Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 263. (Read 554634 times)

legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
December 17, 2020, 09:53:25 AM
Ma people I hail oh una to much I throwaway salute for all of una main main as without una support, I no for fit get dis free oyinbo dollars I go soon received like dis, una well don. At least now I no get any reason to say I no benefit from knowing all of una for dis forum, una welldon again. My broda Mpamaegbu, I undastand ur yanings, no reason am. I get reason besides the reason say dat guys interview go well die. See eh dem been don dey attack ma people badly and nothing worth una to surfer just because of me.

If u observe well afta my public declaration of dat guy post, d attack reduced, u fit see say I try withdraw so the matta go end but no work. Just see as our broda posi account don get red trust just because e been wan help e follow broda. All of una account been dey under serious observation and I try to water the issue down na e make I do wetin I do, I beg for ur forgiveness if I fall ur hands but I do am for my people. Becky666 u too much, in fact all of una much and I see una handwork and I appreciate una badly.

Just know say we no lose instead we live to fight another day. Sometimes e good to lose the fight in order to win the battle. The battle now na our local board. We go win dat battle surely. I dey prepare the thread, we go run dat matta January when every where don cool from all dis contest and we go use the whole of next year demand for am if na wetin e go take. Una thank you again, una do well.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 16, 2020, 07:24:33 PM
I don cast my vote for our boss here @cryptobrainboss
Lol... Dis guy, you nor go kill persin sha. The way wey you take write the name come make me think twice whether somebody don clone him name for forum. I sabi sey dat name long like River Nile na im make. Me I don already cast my vote for owa man CryptopreneurBrainboss. But dat maxwell guy dey push hard oh. One time sef those oda guys dem sef come begin yarn opata sey one thing do one thing for another thread like dat because of that voting thing oh. Well, I believe sey Brainboss must get something out of the award.
Lmao, omo boss no reason am oh Cheesy, na typo  Cheesy Cheesy
Anyhow I just get joy say at least our big bros for here face show, as him take 2nd place, e no easy sha, that maxwell been get enough votes, but anyhow e be naija no dey ever carry last Grin.
Congratulations @CryptopreneurBrainboss, you deserve am boss.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
December 16, 2020, 07:21:16 AM
Omo, I been no come across this vote matte untill today. But still on still BB still came 2nd na the most impressive thing be that. Una dey really tie minds for one goal which be the thing wey dry give those omo oyibo dem Pepe for body. But with time we go triumph. Congratulations @CryptopreneurBrainboss
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 16, 2020, 06:52:16 AM
Na waoooo bros, i like dis politic wey Brainboss do, sometime we use our head dan someone wey dey use anus, Maxwell na pensi wey im interview also mak sense well, so, 4 Brainboss 2 vote im better for both de APC nd PDP. But be rest assure dat dis game gud for all, if u remembered wetin dose peps yan some few days ago, dem be called us "PEARLS" voters, Fivestar4everMVP tank u for dis gesture.

Becky, I get your point. Me too follow read all that roforofo fight on top the vote matta for that thread. I sabi sey Maxwell interview stand well too but I just throw vote for my homeboy unto sey no place like home and some motivation story something something still dey there for Brainboss interview. You gerrit? But my concern be sey BB for just abstain instead of hailing the other persin or do the hailing after dem call the result. At a time sef e com be like sey na only the two of them dey drag the award. Well,  may be na Brainboss himself go answer my question better when im get time.
full member
Activity: 756
Merit: 231
December 16, 2020, 06:16:10 AM
4 de vote eh, dat guy maxwell dey carry de lead but as u don talk am at-all la at-all, our Boss go romass sometin, remember, today na de last day congrats to winners.....
My dear, the thin com weak me somehow when I come even see sey Brainboss wey we dey root for come go vote for the maxwell guy. Me, I nor fit explain why im do that one. E just be like where a candidate of APC for presidential election com go vote for im PDP rival for the same presidential election and com rep am join for the matta. May be Brainboss go explain to us why im fall owa hand there. Him for just abstain from voting like Maxwell do na.
Na waoooo bros, i like dis politic wey Brainboss do, sometime we use our head dan someone wey dey use anus, Maxwell na pensi wey im interview also mak sense well, so, 4 Brainboss 2 vote im better for both de APC nd PDP. But be rest assure dat dis game gud for all, if u remembered wetin dose peps yan some few days ago, dem be called us "PEARLS" voters, Fivestar4everMVP tank u for dis gesture.
legendary
Activity: 2226
Merit: 1049
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 15, 2020, 05:52:32 PM
4 de vote eh, dat guy maxwell dey carry de lead but as u don talk am at-all la at-all, our Boss go romass sometin, remember, today na de last day congrats to winners.....
My dear, the thin com weak me somehow when I come even see sey Brainboss wey we dey root for come go vote for the maxwell guy. Me, I nor fit explain why im do that one. E just be like where a candidate of APC for presidential election com go vote for im PDP rival for the same presidential election and com rep am join for the matta. May be Brainboss go explain to us why im fall owa hand there. Him for just abstain from voting like Maxwell do na.
I don throw my vote give my oga, @brainboss, I really thank God say I no late for this one cus I just see the thread today, and that maxwell  guy be like say na him dey lead, but I still believe say our oga, @brainboss no go carry last, he truly deserve to get the lead for that contest but then, make we see as e go be,
And I won use this opportunity urge those wey never vote make they try chip in their vote ateast before before we enter tomorrow as e be say na tomorrow the vote go end.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 15, 2020, 12:01:11 PM
4 de vote eh, dat guy maxwell dey carry de lead but as u don talk am at-all la at-all, our Boss go romass sometin, remember, today na de last day congrats to winners.....
My dear, the thin com weak me somehow when I come even see sey Brainboss wey we dey root for come go vote for the maxwell guy. Me, I nor fit explain why im do that one. E just be like where a candidate of APC for presidential election com go vote for im PDP rival for the same presidential election and com rep am join for the matta. May be Brainboss go explain to us why im fall owa hand there. Him for just abstain from voting like Maxwell do na.
full member
Activity: 756
Merit: 231
December 15, 2020, 11:18:07 AM
I don cast my vote for our boss here @cryptobrainboss
Lol... Dis guy, you nor go kill persin sha. The way wey you take write the name come make me think twice whether somebody don clone him name for forum. I sabi sey dat name long like River Nile na im make. Me I don already cast my vote for owa man CryptopreneurBrainboss. But dat maxwell guy dey push hard oh. One time sef those oda guys dem sef come begin yarn opata sey one thing do one thing for another thread like dat because of that voting thing oh. Well, I believe sey Brainboss must get something out of the award.
Broda, Dat same day i see dem dey yan but after i read dem talk i just fanshi dem becus dem be wan multivat dem peps 2 vote 4 dem, i wish we wey be naija go get one voice till we get our own board, believ me if dis tin continu we go get our board soon. 4 de vote eh, dat guy maxwell dey carry de lead but as u don talk am at-all la at-all, our Boss go romass sometin, remember, today na de last day congrats to winners.....
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 13, 2020, 10:10:27 AM
I don cast my vote for our boss here @cryptobrainboss
Lol... Dis guy, you nor go kill persin sha. The way wey you take write the name come make me think twice whether somebody don clone him name for forum. I sabi sey dat name long like River Nile na im make. Me I don already cast my vote for owa man CryptopreneurBrainboss. But dat maxwell guy dey push hard oh. One time sef those oda guys dem sef come begin yarn opata sey one thing do one thing for another thread like dat because of that voting thing oh. Well, I believe sey Brainboss must get something out of the award.
member
Activity: 91
Merit: 35
December 12, 2020, 04:13:32 PM
[Vote 2020] Best Bitcointalk Interview
VOTE HERE dis tin dey happening nd many peps 4 hia neva come vote, like weitin Posi said, na our broda nd odas dey struggle for dis vote, mak we support him for dis matter becus our own na our own. Here u go fit read de rules wella Rules for vote una tank-u. Before u vote make u read our broda interview here CryptopreneurBrainboss Interview bikonu becus de tin mak sense.

Anoda one still dey hia Community Award mak we put smile 4 our own face first be4 anoda.

I don cast my own vote already for boss, i think people wey dey no go yet because dis thread no dey very active so person no dey realize easily say post dey for here abi dem no see the voting thread either. Make we continue dey support awa own
full member
Activity: 756
Merit: 231
December 12, 2020, 11:05:18 AM
[Vote 2020] Best Bitcointalk Interview
VOTE HERE dis tin dey happening nd many peps 4 hia neva come vote, like weitin Posi said, na our broda nd odas dey struggle for dis vote, mak we support him for dis matter becus our own na our own. Here u go fit read de rules wella Rules for vote una tank-u. Before u vote make u read our broda interview here CryptopreneurBrainboss Interview bikonu becus de tin mak sense.

Anoda one still dey hia Community Award mak we put smile 4 our own face first be4 anoda.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
December 10, 2020, 07:35:13 AM
I don long wey i hear news so i wan make unah tell me wetin cause the second #EndSar protest?

Announcement
He get a vote wey dey happen for dis house una hear ham and nah our blood Brainboss make unah soro soke for.
I don cast my vote for our boss here @CryptopreneurBrainboss

My people, another police brutality don happen inside Port Harcourt oh, the news just reach me this morning say police go kill Keke driver for rupokwu oh, base on say he Keke driver no gree give am 100 naira as them dey normally task Keke drivers, so just because of 100 naira na the police man take gun shoot the Keke driver oh, like this rupokwu dey hot as boys don vex carry gun too dey find police oh, I hear say dem fire enough shots during dos kin 10am oh, how una see am na, this one fit cause another protest for the country?

hero member
Activity: 2240
Merit: 579
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 09, 2020, 11:16:33 AM
I don long wey i hear news so i wan make unah tell me wetin cause the second #EndSar protest?

Announcement
He get a vote wey dey happen for dis house una hear ham and nah our blood Brainboss make unah soro soke for.
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
December 07, 2020, 01:07:37 PM
It's a wonderful feeling, getting to know that we still gat young vibrant youths that are excelling in the bitcointalk forum. I think it's now time for us to push forward to get our own Naija board in btt. If we can accomplish that, it will be easier for us to identify one another.
Kudos to us that choose crypto over Gee activities. Together we stand and blow together.
One love

Ya. E dey good say Naija dey represented on the forum compared to like 2-4 years ago when we dey very underrepresented. Even though the forum no dey easy peasy, at least something dey for everybody wey put in the work. I believe say very soon, we go get our very own board here on the forum just like the dozen other local boards for other countries. I also know say our contribution for forum no dey go unnoticed and e no go take long before everything go fall in place for us.  No forget to stop here from time to time so we go fit discuss, learn and grow from each other.

member
Activity: 672
Merit: 29
December 03, 2020, 05:23:32 PM
It's a wonderful feeling, getting to know that we still gat young vibrant youths that are excelling in the bitcointalk forum. I think it's now time for us to push forward to get our own Naija board in btt. If we can accomplish that, it will be easier for us to identify one another.
Kudos to us that choose crypto over Gee activities. Together we stand and blow together.
One love
legendary
Activity: 2226
Merit: 1049
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 03, 2020, 05:14:44 PM
My Brother, na true you talk oooh , but if all of us find money japa, who won come fix the country for us, and no forget say as you dey japa, you get family members wey you go leave behind, and how your belle go sweet you where ever you dey if you dey there dey enjoy and know fully well say people wey you leave behind for obodo Nigeria dey suffer?, and again , no forget say if any of your old man or woman them pass on , you go still need to come back from where ever you run go for their burial, na this one oyibo people dey say "He who fights and run away, lives to fight another day".
So for my own opinion, e better make we dey here fight for the betterment of our country ooo , make all of us join hands together to make a difference come 2023.

Baba na truth you Yan. How we wan get better person wey no go dey corrupt minded and power drunk? Who be the person wey you done get for mind in case election matter burst place?
Me never get anybody for mind oooo , but wetin me fit talk or suggest be say, when 2023 finally come, if the  youths in the whole of nigeria fit come out the way we come out for this End sarz protest, select our leaders ourselves, person wey when don trust say him or her no fit mess up, somebody wey we fit hold accountable so that even if the power later enter their head and they begin dey mess up, we no go waste time to kick their ass out and possibly send the person go jail self ..
this na wetin me think oo
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
December 02, 2020, 05:30:22 PM
My Brother, na true you talk oooh , but if all of us find money japa, who won come fix the country for us, and no forget say as you dey japa, you get family members wey you go leave behind, and how your belle go sweet you where ever you dey if you dey there dey enjoy and know fully well say people wey you leave behind for obodo Nigeria dey suffer?, and again , no forget say if any of your old man or woman them pass on , you go still need to come back from where ever you run go for their burial, na this one oyibo people dey say "He who fights and run away, lives to fight another day".
So for my own opinion, e better make we dey here fight for the betterment of our country ooo , make all of us join hands together to make a difference come 2023.

Baba na truth you Yan. How we wan get better person wey no go dey corrupt minded and power drunk? Who be the person wey you done get for mind in case election matter burst place?
legendary
Activity: 2226
Merit: 1049
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 02, 2020, 03:01:40 PM
Every week na one wahala or the other for Naija with these Boko guys. Na the same guys wey Buhari release after the army overpower and catch them for bush, even una president dash them N20k on top as rehabilitation fee for those terrorists. Buhari leave Boko Haram wey im go tag terrorists, begin tag IPOB and #endsars protesters. This morning my belle just dey bitter as I see pictures of rice farmers wey those idiots kill and come chop off their heads even with their hands tied. I nor just wan share that gory pictures here. This is bad mehn! Buhari and his clueless APC should just go and leave us hand jor.
Anytime I wake up and I notice say my parents, siblings and everyone related to me is safe for that day I know say we done dey well already. Naija na place wey person dey sleep with one eye open and the other closed. Even for your place of work you no dey safe, nothing is working under this man's rulership yet he hasn't deemed it fit to resign honourably. Power corrupts truly. Look at how them been dey arrest people anyhow for peaceful protest. Dubai police been name those wey dey sponsor BH yet nothing has been done. The only solution for Nigerian na to find money japa o. Insecurity and hunger for this country too much.
My Brother, na true you talk oooh , but if all of us find money japa, who won come fix the country for us, and no forget say as you dey japa, you get family members wey you go leave behind, and how your belle go sweet you where ever you dey if you dey there dey enjoy and know fully well say people wey you leave behind for obodo Nigeria dey suffer?, and again , no forget say if any of your old man or woman them pass on , you go still need to come back from where ever you run go for their burial, na this one oyibo people dey say "He who fights and run away, lives to fight another day".
So for my own opinion, e better make we dey here fight for the betterment of our country ooo , make all of us join hands together to make a difference come 2023.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
December 02, 2020, 11:39:58 AM
Every week na one wahala or the other for Naija with these Boko guys. Na the same guys wey Buhari release after the army overpower and catch them for bush, even una president dash them N20k on top as rehabilitation fee for those terrorists. Buhari leave Boko Haram wey im go tag terrorists, begin tag IPOB and #endsars protesters. This morning my belle just dey bitter as I see pictures of rice farmers wey those idiots kill and come chop off their heads even with their hands tied. I nor just wan share that gory pictures here. This is bad mehn! Buhari and his clueless APC should just go and leave us hand jor.
Anytime I wake up and I notice say my parents, siblings and everyone related to me is safe for that day I know say we done dey well already. Naija na place wey person dey sleep with one eye open and the other closed. Even for your place of work you no dey safe, nothing is working under this man's rulership yet he hasn't deemed it fit to resign honourably. Power corrupts truly. Look at how them been dey arrest people anyhow for peaceful protest. Dubai police been name those wey dey sponsor BH yet nothing has been done. The only solution for Nigerian na to find money japa o. Insecurity and hunger for this country too much.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 30, 2020, 07:03:05 AM

Jump to: