Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 17. (Read 9496 times)

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 16, 2022, 11:37:43 AM
~snipped~
No wahala bro. One luv! Just dey make sure sey you dey improve wit every post wey you make. Na d koko be dat.

Oga mpa lai dis nah you sopoz collect the colele water as nah you get the meaning of dis proverb.
I feel you but remember sey persin nor fit take eye see im own anus except na anoda persin go tell am how e look like.

Dem no dey ask agboro boy where im sleep and work if you see im in the park or in garage then he is fine. U can can use this proverb in a Getto life situation.
If to sey you supply dis explanation, you for chop dat two buckets of wata straight up.
hero member
Activity: 602
Merit: 504
Top Crypto Casino
November 16, 2022, 10:57:36 AM
Mpa make dem drop another proverb for translation na
Because the proverb guru Don land for the group.  The group dry interesting well well, I just dey discover am now
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
November 16, 2022, 09:10:21 AM
Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am..

Abeg, I go like make someone analyse dat proverb and still tell us situations where we fit apply am.
To avoid wahala always mind your own business, whatever the other person doesn't is not you problem. Do your things and leave the others part for them to do.
Where you sleep and wake up e doesn't matter. As far ras u see me in the morning I am okay. Or in other way. Dem no dey ask agboro boy where im sleep and work if you see im in the park or in garage then he is fine. U can can use this proverb in a Getto life situation.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 16, 2022, 09:05:15 AM
~snipped~
Na on Wednesday morning I go reward d person wey go get d analysis with 2 buckets of colele wata from my fridge.
Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am.
Meaning and usage: This proverb is usually applicable in philandering/flirting situations. It simply means that every beneficiary should be contented with what they're getting from their benefactor once they're able to get what is due to them instead of seeking to prevent the benefactor from dishing out same goodies to others.

Let me break it down. A woman whose husband keeps side-chicks shouldn't be bothered with what he does outside but be concerned that the husband plays the good guy at home by taking up family responsibilities.

@Hyconic, I go give you half of d mark because of the "flirt" wey you mention there. Na only you come close to the answer.
Oga mpa lai dis nah you sopoz collect the colele water as nah you get the meaning of dis proverb. Even tho na funny one, e still mean a lot as nah somtin wey dy happen for we society.  And big ups to you @Hyconic. Small dey cari dey go till we push d ministry to e permanent site.
newbie
Activity: 27
Merit: 3
November 16, 2022, 08:03:35 AM

@Hyconic, I go give you half of d mark because of the "flirt" wey you mention there. Na only you come close to the answer.

Thank you so much sir... I dey happy say I try get the answer small and I no go forget say na you give me my first merit for this platform. Continue the good work boss.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 16, 2022, 04:14:20 AM
~snipped~
Na on Wednesday morning I go reward d person wey go get d analysis with 2 buckets of colele wata from my fridge.
Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am.
Meaning and usage: This proverb is usually applicable in philandering/flirting situations. It simply means that every beneficiary should be contented with what they're getting from their benefactor once they're able to get what is due to them instead of seeking to prevent the benefactor from dishing out same goodies to others.

Let me break it down. A woman whose husband keeps side-chicks shouldn't be bothered with what he does outside but be concerned that the husband plays the good guy at home by taking up family responsibilities.

@Hyconic, I go give you half of d mark because of the "flirt" wey you mention there. Na only you come close to the answer.
newbie
Activity: 27
Merit: 3
November 15, 2022, 01:41:18 PM

@Hyconic you too much and I welcome you specially.
Abeg help us to avoid spamming even as you keep the thread clean, As you drop one yarning allow make another person drop too before you drop another one.

Many thanks boss... Copy that
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
November 14, 2022, 06:59:27 PM
Meaning : It is hard to convince a flirt to stop or desist from his lifestyle, it is when he hits rock bottom or contracts deadly sickness that it would dawn on him that he has actually wasted his money and life.

@Hyconic you too much and I welcome you specially.
Abeg help us to avoid spamming even as you keep the thread clean,
As you drop one yarning allow make another person drop too before you drop another one.

Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am..

Abeg, I go like make someone analyse dat proverb and still tell us situations where we fit apply am.
Na on Wednesday morning I go reward d person wey go get d analysis with 2 buckets of colele wata from my fridge. Make una keep d comments coming. One luv my people.

My chief no wahala we dey wait for you.
Make I still drop another meaning for the proverb as we dey wait,

Meaning:1) Evil doers are not known until they are exposed or caught.
Meaning 2) A cheating man or woman is not known until he or she is infected by a noticeable infection.
For we naija today, so many people dey survive doing evil and nobody dey worry dem until dia cup full and uniform men grab dem na when people dey realize say na evil doings dem dey survive on. The case of David Lyon wey police officers grab for abj na typical example of dis one.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 14, 2022, 11:21:39 AM
Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am..

Abeg, I go like make someone analyse dat proverb and still tell us situations where we fit apply am.
Na on Wednesday morning I go reward d person wey go get d analysis with 2 buckets of colele wata from my fridge. Make una keep d comments coming. One luv my people.
newbie
Activity: 27
Merit: 3
November 14, 2022, 09:25:37 AM
Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am..

Abeg, I go like make someone analyse dat proverb and still tell us situations where we fit apply am.

Meaning : It is hard to convince a flirt to stop or desist from his lifestyle, it is when he hits rock bottom or contracts deadly sickness that's when it would dawn on him that he has actually wasted his money and life.

newbie
Activity: 27
Merit: 3
November 14, 2022, 09:09:32 AM
Proverb: Custard na just akamu wey school for abroad.

Meaning: Packaging can improve ones beauty or appearance.

Proverb: Prick wey go stand go stand, e no need hand to hold am.

Meaning: What will be will be.
@Hyconic. I no say here na platform for us to take bring out we colorful proverbs o, but e go beta if we help give meaning to wetin oga Mpa put for hear so we all fit learn from different ideas brought up. I come in peace Smiley
Okay chief..  I be newbie for here and this na my first post for this thread and as I stumble for where my con3 people dey e sweet my belle well well, na him I say make I follow chuke mouth small. Back to wetin you talk, make I crack my brain small see if I go fit get the meaning or get close to the meaning.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 13, 2022, 07:24:17 AM
Proverb: Custard na just akamu wey school for abroad.

Meaning: Packaging can improve ones beauty or appearance.

Proverb: Prick wey go stand go stand, e no need hand to hold am.

Meaning: What will be will be.
@Hyconic. I no say here na platform for us to take bring out we colorful proverbs o, but e go beta if we help give meaning to wetin oga Mpa put for hear so we all fit learn from different ideas brought up. I come in peace Smiley
newbie
Activity: 27
Merit: 3
November 12, 2022, 04:29:12 PM
Proverb: Custard na just akamu wey school for abroad.

Meaning: Packaging can improve ones beauty or appearance.

Proverb: Prick wey go stand go stand, e no need hand to hold am.

Meaning: What will be will be.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
November 12, 2022, 12:01:26 PM
Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am..

Abeg, I go like make someone analyse dat proverb and still tell us situations where we fit apply am.

Meaning: No one will question your source of wealth, just make money then you are accepted.
In our society today, no one cares to know whether you do the right or wrong things once you are living large and pulling exotic cars everyone will be ok and happy, na guess work I do I go appreciate if our eldest elder Mpa help us out.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 12, 2022, 10:43:03 AM
Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am..

Abeg, I go like make someone analyse dat proverb and still tell us situations where we fit apply am.

My oga, dis one nah deep talk oh. But I go try give am meaning as I understand.

Meaning: You matter less to people when you have nothing to offer them

 Situations wey we fit apply this kind scenario plenty. For instance, for society, we dey see how poverty dey bring insult or trouble where e no dey b4. Biko, seniors for here, make una folo put mouth.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 10, 2022, 05:28:01 AM
Dem nor dey ask He-goat where im sleep. Na whether im wake from sleep or not dem dey ask am..

Abeg, I go like make someone analyse dat proverb and still tell us situations where we fit apply am.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 07, 2022, 12:24:56 PM
Meaning: Your growth and success in life are fastened by your exposure to people with useful information and your ability to utilize the knowledge you have to actualize your goals.
Igbo kwenu! Now I don sabi sey you be nwanna. Ji si ke! But dat your explanation for dat proverb nor too be wetin e mean oh. Ask anybodi wey sabi, den go tell you d real meaning. I salute your new rank, broda mi.
~
K'anaga n'ubi ka oka naka... E simply means – make we just dey mark time as we deh watch wetin dey happen at the moment while we await the main expected thing.

Lol, I dom confirm say true true you be correct nwafor, thanks for the clearer explanation you will always be my chief.
I no be pure Igbo but I dey understand the language weller na pure niger delta guy I be hehehehe.

Am now a Senior Member.

 Congratulations, brotherly. For sure nah hardwork and consistency dey always pay. You don inspire upcoming like me to push harder. Make I drop this one, so the ministry fit continue to move.

Thanks so much big guy your face show and your shoe shine, for the hustle eeh na grace and consistency help me but I no go fail to acknowledge the help wey our chief run for me here. You are next in line, see you at the top senior member in view.
Omo, lai dis I catch that prayer with both leg and hand o. You no lie for dia. No be  muscle alone dem dey use run tins and I folo comot cap for we chief. Congratulation once again, your winning no go stop ya, Ise!!!
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
November 07, 2022, 11:52:08 AM
Meaning: Your growth and success in life are fastened by your exposure to people with useful information and your ability to utilize the knowledge you have to actualize your goals.
Igbo kwenu! Now I don sabi sey you be nwanna. Ji si ke! But dat your explanation for dat proverb nor too be wetin e mean oh. Ask anybodi wey sabi, den go tell you d real meaning. I salute your new rank, broda mi.
~
K'anaga n'ubi ka oka naka... E simply means – make we just dey mark time as we deh watch wetin dey happen at the moment while we await the main expected thing.

Lol, I dom confirm say true true you be correct nwafor, thanks for the clearer explanation you will always be my chief.
I no be pure Igbo but I dey understand the language weller na pure niger delta guy I be hehehehe.

Am now a Senior Member.

 Congratulations, brotherly. For sure nah hardwork and consistency dey always pay. You don inspire upcoming like me to push harder. Make I drop this one, so the ministry fit continue to move.

Thanks so much big guy your face show and your shoe shine, for the hustle eeh na grace and consistency help me but I no go fail to acknowledge the help wey our chief run for me here. You are next in line, see you at the top senior member in view.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
November 05, 2022, 02:19:01 PM

Am now a Senior Member.

 Congratulations, brotherly. For sure nah hardwork and consistency dey always pay. You don inspire upcoming like me to push harder. Make I drop this one, so the ministry fit continue to move.

Proverb: Crocodile strong, nah be say e dey river
Meaning: You tend to perform best when you are in your right element
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
November 05, 2022, 10:07:55 AM

Jump to: