Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 25. (Read 9496 times)

hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 21, 2022, 08:21:16 AM
My people talk say eye wey go reach old age no go begin early age dey give you problem.

Meaning: The brightness of your future is determined by your early preparation.

Dem talk say if you wam chop strong food make you close your door tight.

Meaning: If you want to be very successful,hustle hard in silence.

Una good afternoon.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 20, 2022, 10:54:09 AM
Dem sey drink wey go cause problem between in-laws make e break for road.
Meaning: It's better to preempt any seemingly good thing that may become disastrous on time than allow it bud.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
April 15, 2022, 02:51:50 PM
Proverb: Person way dey deny say, e no dey chop goat skin, them dey later see goat hair for en sh*t.
Omo! See dis guy sha. You don make yourself old man ovanite 🤪.


All of una dey try wella. Na una be di joy of dis thread, I nor go lie una. Na una dey make am stew. Abeg, make una sha dey cap the proverbs in bold so dat e go dey easy for anyone to see. Una doh!
How we go do na man way sabi. As I dey try hang with dimkpa like you, me cef go gats be another dimkpa na...
Any which way, I abi we don hear as you take talk and anything way go make the corner dey go well, na em we wan dey do. E go be as you don talk, nor worry  we dey together!
Make I still drop una small something...

Proverb: My people say, when pikin grow reach you via hight, una don turn mate be that.
Meaning: Respect is not by age anymore, you gats dey earn by means of your behaviour and handling things. Make person no carry hight and achievement cut you off from your respect.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 13, 2022, 09:35:57 AM
Proverb: If you play with small pikin too much, one day him go tell you to show am your prick.
Madt oh! 😆😆. This wan na serious reggae oh.

Proverb: Person way dey deny say, e no dey chop goat skin, them dey later see goat hair for en sh*t.
Omo! See dis guy sha. You don make yourself old man ovanite 🤪. Nice one. Na real gbege go be dat for the shitter na.

Proverb: Dem no dey hide chop crap
Na true my brother. That crap noise when persin dey crack am nor be here sha.

Proverb : no be who call police they win case
I welcome you to the forum, my man. Wellu come, wey 🍞.


All of una dey try wella. Na una be di joy of dis thread, I nor go lie una. Na una dey make am stew. Abeg, make una sha dey cap the proverbs in bold so dat e go dey easy for anyone to see. Una doh!
@Mpa, you no say you be correct person so we go do as e go sweet you sweet us too, we dom hear as you talk but no forget say them no dey dig ground mess.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 13, 2022, 03:00:08 AM
Proverb: If you play with small pikin too much, one day him go tell you to show am your prick.
Madt oh! 😆😆. This wan na serious reggae oh.

Proverb: Person way dey deny say, e no dey chop goat skin, them dey later see goat hair for en sh*t.
Omo! See dis guy sha. You don make yourself old man ovanite 🤪. Nice one. Na real gbege go be dat for the shitter na.

Proverb: Dem no dey hide chop crap
Na true my brother. That crap noise when persin dey crack am nor be here sha.

Proverb : no be who call police they win case
I welcome you to the forum, my man. Wellu come, wey 🍞.


All of una dey try wella. Na una be di joy of dis thread, I nor go lie una. Na una dey make am stew. Abeg, make una sha dey cap the proverbs in bold so dat e go dey easy for anyone to see. Una doh!
member
Activity: 364
Merit: 13
April 12, 2022, 01:05:16 PM
Proverb : no be who call police they win case
Meaning: something might be in favour of you and still turn against you later
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 10, 2022, 03:50:18 PM
Proverb: Dem no dey hide chop crap

Meaning: No matter how smart you are,  people must know when you have arrived(made money)

Ant wey get one leg dey early gather em food.

Meaning: A helpless man helps himself faster than anyone else knowing too well that he is all he's got.

If fowl stop to use leg scatter ground,  hunger go finish em children.

Meaning: Never stop  being who you are especially if people depend on you for survival.
 
Have a lovely evening.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
April 09, 2022, 05:40:41 PM
There is a Nigerian adage that says whenever a child cries and points towards a particular direction, if his mother is not in that direction, his father will be there.
You see this proverb way I don go quote carry come here so, e don tay way I hear this proverb and e been dey hard me to relate or even get the real meaning way follow. Although, as you talk am for there, e dey very self explanatory. Still on still, I gats carry am come where e belong.

Meanwhile, make I drop something for una to take hold the corner.
Proverb: Person way dey deny say, e no dey chop goat skin, them dey later see goat hair for en sh*t.
Meaning: nothing stays hidden forever. That thing way you do for private way eyes no see, e go show face for public later.
legendary
Activity: 840
Merit: 1004
April 09, 2022, 07:32:35 AM
Proverb: If you play with small pikin too much, one day him go tell you to show am your prick.

Meaning: Over familiarity can cause insult.

Proverb: Pikin wey den carry for back no know say the journey far.

Meaning: People that depends on people don't know the pains of earning.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 09, 2022, 02:01:35 AM
Meaning: You can’t leave a predator with a prey and expect that natural selection will not occur
Sharp! Na so di matta be.

Turned a member lately!
Big up, brother man. Congratulobia! Bigger celebrations dey wait you 4 corner. E just dey pain me sey I nor get colele wata to dey sama una as di matta dey hot now.

I still dey loyal ooo.  
I sight you, bro. Make una kontinue di good work wey una dey do. No relent.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 08, 2022, 10:02:25 AM
Proverb:Snake wey one person eye see dey always be like Python.
Meaning: When you encounter challenges or difficulties in life, do not feel that you are the only one facing it.

Okra no dey grow pass person wey plant am.

Meaning: Your master will always be your master no matter who you become tomorrow.


I still dey loyal ooo. 
hero member
Activity: 812
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 08, 2022, 06:57:08 AM
•Garri no believe say e go fit rise, nah hot water ginger am!
 You've got to surround yourself with Positive Folk's.

Pikin weh no get helper suppose get sense
 If your family depends on you, you have to work hard, smart, and stop fooling around with a friend that does depends on he's family.

No matter how good you dey to Goat, e go still chop your yam
 Some humans are good examples of this, you can never get same you reciprocate.

If stranger hear story for town nah indigene cap am.
Quite understable for everyone.

Turned a member lately!
hero member
Activity: 966
Merit: 701
April 07, 2022, 09:08:07 AM
Proverb: Them no dey put goat and yam for the same place and come back to meet the two
Meaning: You can’t leave a predator with a prey and expect that natural selection will not occur
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
April 06, 2022, 12:56:24 PM
Fowl sey im nor fit forget persin wey defeather im tail during raining season.
Meaning: No one forgets someone who renders help to them when they're in dire need.



hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
April 01, 2022, 11:31:34 AM
Like this I wam be like you when I grow.
You don already be like me 🤗

Quote
Something wey dem wear for hand, dem no dey carry mirror look am
You see wetin I yarn there just now? Dat ur proverb be d same thing with, "Obvious things don't require any explanation."
Na now I understand wetin you mean well, no wahala thank you for the observation and correction, small small I go lick this soup wey hot finish, you too much mpa.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
April 01, 2022, 09:35:19 AM
The proverb is saying that he who does evil thinks that everyone else around him is evil.
You be odogwu! Na so e bi. Chai, I for baff you now but fridge just dey dry. No shaking. I go do am everly.
Thank you Oga Mpa, your fridge go full again.
Make I drop one proverb.

Proverb: Okonkwo knows too well that it's a cricket but purposely called it a cockroach.
Meaning: Some times you let go for peace to reign. Don't always be Mr. Right even when you are right.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
March 31, 2022, 02:08:24 AM
Like this I wam be like you when I grow.
You don already be like me 🤗

Quote
Something wey dem wear for hand, dem no dey carry mirror look am
You see wetin I yarn there just now? Dat ur proverb be d same thing with, "Obvious things don't require any explanation."
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
March 30, 2022, 06:04:31 PM
Proverb: You no feet use only eyes sabi soup wey sweet until you taste am.
Nice one. I suppose revisit dis one to baff you. E go be once wata enter my fridge.


These three proverbs below mean the same thing:

1. Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup wey im dey eat...
2. Dem nor dey tell craze man sey war don start...
3. Dem nor dey tell deaf persin sey cold dey...
Meaning: Obvious things don't require any explanation.
You be senior man wey get doings, you dey drop beta proverb we get better meaning.

Like this I wam be like you when I grow.

Something wey dem wear for hand, dem no dey carry mirror look am
You dey try for here.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
March 30, 2022, 02:44:51 PM
Proverb: You no feet use only eyes sabi soup wey sweet until you taste am.
Nice one. I suppose revisit dis one to baff you. E go be once wata enter my fridge.


These three proverbs below mean the same thing:

1. Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup wey im dey eat...
2. Dem nor dey tell craze man sey war don start...
3. Dem nor dey tell deaf persin sey cold dey...
Meaning: Obvious things don't require any explanation.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
March 28, 2022, 08:53:51 AM
Proverb:person wey dey purge no dey select toilet.

Meaning: beggers are not choosers.

Proverb: Firewood wey dem go use for rainy season, na for dry season dem dey gada am.

Meaning: make haste while sun shines.

Proverb: No mata how market full na two pipo dey dia, man and woman.

Meaning: We may be of different believe but we are one.

I salute all the senior men dem for the house.
Pages:
Jump to: