Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 11. (Read 10492 times)

member
Activity: 212
Merit: 12
May 19, 2023, 03:32:41 PM
It's good for us to talk in our forefathers dialect,to prove to us that we are really born and brought up by the lineage of our ancestors.

Provable is the Igbos language,,,,

No matter how hard the jungle is,a Lion can never eat grass,,it means that no matter how bad leadership or the whole world turns into we must try to survive...
An old woman says if the hill learns to break her waist she will learnt to walk and take rest,it means that when the journey of life begins stressful we learn to apply wisdom to it..
hero member
Activity: 1050
Merit: 627
Watch&Pray.
May 18, 2023, 12:10:58 PM
The boat that sail on the sea or an ocean doesn't know it doesn't have an end.
Meaning; No matter how your are suffering or hustling know that one day your maker (God) will answer your prayers. So don't give up keep pushing to get to your destination.

Haba baba abeg make una try dey calm down with dis big big grammar Dem nah, here now we African proverb we no need to blow big big english so dat our elders go hear and follow us chuck mouth. Make we try dey use pidgin even as the corner na African Proverbs in Pidgin so that every bodi go flow 2geda.

No carry dis talk for mind because my people talk say no be only papa and mama wey born pikin dey train am because pikin na every bodi own once Dem give birth to ram.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
May 18, 2023, 02:02:33 AM

3. Pu--y dey sweet oh, but signature campaign sweet pass
Meaning: Women is sweet but money is sweeter.


Guy this your own quote na wa oo. Definitely na your own personal quote no be African quote  Grin. E just be like the kind of quote wey the late Zimbabwe president, Robert Mugabe dey give.

Anyway, make I drop my own quote, hope say dem never splash am here already...

Stealing the village drum is easy but finding a place to beat it peacefully is the problem.

Meaning:  “Stealing the people's mandates is easy, but governing peacefully with the consequences of your actions thereafter is the problem.” I think this na quote wey dey online, I use Google check the meaning com see say e relate to the past election wey de matter still dey court.

But apart from that meaning, me I for still say e mean say anything wey belong to the village, you no fit thief am and still use am for the same village make men no catch you.
hero member
Activity: 1190
Merit: 799
May 10, 2023, 03:24:11 PM
It feels good to finally drop my first African proverb in pidgin for this board wey we dey so, and dey go like this;

1. Na fly wey no dey hear word dey follow dead body enter for grave oh.
Meaning: When a fly fails to hear words it follow the corpes to the grave

2. Pikin wey don say him mama no go sleep for night make eh also ready for night vigil.
Meaning: When a baby fails to sleep at night both mummy and child stays awke till dawn.

3. Pu--y dey sweet oh, but signature campaign sweet pass
Meaning: Women is sweet but money is sweeter.
hero member
Activity: 1316
Merit: 379
WOLFBET.COM - Exclusive VIP Rewards
May 09, 2023, 07:14:13 PM
The boat that sail on the sea or an ocean doesn't know it doesn't have an end.
Meaning; No matter how your are suffering or hustling know that one day your maker (God) will answer your prayers. So don't give up keep pushing to get to your destination.
newbie
Activity: 38
Merit: 0
May 09, 2023, 09:14:28 AM
If breeze blow wella, foul yansh go open. ( Meaning )   "If person go through difficulties too much, people will see your secret"
legendary
Activity: 882
Merit: 800
May 05, 2023, 04:39:49 PM
Our people say any discussion them discussed for night morning na to nod head.
Meaning: always work on your life the way you planned it out and whenever it works people will come jubilating with you thinking it was that easy without planning.
I say make I carry this one come here.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
May 05, 2023, 01:52:34 PM
but e pain me say she kick bucket when tins no soft for me...
I feel you on dat. Somehow somehow we nor need to dey wait until things soft because things nor go everly soft for dis life oh. As life don programme be sey "the more money we make the more problems we get." Those small small things wey we fit do fit go a long way in other people's struggling life.

Oyibo dey call am "once a man, twice a child.
Na dat koko don dey as my avatar text for long oh. Na true principle of life be dat and as dem dey play am, e dey show korokoro.
hero member
Activity: 1008
Merit: 629
May 05, 2023, 01:13:18 PM

No how wey you go take torchlight old woman wrapper wey you nor go see shit there.
Meaning: In life, everyone has their own shortcomings. Sometimes, it's good to look pass these inadequacies.

 Oga boss, no be lie you talk. Mesef no nid torchlight sef and just like @Giftedman tok, e good to do those things seeing as their age don go plus nah two times person dey be small Pikin. (Newborn and old age). Oyibo dey call am "once a man, twice a child. No be to dey shout for them, but rather follow them wit understanding and nah dia blessings dey. At least @Giftedman dey reap am.
hero member
Activity: 1050
Merit: 627
Watch&Pray.
May 04, 2023, 06:10:17 PM
but on a normal I go just help her tidy the stuff like say nothing happen because I know say old age go reach everybody unless person wey die before em time...
I sure sey granny go don pour ororo for your head join too.

She pour me better ororo for my head no be small but e pain me say she kick bucket when tins no soft for me but I dey happy say I dey alive dey see tins and tins wey she bin pray for me dey show face wella, tears dey drop for my eyes now but I no fit shout because na oluwa Sabi why beta people dey go home early.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
May 04, 2023, 05:25:32 PM
but on a normal I go just help her tidy the stuff like say nothing happen because I know say old age go reach everybody unless person wey die before em time...
You do well my guy. E show sey you get sense. Our people sey pikin wey sabi cover im parents shame na pikin wey get sense be dat. I sure sey granny go don pour ororo for your head join too.
hero member
Activity: 1050
Merit: 627
Watch&Pray.
May 04, 2023, 01:16:24 PM

No how wey you go take torchlight old woman wrapper wey you nor go see shit there.
Meaning: In life, everyone has their own shortcomings. Sometimes, it's good to look pass these inadequacies.

My chief, wetin you talk make sense well well and the meaning come enter well for my brain. Via say I don stay with my granny well well, I no even need to use light see small small shit self but on a normal I go just help her tidy the stuff like say nothing happen because I know say old age go reach everybody unless person wey die before em time, you do well and I salama for you my elder.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
May 04, 2023, 08:45:24 AM

No how wey you go take torchlight old woman wrapper wey you nor go see shit there.
Meaning: In life, everyone has their own shortcomings. Sometimes, it's good to look pass these inadequacies.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
April 27, 2023, 04:03:19 PM
NO matter how dark room wan be, man go still  locate woman breast.BTC
Dis guy, hia. Well, I nor talk pass dis wan.

proverb:  where sugarcane dy sweet  pass nah for em joint
Tell me somethin wey I nor know. Me nor even dey like dat sugarcane joints sef.

Dem say pikin wey eat leak plate no tell em mama thank you no go see plate to leak again.
Na so life be oh. I go just dey look people wey dey dispise their humble start and days of little beginnings once dem make am big with one eye. These people nor wise at all.
sr. member
Activity: 812
Merit: 455
April 25, 2023, 02:48:37 AM
proverb:  where sugarcane dy sweet  pass nah for em joint

Meaning: good things of life can appear difficult to achieve but at the end it's Worth it.

hero member
Activity: 1050
Merit: 627
Watch&Pray.
April 24, 2023, 08:58:19 AM
Dem say pikin wey eat leak plate no tell em mama thank you no go see plate to leak again.

Meaning:When you are grateful for the little you were given, you open more door for more to come your way.

Even as everyhere red for our economy now, try dey appreciate anybody wet dey show you love or person wey dey carry you along, no use bad attitude pursue your destiny helper oo e get why,

na better salutation I carry come for my elders here una too much.

newbie
Activity: 20
Merit: 1
April 20, 2023, 02:32:32 PM
NO matter how dark room wan be, man go still  locate woman breast.BTC
There is always a way when something matters much.

1)Craze no hard to form,na the trekking be wahalaBTC
Easier said than done

2)Opolo eye no be open eyeBTC
Having Big eyes doesn’t make you civilised
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
April 19, 2023, 09:10:43 PM
Dem say road wey man pass pick money, every time wey em dey pass dia em eyes no go comot for ground.
Nor be lie at all 😂. Na continuous strolling man go dey do around that area oh.

Proverb; leg wey no dy rest go always waka enter snake pit
Somehow somehow, the meaning nor too tally. Maybe you go need explain again.

Don't set sails Using Someone else's star:    

The eye never forgets what the Heart has Seen
Chairman, abeg we nor too go school for this thread. Na im make us dey use pidgin English dey yarn. Edit your post to pidgin.
member
Activity: 322
Merit: 10
April 19, 2023, 05:20:59 PM
Don't set sails Using Someone else's star:    
meaning:
Avoid imitating somebody else because you will end up disappointed. Grin Grin Grin



The eye never forgets what the Heart has Seen
meaning
That all issues that Pricked the heart will be remembered whether they be good or bad.
jr. member
Activity: 88
Merit: 5
April 17, 2023, 05:44:31 PM
Wait your mama go sit down see, you go climb the highest mountain, you no go still see am..lol I no really know why my mom dey always tell me this thing.
Pages:
Jump to: