Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 16. (Read 9496 times)

sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
December 06, 2022, 04:14:25 PM
You dey highly welcome @sokani to dis our corner and na for right-hand side I wam make you sit down hear and learn from elders dem wey dey here. Wetin you talk about words of elders make sense because na only person wey get four eyes dey see when witch dey pass and as I see your foot step you go do well.

Make I use this wise word take welcome you.

Proverb: No be every person wey dem call hope get hope

You fit drop your own meaning make we flow together.

Thank you my brother.
E be like you just bake this one bring am out from fire as e dey hot Smiley

Proverb: No be every person wey dem call hope get hope.
Meaning: You don't inherit an attribute by having a good name.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
December 05, 2022, 02:47:22 PM
Hello guys! This one na the second naija thread wey I don see for here, we no dey carry last sha. I greet all of una senior men and women dem. E good make person try identify himself with him own people especially for place like this. I dey look forward to the words of wisdom from my elders and make we join hands together make this place better.

You dey highly welcome @sokani to dis our corner and na for right-hand side I wam make you sit down hear and learn from elders dem wey dey here. Wetin you talk about words of elders make sense because na only person wey get four eyes dey see when witch dey pass and as I see your foot step you go do well.

Make I use this wise word take welcome you.

Proverb: No be every person wey dem call hope get hope

You fit drop your own meaning make we flow together.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
December 05, 2022, 01:22:00 PM
Hello guys! This one na the second naija thread wey I don see for here, we no dey carry last sha. I greet all of una senior men and women dem. E good make person try identify himself with him own people especially for place like this. I dey look forward to the words of wisdom from my elders and make we join hands together make this place better.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
December 01, 2022, 12:36:23 PM

If Dem join join piss for a particular spot e dey bring foam
 
This one nah funny but meaningful proverb oh, if you just use surface eye take look am, nah just laugh pesin go laff comot face, but msg dey. We don enter new month and e go gud as we dey jolly dey celebrate, make we dey vigilant too.
 Elder, make I drop dis one here
Proverb: Okra say e know say nah you buy am, but if you no chop am with respect, e go spoil ya shirt
Meaning; Accord everyone with respect since respect is reciprocal
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
November 30, 2022, 04:45:33 AM
if dem join join piss for a particular spot e dey bring foam.

Elder Mpa, this one dom burst my head this morning because I still dey remember how me and my guys dem dey piss together when we dey grow up just to see as the piss go foam. Thanks so much for taking me back to my childhood life nothing pass to dey wia elders wey dey talk things wey dey happen for real life dey.

Abeg make I drop one here.

Person wey dey blow trumpet dey also comot catarrh

Meaning: The simple meaning wey I get for this word na say person wey work go chop.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 30, 2022, 03:21:52 AM
I just dey reach here now and I don dey para say I don miss plenty tori and I don take time read plenty parable fr here wey I don laugh tire.
E come be like say plenty old men full the house wey just dey disguise as youngie them.
One of the proverb we sweet me na the one wey them talk say "Even if goat get frown face e no go lack buyer for market
I no dey too reason the meanings oo but the way person dey take time arrange this talk dey burst my head because I dey really reason am say our fore father's been really get big talks for mouth.
My broda I welcome you too. My gas don finish if not I for try cook you small somtin as e be say your journey to find here bin choke. Make you use the proverbs wey jakpa for ya take hold bodi. welcome once again.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 30, 2022, 12:02:55 AM
I just dey reach here now and I don dey para say I don miss plenty tori and I don take time read plenty parable fr here wey I don laugh tire.
I see say our eldest elder wey be@ Mpa dom pour you holy water no worry more go reach you as you continue to dey sit down wia elders dey.
Dis guy sef, you nor go kill persin here sha 🤣 wit all these ur accolades. Anyway, it goes well sey dis owa corna dey enlarge small small as more people dey fall in. Nothing wey pass unity in numbers as owa people dey talk sey if dem join join piss for a particular spot e dey bring foam. Na so we go dey do here to bring joy and betta wisdom to owaselves. One luv!
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
November 26, 2022, 11:44:44 AM
I just dey reach here now and I don dey para say I don miss plenty tori and I don take time read plenty parable fr here wey I don laugh tire.

I salute and welcome you specially @Obari. You no need to para because every correct word wey all the elders for here dom drop still dey ground just take time chop them one by follow. This our corner na beta place wey we dey drop words of wisdom wey dey help us for our everyday lives and e dey also help our society. I see say our eldest elder wey be@ Mpa dom pour you holy water no worry more go reach you as you continue to dey sit down wia elders dey.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 26, 2022, 02:15:29 AM
I just dey reach here now and I don dey para say I don miss plenty tori and I don take time read plenty parable fr here wey I don laugh tire.
My broda, we welcome you wella. Welcome, wey bread 🤪

~
I welcome you too for owa abule. I for still pour you colele wata but e don finish for my fridge. Abeg, you go help us here. We nor too go school to dey understand pure English. We dey break am here with pidgin.
newbie
Activity: 27
Merit: 3
November 25, 2022, 08:16:15 PM
Oga boss I greet you. This wan you talk na exactly wetin dey wori pipo. Small achieve you feel say you don big pass evribody. This your own don inspire me to drop this one but the house go help give meaning to am.

Proverb: Who dem give quit notice no dey pack for daytime

Hmmmm... This one is strong, I came up this meaning.

When the services or contract of a wicked boss/superior is terminated at work, bidding farewell to colleagues cannot be in the picture as a result of shame.
sr. member
Activity: 560
Merit: 424
I buy all valid country Gift cards swiftly.
November 25, 2022, 04:20:27 AM
I just dey reach here now and I don dey para say I don miss plenty tori and I don take time read plenty parable fr here wey I don laugh tire.
E come be like say plenty old men full the house wey just dey disguise as youngie them.
One of the proverb we sweet me na the one wey them talk say "Even if goat get frown face e no go lack buyer for market
I no dey too reason the meanings oo but the way person dey take time arrange this talk dey burst my head because I dey really reason am say our fore father's been really get big talks for mouth.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 25, 2022, 02:36:38 AM
~

Our oga I greet oh. you scarce like fowl teeth.
Na true my broda for dis ur talk and dat ogbenge proverb wey you drop there too. Owa people talk sey if persin see wetin dey bigger than farmland, dem dey sell barn. I get better offline engagement last week wey tie me down. I still neva even dey free dis week sef but I go try dey spy here.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 24, 2022, 10:18:26 PM
Proverb: Even if goat get frown face e no go lack buyer for market
Naturally, na sheep dey like smile from time to time. As for goats, dat wan na original frowner.

Proverb: Who dem give quit notice no dey pack for daytime
Nor be lie, bro. Especially if him come get people wey im dey owe money for dat area.

 Our oga I greet oh. you scarce like fowl teeth. E no good make you knak us beta proverbs make we take colele our body dis weekend? As we dey wait your own, I say make I keep dis one here.
 
Proverbs: person wey naked no dey put hand for pocket
Meaning: You only give what you have
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 24, 2022, 07:40:15 AM
Proverb: Even if goat get frown face e no go lack buyer for market
Naturally, na sheep dey like smile from time to time. As for goats, dat wan na original frowner.

Proverb: Who dem give quit notice no dey pack for daytime
Nor be lie, bro. Especially if him come get people wey im dey owe money for dat area.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 23, 2022, 12:14:04 PM

Meaning: Do not be happy about someone's disability because they have the ability to achieve what you have right now and even more.
Oga boss I greet you. This wan you talk na exactly wetin dey wori pipo. Small achieve you feel say you don big pass evribody. This your own don inspire me to drop this one but the house go help give meaning to am.

Proverb: Who dem give quit notice no dey pack for daytime
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
November 22, 2022, 09:16:58 AM
Proverb: Even if goat get frown face e no go lack buyer for market

Meaning: Do not be happy about someone's disability because they have the ability to achieve what you have right now and even more.

Proverb: Dem say na the same sun wey melt wax fit still harden clay

Meaning: The problems you are currently facing right now will inspire and motivate you to desire success. No condition is permanent in life and one day you will remember all you have been through and how you survived.

I salute everyone in the house.
newbie
Activity: 27
Merit: 3
November 19, 2022, 09:52:41 AM
I greet all of una cos una face show pass daddy showkey...
Make I drop this one here;

Proverb : Na after you cross the river you fit tell the crocodile say him mouth de smell...

need una help for meaning biko

When you are working for someone and you are giving your all but he/she doesn't appreciates it and treats you badly and you keep your head down and pretend it's actually nothing because you have something you are trying to get/achieve and when you finally achieves it, you can let the person know about his/her actions.
sr. member
Activity: 546
Merit: 418
November 18, 2022, 09:53:42 AM
I greet all of una cos una face show pass daddy showkey...
Make I drop this one here;

Proverb : Na after you cross the river you fit tell the crocodile say him mouth de smell...

need una help for meaning biko
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 17, 2022, 12:27:53 PM
Mpamaegbu I hail you without my slippers oh even everybody wey no get pepper body for here...una well done.
Me I just dy come oh as newbie but I no be bettle...
Make I forget for proverb here;

Proverb: Lion say if na big belle dem dey look he for no be King for the same bush wey elephant dey.
Meaning: The strength of a man is not measured by his size.
Welcome, bruh. E good as more pipo dey come locate ya. E get d way we go push for the popularity of this our local board, we big oga dem go reason make am a bigger board..
I say make I just drop this one here as e dey me today.
Proverb: Nah wen house don collapse wey goat fit climb am
The moment you degrade yourself, you lose your value and self respect

 More meanings to this go dey appreciated. Una doh!!🙌
sr. member
Activity: 546
Merit: 418
November 17, 2022, 11:48:03 AM

Jump to: