Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 10. (Read 9496 times)

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 04, 2023, 06:25:32 PM
but on a normal I go just help her tidy the stuff like say nothing happen because I know say old age go reach everybody unless person wey die before em time...
You do well my guy. E show sey you get sense. Our people sey pikin wey sabi cover im parents shame na pikin wey get sense be dat. I sure sey granny go don pour ororo for your head join too.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 04, 2023, 02:16:24 PM

No how wey you go take torchlight old woman wrapper wey you nor go see shit there.
Meaning: In life, everyone has their own shortcomings. Sometimes, it's good to look pass these inadequacies.

My chief, wetin you talk make sense well well and the meaning come enter well for my brain. Via say I don stay with my granny well well, I no even need to use light see small small shit self but on a normal I go just help her tidy the stuff like say nothing happen because I know say old age go reach everybody unless person wey die before em time, you do well and I salama for you my elder.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 04, 2023, 09:45:24 AM

No how wey you go take torchlight old woman wrapper wey you nor go see shit there.
Meaning: In life, everyone has their own shortcomings. Sometimes, it's good to look pass these inadequacies.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 27, 2023, 05:03:19 PM
NO matter how dark room wan be, man go still  locate woman breast.BTC
Dis guy, hia. Well, I nor talk pass dis wan.

proverb:  where sugarcane dy sweet  pass nah for em joint
Tell me somethin wey I nor know. Me nor even dey like dat sugarcane joints sef.

Dem say pikin wey eat leak plate no tell em mama thank you no go see plate to leak again.
Na so life be oh. I go just dey look people wey dey dispise their humble start and days of little beginnings once dem make am big with one eye. These people nor wise at all.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
April 25, 2023, 03:48:37 AM
proverb:  where sugarcane dy sweet  pass nah for em joint

Meaning: good things of life can appear difficult to achieve but at the end it's Worth it.

hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 24, 2023, 09:58:19 AM
Dem say pikin wey eat leak plate no tell em mama thank you no go see plate to leak again.

Meaning:When you are grateful for the little you were given, you open more door for more to come your way.

Even as everyhere red for our economy now, try dey appreciate anybody wet dey show you love or person wey dey carry you along, no use bad attitude pursue your destiny helper oo e get why,

na better salutation I carry come for my elders here una too much.

newbie
Activity: 20
Merit: 1
April 20, 2023, 03:32:32 PM
NO matter how dark room wan be, man go still  locate woman breast.BTC
There is always a way when something matters much.

1)Craze no hard to form,na the trekking be wahalaBTC
Easier said than done

2)Opolo eye no be open eyeBTC
Having Big eyes doesn’t make you civilised
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 19, 2023, 10:10:43 PM
Dem say road wey man pass pick money, every time wey em dey pass dia em eyes no go comot for ground.
Nor be lie at all 😂. Na continuous strolling man go dey do around that area oh.

Proverb; leg wey no dy rest go always waka enter snake pit
Somehow somehow, the meaning nor too tally. Maybe you go need explain again.

Don't set sails Using Someone else's star:    

The eye never forgets what the Heart has Seen
Chairman, abeg we nor too go school for this thread. Na im make us dey use pidgin English dey yarn. Edit your post to pidgin.
member
Activity: 322
Merit: 10
April 19, 2023, 06:20:59 PM
Don't set sails Using Someone else's star:    
meaning:
Avoid imitating somebody else because you will end up disappointed. Grin Grin Grin



The eye never forgets what the Heart has Seen
meaning
That all issues that Pricked the heart will be remembered whether they be good or bad.
jr. member
Activity: 70
Merit: 5
Bet2Dream.com
April 17, 2023, 06:44:31 PM
Wait your mama go sit down see, you go climb the highest mountain, you no go still see am..lol I no really know why my mom dey always tell me this thing.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
April 17, 2023, 02:24:09 AM
Meaning: if you allow everyone into your business, you invite enemies and attackers into your business, and your secrets are your power.
Na confam talk be this.

Proverb: Man wey see how pepper enter e brother eyes go learn to wash hand well after e dun chop, he nor suppose mumu put hand for eye too.

Meaning: Try to learn from people's experience, they say experience is the best teacher, but do not let it always be your teacher.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 13, 2023, 06:51:35 PM
Person wey allow different legs to the enter their house, na him invite snake enter his house oooo.

Meaning: if you allow everyone into your business, you invite enemies and attackers into your business, and your secrets are your power.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 13, 2023, 10:19:00 AM
Proverb; leg wey no dy rest go always waka enter snake pit

Meaning; If someone is busy doing nothing he or she can easily get into trouble.

The meaning no too clear for me Shaa unto say I dom see different people wey dey always busy but yet every time Dem dey always enter one wahala or the oda. Nice one OOO I know say e get how elders dey reason I fit dey reason another way round while you dey reason go another side, you do well.


sr. member
Activity: 560
Merit: 418
April 13, 2023, 09:53:01 AM
Proverb; leg wey no dy rest go always waka enter snake pit

Meaning; If someone is busy doing nothing he or she can easily get into trouble.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 10, 2023, 12:35:12 PM
I no fit forget wia I start from and my grand mama say okoro no fit big pass person wey plant am.

My people I greet Una, one mad mama for my area say e dom tey wey we see last like say me and she dey see before haha haha.

Make I drop one word of wisdom here I believe say all the elders here go understand wia I go after now.


Dem say road wey man pass pick money, every time wey em dey pass dia em eyes no go comot for ground.




You are more focused when your efforts are appreciated and you get motivated when success is attached to your hustle.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 10, 2023, 12:10:45 PM
*This one fit no funny but many sense dey the talk and if you try download ammm well you go get many messages.
Na betta sense full dis wan well well. I dey always use am.

Anoda situation na for family wey Oko miss (Marle/Mama) dey and pikin dem plenty. If na where cooperation nor dey everybodi go dey expect sey the other don send monthly stipend go give am and if care is not taken, Oko miss fit nor see anything at the end.

Those of us wey still dey live for public house/rent go understand dis one well too. Who go put sumo off when tank full 🤪. Who wan lock gate, especially when one idiot drives out and no lock the gate 🤪 who wan change burnt bulbs wey dey compound 🤪. Every tenant go dey expect the other persin to do am but if na for private houses, no one need to wait or expect another persin to do am. You go just run the parole kiakia.
member
Activity: 308
Merit: 26
April 06, 2023, 07:54:53 AM
Proverb :  No be every car wey pass you go put mouth

Meaning : You don't converse in every discussion..

Proverb :  Who belle full go still hungry.

Meaning :  No income is ever sufficient for anyone we always needs more
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 05, 2023, 07:25:59 PM
Cow we're belong to community, na hunger for kill.

*Meaning animal were be say na every body get ammm go die for negligence, sake of say every body go think so somebody done feed the any and at the end nobody go feed ammm las las.

*This one fit no funny but many sense dey the talk and if you try download ammm well you go get many messages.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 05, 2023, 05:26:57 PM
BTC no be how pikin dey play with him mama nipples The play with him Papa toto
meaning=shouldn't use the hand for house fly to catch 🐝 bee
Which wan com be toto for man again? Na blokos dem dey call those two small balls wey dey follow peepee go everywhere for man body. Toto na vagina for woman. Again, na two proverbs you throw enta there sef. The wan wey you take wan explain am na anoda proverb too.

I for pour you colele wata but I gat nothin now. Keep it up, my gee.
newbie
Activity: 20
Merit: 1
April 03, 2023, 02:01:48 AM
BTC no be how pikin dey play with him mama nipples The play with him Papa toto
meaning=shouldn't use the hand for house fly to catch 🐝 bee

2)BTCI get am before no be property
meaning=stop living in the past glory

BTCBecause your indomie quick done no mean say pesin wey dey cook beans dey lazy.
Meaning= because you make it today doesn't mean am lazy, just time
Pages:
Jump to: