Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 23. (Read 9496 times)

hero member
Activity: 784
Merit: 589
May 23, 2022, 11:34:10 AM
Proverb: stick wey Dem dey use put for ear, if e touch your eye, you fit blind.
Meaning
 A situation or a condition of life could seem favorable to Mr A, but should Mr B engage in this, he might not succeed.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
May 22, 2022, 09:21:15 AM
I greet all of una for this Sunday, I say make I check us here. Oga Mpa hope you full ground.
I appreciate the proverb wey CryptocurrencyKing carry come here.

Proverb: My people say, the day way e go favour madman, e no go need to mad plenty.
No be lie my brother, no be how tough you don hustle, no be the kind hard work you don do for life. Any time your turn reach, even if you do the wrong thing, result go show for you.

You no fit climb de ladder of success when your hand dey your pocket

You have to work hard to be successful.
Correct talk, we go need to make efforts my brother. When you don try Oluwa go acknowledge your efforts. My mother talk say, "Dem no deh dey house see animal wey juju kill"
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 19, 2022, 02:28:09 AM
De insect wey dey eat kola nut dey inside the leaf.

Your enemy is always closer to you than you think.

You no fit climb de ladder of success when your hand dey your pocket

You have to work hard to be successful.

You no go borrow person your knife when your yam dey fire.

Satisfy yourself first before thinking of others.

Person wey snake dom bite dey fear lizard

Be careful with the situation that has caused you pain before.

I salute all my people for the house, all of una too much.
hero member
Activity: 812
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
May 18, 2022, 06:40:35 PM
No be to dey run kitikiti or run run Kata Kata, Na who Sabi road dey reach wia e dey go!

This ain't no proverb although but, it's best adviced we follow who knows the way ahead (High Reputable Members) and not rush.(Newbies)

Cassava wey mature go turn to Garri one day

Growth is a must, but one will go through the process so as to be shaped and refined during this process.

E done tey weh I carry leg put for this side, I say make I drop the little I grab. Corrections gud kwa buh, plenty pipuu get how Dem dey take interpret their proverbs! What I'm saying is that perception differs from others!
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 18, 2022, 06:07:10 PM
Note: I agree with the meaning assuming that the low income job is not a toxic work environment Grin.
🤣🤣 I like dat caveat wey you take style put there because some jobs nor good for persin to keep at all whether you get any side hustle or not. Welcome back to d fold, bro.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
May 18, 2022, 02:59:31 PM
Omo e don tey wey I enter here. I don miss all the wise funny proverbs when I read here. I like some of the new ones wey I don read here. Sometimes, I even dey ask myself how dem take they reason all these proverbs.
Well I say make I drop my own:

Proverb: E better say make you hold eba/garri/ fufu for hand dey find soup.
Meaning: As it relates to job search- It is better you maintain your low paying job while searching for a well paying job, than to quit the job to start looking for a well paying job.

Note: I agree with the meaning assuming that the low income job is not a toxic work environment Grin.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 18, 2022, 02:23:16 PM
@CryptocurencyKing, my broda! D thing tire my bones, nor be small. E come e like d leadership nor sabi wetin dem go do again to steady dis cowtry.

Family way de pound yam de disturb everybody,  no suppose think say other people no de follow chop for their domot
My dear, nor be small thing oh. Na so my neighbours dem go dey pound pound anything from pepper to crayfish every time like inside bush people instead of dem to use blender or kuku blend d stuff for market. Honestly, sometimes you go think sey persin wey go school go even get common sense sey day pound pound thing dey disturb but dem sense nor dey tell dem so.
member
Activity: 65
Merit: 17
May 15, 2022, 07:38:52 AM
Family way de pound yam de disturb everybody,  no suppose think say other people no de follow chop for their domot
Meaning: Just because you have  climbed up the ladder of success doesn't make others poor


Dog way follow cheater do race no go reach finish line.
Meaning: Associating with the wrong crowd can cost you everything
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
May 15, 2022, 05:37:30 AM
I greet una inside this morning o. I dey see how una dey take hold side for the forum and we country as we dey look we nation dey waka go where we no understand so. Una dey try. I bin take leg waka enta we corner and me go like drop sometin for una to use dey encourage ourselves for the forum nd we country way be as e be so.

Proverb: My people say, the day way e go favour madman, e no go need to mad plenty.
Meaning: you might be going through all the toughness of this world, always working so hard to earn not just a living, also your survival but, on your best day, your lucky day, you won't even get to work hard or project yourself as qualified enough and yet, you would be favoured amongst all.

Make una dey work and live gud  life!
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 14, 2022, 11:52:58 PM
Oga Mpa you and uchgod-21 una too much, this kind better thing wey una and other senior men dem dey do here no be everybody go feet doam.
My guy make nobodi deceive you oh, d koko be sey without junior men d senior men be like basket wey dem dey pour wata enta. E nor fit hold anything 🤔.

In addition, your post brings to the fore of a popular saying in my tribe, this I will loosely translate here - A man with a healthy penis doesn't know the travails of one with the elephantiasis of the scrotum.
No be lies I dom see am with my two koro koro eyes you no be small man for here na elder you be.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 14, 2022, 10:33:40 PM
Oga Mpa you and uchgod-21 una too much, this kind better thing wey una and other senior men dem dey do here no be everybody go feet doam.
My guy make nobodi deceive you oh, d koko be sey without junior men d senior men be like basket wey dem dey pour wata enta. E nor fit hold anything 🤔.

In addition, your post brings to the fore of a popular saying in my tribe, this I will loosely translate here - A man with a healthy penis doesn't know the travails of one with the elephantiasis of the scrotum.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 14, 2022, 11:08:12 AM
GiftedMAN and everyone wey dey drop proverbs here dey try, e no easy.
Na so my guy, e no easy at all for Ezekiel too. If sand think sey wetin rice dey do for pot easy make im too cooperate with im brothers to rise full pot na. I hail all of una. Una correct. Africa (Nigeria) nor complete without proverbs and na d major thing wey make me start dis thread.
Oga Mpa you and uchgod-21 una too much, this kind better thing wey una and other senior men dem dey do here no be everybody go feet doam. Person wey em manhood dey ok no go understand the pains wey person wey get gonorrhea dey face.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 14, 2022, 08:56:19 AM
GiftedMAN and everyone wey dey drop proverbs here dey try, e no easy.
Na so my guy, e no easy at all for Ezekiel too. If sand think sey wetin rice dey do for pot easy make im too cooperate with im brothers to rise full pot na. I hail all of una. Una correct. Africa (Nigeria) nor complete without proverbs and na d major thing wey make me start dis thread.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
May 14, 2022, 08:41:32 AM
uchegod-21 dey perfectly correct for dat analysis and even with d example wey im throw take join am. I for still baff you as I baff am for ur attempt too, you try, but na my last bucket of wata I pour am so. Wetin you go talk for owa African proverbs be sey different proverbs fit mean one thing but nor be sey one proverb fit mean several things. No. As dem dey talk for Igbo sey different tribes get different ways wey dem dey take laugh. Na so d thing be.

Oga Mpa, you too make sense for here. You see those words wey I bend, plenty wisdom dey inside.
Elders dey yarn different proverbs to express one thing, but one proverb no dey mean different things.
If one proverb dey mean different things, no need to dey write interpretation of proverbs. Because you fit interpret go left and me interpret go right and both of us go dey correct.

GiftedMAN and everyone wey dey drop proverbs here dey try, e no easy. E get the day person make me vex for night, na this thread I use calm myself and get inspiration. Na correct thread be this .
African proverbs is full of wisdom.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 14, 2022, 06:44:18 AM
Proverb: Goat wey everybody dey feed dey always suffer.

Meaning: Nobody takes responsibility for any public thing so don't depend on the public to take good care of you.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
May 14, 2022, 12:55:12 AM
@uchegod-21 African proverb no get only one interpretation or meaning, you feet get another interpretation while I get another one e feet no make sense or point to the direction wey you expect but look deep inside the talk you go understand well, proverb na words of elders no be something wey you no go reason well before you understand.
uchegod-21 dey perfectly correct for dat analysis and even with d example wey im throw take join am. I for still baff you as I baff am for ur attempt too, you try, but na my last bucket of wata I pour am so. Wetin you go talk for owa African proverbs be sey different proverbs fit mean one thing but nor be sey one proverb fit mean several things. No. As dem dey talk for Igbo sey different tribes get different ways wey dem dey take laugh. Na so d thing be.

I salute all of una wey dey continue to push dis owa corner here. Na real tight corner be dis. I believe sey d thing dey improve owa yarns with elderly people wey sabi proverbs too. Chinua Achebe sey proverb na d palm oil with which words are eaten, quote and unquote.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 13, 2022, 04:59:15 PM
Proverb: dem talk say as bitter kola sound for ear no be so e dey sweet for mouth

Meaning: Do not expect anything much from anybody people changes.

I beg to disagree with this interpretation. The proverb and the meaning purely differ.
"As bitter kola sound for ear no be so e dey sweet for mouth" This is saying that as sweet as bitter kola sounds to the ear when chewed, is not that sweet when you taste it.
This means that there is always unknown truth or some kind of pains in everything that seems good or perfect.
I want to use cryptocurrency we are into as an example.
Many people will hear that there is money in the crypto and jump in, not knowing that a time like this when the market will be red exists.
So, everything is not always as good as it is presented, it is when you enter into it, you will discover the untold part.

The meaning has nothing to do with people changing.
@uchegod-21 African proverb no get only one interpretation or meaning, you feet get another interpretation while I get another one e feet no make sense or point to the direction wey you expect but look deep inside the talk you go understand well, proverb na words of elders no be something wey you no go reason well before you understand.

hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
May 13, 2022, 03:42:14 PM
Proverb: dem talk say as bitter kola sound for ear no be so e dey sweet for mouth

Meaning: Do not expect anything much from anybody people changes.

I beg to disagree with this interpretation. The proverb and the meaning purely differ.
"As bitter kola sound for ear no be so e dey sweet for mouth" This is saying that as sweet as bitter kola sounds to the ear when chewed, is not that sweet when you taste it.
This means that there is always unknown truth or some kind of pains in everything that seems good or perfect.
I want to use cryptocurrency we are into as an example.
Many people will hear that there is money in the crypto and jump in, not knowing that a time like this when the market will be red exists.
So, everything is not always as good as it is presented, it is when you enter into it, you will discover the untold part.

The meaning has nothing to do with people changing.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
May 13, 2022, 06:07:12 AM
I welcome myself to the African wise saying Thread.
Lol, nor be small thing you dey do oooo, you enter where wise man dey break kola dey share wisdom, na only you cun carry hand dey welcome yourself, elder nor be soo ooo. Try follow tradition, na the people wey dey inside suppose dey welcome you so...na so e suppose be. All the senior men here, make una nor vex...Our man @Agbe nor know how we dey do things for here,  i dun give am the OT of how we dey run am, make una welcome am still.

Our people talk say(Proverb): Fish nor believe say na water wey been e friend nai dem go use cook am.
Meaning:  No one can be trusted completely.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
May 11, 2022, 02:11:35 PM
Proverb: No call forest wey shelter you jungle


Meaning: Do not look down on anybody that is helping you or taking care of your responsibilities.

I salute all my brothers and sisters here.
Pages:
Jump to: