Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 15. (Read 10546 times)

member
Activity: 308
Merit: 32
January 25, 2023, 05:45:43 PM
Proverb: Eye wey see go chop .

Meaning: since am there then I will partake in what is been shared.

Proverb: No dey drink panadol for my headache
 
Meaning: don't get unnecessary worried about me.

Proverb: money no like noise na why dem no dey play song for bank

Meaning: rich people are not noisy.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
January 25, 2023, 05:17:11 PM
~snip~
My chairmo, I hail you. Abeg nor vex. Sometimes person too dey forget. But no worry I don take corrections. For my next post na better pidgin wey I go sama wella.
I see they good work wey you dey too here and I know e go continue. I also like as I dey see other new new members dey drop one or two for the thread, e dey sweet my body well well.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 25, 2023, 05:06:20 AM
~
Chairmo, I hail una. I hail una put on top again. Abeg, e go good make una dey align una format with pidgin. Na pidgin we dey knack here. We nor too go school. Na night class we go here. Help us dey put una proverbs for pidgin and then the explanation for English.



I greet all of una wey dey keep here warm. I wish I get colele wata to pour all of una sef. E dey sweet my belle wenever I see my people and come see sey una carry badge for body. E show sey Oluwa dey still put bread for una tables, im nor allow una see shege and red pepper wey most of owa compatriots dem dey see unto bad administration for Naija. Abeg, make una hold here tight and nor allow any fvck up rub una. Persin wey dem tell make im ride on, e mean sey d thing wey im dey do dey good. Una ride on!
newbie
Activity: 14
Merit: 1
January 23, 2023, 04:04:20 PM
Only a fool tests a drive with his two leg
This means - you don't jump straight into a situation without thinking about it first


A roaring lion kills no one
Mean you cannot achieve or gain anything by merely sitting around and just talking about it

Life is like a mist or a shadow, it
Mean- quickly passes by life is too short, and you only live it once.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
January 23, 2023, 01:50:27 PM
Proverb: If a road is good, you would go through it twice
Meaning: A business person who is honest will get a return customer and a referrals.

Proverb: When death is calling a dog, it will block the dog from perceiving the smell of poop.
Meaning: A person who will get harmed will ignore all the warning and tell-tale signs before he gets hurt.

Proverb: If you do fast fast, you will overcome any hindrance on your way.
Meaning: Cultivate a sense of urgency so that you will be able to beat any trouble on your way.

Proverb: A farmer's dirty hand used to cultivate food is the same hand that will be used to harvest the crops.
Meaning: Na who work go see food chop.

 
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
January 18, 2023, 02:14:33 PM
E come be like say I dom forget dis we corner but today as my old malle yarn better word of wisdom give me I say make I sharam with my people here so dat we go still use am learn and grow in wisdom.


Proverb: Dem say person wey no dodge your brain as em bite you for head when you dey bite em for  yansh no dodge shit.

Meaning: When someone refused to be merciful to you in time of difficulties, don't forget to make them feel the pains they caused you when they encounter same situation.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
January 17, 2023, 04:05:00 PM
Proverb: Who dey argue with king, na him dey tey for kneel down.

Meaning: Ignore an authority to your own peril.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
January 17, 2023, 11:07:52 AM
Proverb: Person wey dey purge nor dey select toilet

Meaning: A beggar has no choice.

Proverb: Dem nor dey use night dey find black goat because e go hard you to find.

Meaning: What you have to do do quick.

Proverb: A hen with many chicks doesn't know how to run from a fight. She'll get stuck in it.

Meaning: A man with kids shouldn't look for trouble be because it will be difficult for him to escape with his kids when trouble comes looking for him.

Proverb: Sense be like bag, everybody with him own for head.

Meaning: Everybody get him sense, so dem nor go say Dem nor Sabi wetin Dem dey do.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
January 15, 2023, 03:30:48 AM
Proverb; Ibo piple say when man say YES ehem chi go follow say YES too.

MEANING; A man's actions affect his destiny as determined by his chi...

Una good day oh if better meaning come up make una add am biko... Oga Mpa I hail you
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 11, 2023, 07:45:31 AM
For example when I been dey for this thread I was treated well that is why I enter here again.
Ok, but I hope you nor relax com spoil owa TV remove sha 🤪😁
Oga Mpa, I no too understand the pidgin grammar wey you knack. But I sure say I no go break the TV wey all of us dey carry watch match  Grin
Shue! Na so u quick forget dat owa proverb on "feel at home, feel at home na so visitor dey take spoil TV remote" as you sey you were warmly embraced for d thread d first time wey u come here na?


Na persin wey carry palm fronds goat dey follow.
Meaning: People will run after you and do your bidding when you've what they want or long for.
sr. member
Activity: 812
Merit: 455
January 11, 2023, 05:11:30 AM
Proverb Our elders say sun go shine for people wey stand be4 am and shine on those piple wey knee down dem.

Meaning the important things will be done first than the less important things.
hero member
Activity: 1218
Merit: 658
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 10, 2023, 04:19:47 PM
For example when I been dey for this thread I was treated well that is why I enter here again.
Ok, but I hope you nor relax com spoil owa TV remove sha 🤪😁
Oga Mpa, I no too understand the pidgin grammar wey you knack. But I sure say I no go break the TV wey all of us dey carry watch match  Grin

Hang your cap for where your hand go reach.

Meaning: Do things that are within your reach.

My brother sometimes we go need to try things wey no dey our reach. If you no stretch your limit sometimes you no go know how far you go fit go. If you keep trying only the things wey dey your reach (your comfort zone) you fit no grow in life. Or you go fit grow but you no go grow reach your potentials.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
January 10, 2023, 02:21:32 PM
Proverb: If a child no mature enough and tie wrapper. If breeze blow the wrapper will cover the face
Meaning: There should be maturity and experience in whatever one wants to does so as to be able to face the challenges when it comes up

Proverb: Some that pursues a chick, the chick will be running and the person pursuing it will be falling
Meaning: Whoever plans evil against someone whose hands are pure, will be the one to fall for it.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 09, 2023, 10:35:09 PM
For example when I been dey for this thread I was treated well that is why I enter here again.
Ok, but I hope you nor relax com spoil owa TV remove sha 🤪😁

Hang your cap for where your hand go reach.
True talk my broda.
jr. member
Activity: 50
Merit: 1
January 08, 2023, 12:10:13 AM
Hang your cap for where your hand go reach.

Meaning: Do things that are within your reach.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
January 04, 2023, 05:00:57 PM
I like say this thread don enter our Naija board. E go dey easier now to drop one or two wisdom from time to time.

So earlier this week when I dey talk with my grandma, she drop one proverb for our local language as I dey tell am about one matter.

Proverb: Soup wey hot na patience dem dey take chop/ lick am.

Meaning: No matter how urgent a task dey, make you dey patient do am
hero member
Activity: 1218
Merit: 658
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 04, 2023, 04:11:50 PM
Good one Oga Mpa for moving this thread to our local board e make sense.
E don tey I come here to collect wisdom. Na many things wey full person head shaa. But still on still Baba God na King.

As I don reach here make I for find one drop

If you weed road wella, dem go follow the road two times

Any opportunity you have to impress or help someone do it well.
For example when I been dey for this thread I was treated well that is why I enter here again. So, I don follow the road twice because dem weed am well
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Enjoy 500% bonus + 70 FS
January 04, 2023, 03:39:51 PM
Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control.
Meaning: It's commonsense not to over step one's bounds when given a free hand.
@Mate2237, you go find dat same yarn for the first page here. Na im I quote for you join.



Dem nor dey take eye put fish for soup
Meaning: No one gets the best of what they want by mere wish without putting in the work for it.
I don see am nd I like di yarn. Some pesen dey over do wen given di opportunity 2 do something. For di won u drop, na so life dey bi dat. Everyone has high taste. Di eye dey find di best everytime.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
January 04, 2023, 12:01:03 PM
Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control.
Meaning: It's commonsense not to over step one's bounds when given a free hand.
@Mate2237, you go find dat same yarn for the first page here. Na im I quote for you join.



Dem nor dey take eye put fish for soup
Meaning: No one gets the best of what they want by mere wish without putting in the work for it.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
January 04, 2023, 11:30:39 AM

Feel at home, feel at home nai dey make visitor dey spoil remote control 4 di house wey im visit.
Weti bi d meaning?

Meaning: Be careful of the people you help or invite into your life because some persons will abuse the privileges given to them.
I hope I get am or I come close to the meaning Smiley
Pages:
Jump to: