Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 264. (Read 554634 times)

hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
November 28, 2020, 06:45:34 PM

...
Yes oooo, but some people still enter dat mottor wey carry some investor back in 2017, wit my koro-koro eye ethereum fell nd as i sey make i take profit wit my little stash my trade was cancelled nd i went down in sorrow, broda u see dis life eh, God dey.

Sorry for your recent loss bro. I been take break from crypto and moved my small stash to USDT so I no dey take advantage of this recent bull run coz of that. So when the price go high, I been wan take advantage of am and open some trades but due to exams that day, I no do am. Next thing I know, Bitcoin and the entire market just crashed. E shock me to see everything at 20% loss.

I wish u success in your EXAMS, make sure sey u get 'A's abeg, becus AAU Ekpoma no go ever give u dat tin wen u dey Computer Science Dept, maybe dem don change shiaaa.

Thanks for the wishes bro. Almost done sef. The good thing say ni be Ekpoma but my school dey very harsh so e go be similar treatment like Ekpoma.

It's good to be back here to this thread with you all.
full member
Activity: 756
Merit: 231
November 28, 2020, 02:51:16 PM
My broda, many tins dey happen for dis market, hope sey no b me d negative ones dey happen only? Trade eh, na scam Cheesy I see am, especially wen u no get otumopor. E b like sey theory na em  people dey use pass practical for trading: e shock u abi? Me self I sabi theory well-well but dey fuckup during practicals Cheesy I don lose some dollars now.
Chaiii! E just be like say you dey my mind. The trading eh, e be like say na you(we) them dey wait for. Like say one man just dey wan side dey move the wave and as e dey move am, e dey watch you. Once you say make you place trade, na once you go begin see consolidation or the trend go just go against you.
E con be like say, the theory way person know don dey out dated. The matter tire me just now.
I been venture into trading in the last couple of months back, baba na the same thing I see ooo. Once you place your sell other and it bought up boom the market go just speed up but when you come buy na then the market go just drop. I lost almost all my profits and even capital join self but I borrow my self brain I come jarpa.
I talked wit one of my bros nd him said dat de market be like sey na watch something, once u never buy hmmmm de market go dey show plenty green colors 'BUT' wen u buy na dem ur village watch go come turn dat green wey u see just now to 'RED'. I bought KAVA some months ago nd dis coin no wan reach $3 make i sell for profit, u see how dis life no balance abi?. Broda make we no worry too much becus our turn go soon reach.

... In the meantime, I hope una been take advantage of the recent green market in crypto? Don't forget to take profits wey you fit use for Christmas sha.
Yes oooo, but some people still enter dat mottor wey carry some investor back in 2017, wit my koro-koro eye ethereum fell nd as i sey make i take profit wit my little stash my trade was cancelled nd i went down in sorrow, broda u see dis life eh, God dey.

I wish u success in your EXAMS, make sure sey u get 'A's abeg, becus AAU Ekpoma no go ever give u dat tin wen u dey Computer Science Dept, maybe dem don change shiaaa.
hero member
Activity: 2030
Merit: 789
Top Crypto Casino
November 27, 2020, 06:36:29 PM
I greet my fellow community members this lovely evening especially our chairman, Brainboss. Abeg, I wan apologize to the house for going AWOL for the past couple of weeks. School come happened so I been gats prepare for semester exams I never write for over 7 months. This country na wao Oo  Shocked Well sha, I been come to salute the house as I dey kamkpe moving forward.  I go try catch up with everything wey I don miss. In the meantime, I hope una been take advantage of the recent green market in crypto? Don't forget to take profits wey you fit use for Christmas sha.
member
Activity: 504
Merit: 57
November 27, 2020, 04:42:03 AM
My broda, many tins dey happen for dis market, hope sey no b me d negative ones dey happen only? Trade eh, na scam Cheesy I see am, especially wen u no get otumopor. E b like sey theory na em  people dey use pass practical for trading: e shock u abi? Me self I sabi theory well-well but dey fuckup during practicals Cheesy I don lose some dollars now.
Chaiii! E just be like say you dey my mind. The trading eh, e be like say na you(we) them dey wait for. Like say one man just dey wan side dey move the wave and as e dey move am, e dey watch you. Once you say make you place trade, na once you go begin see consolidation or the trend go just go against you.
E con be like say, the theory way person know don dey out dated. The matter tire me just now.
I been venture into trading in the last couple of months back, baba na the same thing I see ooo. Once you place your sell other and it bought up boom the market go just speed up but when you come buy na then the market go just drop. I lost almost all my profits and even capital join self but I borrow my self brain I come jarpa.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 26, 2020, 05:10:55 PM
True it's been quiet for a while. I think everybody dey hustle for festive now. As the topic wey dey ground now be endsars, wetin dey sup with endsars movement by soro soke generation? We dey regroup to re-strategize or awa youth don tire or we dey afraid. We for continue to soro soke.
The #endsars matta never end like dat oh as UK and Canada don begin chooke mouth for the matter. CNN even release two reports documentary ontop the matta, UK Parliament dey debate the appropriate sanctions for the people wey dey involved for the massacre for Lekki and other atrocities. One UK parliamentarian even finger Yakubu Gowon as one of those wey loot owa cowtry die when im dey as presido. Just google YouTube or even for Twitter you go see sey wey are winning those polithievecians hands down!

May be you go don see these clips dem?

member
Activity: 91
Merit: 35
November 26, 2020, 02:08:39 PM
Wetin dey happen my people! This owa thread just dey too quiet like sey somebody mute am. Abi na the endsars matter still dey carry everybody mind comot from this forum in retaliation ni abi na Xmas wahala dey cut una mind? More than a week na wey somebody throw yarns for here last. Abeg oh, I nor fit shout. But shey una dey see wetin Bitcoin dey do now? The dance nor be here oh. I like the thing because as e dey happen for Bitcoin na so altcoins dem go carry body join dem. Small time now alts dem go begin rise in power too.

True it's been quiet for a while. I think everybody dey hustle for festive now. As the topic wey dey ground now be endsars, wetin dey sup with endsars movement by soro soke generation? We dey regroup to re-strategize or awa youth don tire or we dey afraid. We for continue to soro soke.
member
Activity: 143
Merit: 17
November 25, 2020, 04:50:11 AM
I don’t know how to construct that and I wish to know if there is anyway you can still educate us about this function
Okay I feel I can help.

1. Write the topic you wish to post after writing highlights it.

2. Lookup there's a Change Color button click and select the color of your choice.

Hope say e help.

(sample)
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
November 24, 2020, 06:24:04 AM
Wetin dey happen my people! This owa thread just dey too quiet like sey somebody mute am. Abi na the endsars matter still dey carry everybody mind comot from this forum in retaliation ni abi na Xmas wahala dey cut una mind? More than a week na wey somebody throw yarns for here last. Abeg oh, I nor fit shout. But shey una dey see wetin Bitcoin dey do now? The dance nor be here oh. I like the thing because as e dey happen for Bitcoin na so altcoins dem go carry body join dem. Small time now alts dem go begin rise in power too.
Na plenty things offline dey keep person off this place some times, you suppose know as he dey be. If you too dey online for 9ja you fit dey lose some offline benefits in no time. Person gats dey for both places with equal forces. Greetings and hailings senior man.
member
Activity: 350
Merit: 37
★777Coin.com★ Fun BTC Casino!
November 24, 2020, 03:20:18 AM
[4]:  All discussions are welcomed here and when you want to start a new discussion use this code
Code:
[b][color=red]NEW TOPIC[/color][/b]
followed by your topic subject.
Example: NEW TOPIC: What's your experience on forum so far?

I quote  CryptopreneurBrainboss, I applaud you for all your efforts to these community and more especially creating Avenue for Africa’s to contribute to the community and also share information about their local regions. I have a couple of NEW TOPICs I wish to post but I find it difficult to post here because of the police that all NEW TOPICS must appear in Red font ( only the headline) I don’t know how to construct that and I wish to know if there is anyway you can still educate us about this function because I believe there are other members who wish to share New Topics but are challenged and limited by these.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 22, 2020, 01:02:29 PM
Wetin dey happen my people! This owa thread just dey too quiet like sey somebody mute am. Abi na the endsars matter still dey carry everybody mind comot from this forum in retaliation ni abi na Xmas wahala dey cut una mind? More than a week na wey somebody throw yarns for here last. Abeg oh, I nor fit shout. But shey una dey see wetin Bitcoin dey do now? The dance nor be here oh. I like the thing because as e dey happen for Bitcoin na so altcoins dem go carry body join dem. Small time now alts dem go begin rise in power too.
full member
Activity: 1190
Merit: 123
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
November 14, 2020, 03:53:40 AM
Make I even warn all of us here. Abeg, make una shine una eyes wella oh. Una sabi sey many eyes dey this owa joint now. Una know sey anything naija dey draw suspicion as bad belle don too much for us. Sometimes I nor dey blame these oyibo people as dem dey take view us as ole. Na owa bad leaders dem cause am for us. Make we all dey careful with anything we dey do here, abeg. Cowtry hard.

No true you talk, no be easy simetin as the moment you identify yourself with Nigeria you don dey play away match wey chances plenty you go lose. I don get rejected just because I be Nigeria plenty time for campaign management but dat one no stop me from hyping my motherland any opportunity I see. If you no believe my ability I no fit work with you, just because I from Nigeria hi mean say I be scammer.
As in the tin just weak me like this, white pple get zero trust Wenever dem dey deal with any Nigerian, dem dey feel like say all of us na the same,if I talk about yahoo boys now, boom them go wan finish me, but seriously them dey spoil our name sha, imagine say 10 people dey one room, 9 na white then 1 na black, if smtin loss, everybody go dey suspect that one black man way dey there, I no knw wetin this black skin do them,but any how boss just keep your head up, believe in yourself, other opportunities go present themselve soon,good luck.
My people una well done oo, my name na Emma and I dey base for Rivers state, port Harcourt, I dey very happy to see my broders here , e dey give me joy, I no even know say place like dis dey for dis forum wey I fit see my people if not I for don link up since but thanks to my paddi, my close friend wey introduce me here , I know say like dis our country get as e b, but with youth like us wey get sense we fit change everything. So I say make I introduce my self here and try to relate with my brothers too.
Ah welcome bro, e good as you come identify here with us oh, just follow the forum rules and you go dey fine  Smiley.
@BlackVirues I sorry for your mama death, may her soul rest in peace. I just dey imagine wetin you dey pass through, e no easy.  
Baba thank you I no wish anybody this road I no sleep a night without crying my maale never clock better 46 years na my papa I pity most my mama was his everthing wife and only friend. God go heal us.

I dey careful with this one we learn from mistakes na God hand e dey
Sorry for your loss my bro, please accept my condolence, STAY STRONG.
 Cry sadly there will always be days like this, but God go see us through.
member
Activity: 91
Merit: 35
November 13, 2020, 11:00:47 AM
@BlackVirues I sorry for your mama death, may her soul rest in peace. I just dey imagine wetin you dey pass through, e no easy.  
Baba thank you I no wish anybody this road I no sleep a night without crying my maale never clock better 46 years na my papa I pity most my mama was his everthing wife and only friend. God go heal us.

I dey careful with this one we learn from mistakes na God hand e dey

I miss d part wey you mention your mama, so sorry to hear that o. Accept my condolences, i pray God go give u and ur family comfort. No tear body too much, universe get in plan for us and know why whatever dey happen dey happen.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 12, 2020, 05:41:01 PM
@BlackVirues I sorry for your mama death, may her soul rest in peace. I just dey imagine wetin you dey pass through, e no easy.
Oh, so na about im Marle death him later yarn there. Sorry bro. Na God go comfort you for that one. Take heart.

This thing you come yarn for here so,  no ur village ppl make you come yarn for here, as u Don confess here you don use ur hand bring wahala 4 ur head. No be everything u go yarn here as no be everybody want better for u..  

Let's hope d winch no see am oooo. Goodluck
Lol... Na real village people oh. Na the same thing wey Brainboss warn am too. But e be like sey the guy don wipe dat yarn comot for here. And me dey think sey na too much wahala wey dey im head nor make am reason the matter wella before e come yarn the dust opendentially here. I believe sey im don give himself better brain na. One love my people!
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
November 11, 2020, 10:02:35 PM
Make I even warn all of us here. Abeg, make una shine una eyes wella oh. Una sabi sey many eyes dey this owa joint now. Una know sey anything naija dey draw suspicion as bad belle don too much for us. Sometimes I nor dey blame these oyibo people as dem dey take view us as ole. Na owa bad leaders dem cause am for us. Make we all dey careful with anything we dey do here, abeg. Cowtry hard.

No true you talk, no be easy simetin as the moment you identify yourself with Nigeria you don dey play away match wey chances plenty you go lose. I don get rejected just because I be Nigeria plenty time for campaign management but dat one no stop me from hyping my motherland any opportunity I see. If you no believe my ability I no fit work with you, just because I from Nigeria hi mean say I be scammer.

@BlackVirues I sorry for your mama death, may her soul rest in peace. I just dey imagine wetin you dey pass through, e no easy. In regards to you account I go advice you abandon this account as you don already compromise am by associating am with your 4ma account. Dem gi ban u again and you might never know who fit betray you here, trust no one.

Although the forum dey against ban evasion (that's creating another account when they don ban the first one) no body go disturb you as far you fit stay under a new identity. 
member
Activity: 91
Merit: 35
November 11, 2020, 02:09:24 PM
Abeg make Una dey careful with the wallet Una dey use the one I use for my  2015 banned account bounty hunting days I make mistake use am for signature campaign den ban the account the same day my mama die na high bp I go through una brother Blackp*ssy Don show for jungle again make Una try for me

This thing you come yarn for here so,  no ur village ppl make you come yarn for here, as u Don confess here you don use ur hand bring wahala 4 ur head. No be everything u go yarn here as no be everybody want better for u.. 

Let's hope d winch no see am oooo. Goodluck
member
Activity: 143
Merit: 17
November 11, 2020, 01:18:12 PM
<...>
Baba De matter tie wrapper for here o my village people carry matter follow me for here dis oyibo no get joy for us den dey disburse merit for der local board like madt make we try be our brothers keeper
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 11, 2020, 10:19:19 AM
Abeg make Una dey careful with the wallet Una dey use the one I use for my  2015 banned account bounty hunting days I make mistake use am for signature campaign den ban the account the same day my mama die na high bp I go through una brother Blackpussy Don show for jungle again make Una try for me
I nor too understand your yarns  for here oh. Wetin you dey talk here be sey na you be the same person as Blacklist and dem don ban that account sake of sey you use wallet address wey you use for account wey you open for 2015 take run signature parole? Well, if dat na wetin you mean to talk there be dat, e mean sey wetin you dey do now with this new account be ban evasion. If dem find out sey na you still get this new account, dem go slam you with another ban join. That one go be permanent ban. Ban evasion na ogbenge bad thing for here oh. You mention your mama there. Writing do Marle? She too dey Crypto?

Make I even warn all of us here. Abeg, make una shine una eyes wella oh. Una sabi sey many eyes dey this owa joint now. Una know sey anything naija dey draw suspicion as bad belle don too much for us. Sometimes I nor dey blame these oyibo people as dem dey take view us as ole. Na owa bad leaders dem cause am for us. Make we all dey careful with anything we dey do here, abeg. Cowtry hard.
sr. member
Activity: 1162
Merit: 276
November 11, 2020, 04:05:34 AM
Username:crptomagma
Gender: Male
State of resident (optional): Portharcourt
Skills: Crypto Enthusiasts, Visual communicator, Fx- trader

I salute everyone here fundamentally. It’s important we keep our eyes on watch tower for the days are evil especially those from Nigeria because as e be now the country dey hot. Even in the face of the  prevailing circumstances in our country we shall continue to excel and never to stumble. My advice for all of us don’t give up on your dreams, keep believing and when it’s time to do bitcoin business with anyone be sure of the person or better still let’s all transactions be carried in the right board for security reasons. No loose guard, always be guided and seek for advice from others. E get why!

Welcome brother, Una dey make us feel proud as interest from obodo naija dey dey very powerful very soon dem go just dash us our own board make we for dey gather momentum dey strong like others. For everyone of Una wey dey get my back with meriti I really dey grateful. Una be the most vita humans wey naija bred. God no go shame Una Chineke go bless Una this festive season. Amin
legendary
Activity: 2226
Merit: 1049
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
November 09, 2020, 05:22:29 AM
Very soon BTT sef go get Port Harcourt branch  Grin. Una don plenty for dat angle now. I hope una go arrange a kind of get together this festive period, to relax and eat Bitcoin money small. I hope the Obigbo wahala nor reach your side sha? Wike na big disappointment.

Abi, wike na fuck up man, afta all e para see wetin dey happen for e door pose. The story no be here oh like bloody sometin na e dey happen der. About the get together, if chance come out we suppose organized am but I sure by dat december time most people go dey busy, me especially but make we dey see how d tin go play out.
This get together thing for make brain well well, as e go be a very good opportunity for all of us to meet each other in person, share crypto stories and ideas, and if possible self, we fit from this opportunity, organize ourselves, launch our own crypto project/company wey go serve us, our children, our country and the globe as a whole, we fit do am, the most important thing na for us to put ideas together...Abi wetin una think?
Dis na challenge to odars wey dey here from odar zones nd not yet known demselves. E go gud sey dis kind tin start from Port-H becus dem many for hia. As for Fivestar4everMVP, e go make alot of sense if dem or any grup go fit form such colabo for dis type of business, but my fear go be betrayal of trust, i don do dis type before when FB was new in d market wit some radom friends but later we disintegrated from our common goal. Hope we have like minded innovators among us, den, dis can work very well sir.

Dose wey dey Abuja make una dey raise una hand now before i go check dis classroom.
Na true you talk my brother, even me wey suggest wetin I suggest, I thought about that betrayal of trust thing, because na something to be very weary of, and the chances say one or two persons must fuck up dey there, but then, I believe say if we do our home work well well, like proper physical and background investigation of every one wey wish to join the team, and setting up of strict rules everyone must abide to, and if possible, we can have the firm registered with a security body where we fit arrest anybody or person wey bring kata kata amongs us, if we no see the person arrest, we fit go for their family members as long as we have the law to back us up.
full member
Activity: 756
Merit: 231
November 08, 2020, 09:03:52 AM

Jump to: