Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 24. (Read 9496 times)

hero member
Activity: 854
Merit: 1246
May 10, 2022, 04:44:20 AM
FOWL HAS NO NEST:  

MEANING: Lazy person has no building.

FOWL YANSH DON OPEN
:
MEANING: The secret don open.

NO BE BOBO JUICE:
MEANING: No be small thing

I welcome myself to the African wise saying Thread.
member
Activity: 71
Merit: 22
May 05, 2022, 06:09:46 AM
See this 2 Men them day i just welcum for we other area. Una leg still carry una cum here too! Chaiii, una waka well my pple nd no be only waka o, una don dey show us say, una no b 2day pikin nd d area way una from cum out for we naija, una dey seatdon for old men floor. I gbadu una nd as e be like dis eh, una go collect cooli water for head, e no easy. Una dey try!
Big man, I dey loyal ooo, thanks for the OT and encouragement wey you dey always give. Your face show, your shoe still con shine, Gbayi!

Mina y, d 2 proverb way I carry put inside my post so eh, e mak brain no be lie. Shake dey reach elbow, lol,,, na waa o... abi you wan climb pepper try b4... salama 4 una.
If person no dey careful some handshake dey reach elbow ooo. When person dey receive handshake, make person dey sabi when to commot hand cause some handshake dey reach elbow inside life, and the result no dey make.
hero member
Activity: 896
Merit: 645
May 05, 2022, 05:43:02 AM
Proverb: Handshake wey don cross commot from hand reach elbow, na invitation for war.
Meaning: Over familiarity can lead to disrespect.

U fit Waka round pepper tree, but u no fit climb am.
You can only be boastful but u can't actually do more than your strength.
See this 2 Men them day i just welcum for we other area. Una leg still carry una cum here too! Chaiii, una waka well my pple nd no be only waka o, una don dey show us say, una no b 2day pikin nd d area way una from cum out for we naija, una dey seatdon for old men floor. I gbadu una nd as e be like dis eh, una go collect cooli water for head, e no easy. Una dey try!

Mina y, d 2 proverb way I carry put inside my post so eh, e mak brain no be lie. Shake dey reach elbow, lol,,, na waa o... abi you wan climb pepper try b4... salama 4 una.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 05, 2022, 03:28:55 AM
Proverb: Dem say fowl no dey forget person wey trim em feathers during raining season.

Meaning: A person will never forget the help rendered to him in difficult moments.


This proverb says a lot about me.

I turned member today...
member
Activity: 74
Merit: 18
May 03, 2022, 04:22:04 PM
Mess when person mess under water, d gbudugbudu go bring am up
Meaning: nothing is hidden under the sun.

U fit Waka round pepper tree, but u no fit climb am.
You can only be boastful but u can't actually do more than your strength.
hero member
Activity: 812
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
May 02, 2022, 10:33:11 PM
Umuntu ngumuntu ngabantu

This is a popular South African proverbs that says, To be human is to recognize the humanity of others, more like people become people through people.

hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 02, 2022, 06:21:26 PM
Proverb: dem talk say as bitter kola sound for ear no be so e dey sweet for mouth

Meaning: Do not expect anything much from anybody people changes.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 02, 2022, 12:20:27 PM
Is this forum only for african proverb or we can add our local language proverbs too?
ALthough I have read so many good proverbs and I will keep coming back to learn more about African Culture.
Love XOXO
Yes dear. The thread (not forum) is strictly dedicated to Proverbs that are relatable to Africa and said in pidgin English. If you've any proverb that we Africans can relate to, you're free to say it but on the condition that it has to be written in pidgin too. Thank you for stopping by and reading our posts. Don't stop reading.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 01, 2022, 05:51:30 PM
Proverb: My people talk say no matter how river deep,sand must dey inside.
Lol, nor be lie! this one hit hard nor be small.
na correct correct yanning una dey drop for here.

Proverb: Na the same mama born akara and moi moi, na wetin dem pass through make dem dey different.

Meaning: What matters most is how you finish and not start.
@Rruchi man, this one sweet me for belle, akara and moi moi na from desame papa and mama oooo good one.
member
Activity: 71
Merit: 22
May 01, 2022, 04:36:30 PM
Proverb: Old firewood dey quick catch fire.
Meaning: Old habit die hard.

Proverb: Handshake wey don cross commot from hand reach elbow, na invitation for war.
Meaning: Over familiarity can lead to disrespect.

Proverb: Na clap dem take dey enter dance.
Meaning: You don't have to start big, start small, start from somewhere.
full member
Activity: 1204
Merit: 110
April 30, 2022, 05:13:47 AM
Proverb: My people talk say no matter how river deep,sand must dey inside.
Lol, nor be lie! this one hit hard nor be small.
na correct correct yanning una dey drop for here.

Proverb: Na the same mama born akara and moi moi, na wetin dem pass through make dem dey different.

Meaning: What matters most is how you finish and not start.
Is this forum only for african proverb or we can add our local language proverbs too?
ALthough I have read so many good proverbs and I will keep coming back to learn more about African Culture.
Love XOXO
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
April 29, 2022, 12:59:23 PM
Proverb: My people talk say no matter how river deep,sand must dey inside.
Lol, nor be lie! this one hit hard nor be small.
na correct correct yanning una dey drop for here.

Proverb: Na the same mama born akara and moi moi, na wetin dem pass through make dem dey different.

Meaning: What matters most is how you finish and not start.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 28, 2022, 03:42:36 AM
Proverb: Dem say toad no dey waka for day time for nothing na either em dey pursue something or something dey pursue am.

Meaning: there's a reason for everything we do in life.

Proverb: My people talk say no matter how river deep,sand must dey inside.

Meaning: There's solution to whatever you are passing through in life.

My people una good day.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 28, 2022, 03:37:28 AM
Only where you go confirm am say money no fit buy happiness na when sickness hold you way be say, na die you dey! Omo, thenonly thing you go dey reason first first na to well.
My dear, na ogbenge talk you yarn there. Dis one dey make me laugh when I see people dey boast "do you know who I am?" Na wen you enta hospital you go see wealthy men looking like vegetables you go sabi sey nothin truly dey dis life oh. With all their cash dem nor fit save themselves. People supposed dey humble and take dis life jeje. Nothing dey am.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
April 27, 2022, 10:33:19 AM
Some African spice for the aroma in the house,

Proverbs: E go better, e go better, nai make igbo man still dey kano.
Meaning: When there is hope there is life.

Proverbs: Bring suya! bring suya! you nor know say na cow body dey suffer am.
Meaning: every action has a unique recompense.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 25, 2022, 06:36:22 PM
Proverb: Dem say when wound heal dem go forget the pains

Meaning: Never hinder your progress with your past.

Proverb: Dem say no be who smile with you dey happy with you

Meaning: Life is more than what you see physically.

I hope say we dey kajard, Una good day.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
April 25, 2022, 03:38:31 PM
Proverb: price of bed no dey determine if your sleep go sweet
Meaning: money cannot buy everything
You see this money can't buy happiness talk, na true only to some extent o. Money get power, too much power na em this thing we dey call money get. If you see person way don know money, even pikin cef and you carry money wave am fir face, e go smile.
On a normal, them say after God, na money and e get why!

Only where you go confirm am say money no fit buy happiness na when sickness hold you way be say, na die you dey! Omo, thenonly thing you go dey reason first first na to well. Because, them no dey price am like others. Others be say, you go dey push price until e go full for eye and to reject go con be wahala.
hero member
Activity: 1120
Merit: 555
April 24, 2022, 03:24:33 PM
Proverb: price of bed no dey determine if your sleep go sweet
Meaning: money cannot buy everything
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 24, 2022, 07:57:48 AM
Rruchi man, make I congratulate you in advance first unto Hero man wey you go be this week, whether or whethern't. Bro, enjoy the step up because you deserve am too. To others, make una nor relent. Make una continue to dey keep una heads high, e go soon reach everybody. Jollof rice wey dey bottom pot today na im go dey top of cooler tomorrow.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
April 24, 2022, 02:45:28 AM
Dem sey drink wey go cause problem between in-laws make e break for road.
Meaning: It's better to preempt any seemingly good thing that may become disastrous on time than allow it bud.
My Oga dem, i dun miss una representation for this corner dieeeee, nor be small thing una dey do oooo, to dey push am dey go jejely, e nor easy at all! three gbosa for una. I say make i enter this corner come add small curry to the "pot of wisdom" wey 24/7 dey on top fire for here but nor dey burn.

-Dem say Bouncer for club nor suppose dey wear senator(native) on friday night
Meaning- Dress the way you want people to address you, and properly for every occasion accordingly.
Pages:
Jump to: