bother me be say -  nor be to follow do 1 million march o. Shey the 1 million "marchers" don collect PVC?
full member
Activity: 882
Merit: 207
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings

You dey highly welcome shaddyblinkz. Here na our naija board, so just feel lyk say you dey home already. Anything wey you wan ask drop am here and our people here go help you answer your question. But as beginner wey you be com join dis forum, make you go through dis board well Beginners and Help “ https://bitcointalk.org/index.php?board=39.0” make you read the rules for posting for dis forum so dat you go dey more guided. You dey welcome once again.

Thanks boss, e dey really feel like home already. I don dey navigate my way there like this. Thanks once more

U dey welcome, u go tok ur state, lga, and community probably ur Village  Grin nd weti u dey do need can do. Wow tell u 2 come here, I mean ur mentor in di forum so di pesen go dey guide u. Finally 4rom Mai side make u go read di rules wella for beginners & help board.

Thanks boss. Make I introduce myself well;
    Username: Shaddyblinkz
    Gender: Male
    State of resident: Abuja
    Skills: Freelance writer
    Mentor: CryptopreneurBrainboss (Though I still dey see others work wei dey motivate me)
 
Welcome bro, I see the reception wey you don get. E suppose be motivation for you to keep up and contribute with better posts wey get talking points.  You will enjoy creating contents here as we enjoy reading it. Just do your best and you go rank up with the benefits wey follow.
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Politics of the country is of national interest and everyone needs to take it very seriously. We Nigerians are at a very critical point in our political situation. yes there is no historic event happening just yet, but I say this because the intelligence and resolve of the citizens of Nigeria is transforming and the era we are now is an era where enough is enough.

Senior man, make I no lie you, I give Nigerians just this last election, if nothing happen, I go commot my hand and mind for anything wey concern government and politicians. See I no go even read or listen political news again. I go just dey totally apolitical.

This one don pass enough is enough. Year in year out people like Atiku, Wike, Tinubu go dey use dollars dey buy and bribe their way out and yet nobody go dey prosecuted. Just few days ago Wike talk how PDP chairman collect bribe for billion. You know wetin be billion abi? We don commot for million bribing and corruption.  Na for millions of dollars or zillions of Naira. Chei we don finish o...
Nigeria politicians their own Dom too much self so so bribe bribe,the country self the corruption too much. These old men wey dey lead us so, me I no see any good thing wey them get for head to offer Nigeria,na only to thief our money,oppress us ,intimidate us and give us false hope dem sabi. Nigeria need to see say nothing them get to offer.

 Its is high time we the youth use one voice tell this old men say na we get the country no be them again since them time don pass and take the country from their hand by voting for Peter Obi,if not our suffer still plenty and e must affect our children if we no use our head now o.
hero member
Activity: 798
Merit: 1045
Goodnight, ohh Leo!!! 🦅
@shaddyblinkz
You're dormant -- or prolly -- way too slow to have made only 2 post since February, that's appalling!

Anyways, I'm welcoming you but , not as a newbie' ; I mean, you've been stuck in there for too long ☹️
Maybe you'll have to keep it together and figure things out for yourself.
Cheers,

Sandra 👩‍🦱
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.
Politics of the country is of national interest and everyone needs to take it very seriously. We Nigerians are at a very critical point in our political situation. yes there is no historic event happening just yet, but I say this because the intelligence and resolve of the citizens of Nigeria is transforming and the era we are now is an era where enough is enough.

Senior man, make I no lie you, I give Nigerians just this last election, if nothing happen, I go commot my hand and mind for anything wey concern government and politicians. See I no go even read or listen political news again. I go just dey totally apolitical.

This one don pass enough is enough. Year in year out people like Atiku, Wike, Tinubu go dey use dollars dey buy and bribe their way out and yet nobody go dey prosecuted. Just few days ago Wike talk how PDP chairman collect bribe for billion. You know wetin be billion abi? We don commot for million bribing and corruption.  Na for millions of dollars or zillions of Naira. Chei we don finish o...
sr. member
Activity: 630
Merit: 453
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID

Thanks boss. Make I introduce myself well;
    Username: Shaddyblinkz
    Gender: Male
    State of resident: Abuja
    Skills: Freelance writer
    Mentor: CryptopreneurBrainboss (Though I still dey see others work wei dey motivate me)
 
Bro I dey welcome you in even though I nava dey  long for forum I dey welcome you. When I joined I think say I late wen I no quickly know the bitcointalk.org but as I see you now I dey motivated now  once again you are welcome to the land of knowledge.
member
Activity: 756
Merit: 30
Thanks boss. Make I introduce myself well;
    Username: Shaddyblinkz
    Gender: Male
    State of resident: Abuja
    Skills: Freelance writer
    Mentor: CryptopreneurBrainboss (Though I still dey see others work wei dey motivate me)
 
Welcome brother. Na home you dey here feel free to relate anything wey no too clear for you with our senior men here. I for like say may you try read some forum rules for proper guidance but e be like say you Don familiar with the forum already base on say you Sabi how to quote properly. Goodluck
hero member
Activity: 826
Merit: 562
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings
You are welcome my brother thank God say you locate us,this forum na to dey read na e be your work for now,no  rush post make sure say anything wet u won know u ask question. Life dey easy for here but you need to dey careful with the rules and regulations so that you no go fall for law. We be one so we dey for you anoda thing be say u go try dey active for easy recognition.
hero member
Activity: 1036
Merit: 861
Livecasino.io
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings
You dey very welcome to the forum. Dem tok say follow who know road and I dey tell you say as you dey follow our 001 you nor fit loss. See eh, you will like it here if you dey your lane for the forum, you must to see 10x growth. I nor go lie give you, sometime small discouragement fit enter your mind base on one or two things but make you nor reason am. Always they try link up with guys here make them yarn you their own story becasue na from there you go take draw strength from. I take God beg you NO Plagiarize o. If you copy copy anything add link to were you copy am from. Once again welcome.
newbie
Activity: 8
Merit: 0
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings

You dey highly welcome shaddyblinkz. Here na our naija board, so just feel lyk say you dey home already. Anything wey you wan ask drop am here and our people here go help you answer your question. But as beginner wey you be com join dis forum, make you go through dis board well Beginners and Help “ https://bitcointalk.org/index.php?board=39.0” make you read the rules for posting for dis forum so dat you go dey more guided. You dey welcome once again.

Thanks boss, e dey really feel like home already. I don dey navigate my way there like this. Thanks once more

I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings
U dey welcome, u go tok ur state, lga, and community probably ur Village  Grin nd weti u dey do need can do. Wow tell u 2 come here, I mean ur mentor in di forum so di pesen go dey guide u. Finally 4rom Mai side make u go read di rules wella for beginners & help board.

Thanks boss. Make I introduce myself well;
    Username: Shaddyblinkz
    Gender: Male
    State of resident: Abuja
    Skills: Freelance writer
    Mentor: CryptopreneurBrainboss (Though I still dey see others work wei dey motivate me)
 
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings
U dey welcome, u go tok ur state, lga, and community probably ur Village  Grin nd weti u dey do need can do. Wow tell u 2 come here, I mean ur mentor in di forum so di pesen go dey guide u. Finally 4rom Mai side make u go read di rules wella for beginners & help board.
hero member
Activity: 910
Merit: 686
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings

You dey highly welcome shaddyblinkz. Here na our naija board, so just feel lyk say you dey home already. Anything wey you wan ask drop am here and our people here go help you answer your question. But as beginner wey you be com join dis forum, make you go through dis board well Beginners and Help “ https://bitcointalk.org/index.php?board=39.0” make you read the rules for posting for dis forum so dat you go dey more guided. You dey welcome once again.
newbie
Activity: 8
Merit: 0
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings
legendary
Activity: 1022
Merit: 1341
Politics of the country is of national interest and everyone needs to take it very seriously. We Nigerians are at a very critical point in our political situation. yes there is no historic event happening just yet, but I say this because the intelligence and resolve of the citizens of Nigeria is transforming and the era we are now is an era where enough is enough.

We have seen the recent matches and revolutionary movements across different state of the country, many said it was just social media support but we have now see how people actually takes this very seriously. This is a make or break point for Nigeria, we haven't come this close in recent past elections in making a wise choice, what ever decision we make come 2023 would either make or break the country.

You don't tell a man who to vote I know this but I can only encourage us to kick aside tribe, sentiment or personal interest and vote wisely come next year elections.
U Don tok di tru. Bt won thing u v 2 kno bi say, dere r 2 pipo wey dey determine wo go win 4 election. INEC n di court. Dis tin wey I dey tok e don happon 4 mani state 4 we contri. Me sef I don see 4 mai state. We voted 4 di candidate wey we like fat time bt court come say na di pesen wey loss 4 d election nai win di election na so we take loss out. Dia 4 we v 2 fight INEC n court. Dis 2 agents r d major problem 4 we 9ja.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Me I go dey use common sense dey reason the thing Grin
Baba who tell you say common sense dey common, common sense no common oooo no be everybody fit get common sense and in fact common sense is very expensive this days.
Make I know lie you even me I fall for that guy comment and I been the think say the guy make sense na guys from hear come make me reason the matter again I come discover say the guy were make that comment no dey right at all and with simple logical thinking person go see say the comment na nonsense comment.
hero member
Activity: 1036
Merit: 625
BTC, a coin of today and tomorrow.

This picture and the comment dey make me laugh since and I wan roll for ground self. The person wey reply that thing confuse or e high. The person mean say as dem.born Tinubu him kuku marry from birth Grin
But we know say Tinubu age na scam, but this one no join make sense.

E get some things wey you go see, you go reason say school no be scam o.
I remember those word problems dem dey give us for maths. Like;

If Tinubu is X years old,
The wife is X - 8 years old.
Let the age of Tinubu be 76yrs.
How old will be the wife after 2023 election  Grin Grin

My mate go begin use the data wey dem give for question dey form algebraic equation.

Jump to: