Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 266. (Read 554634 times)

member
Activity: 70
Merit: 26
October 30, 2020, 06:10:05 PM
Anyways for music lover#MadeInLagos don finally drop atleast one good thing don from the countey of recent as na only entertainment dey do the country proud, the rest an waste.
trending in 16 countries and still counting star boi to de moon
member
Activity: 70
Merit: 26
October 30, 2020, 06:05:57 PM
Ma brodas na wah for dis country we dey inside, just imagine how the government take end the matta for ground without doing anything. Even dat mumu wey dem dey call desmond idiot (yes idiot) dey talk rubbish. E don't n clear for our eyes say the government no regard us the youths.
Desmond idiot abi Eliot is a proof that a young person could be elected president and still fail us for dis country, calling us children and talking trash na thunder go fire am na now i see why mothers nodey allow der daughters marry am for movies.... foolish boi
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
October 30, 2020, 05:25:45 PM
Make una no vex oh say I no dey post here like dat, even normal forum posting dis days dey hard me. I just dey too occupied. Concerning my promise, eh I never get enough sMerit on me but I dey see wetin all of una wey participants write. When Small tin enta my hand I go do the needful just continue and keep this thread active.

Ma brodas na wah for dis country we dey inside, just imagine how the government take end the matta for ground without doing anything. Even dat mumu wey dem dey call desmond idiot (yes idiot) dey talk rubbish. E don't n clear for our eyes say the government no regard us the youths.

Anyways for music lover#MadeInLagos don finally drop atleast one good thing don from the countey of recent as na only entertainment dey do the country proud, the rest an waste.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
October 29, 2020, 05:13:10 PM
My people I hail,
I for join the talk wey dey ground though but never sabi how things dey go for this forum cause my blood brother gangan (user Posi) just introduce me here.
I greet all the people (Charles-Tim, nelson4lov, CryptopreneurBrainboss, Mpamaegbu, Upgrade00, Gozie51, BIT-BENDER etc.) for the house una well done and I beg una make you put through.
Show brother some love.

#End Sars #Police Brutality #End Bad Government
Waiting I feel let you know first be say this forum feel seem hard at first but no dey hard at all, I remember when I dey newbie, I think sey e hard, if you dey determined, know sey you go rank up like many of us wey dey this forum.

Na the forum rules be this:
Unofficial list of (official) Bitcointalk.org rules, guidelines, FAQ
https://bitcointalksearch.org/topic/unofficial-list-of-official-bitcointalkorg-rules-guidelines-faq-703657

Read this merit and ranking requirements
Merit & new rank requirements
https://bitcointalksearch.org/topic/merit-new-rank-requirements-2818350

You don know about crypto before or you be newbie? So I go know more advice to give.

You are welcome.
member
Activity: 91
Merit: 35
October 29, 2020, 02:09:55 PM
My people I hail,
I for join the talk wey dey ground though but never sabi how things dey go for this forum cause my blood brother gangan (user Posi) just introduce me here.
I greet all the people (Charles-Tim, nelson4lov, CryptopreneurBrainboss, Mpamaegbu, Upgrade00, Gozie51, BIT-BENDER etc.) for the house una well done and I beg una make you put through.
Show brother some love.


Welcome my brother, me sef join the forum not long ago. I wish we get our own board wey go dey easy to yarn well well
member
Activity: 70
Merit: 26
October 29, 2020, 12:55:18 PM
My people I hail,
I for join the talk wey dey ground though but never sabi how things dey go for this forum cause my blood brother gangan (user Posi) just introduce me here.
I greet all the people (Charles-Tim, nelson4lov, CryptopreneurBrainboss, Mpamaegbu, Upgrade00, Gozie51, BIT-BENDER etc.) for the house una well done and I beg una make you put through.
Show brother some love
Baba welcome na jeje we dey do for here just dey interact for the group better tins go come

No plagiarism.No spamming
newbie
Activity: 1
Merit: 1
October 29, 2020, 12:43:51 PM
My people I hail,
I for join the talk wey dey ground though but never sabi how things dey go for this forum cause my blood brother gangan (user Posi) just introduce me here.
I greet all the people (Charles-Tim, nelson4lov, CryptopreneurBrainboss, Mpamaegbu, Upgrade00, Gozie51, BIT-BENDER etc.) for the house una well done and I beg una make you put through.
Show brother some love.

#End Sars #Police Brutality #End Bad Government
sr. member
Activity: 2226
Merit: 270
Chainjoes.com
October 29, 2020, 12:27:33 PM
I am more worried now, will the lives of those killed at tollgate just be in vain? I suspect the government trying to restore normalcy. Although the youth might need too take the bull by the horn but we might need help from some elders in politics. The recent outburst reveal the extent of dirt in our politics, how to tame the hooligans, seek support from military, protect ourselves and control tribalism among the youth.
legendary
Activity: 2226
Merit: 1049
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
October 28, 2020, 01:19:16 AM
To make we country Nigeria a better place for we all.. The things wey we need to do, my fellow brothers them don already talk am, and e no make sense make I come dey suggest wetin my brothers don suggests already, but the Question wey me won ask now be say.. How we won take do am?, like to cut cost of governance wey be one of the most important thing wey we must do if we Wan end bad government in Nigeria, how we go take do am to make all this government officials gree say they go cut their own salaries??
With the kind population wey Nigeria get, and with how poor the country come be, if we dey talk about people generally and wealth availability, with the kind monthly money wey those people wey dey top dey collect, Nigeria no fit develop, aside monthly allowance, them dey collect monthly salary wey many Nigerians no fit collect after hard labour for 30 years. But, e no easy say that feel change o, you think all those senate feel gree, I no think so.
Na the issue wey me self carry put for ground be that, just imagine how many innocent people wey loose their precious life for just this small #EndSARS protest wey happen few weeks ago before hoodlums come hijack the protest, when e come involved money now, most of those old baba them fit choose to rather loose their life than loose the benefits wey come with their throne, and that one fit cause real war for Nigeria ooo... But on the other hand, this one no be wetin we go run from, na wetin we go still fight for.
member
Activity: 70
Merit: 26
October 27, 2020, 09:00:41 PM
Una wey country don tire wey get Nigerian passport check out dis countries u fit enter without Visa dem go dash u wife join.

https://bitcointalksearch.org/topic/--5284822
Nice one Blackpussy, I suppose don't comment for your post, but I no like the 'Beginners and help board' wey you post ham, e feel possible say moderator go carry ham go 'off topic', e go make sense to carry ham for 'Politics and Society', because I no wan short of posts counts. I dey feel your presence for this forum, I believe in time you go rank up soon, well done.
Thank you baba na you be de second person wey dey talk dis tin I go move am tomorrow If moderator no move am
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
October 27, 2020, 03:04:58 PM
Una wey country don tire wey get Nigerian passport check out dis countries u fit enter without Visa dem go dash u wife join.

https://bitcointalksearch.org/topic/--5284822
Nice one Blackpussy, I suppose don't comment for your post, but I no like the 'Beginners and help board' wey you post ham, e feel possible say moderator go carry ham go 'off topic', e go make sense to carry ham for 'Politics and Society', because I no wan short of posts counts. I dey feel your presence for this forum, I believe in time you go rank up soon, well done.
member
Activity: 70
Merit: 26
October 27, 2020, 12:43:18 PM
Una wey country don tire wey get Nigerian passport check out dis countries u fit enter without Visa dem go dash u wife join.

https://bitcointalksearch.org/topic/--5284822
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
October 27, 2020, 11:33:14 AM
yahoo yahoo don tear everywhere now we dey act like e dey cool, youths no wan work hard now to get the money again oh, dem dey wait for their clients to pay
Yahoo yahoo no carry gun hold any bOdy for money una just dey talk anyhow for dis country for unnecessary tin we get serious problem to settle nobe dis one baba
them no get a single respect for a civilian na why we raise concerns come even protest join on top. Even we crypto enthusiasts like this no dey safe from them. Well good thing say them disband them and still plan to reform them.

I agree with you sha, those Sars na "rogue agents" them be, imagine federal government to go recruit retired cultists them come give them gun, omo the kin body bags the people drop ehn, no be chaise, e just be asif them collect license to dey kill person anybody them see, and that wan way buhari say him don disband sars na major scam, you disband them still carry them put for other policr department way then fit see gun use, nothing go still stop them from harassing young boys.
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
October 27, 2020, 11:03:37 AM
yahoo yahoo don tear everywhere now we dey act like e dey cool, youths no wan work hard now to get the money again oh, dem dey wait for their clients to pay
Yahoo yahoo no carry gun hold any bOdy for money una just dey talk anyhow for dis country for unnecessary tin we get serious problem to settle nobe dis one baba

The struggle for #EndSARS no be to solve yahoo boys problems coz na SARs be their biggest menace. But that's not the issue. Na to end police brutality once and for all. If person go fo yahoo (fraud) and them catch am, na to arrest am and try am at a later date but those men turn am to shoot on sight. Whether you be yahoo boy or not, them no get a single respect for a civilian na why we raise concerns come even protest join on top. Even we crypto enthusiasts like this no dey safe from them. Well good thing say them disband them and still plan to reform them.

Well that aside, e just better say youths don dey finally wake up and gearing to take the mantle from the old. Things fit finally change for the better in Nigeria.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 27, 2020, 08:24:44 AM
You have commented well, there was a time we are practicing regional government before in Nigeria, but one of the military rulers from Northern Nigeria thought otherwise, because of selfish reasons and self-centeredness discontinued the regional governmental policies and centered it to federal level. Possibly, Nigeria might not have been like this if this was not changed, politics is just over everything and everywhere, no leader is loyal to his country but loyal to their families and filled with sense of nepotism. I believe we can see how citizens are like nothing before the leaders, see our palliative rice, indomie and other foods, they just kept it without distributing it to the citizens, if not because of EndSARS, this will remain hidden, see thousands of bags of food stored without them reaching citizens for consumption, this is uncalled for.
Hia! Grammar ti poju! You forget sey once we enter this house na for outside we dey leave owa grammar ba? Nor let somebody do you atarodo here oh 🙄 Abi na to report ya matter to General Buhari remain sef.

Username: Cryptocurencyking
Gender: Male
Country and state of resident: Nigeria
Skills: Still developing my trading technique
Welcome, wey bread bro. E bi like sey you don even tey small for here sef. E good as you join us here so that we all go dey run the game dey go together. Make una dey do owa country proud dey go for here. Naija youths nor lazy, na bad leadership be we problem. Soon, by fire by force we go flush all of them out.


Situs Judi Dominoqq Terpercaya 2020 yang memberikan Anda kemudahan dalam bermain judi online 24 jam pertama di Indonesia
Which one be this oh, ntori oloru? Brainboss abeg delete that shit poster. Na so dem dey do oh. If na for dem local board you go see persin wey go merit that shitpost.




The Right Spirit
member
Activity: 91
Merit: 35
October 27, 2020, 07:28:18 AM
yahoo yahoo don tear everywhere now we dey act like e dey cool, youths no wan work hard now to get the money again oh, dem dey wait for their clients to pay
Yahoo yahoo no carry gun hold any bOdy for money una just dey talk anyhow for dis country for unnecessary tin we get serious problem to settle nobe dis one baba

E true say nobody carry gun put 4 head but na here e go start then juju go enter wey dem go start to do plenty blood sacrifice. Make we empower ourself do better sensible and lucrative legal tin. Na we youth fit make that happen. Make we condemn anything wey no good and boost tins wey go make our nation better.
member
Activity: 504
Merit: 57
October 26, 2020, 03:36:23 PM
In the issue of resource management and mismanagement of the common wealth of Nigeria as a nation comes with the forceful co existence between the northern and the southern proletariat in 1914, I will say this was the time they sold to us whatever problem we are facing as a nation. First the national institutions of government is weak and also our constitution is faulty. Once we can have strong institutions the issue of corruption and bad governance will end.
member
Activity: 70
Merit: 26
October 26, 2020, 01:07:17 PM
yahoo yahoo don tear everywhere now we dey act like e dey cool, youths no wan work hard now to get the money again oh, dem dey wait for their clients to pay
Yahoo yahoo no carry gun hold any bOdy for money una just dey talk anyhow for dis country for unnecessary tin we get serious problem to settle nobe dis one baba
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
October 26, 2020, 04:21:21 AM
Una dey see how dem Russians padi dey give merit. No dull am, I 4 yan beta if I sabi talk make them no know, make una soji ara wa now. Not about me but your padi wey dey here.
You don talk sense, but this single thread na still wahala, normally merit go dey come small for this thread. But, if we don get our normal local board, things go make sense pass now, we go get opportunity to create topic, and more replies too go dey, na waiting we dey wish for na, if topics and replies dey good and worthy to be merited, we no go hesitate. Come see English/general boards, na there you feel post something wey good but no go see merit collect, na some merit source and few users wey dey loyal to that extent, and naa why some of us still dey rank up small, but most dey local board, so e no possible say I get enough merit, see my brother post something wey dey authentic and I no go merit ham, he no possible. But first, make we continue posting good, get more merit source and claim our local board, you will see progress among us. I con dey see 2021 down for now say the year na Naija progress for this forum. Together, we can do this. Making this forum active is one of the requisites wet dey essential before we can get local board.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
October 26, 2020, 03:32:31 AM
@charles-tim those are the among multitasking challenges Nigeria face, a country you don't get water,light,security, jobs from the government citizen has to get other ways/alt to get those essentials, and if by any chance -especially when elections are close- a government give low budget essentials they want the citizen to see it as a favour and not their duty.
Nigerian youth has chosen to stand against bad government and as we do that there is no compromising,
+cyber crime
+looting
+robbery
+cultism
+drug -abuse/peddling
And more are against what we fight for, if there is going to be a new nigeria we should Call every spadea spade.
Cyber crime and cultism na tire me pass, yahoo yahoo don tear everywhere now we dey act like e dey cool, youths no wan work hard now to get the money again oh, dem dey wait for their clients to pay, Cultism dat wan dey very stupid, just go join smtin way go make u no go fit sleep well for house, na to just dey walka dey find who dem go oppress if na their enemy them jam na to kill am, for me e go dey very hard to rectify this yahoo stuff and Cultism for Nigeria, almost impossible  Lips sealed.
Jump to: