Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 21. (Read 10546 times)

hero member
Activity: 980
Merit: 636
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 26, 2022, 03:29:47 PM
PROVEB: Pikin wet roast biye biye Na him go smell am

MEANING : Pikin wey do bad thing na him go face the consequences.

legendary
Activity: 1568
Merit: 1139
Top-tier crypto casino and sportsbook
September 24, 2022, 12:49:37 PM
PROVERB: Small pikin wey dey fear mouth odor , never dey ready to learn from old men.

MEANING: You must be ready and prepared to face any challenge whenever you set out to achieve a goal, don't always expect it to come easily.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
September 21, 2022, 06:32:20 PM
Ok oh Adbitco and GiftedMAN, I don hear wetin una talk. Sense dey am wella. Owa people sey wetin person nor know pass am. I nor know dis wan.
abeg I go be like you when I grow 😆 .
You don already grow na – 70 years old man 🤣

Person wey no dey near fire em yam no go done well
Confirmento!
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
September 20, 2022, 07:36:46 AM
Person wey no dey near fire em yam no go done well
Meaning: For you to be successful in anything you are doing, you must be committed, vibrant and motivated otherwise you will always fail.
I bin dey with some elders today and when dem yarn dis proverb I say I must carry am tell my brothers for here, una good afterbnoon.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
September 16, 2022, 01:49:55 AM
Hello my people. Na my first time for here b dis, I no know say dis kind thread dey for here again aside our naija local board. So as I don burst here, I say make I follow add for we proverbs for Africa with pidgin.

Hand wey dey shake, still dey together with him body.

Meaning: For every good and bad you do, it will still follow you everywhere.

This proverb dey emphasize say anything wey we wan do for dis life make we always think of the repercussions later, wether good or bad.

@Asiska02 I give you beta salutation as you dom finally locate here wey confirm elders dey sit down dey yarn better proverbs wey dey help lives and dey also educate old and younger ones about tins wey dem suppose know and do for our society.

Your proverb make sense well well and the meaning self come enter my body because me I believe say dat word wey oyibo dey call KARMAL no dey ask of person house address before e go visit am. You try well well and I go like to dey see more of your yarnings for here.

Ok oh Adbitco and GiftedMAN, I don hear wetin una talk. Sense dey am wella. Owa people sey wetin person nor know pass am. I nor know dis wan.

@Oga Mpa you na confirm elder infact I go add chief to you because some elders no dey agree for wetin oda people talk even when dem no say sense dey for wetin dem yarn, abeg I go be like you when I grow 😆 .
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
September 14, 2022, 07:56:52 PM
Ok oh Adbitco and GiftedMAN, I don hear wetin una talk. Sense dey am wella. Owa people sey wetin person nor know pass am. I nor know dis wan.

Asiska02, your yarn enta my skull. Correct. I suppose pour you colele wata so on top dat one but my fridge just dey empty. Again, I welcome you. Make yourself a home here.
hero member
Activity: 1008
Merit: 702
September 13, 2022, 02:16:46 PM
Hello my people. Na my first time for here b dis, I no know say dis kind thread dey for here again aside our naija local board. So as I don burst here, I say make I follow add for we proverbs for Africa with pidgin.

Hand wey dey shake, still dey together with him body.

Meaning: For every good and bad you do, it will still follow you everywhere.

This proverb dey emphasize say anything wey we wan do for dis life make we always think of the repercussions later, wether good or bad.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
September 07, 2022, 12:02:07 PM
I don see where people repent and turned new leaf oh. E fit still happen with prostitutes too.

@Oga Mpa, this one  dey me hard to believe oo because dose olosho people get one spirit wey dey inside dem and the spirit dey very hard to comot no matter the new paint wey dem take paint dia body (repentance). I still dey remember the mistake wey one of my guy do last two years wey em go marry one olosho wey em jam for club, padi man go offshore em wife go carry anoda man come house come run show after em swear for my guy say she dom repent and na jesus be her middle name now. Olosho go always be olosho.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 07, 2022, 06:37:49 AM
Meaning: A prostitute is always a prostitutes no matter any kind  life you gave to her, she still remains the same.
I don see where people repent and turned new leaf oh. E fit still happen with prostitutes too.

Hehe @MP my brother is not easy sha, such life is demonic and it takes only the grace of God for them to get total free from such life and even as that ones once they still have the feeling. I have witness a fully dedicated one at then who gave her life and surrendered her life even relocated to another state but still feels the same, since there wasn't her place or where i was well known she decided do and maintain her life forgotten that she can't hide from God instead only hiding from man. So you see, which is why i said they remains the same.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
September 07, 2022, 05:30:10 AM
Meaning: A prostitute is always a prostitutes no matter any kind  life you gave to her, she still remains the same.
I don see where people repent and turned new leaf oh. E fit still happen with prostitutes too.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 04, 2022, 01:25:50 PM
Omo no be joke like dis me never near here before I just dey scroll down i come touch this corner and e sweet me to see say this part of our proverbs dey, although if you check our local thread I dey mostly use proverbs dey post but nevertheless as I see here now I go begin make use of this place wella. But anyhow e be make I drop one before I tuama.

Mango 🥭 tree wey dem swipe for morning time no mean say the leaves no go fall again before the next morning.

Meaning: No matter how you try help no mean say de pesin go keep body for you to help am again.

No matter how you try to clean the anus it can never stops smelling

Meaning: A prostitute is always a prostitutes no matter any kind  life you gave to her, she still remains the same.

Make I leave this one here, I dey come make I go market.
legendary
Activity: 1568
Merit: 1139
Top-tier crypto casino and sportsbook
August 31, 2022, 04:38:36 PM
Person wey know say e go chop okra soup for party, nor dey wear white go.
Meaning: Plan ahead, make preparations.

Plate dey turn dirty plate once food finish for inside.
Meaning: Don't allow yourself be in a position where you no longer have any value to give.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
August 31, 2022, 03:36:27 AM
If you allow pregnant woman take vex rush enta house born, she go born mad person.
Meaning: Critical decisions aren't supposed to be taken in anger, the resultant effects are often regrettable.
legendary
Activity: 1162
Merit: 1390
August 27, 2022, 01:26:35 AM
I never come here b4 afta di 1st proverb wey I dropped nd I no fit remember di time, 2day as I dey pass I come say make I hold break nd I sa hold di break I come see say d toris wey dey here dey sweet me 4 bele. Nai come say me I go dey tori 4 here dis 4ront. Bcoz even dis place 2 dem dey use am dey join 4 di work we dey do 4 we company. African sayings we dey here just dey like fun 4 we tok tok place.

Di Lion wey bi di leader 4 di jungle e no strong pass Tiger if Dem dey 1 by 1. Lion dey kill Tiger wen Dem (Lion) e dey plenty well well nd di Tiger na onli 1.

Meaning: Di Leader we e no dey carry oda pipo dey Join body dey waka e no fit make am. Nd if attacked come he go sufferam.

If you mess inside the water, the smell must come later and everyone go perceive am.

Meaning: Wen u do something secretly, everyone go still hear am later.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
August 24, 2022, 12:46:27 PM
@GiftedMAN, you sef na sabi man you be. 🤗
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
August 24, 2022, 06:36:44 AM
Persin wey wan make dog trust am and be im friend nor dey raise stick where dat dog dey.
Meaning: For one to earn the trust of another, one ought to exemplify it both in words and deeds.

Abeg you go permit me to call you elder because na wetin things wey dey come out from your brain show say you be.
On a norm,person wey wam make you trust am no suppose do tins wey go hurt you no matter anything because no matter how the person  go take beg, once em dom show bad sign before you no go fit trust am again even if you dey relate weller with am. Secondly, e no good for anybody to dey claim Jesus while em be judas because na wetin dey our society today and e dom make tins spoil well well so like dis anybody wey dey closer to me wey dey do anyhow I no feet trust the person at all.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
August 24, 2022, 04:04:47 AM
Persin wey wan make dog trust am and be im friend nor dey raise stick where dat dog dey.
Meaning: For one to earn the trust of another, one ought to exemplify it both in words and deeds.
hero member
Activity: 980
Merit: 585
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
August 23, 2022, 03:10:39 AM
@Oluwa- btc, dis your proverb go well and de meaning come sweet me for body as e be say na tins wey I dey see for my face wey dey happen dis days. Dis one show say you dom sit down with elders small and you dom hear some beta word from dem.
I hope say no bodi dom sheet say make you park am because dis days sheet dey over smell and e feet make person do tins wey em no plan to do.

I sit down with elders true true nah so I come hear am I come they reminise wetin person do me for that kind 2020 I don forgive ohh but I no go fit forget the pain and everything, the sweet part be say I don learn, I dey grow and when another thing like that wan sup I go surely know how to prevent am! Payback nah less, but I no wan payback.

Na true you talk sey dis place come be like wetin persin japa leave. No worries I dey kampe. Make I congratulate you for your senior man rank. Na small time e remain make e become official. You be correct my broda.
[/quote]

Biq Brother Mpa!! All my growth 4 the forum nah for here I dey celebrate am,  Member ohh, 100 merit, Full Member now Potential Senior Member Anticipated. I dey thankful to Al them weh dey support people growth from them hearth, some dey see am like competition kwa lol but all nah make am sweet ( Na less ).

 I been no sahbi chi chi bout BTC, but now, I dey learn am with my time dey read more of it than I dey do before, dey join Bitcoin spaces and listening to Bitcoin Podcast, E dey do me like say I dey play ball. I dey truly learn am from my Heart. Once more thank You for the wishes in due time, e go set! You be Man no forget, your baby brudda loyal scata lol 🦍🖤❤️
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
August 22, 2022, 07:56:15 AM
This our corner weh we dey come chop wisdom upon wisdom done dey grow green grass as we no dey active! Yeah everyone dey try to rank up see front e no sexy but make we still dey touch down this ends.
Na true you talk sey dis place come be like wetin persin japa leave. No worries I dey kampe. Make I congratulate you for your senior man rank. Na small time e remain make e become official. You be correct my broda.

~
Edit your post. Your comment dey inside person post wey you quote and e nor set like dat.
hero member
Activity: 1078
Merit: 641
Watch&Pray.
August 20, 2022, 09:27:03 AM
Proverbs : No be who sheet dey know how e smell, na who park the sheet go remember the smell and know how e be!

Meaning: Truthfully, What you do to others or someone would be easily forgotten by you, but not the person who got hurt!

Jump to: