Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 12. (Read 9498 times)

sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
February 26, 2023, 10:16:13 AM
Who dey purse small chicken go dey fall and the small chicken go dey run.
Meaning: Person wey dey plan you say him go do you bad nor go fit do you harm

Dem nor dey use early momo take know say market nor dey.
Meaning: Nor use wetin you dey see now take judge the future say e nor go better

Vulture take say nothing concern am with barber because him don already bald head.
Meaning: Nor dey listen to wetin dem talk for your back because e nor concern you

If person wey get boil for under him leg dey vex, make him use the leg match ground
Meaning: If you nor dey patient for life you go fit lose plenty things.

Big man this your quotes them really funny I no go lie and since I no dey see any link, I go believe say na you write them and na you be the original writer and I go like contradict some of this your quotes them and make you no reason am but try bless me if I sharp😂

Who dey purse small chicken go dey fall and the small chicken go dey run.
Meaning: Person wey dey plan you say him go do you bad nor go fit do you harm
I no see any reason wey dull senior man like me go dey pursue small chicken come dey still fall for ground na?
Abi stick no dey ground to wipe am wetin no nice except say no be to kill am.

Meaning: your enemy fit worry you and even kill you and nothing you fit still do about am.


Dem nor dey use early momo take know say market nor dey.
Meaning: Nor use wetin you dey see now take judge the future say e nor go better

Boss if you been get shop then you go understand say you fit use how the morning be judge how the day go be especially for my area wey dey always dey very quiet .

Meaning: e get people wey you fit use wetin dem dey do now judge them especially notorious persons.

Vulture take say nothing concern am with barber because him don already bald head.
Meaning: Nor dey listen to wetin dem talk for your back because e nor concern you

No mind that talk about because even person wey get bald hair, he go still need dey visit barber shop to fit dress the hair make him look sharp.

Meaning: sometimes we need to dey hear wetin people dey talk so that we go know wetin we dey do right or wrong sometimes.


If person wey get boil for under him leg dey vex, make him use the leg match ground
Meaning: If you nor dey patient for life you go fit lose plenty things.

Na lie me I don use vex seat down with boil for yansh and I no still die
Meaning: sometimes patients no dey sweet because even now na hunger go kill patient dog.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 26, 2023, 08:43:24 AM
~
For the other way round, I remember when one of my friend been dey for sick bed and I dey with am dia, omor na that side I come dey get my breakfast, launch and dinner because dem dey bring correct food come give my nigga steady lol....
Shey you come begin pray make d guy sickness nor go ba 🤪. Na joke I dey oh, no go think am hard oh.

Quote
I dom miss my people here especially my chief @Mpa.
My brotha, I miss you too like how mad people dey take miss dortie!
jr. member
Activity: 225
Merit: 7
February 26, 2023, 04:10:18 AM
You can throw more meaning to this

Anus talk say" if to say I know say Vagina go get plenty visitors, I for no gree be Anus neighbour"
Meaning: Wealth comes with it's sacrifice.

Don't crusify me wen you read this post  Cool
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
February 24, 2023, 04:01:12 PM
As dem dey cook for persin wey dey sick, na so persin wey dey look after am go dey refresh from the meals.
Meaning: No matter what happens, there will always be those who will profit from bad situations. It just depends on what part of the divide you're.

Dis one na true talk you no need to think am two times before you know say even as we country bad now e get plenty people wey dey benefit full-time. For the other way round, I remember when one of my friend been dey for sick bed and I dey with am dia, omor na that side I come dey get my breakfast, launch and dinner because dem dey bring correct food come give my nigga steady lol....

I dom miss my people here especially my chief @Mpa.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 23, 2023, 08:16:25 AM
As dem dey cook for persin wey dey sick, na so persin wey dey look after am go dey refresh from the meals.
Meaning: No matter what happens, there will always be those who will profit from bad situations. It just depends on what part of the divide you're.
member
Activity: 213
Merit: 12
February 16, 2023, 02:17:32 PM
Cow wey no get tail na God dey drive flys for him..
Meaning: person who has no helpers God is always his helper..
member
Activity: 308
Merit: 26
February 15, 2023, 02:15:32 PM
Proverbs: Them no dey use tongue eat bone.

Meaning: some hard situations requires hard approach.

Proverbs: you fit Sabi who you love, but you fit no Sabi who love you
Meaning: you don't actually know if you are loved by who you love.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 11, 2023, 03:24:29 PM
Proverb: na the same water fish they stay inside, na the same water them dey carry cook am.

Meaning: don't trust anyone your close one can be used against you.
Dis particular wan remind me of – If trust dey, wata for nor dey fit boil fish.

~
Na true be everithing wey you yarn put there. I suppose pour you colele wata join now. I go do am still.

Na fool dey tests the depth of a river with no foot
I believe sey na "both feet" you be wan write there because na so e bi.
jr. member
Activity: 51
Merit: 1
February 09, 2023, 02:04:14 AM
Dey no dey use big penis threaten olosho

Bird way flies from low land and  Birch perch   on top of dey hill is on the ground

Na fool dey tests the depth of a river with no foot
member
Activity: 308
Merit: 26
February 08, 2023, 02:46:29 PM
Proverb: Person wey waste time for bathroom no mean say em  dey baf well..
Meaning: it's not about how far, but how well.

Proverb: Shit wey dem cover with sand no they quick smile.
Meaning: a bad character Hiden is not always noticeable.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
February 08, 2023, 11:00:40 AM
Proverb:- If you see ripe corn you go know with only look

Meaning:- there is a time for things, a natural order that cannot be manipulated
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
February 07, 2023, 07:04:14 AM
Who dey purse small chicken go dey fall and the small chicken go dey run.
Meaning: Person wey dey plan you say him go do you bad nor go fit do you harm

Dem nor dey use early momo take know say market nor dey.
Meaning: Nor use wetin you dey see now take judge the future say e nor go better

Vulture take say nothing concern am with barber because him don already bald head.
Meaning: Nor dey listen to wetin dem talk for your back because e nor concern you

If person wey get boil for under him leg dey vex, make him use the leg match ground
Meaning: If you nor dey patient for life you go fit lose plenty things.



hero member
Activity: 784
Merit: 589
February 06, 2023, 11:51:27 PM
Proverb: when moon dey shine, hand no fit cover am..

Meaning: Someone who has a character, can never hide it..

 Una fit add small knowledge to this one my elders, I hail una
jr. member
Activity: 40
Merit: 2
February 06, 2023, 09:11:50 PM
Proverb: the day wey u need wife, na that day mad people dey full market
Meaning: The day wey you dey find something, you no go almost see am.

Proverb: No matter how far your piss go, the last drop dey always fall for your feet
Meaning: Any action wey you take, consequences dey always follow.

Proverb: Person wey swallow full coconut get full confidence for him yansh
Meaning: Before person take decisions, him dey very sure say him go fit stand up for anything wey come out.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
February 06, 2023, 01:25:15 PM
You dey try.
Body dey sweet me as i dey see say activity for this our corner dun increase.

Na new year be this and many of our expectations dey very high concerning the year unto the things and things wey we dun plan. Our people say;
PROVERB: Nor go troway the water wey you get for inside house because say you dey hear thunder and you dey expect rain to fall.

MEANING: As you expect better opportunities, hold on and don't neglect the one you have.
member
Activity: 378
Merit: 76
Eloncoin.org - Mars, here we come!
February 05, 2023, 04:45:53 PM
Fly wey no dey hear word go follow death body enter grave.

Meaning: anyone that refused to take correction will always fall a victim
member
Activity: 308
Merit: 26
February 04, 2023, 06:26:52 PM
Proverb : Goat wey wan  chop shit go surely vomit am when em taste am..

Meaning: you cannot take what is not yours.

Proverb: na the same water fish they stay inside, na the same water them dey carry cook am.

Meaning: don't trust anyone your close one can be used against you.
newbie
Activity: 28
Merit: 15
February 04, 2023, 02:22:52 PM
Proverb: Rain no de fall for one roof

Meaning: Everyone experiences blessings at some point in time.

Proverb: if you shit you no wash yansh the smell go follow you anywhere you go

Meaning: Your negative deeds will follow you wherever you go.
member
Activity: 213
Merit: 12
February 02, 2023, 08:06:18 AM
Pikin wey say e mama no go sleep himself no go sleep too: meaning:a child who said her mother will not sleep,he or she will not sleep too
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 02, 2023, 04:25:05 AM
~
My broda, your comments deserve colele wata. E just dey pain me as I nor get any to bless you with. Na ogbenge yarns you drop there so. Keep am up. You dey try.


Na rat wey dey house dey tell d one wey dey outside sey fish dey hidden for house.
Meaning: Whatever happens to one is often traceable to those around one.
Pages:
Jump to: