Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 14. (Read 9540 times)

hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 10, 2023, 05:19:47 PM
For example when I been dey for this thread I was treated well that is why I enter here again.
Ok, but I hope you nor relax com spoil owa TV remove sha 🤪😁
Oga Mpa, I no too understand the pidgin grammar wey you knack. But I sure say I no go break the TV wey all of us dey carry watch match  Grin

Hang your cap for where your hand go reach.

Meaning: Do things that are within your reach.

My brother sometimes we go need to try things wey no dey our reach. If you no stretch your limit sometimes you no go know how far you go fit go. If you keep trying only the things wey dey your reach (your comfort zone) you fit no grow in life. Or you go fit grow but you no go grow reach your potentials.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
January 10, 2023, 03:21:32 PM
Proverb: If a child no mature enough and tie wrapper. If breeze blow the wrapper will cover the face
Meaning: There should be maturity and experience in whatever one wants to does so as to be able to face the challenges when it comes up

Proverb: Some that pursues a chick, the chick will be running and the person pursuing it will be falling
Meaning: Whoever plans evil against someone whose hands are pure, will be the one to fall for it.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 09, 2023, 11:35:09 PM
For example when I been dey for this thread I was treated well that is why I enter here again.
Ok, but I hope you nor relax com spoil owa TV remove sha 🤪😁

Hang your cap for where your hand go reach.
True talk my broda.
jr. member
Activity: 48
Merit: 1
January 08, 2023, 01:10:13 AM
Hang your cap for where your hand go reach.

Meaning: Do things that are within your reach.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
January 04, 2023, 06:00:57 PM
I like say this thread don enter our Naija board. E go dey easier now to drop one or two wisdom from time to time.

So earlier this week when I dey talk with my grandma, she drop one proverb for our local language as I dey tell am about one matter.

Proverb: Soup wey hot na patience dem dey take chop/ lick am.

Meaning: No matter how urgent a task dey, make you dey patient do am
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
January 04, 2023, 05:11:50 PM
Good one Oga Mpa for moving this thread to our local board e make sense.
E don tey I come here to collect wisdom. Na many things wey full person head shaa. But still on still Baba God na King.

As I don reach here make I for find one drop

If you weed road wella, dem go follow the road two times

Any opportunity you have to impress or help someone do it well.
For example when I been dey for this thread I was treated well that is why I enter here again. So, I don follow the road twice because dem weed am well
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 04, 2023, 04:39:51 PM
Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control.
Meaning: It's commonsense not to over step one's bounds when given a free hand.
@Mate2237, you go find dat same yarn for the first page here. Na im I quote for you join.



Dem nor dey take eye put fish for soup
Meaning: No one gets the best of what they want by mere wish without putting in the work for it.
I don see am nd I like di yarn. Some pesen dey over do wen given di opportunity 2 do something. For di won u drop, na so life dey bi dat. Everyone has high taste. Di eye dey find di best everytime.
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
January 04, 2023, 01:01:03 PM
Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control.
Meaning: It's commonsense not to over step one's bounds when given a free hand.
@Mate2237, you go find dat same yarn for the first page here. Na im I quote for you join.



Dem nor dey take eye put fish for soup
Meaning: No one gets the best of what they want by mere wish without putting in the work for it.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
January 04, 2023, 12:30:39 PM

Feel at home, feel at home nai dey make visitor dey spoil remote control 4 di house wey im visit.
Weti bi d meaning?

Meaning: Be careful of the people you help or invite into your life because some persons will abuse the privileges given to them.
I hope I get am or I come close to the meaning Smiley
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 03, 2023, 05:33:38 PM
Abeg make una put mouth 4 dis tok tok, me I no kno di meaning, so if una know di meaning make una tell me. I just like di tok tok. I no kno whether peson don tok am oo.
Nai bi dis.
Feel at home, feel at home nai dey make visitor dey spoil remote control 4 di house wey im visit.
Weti bi d meaning?
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 30, 2022, 02:14:34 PM
The person we're dey look for wife materials 100 yards,  make him ready to be professional tailor to saw the materials well!
Meaning: A young man who is looking for a good wife, should first be ready and disciplined to be a good husband.
hero member
Activity: 700
Merit: 523
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
December 28, 2022, 02:13:59 PM
I greet the full house,I dey enjoy this board now but sometimes I still dey Jones dey go d previous place Grin
I no know whether person son drop this one.

proverb : Dog no dey born goat

meaning : your child will display your character i.e if u are good,same with your child and if you are bad,same with your child
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 28, 2022, 01:37:52 PM
Proverb; Person wey get ynash no sabi use am sit down.

MEANING; You don't appreciate that thing you have until you lose it

Una fit throw more Meaning to this proverb.
Merry Xmas enjoyment oh...
legendary
Activity: 2688
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
December 28, 2022, 01:20:55 PM
No matter how lavishly well wey you entertain persin wey ride bicycle come visit you, if im dey go im must open yansh for you.
Meaning: The peculiarity of things must always reflect at the due time, in spite of how anyone wants to change it.
full member
Activity: 840
Merit: 137
December 26, 2022, 06:28:54 PM
I greet everybody wey dey here oh,,my senior men dem,,una face shoe,una shoe shine.Our father's dey say "wetin dey in-between person teeth,the tongue no dey fit leavam"
Meaning:as long as there is a situation on ground,people can't stop talking about it.
There are so many proverbs that were used by our forefathers in different dialects,but interpreting it is difficult.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
December 24, 2022, 07:58:52 AM

The proverbs weh deh this place reminds me of village setting and I happy as the thread hang body enter local board. At least now we go deh quick see posts for here. Make I run drop one too.

Person weh go good go still deh good, no be by Christian name weh them deh call am.

Meaning: To be of good nature is something inborn and not by naming or name calling.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
December 24, 2022, 07:14:18 AM
All these proverbs I dey see here dy sweet my body I no go lie, e dy do me to become elder for my village.

All the senior comrades wey dy here I greet una.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
December 23, 2022, 08:16:28 PM
wen cow-mama dey chop grass the pikin dem dey look the mama mouth.

MEANING; Children should always learn by following examples of their elders.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
December 23, 2022, 12:56:48 PM
Mpamaegbu my senior brah I don miss this thread o this new year na we get am
Mess way go smell no Dey loud.
lmao, and sake of say as e nor dey loud, many people nor dey expect am.

Make I be the first person to wish everybody for this our corner Merry Christmas and a Happy New Year Cheesy.

Proverb: Person wey pour oil for many fingers, na im dey lick fingers long pass.

Meaning: Spread your investments, so you can enjoy it better.

hero member
Activity: 798
Merit: 547
Leo is resting.
December 23, 2022, 10:42:06 AM
Nor be the same day wey persin dig hole for ground frog dey fall inside am.
Meaning: Perseverance and patience are key virtues for success.

I shared dis ogbenge yarn for local hangout yesterday but still wan share am here wey be the root for yarns like that.

This one na beta word wey the meaning self make sense well well unto say na em make we dey this our corner wey we dom dey fine since true talk patience na the key to success and anybody wey wam succeed in any good thing must get patience or else e go hard am or the person fit end up doing tins wey no go well.

This word patience still remind me one grammar wey my form master been dey blow for those days wey I dey small em say the end shall justify the means. I dey happy say we dom finally arrive here.
Pages:
Jump to: