Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 18. (Read 9496 times)

hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
November 03, 2022, 02:21:04 PM
Meaning: Your growth and success in life are fastened by your exposure to people with useful information and your ability to utilize the knowledge you have to actualize your goals.
Igbo kwenu! Now I don sabi sey you be nwanna. Ji si ke! But dat your explanation for dat proverb nor too be wetin e mean oh. Ask anybodi wey sabi, den go tell you d real meaning. I salute your new rank, broda mi.

Thank you my chief, I no go lie you na wetin my own understanding give me na em I carry come yarn as the meaning so but as my senior elder and chief wey you be you fit still explain more to me so that I go fit add to my own knowledge. No forget say talk wey get power dem no dey use am play.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 03, 2022, 01:38:11 PM
Meaning: Your growth and success in life are fastened by your exposure to people with useful information and your ability to utilize the knowledge you have to actualize your goals.
Igbo kwenu! Now I don sabi sey you be nwanna. Ji si ke! But dat your explanation for dat proverb nor too be wetin e mean oh. Ask anybodi wey sabi, den go tell you d real meaning. I salute your new rank, broda mi.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
November 03, 2022, 08:40:51 AM
My people I say make I drop dis word of wisdom wey my grandma use Igbo give me as I dom become Senior member today,

Proverb: Anaga nu bi oka anaka
English : Na the more you visit your farm na the more your corn go mature.

Meaning: Your growth and success in life are fastened by your exposure to people with useful information and your ability to utilize the knowledge you have to actualize your goals.

Am now a Senior Member.

hero member
Activity: 784
Merit: 589
October 28, 2022, 07:01:23 AM
PROVERB: Na where person take dey fear to say "no i nor wan chop", na im e take dey chop poison.
Honestly, na true you yarn here. Wen e reach like dat, me I nor dey send anybody oh. I go tell you sey I nor eat, hoohaa! I nor go wan please anybodi com displease my conscience. Once bodi do me sey make I dodge, I dodge at once. Most times, wen persin disobey dat signal na real gbege e dey carry person enta oh.

Oga boss, ya geh dey local, I mean loyal oh. E good to respect signal wey bodi dey give before you go regret. Although my own no be food mata, but my bodi bin no do me to waka one waka like dat but I still use strong head go. Nah God nai save my life say I come back although I loss property o.

Those proverbs wey you put dia rili pack meaning o. Your wisdom rili long
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
October 27, 2022, 09:58:03 PM

PROVERB: If your mates dey craze you follow them craze so that dem go cure all of una at one time

MEANING: If your sets of friends are making progress in life why not wake up sets your goals, work harder and become successful in life so  when others are celebrating you could also celebrate with them and not being used as an errand boy or leaving a regretful life.

This one na strong 💪  word oo I no go lie you but I hope say you still remember say as e work for John no be so e go work for Peter?
And my people dey talk say when man wake up na the time wey me own day break so I feel say you fit set your goals when you and your friends dey hustle but tins no go work out but na when dem dom make am you fit see road through them e dey happen and I believe say everything na with time and luck.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 27, 2022, 01:51:52 AM
~
One time I tell my small cousin to wake up and hustle fast. D guy get handwork but e nor dey serious with am and the reason be sey him dey see himself as comfortable because all im mates dem dey d same level then with am. I tell am sey d day wen im go realize sey time don go na d day wey im go hear sey some of his mates don top up and e go begin hard am. Na d thing wey dey happen na with d dude. Dem don leave am behind.
hero member
Activity: 1400
Merit: 650
Always Act Smart and Play Safe With Your Funds
October 27, 2022, 01:25:08 AM

PROVERB: If your mates dey craze you follow them craze so that dem go cure all of una at one time

MEANING: If your sets of friends are making progress in life why not wake up sets your goals, work harder and become successful in life so  when others are celebrating you could also celebrate with them and not being used as an errand boy or leaving a regretful life.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 26, 2022, 11:35:09 AM
PROVERB: Na where person take dey fear to say "no i nor wan chop", na im e take dey chop poison.
Honestly, na true you yarn here. Wen e reach like dat, me I nor dey send anybody oh. I go tell you sey I nor eat, hoohaa! I nor go wan please anybodi com displease my conscience. Once bodi do me sey make I dodge, I dodge at once. Most times, wen persin disobey dat signal na real gbege e dey carry person enta oh.

Proverb; Na person wey snake don bite dey see rope for ground dey run
Anoda wans wey resemble dat proverb na:

1. Persin wey mad man kill im mama dey fear mechanic.
2. Persin wey bee sting before dey always japa wen e see tsetse fly.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
October 22, 2022, 06:01:52 AM
Dem sey e nor dey good make craze people scarce for community but na from which person family e go come from bi d problem.
Meaning: It's normal to have natural abnormalities occur once in a while to keep reality in check but no one would want to bear the brunt of such happenstance.
Oga mi, dis one choke o. E just remind me of one story I bin ya wen I small wey the title na who will bell the cat?
E no gud as Boko Haram dey wori us upandan but na who go go stop them na?
 I no go lie, dis one you drop hit wetin dey wori us for we contri but we no gree admit. Make I drop this one here na.

Proverb; Na person wey snake don bite dey see rope for ground dey run

Someone who has had a bad experience will not like to repeat it no matter how appealing it may appear

legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
October 20, 2022, 02:56:16 PM
PROVERB: Na where person take dey fear to say "no i nor wan chop", na im e take dey chop poison.

MEANING: Failing to set boundaries and be straight forward with some people and decision respectively is often what leads to insults and problems. Maturity is knowing when to be straightforward, and sticking with your decision.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
October 20, 2022, 08:08:29 AM
Dem sey e nor dey good make craze people scarce for community but na from which person family e go come from bi d problem.
Meaning: It's normal to have natural abnormalities occur once in a while to keep reality in check but no one would want to bear the brunt of such happenstance.

My chief, I no go lie you talk true but water dey run my eyes as I dey see this correct word of wisdom wey you drop now.
For my mind eeh if e dey possible I no go like make craze people dey at all because na bad thing be that and e no go make the community get good reputation especially if dem plenty well well 😆. Take wetin happen for Lekki tollgate wey we dey remember today as an example, you go like make this kind thing happen again?  If na this kind thing be the madness wey we dey talk about baba me no want am again because I know how many of my men wey go down that faithful day, I am in pains.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 20, 2022, 07:50:21 AM
Dem sey e nor dey good make craze people scarce for community but na from which person family e go come from bi d problem.
Meaning: It's normal to have natural abnormalities occur once in a while to keep reality in check but no one would want to bear the brunt of such happenstance.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
October 18, 2022, 10:49:32 AM
I dey welcome all the senior men dem wey dom enter this place wey elders dey discuss things dem wey make sense I say make I officially welcome una. For the election wey dom set like dis I say make I use dis word wey my granny give me remind una something now.

Proverb: You go fit deceive blind person say oil dey inside soup even when e no dey but you no fit tell dem say pepper and salt dey for soup when e no dey.

Meaning: People are easily scammed because of little or no knowledge of what they are into not when they are aware of what they are doing or what they want.

Proverb: person wey wise no dey make one mistake two times

Meaning: You get better when you fall and rise not when you fall and fall again.

Na the things wey dey happen for our country today make me dey yarn like dis abeg make all of us put hand use one mind vote better person wey no go carry us enter another 8years of hunger and hardship because suffer dom tire me like dis for here.

Rush go buy pms(Fuel) keep because scarcity go begin for naija this weekend.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
October 15, 2022, 07:07:04 AM
As I enter here e come be like say area dry so I say make I drop dis word wey my grandfather yarn today give one of my brother wey dey form say em sabi waka waka.
Nice one. Una wey still get grannies na treasure una get oh. Make una treasure dem now wey dem dey alive by moving close to dem and relate wella. Na una go benefit am pass. From time to time sef make una groove dem join. BTC money too much, e nor dey finish 😆

No wahala my Chiefoo I go do as you talk. I dey try my best to dey show dem love but you know say as dem dom old like that dem dey behave like small children now if you no get mind you no go fit endure there wahala finish, thank you for the heads up I dey very grateful to come across elder wey dey like you.

Proverb: Cow wey dey rush to go abroad, go come back as corn beef

Meaning; One who refuses to take instructions or correction will end up in trouble.
 
 Tank you veri much😁

Correct yarning my brother @ Majestic -milf, your proverb make sense weller I wish say I get holy water I for baff you but no worry on how we still dey together you go collect wotowoto, welcome and keep it up.
Only this one you tok like this don gimme burse my bololo dada. I dey enjoy all the proverbs I don see ya. All of dem dey make me laff but meaning jabarata. Beta oil dey ya head @GiftedMan.

Mai drop dis one ya.
  Proverb: Na only mumu dey test if water deep with im two legs
Meaning: Before taking any decisions, think properly to avoid problems.
Proverb: Rain nor dey fall one side
Meaning: Trouble comes to everyone, both the black and the white
jr. member
Activity: 518
Merit: 1
October 14, 2022, 06:56:30 AM
Proverb: D person wey fight and run away know how im strength reach.

Meaning: He who fights and runs away, lives to fight another day.

Correct man, you try well well as you come drop better yarning here.
This word wey you drop na popular word wey I dom hear since but for my own side eeh, I believe say wey fight run away dey run to go carry weapon oo 😆 anyhow I welcome you correct elder.

Thank you my ogas @GiftedMAN, @Mpamaegbu at the topmost top and to every person wey dey contribute to the success of this thread, I dey trowey salute.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 12, 2022, 10:09:32 PM
~
No wahala my Chiefoo I go do as you talk. I dey try my best to dey show dem love but you know say as dem dom old like that dem dey behave like small children now
Na wetin we suppose expect for old age be dat na. Read d text wey dey for my avatar you go understand betta. Na why we dey try beg Tinubu to go home and rest but baba wan die for dat matta.

crytolad, I hail thee. Welcome to owa corner.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
October 12, 2022, 01:51:08 PM
I say make I enter this corner today, con follow contribute for wetin sup for here.

PROVERB: BIG TREE NOR DEY LACK WATER

MEANING: A big tree has many branches over time, as it develops branches, its root grow deeper, means it cannot lack water. As you help people, you cannot go small from helping.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
October 11, 2022, 05:20:25 PM
Proverb: D person wey fight and run away know how im strength reach.

Meaning: He who fights and runs away, lives to fight another day.

Correct man, you try well well as you come drop better yarning here.
This word wey you drop na popular word wey I dom hear since but for my own side eeh, I believe say wey fight run away dey run to go carry weapon oo 😆 anyhow I welcome you correct elder.
jr. member
Activity: 518
Merit: 1
October 11, 2022, 04:58:41 PM
Proverb: D person wey fight and run away know how im strength reach.

Meaning: He who fights and runs away, lives to fight another day.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
October 08, 2022, 06:38:52 AM

Jump to: