Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 20. (Read 9479 times)

hero member
Activity: 854
Merit: 1246
August 27, 2022, 02:26:35 AM
I never come here b4 afta di 1st proverb wey I dropped nd I no fit remember di time, 2day as I dey pass I come say make I hold break nd I sa hold di break I come see say d toris wey dey here dey sweet me 4 bele. Nai come say me I go dey tori 4 here dis 4ront. Bcoz even dis place 2 dem dey use am dey join 4 di work we dey do 4 we company. African sayings we dey here just dey like fun 4 we tok tok place.

Di Lion wey bi di leader 4 di jungle e no strong pass Tiger if Dem dey 1 by 1. Lion dey kill Tiger wen Dem (Lion) e dey plenty well well nd di Tiger na onli 1.

Meaning: Di Leader we e no dey carry oda pipo dey Join body dey waka e no fit make am. Nd if attacked come he go sufferam.

If you mess inside the water, the smell must come later and everyone go perceive am.

Meaning: Wen u do something secretly, everyone go still hear am later.
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 24, 2022, 01:46:27 PM
@GiftedMAN, you sef na sabi man you be. 🤗
hero member
Activity: 686
Merit: 527
To excel in every good thing
August 24, 2022, 07:36:44 AM
Persin wey wan make dog trust am and be im friend nor dey raise stick where dat dog dey.
Meaning: For one to earn the trust of another, one ought to exemplify it both in words and deeds.

Abeg you go permit me to call you elder because na wetin things wey dey come out from your brain show say you be.
On a norm,person wey wam make you trust am no suppose do tins wey go hurt you no matter anything because no matter how the person  go take beg, once em dom show bad sign before you no go fit trust am again even if you dey relate weller with am. Secondly, e no good for anybody to dey claim Jesus while em be judas because na wetin dey our society today and e dom make tins spoil well well so like dis anybody wey dey closer to me wey dey do anyhow I no feet trust the person at all.
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 24, 2022, 05:04:47 AM
Persin wey wan make dog trust am and be im friend nor dey raise stick where dat dog dey.
Meaning: For one to earn the trust of another, one ought to exemplify it both in words and deeds.
hero member
Activity: 798
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
August 23, 2022, 04:10:39 AM
@Oluwa- btc, dis your proverb go well and de meaning come sweet me for body as e be say na tins wey I dey see for my face wey dey happen dis days. Dis one show say you dom sit down with elders small and you dom hear some beta word from dem.
I hope say no bodi dom sheet say make you park am because dis days sheet dey over smell and e feet make person do tins wey em no plan to do.

I sit down with elders true true nah so I come hear am I come they reminise wetin person do me for that kind 2020 I don forgive ohh but I no go fit forget the pain and everything, the sweet part be say I don learn, I dey grow and when another thing like that wan sup I go surely know how to prevent am! Payback nah less, but I no wan payback.

Na true you talk sey dis place come be like wetin persin japa leave. No worries I dey kampe. Make I congratulate you for your senior man rank. Na small time e remain make e become official. You be correct my broda.
[/quote]

Biq Brother Mpa!! All my growth 4 the forum nah for here I dey celebrate am,  Member ohh, 100 merit, Full Member now Potential Senior Member Anticipated. I dey thankful to Al them weh dey support people growth from them hearth, some dey see am like competition kwa lol but all nah make am sweet ( Na less ).

 I been no sahbi chi chi bout BTC, but now, I dey learn am with my time dey read more of it than I dey do before, dey join Bitcoin spaces and listening to Bitcoin Podcast, E dey do me like say I dey play ball. I dey truly learn am from my Heart. Once more thank You for the wishes in due time, e go set! You be Man no forget, your baby brudda loyal scata lol 🦍🖤❤️
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 22, 2022, 08:56:15 AM
This our corner weh we dey come chop wisdom upon wisdom done dey grow green grass as we no dey active! Yeah everyone dey try to rank up see front e no sexy but make we still dey touch down this ends.
Na true you talk sey dis place come be like wetin persin japa leave. No worries I dey kampe. Make I congratulate you for your senior man rank. Na small time e remain make e become official. You be correct my broda.

~
Edit your post. Your comment dey inside person post wey you quote and e nor set like dat.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
To excel in every good thing
August 20, 2022, 10:27:03 AM
Proverbs : No be who sheet dey know how e smell, na who park the sheet go remember the smell and know how e be!

Meaning: Truthfully, What you do to others or someone would be easily forgotten by you, but not the person who got hurt!


@Oluwa- btc, dis your proverb go well and de meaning come sweet me for body as e be say na tins wey I dey see for my face wey dey happen dis days. Dis one show say you dom sit down with elders small and you dom hear some beta word from dem.
I hope say no bodi dom sheet say make you park am because dis days sheet dey over smell and e feet make person do tins wey em no plan to do.
hero member
Activity: 798
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
August 20, 2022, 08:57:39 AM
This our corner weh we dey come chop wisdom upon wisdom done dey grow green grass as we no dey active! Yeah everyone dey try to rank up see front e no sexy but make we still dey touch down this ends. Make I knack 1 drop for the day as I dey watch match this one hit me hard I say I must drop am!

Proverbs : No be who sheet dey know how e smell, na who park the sheet go remember the smell and know how e be!

Meaning: Truthfully, What you do to others or someone would be easily forgotten by you, but not the person who got hurt!
hero member
Activity: 686
Merit: 527
To excel in every good thing
August 10, 2022, 02:25:23 PM
E good to wake persin wey dey sleep mess so dat im too go follow smell am.
Meaning: Always make sure those who ferment trouble won't run away from the scene once the trouble escalates.

Dis one enter my body I no go lie and I believe say if we dey hold anybody wey cause trouble when the matter don rise e go make sense well well and e go help us reduce crime and gbegerity for our obodo naija too. I remember dat time when I dey grow up my grandmama go use our native dialect talk to me when she sense say I wam make trouble and she go say okota oburu, person wey cause wahala go use em head carry am. Wetin you talk na correct word.
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 10, 2022, 11:31:48 AM
E good to wake persin wey dey sleep mess so dat im too go follow smell am.
Meaning: Always make sure those who ferment trouble won't run away from the scene once the trouble escalates.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
August 06, 2022, 07:15:25 AM
E dun tey i enter this corner, I been dey yan with elder yesterday unto some kind discussion, e get wisdom wey e drop wey i go like share with una...

PROVERB: Person wey say e like get big teeth dun already reason how e go take close am, that is nor go dey tell am how to close am

MEANING: People already know that there are consequences to any decision the choose to take, sometimes it is unnecessary to worry about a person's choice.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
To excel in every good thing
August 05, 2022, 05:38:23 AM
Proverb: The tin wey you think say you hold the pikin I hold the mama
Abeg, I go like make you rephrase dat yarn as e nor too complete for my brain. Abi na typographic error dey there in?

Oga Mpamaegbu, this my yarning no complete as you talk unto say I been dey go through some dirty things for my mind but I go try to explain am here small because that proverb get deep meaning and e need person wey dom stay wia elders dey to understand well.
No, nor be d explanation to d proverb I dey talk. Na d way wey you take write am I dey refer to. Just read am out to yourself, e bi like sey e get line or spelling wey nor enta well.

Abeg oh, nor let owa cowtry matta drive you crazy. All man sabi sey Naija don cast, na real dead man walking be dis cowtry now. Sober up my guy.

Chia my brother everything just tire me, abeg I dom amend am and na the correct yarning be dis, my head full I no feet even understand myself like dis, area too rough you no go understand. You do well as you take dey always reason my matta.
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 04, 2022, 01:43:12 PM
Proverb: The tin wey you think say you hold the pikin I hold the mama
Abeg, I go like make you rephrase dat yarn as e nor too complete for my brain. Abi na typographic error dey there in?

Oga Mpamaegbu, this my yarning no complete as you talk unto say I been dey go through some dirty things for my mind but I go try to explain am here small because that proverb get deep meaning and e need person wey dom stay wia elders dey to understand well.
No, nor be d explanation to d proverb I dey talk. Na d way wey you take write am I dey refer to. Just read am out to yourself, e bi like sey e get line or spelling wey nor enta well.

Abeg oh, nor let owa cowtry matta drive you crazy. All man sabi sey Naija don cast, na real dead man walking be dis cowtry now. Sober up my guy.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
To excel in every good thing
August 04, 2022, 12:31:03 PM
Proverb: The tin wey you think say you hold the pikin I hold the mama
Abeg, I go like make you rephrase dat yarn as e nor too complete for my brain. Abi na typographic error dey there in?

Oga Mpamaegbu, this my yarning no complete as you talk unto say I been dey go through some dirty things for my mind but I go try to explain am here small because that proverb get deep meaning and e need person wey dom stay wia elders dey to understand well.


1)You fit use dis proverb on person wey fit say em get spiritual powers pass everyone, when you come notice say your own pass the person own, you let the person know say em power na pikin compared to wetin you get.


2) person wey dey always claim say no body sabi something pass am, like for book or skill wey em dey do, you go also let the person know say em wisdom and knowledge na childs as your own na baba wia em own dey.


You fit still add your own meaning as we dey learn everyday.

legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
August 04, 2022, 08:40:44 AM
Proverb: The tin wey you think say you hold the pikin I hold the mama
Abeg, I go like make you rephrase dat yarn as e nor too complete for my brain. Abi na typographic error dey there in?
hero member
Activity: 686
Merit: 527
To excel in every good thing
August 03, 2022, 05:30:42 AM
Proverb:The tin wey you get na the pikin I get the mama.

Meaning: You may feel like an encyclopedia until you realized that others have more knowledge and experience than you, especially in your field or course of discipline.


My people e don longy wey I never visit here, hope say una dey kajard.
full member
Activity: 728
Merit: 179
Eloncoin.org - Mars, here we come!
July 29, 2022, 01:08:19 PM
Na watin dey sweet goat, na em go kill am!

MEANING: Too much pleasure or greed can lead one to an early demise. Let everything be done with moderation.
legendary
Activity: 2660
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
July 21, 2022, 02:14:31 AM
Nice to still see you here, @Sandra_hakeem.

Na only woman wey dey sell ogiri/iru/locust bean go fit sabi fly wey dey blind for one eye.
Meaning: Be consistent in whatever you do, with time you will have a mastery of it and can easily place it.
hero member
Activity: 714
Merit: 1004
Goodnight, ohh Leo!!! 🦅
July 17, 2022, 09:43:50 AM
It's been a while here  Cheesy
I'm not really good at this but I have heard elders speak so many times, some which I can't even recall Roll Eyes
My entry:

* proverb:chick wey go grow turn better fowl,elders dey Sabi right from the day mother hen hatch am
Meaning: You can easily foresee the future of something or someone through the character with which they portray today and be certain which one turns out to be a 'bad egg' .
* proverb:na only mumu dey dip two leg for river to Sabi in depth
Meaning: you don't just go into making decisions or doing something without thinking of its repercussions.
* proverb:man wey dey pay loyalty give people wey get mouth pass am dey pave way for him own time to come
Meaning: respect is reciprocal and what goes around comes around; what anyone sows is what he reaps.
* proverb:person wey no know one thing fit still know another thing
Meaning: no one knows everything but everyone knows something that the other does not.
* proverb:no abuse the forest wey shelter you,come dey call am jungle simply because e no dey spacious
Meaning: don't neglect or insult who's taking your responsibilities as his priorities simply because he isn't presentable as your dumb brain thinks ; always be proud of them no matter what.

Sandra  Kiss
hero member
Activity: 686
Merit: 527
To excel in every good thing
July 16, 2022, 07:30:18 AM
~snipped~

If we relate dis matter for our society today, you go see how small small boys dey misbehave for street especially when small change enta dia hand dem go dey feel like say nobody dey like dem but dem go forget say na person been dey give dem food and shelter before dem start to dey see small small coins. You do well for this wise proverb wey you drop.
My broda, d matta com even worse tie wrapper join as Yahoo boys enta vibe. D small small boys dem nor wan know who elder dem again once dem hit maga. But once d change finish, dem dey humble like over riped plantain.

Baba, dose boys no get respect at all, you need to see the way dem dey mumu for club if dem cash-out, dem go wam make everybody comot dia make only dem stay. When money come finish for dia hand, you go see some of dem wey no get sense come dey near you with dia senior man I hail you greetings. Abeg the world dom spoil.
Pages:
Jump to: