Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 22. (Read 9496 times)

hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
June 18, 2022, 04:47:10 PM
GiftedMAN, you funny die 🤣. Everibodi wey dey drop yarns here na elder oh. Rememba sey na proverbs elders dem dey take relate with demselves and if we all dey fit do am here na im be sey we too much too.
No be lie wey you talk my broda, everybody wey dey here dey do very well, since wey I sabi this place ah no go lie for you I dom get beta inspiration for the yarnings wey men dem dey yarn for here, i dey happy 😂 say I locate place like this. I dey always praise you because na you create this thread so no reason am you be real elder and your face show pass tinubu own.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 18, 2022, 02:11:42 AM
GiftedMAN, you funny die 🤣. Everibodi wey dey drop yarns here na elder oh. Rememba sey na proverbs elders dem dey take relate with demselves and if we all dey fit do am here na im be sey we too much too.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
June 16, 2022, 08:32:26 AM
Proverb: Nku n'ona mba n' eghere MBA nri

Did  na popular Igbo proverb

Meaning: The solution to the problems in a community would invariably be found within the community
Na true yarn, nice one but next time make you try do transliteration to pidgin first b4 you give meaning for English. Remember sey na pidgin we take dey cap for here.
@Mpamaegbu I dom hear wetin you talk and I dom take correction, our people say if elder see bad thing wey small pikin dem dey do no talk say the mouth wey him close go kill am but if em talk the small pikin dem no hear na the small pikin dem go die, you dey do well.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 16, 2022, 12:17:07 AM
Proverb: Nku n'ona mba n' eghere MBA nri

Did  na popular Igbo proverb

Meaning: The solution to the problems in a community would invariably be found within the community
Na true yarn, nice one but next time make you try do transliteration to pidgin first b4 you give meaning for English. Remember sey na pidgin we take dey cap for here.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
June 13, 2022, 09:29:30 AM
-trim-
Dis guy,,, ur talk too dey swt me 4 bodi. Watin con dey shock me cef b say, na d 2 last one dem dey always off me. I no jst understnd bt na so e jst be. Abi u dey use d 1st one run intro... E mak brain shah.

No be small kind tin dose Owo women do dere o. Dem practice watin no nice nd get immediate result within d community. Last last, foreign juju dey respect community juju o, as na em get ground. Mina y, mak we no 4get culture shah. People way 4get dere way of life, don lose for life.

Matters way sup 4 Church, na traditional means dem use solve am. Irony, na so Oyibo use talk am. Una weldone.
My brother you do well. The truth of the matter be say God bin chase devil comot for heaven but em no collect all the powers from am.

Proverb: Person wey no sabi one tin sabi anoda one.

Meaning: No one knows everything, but everyone knows something.

Una Happy Democracy Day!

No forget say your PVC na your Power
Go Get Yours.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
June 12, 2022, 05:41:30 PM
-trim-
Dis guy,,, ur talk too dey swt me 4 bodi. Watin con dey shock me cef b say, na d 2 last one dem dey always off me. I no jst understnd bt na so e jst be. Abi u dey use d 1st one run intro... E mak brain shah.

No be small kind tin dose Owo women do dere o. Dem practice watin no nice nd get immediate result within d community. Last last, foreign juju dey respect community juju o, as na em get ground. Mina y, mak we no 4get culture shah. People way 4get dere way of life, don lose for life.

Matters way sup 4 Church, na traditional means dem use solve am. Irony, na so Oyibo use talk am. Una weldone.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
June 10, 2022, 09:40:56 AM
Proverb: Nku n'ona mba n' eghere MBA nri

Did  na popular Igbo proverb

Meaning: The solution to the problems in a community would invariably be found within the community

Perfect example na the way Owo Community people take join-hand catch hoodlums wey do the killing for inside Catholic Church on Sunday last week for Ondo state.


Dem say maize dey die after e bear fruit because e no dey rooted into de ground.


You will never get to the top and stay prosperous without a good foundation.


Dem say no sail with another person star


Avoid copying someone else, just because someone has been successful in what he or she does should not be what will make you to do the same thing and expect to be successful.

My people yesterday make me 90days for the forum and where I dom reach today na una help me.
hero member
Activity: 784
Merit: 544
June 09, 2022, 05:02:57 AM
PROVERB ~ If Fowl no chuk him food well before him eat am,  e dey cause him death without getting sick.

Meaning ~ Rushing into something without  proper examination will put you into sudden problem or  unfortunate death.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 09, 2022, 02:10:58 AM
Tortoise sey im nor know why people too dey gossip am anytime wey dem see am pass sey him nor sabi walk but for im own mind, him dey waka wella
Meaning: People are not likely to value whatever an uninfluential person does, even when he does it excellently well.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
June 05, 2022, 01:10:24 PM
Dem say small pots get ears

Meaning: Don't forget that children can hear what you're saying and probably repeat all the embarrassing parts to their friends.


If you dey look for fly wey dey your food e mean say you dom belleful.


Meaning: If you have the energy to complain about silly things, it means you don't have real problems.
This first two eh, the thing enta me o. Xpecially d frist 1, d thing enta me wella nd I concur say eh, na so e be 4 life. Wth all dis small ear way do not tea eye dis days.

Oya na, make una for collet dis one carry join hold una side.
Proverb: our pple dey talk say, if u follow how snake long rch, u fit cut tree finish 4 forest.
Meaning:  if persn follow hw situation be or d way somtin dey worry u reach, you fit put hand 4 watin u no go like later. Mak I cut am short, hunger ft mak u thief.

Dat na to say, mak u no carry situation, follow up matter!

My brother your talk sweet me for body, if all of us carry dey way e be us for body eeh we for dom do wetin oyibo people dey call 'unthinkable' but las las we dey survive and everything go later dey ok.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
June 04, 2022, 10:41:41 AM
Dem say small pots get ears

Meaning: Don't forget that children can hear what you're saying and probably repeat all the embarrassing parts to their friends.


If you dey look for fly wey dey your food e mean say you dom belleful.


Meaning: If you have the energy to complain about silly things, it means you don't have real problems.
This first two eh, the thing enta me o. Xpecially d frist 1, d thing enta me wella nd I concur say eh, na so e be 4 life. Wth all dis small ear way do not tea eye dis days.

Oya na, make una for collet dis one carry join hold una side.
Proverb: our pple dey talk say, if u follow how snake long rch, u fit cut tree finish 4 forest.
Meaning:  if persn follow hw situation be or d way somtin dey worry u reach, you fit put hand 4 watin u no go like later. Mak I cut am short, hunger ft mak u thief.

Dat na to say, mak u no carry situation, follow up matter!
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
June 03, 2022, 12:07:33 PM
Nor be small thing o. Choi, all these proverbs wey i don read here dey burst my dada.

Proverb: Any pikin wey dey laugh him papa because say him yam don spoil dey laugh the hungry wey go show am shege shege
Meaning: Never laugh at, mock or despise your family or members no matter what they are going through.

Proverb: Goat wey dey find food for thief compound na pot of soup e go enter.
Meaning:  No matter how bad your situation(unemployed, broke) is, do not be pressured to get involved in crime or any illegal activity. 

 
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
June 02, 2022, 01:17:46 PM
Dem say small pots get ears

Meaning: Don't forget that children can hear what you're saying and probably repeat all the embarrassing parts to their friends.


If you dey look for fly wey dey your food e mean say you dom belleful.


Meaning: If you have the energy to complain about silly things, it means you don't have real problems.


Any place wey honey dey ant go dey also.


Meaning: If something nice happens, there will always be small problems associated with it.


I greet all my people for here, una too much.
hero member
Activity: 812
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
June 02, 2022, 12:15:31 PM
Ugubuntu - I done show my face here again ohhh... I done talk am before, I go still talk am again, ugubuntu ngabantu

People become people through people and this is true, I dey delight to everyone weh put hand for my growth.
I turned a Full member once more today, I say make I share my news for here first!

Proverbs : Cow weh dey rush go oyibo land go come back as corn beef!


Whoever does thing's in a rush doesn't gets good results and outcome from it!

Ornah Happy New Month kwa🖤
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
June 01, 2022, 08:20:33 AM
Proverb: no matter the heat of the sun e nor go fit cook beans
Meaning: Actions made in anger are always regrettable decisions. Think twice when angry before you act
I don dey try relate dis ur proverb wth d meaning way u cap nd somehw, e no dey enta 4 me. Abi u 4 twist am anoda way mak I 4 follo well although, d proverb na familiar street yarn 4 we pighin shah. Anyhow e be, d coco way com out be say,
Na true wey you talk, @Mr.right. Poka, oya come recap ur yarn 🧐.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
May 29, 2022, 12:43:20 PM
Proverb: no matter the heat of the sun e nor go fit cook beans
Meaning: Actions made in anger are always regrettable decisions. Think twice when angry before you act
I don dey try relate dis ur proverb wth d meaning way u cap nd somehw, e no dey enta 4 me. Abi u 4 twist am anoda way mak I 4 follo well although, d proverb na familiar street yarn 4 we pighin shah. Anyhow e be, d coco way com out be say,

No where way ur vex reach. Nd e go sure say, mak u no dey tak decision wen u dey vex on any matter. U fit mak a beta big mistak way u no go fit correct or way u go regret last last. So, mak we dey use our head nd try calm down  b4 we react to matters.

Na like dis me I take follo rch. E fit mean anoda thing 2 anoda persn shah. Anyhw e be, una dey try. Mak una dey carri we dey go! Lol
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
May 27, 2022, 03:59:57 PM
Proverb: no matter the heat of the sun e nor go fit cook beans
Meaning: Actions made in anger are always regrettable decisions. Think twice when angry before you act
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
May 26, 2022, 07:58:38 PM
Proverb: E better say make you hold eba/garri/ fufu for hand dey find soup.
lmao, Person wey dun go all those kind camp meeting them before go fit relate proper with this this yanning. Nice one!

Proverb: Guyman wey dey form friend to fine girl wey e like, las las na invitation e go follow get for her wedding.

Meaning: Take action, be proactive.

Proverb: Goat wey get goatie, e nor mean say e dey wise.

Meaning: Be careful where and whom you take advice from.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 25, 2022, 02:09:41 PM
Dem say when a man fence em house you go know em level of wisdom.

Your knowledge always reveals in your activities.
member
Activity: 65
Merit: 17
May 23, 2022, 11:54:49 AM
My dear, nor be small thing oh. Na so my neighbours dem go dey pound pound anything from pepper to crayfish every time like inside bush people instead of dem to use blender or kuku blend d stuff for market. Honestly, sometimes you go think sey persin wey go school go even get common sense sey day pound pound thing dey disturb but dem sense nor dey tell dem so.
my broda!!! no de mind some people oo!!! if you follow people nonsense de vex, e no de end. You self you know say no be everybody way go school de get sense. na pride de do make some people do nonsense.

PROVERB: Some people de like forget say if them like make them jump reach heaven, you go still land for ground.  
MEANING Person no suppose de do pass em-self
Pages:
Jump to: