Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 27. (Read 9496 times)

jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 08, 2022, 01:45:35 AM
Proverb: pikin wey I back Cross River dey complain say e match fish.

Meaning: some people are just ingrates(ungrateful) just help if you want to.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
March 07, 2022, 05:29:44 AM
I dey happy as i dey see say activities for this our corner dey increase day by day, to all our newbies wey dey here, i dey welcome una, make una continue to dey add ginger to our side, we dey do well. I dun come with small wisdom for the house today again, i go like to share am to the benefit of everybody.

Proverb: Our people talk say na with care nai dem take dey kill fly wey perch for person scrotum sack.
Meaning: You must handle sensitive issues and matters with care.
jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 06, 2022, 04:48:41 PM
PROVERB: NO FOOD FOR LAZY MAN NO B FOR PIKIN WEY MAMA DEY SELL FOOD.
MEANING:some people are born with silver-spoon,don't go about competing with them.
legendary
Activity: 840
Merit: 1004
March 06, 2022, 08:16:32 AM
Proverb: If you pursue mad man wey collect your towel when you dey baff, people go call you mad man too.
Meaning: Two wrongs cannot make a right.

Proverb: Na rat wey dey inside house dey tell rat wey dey outside say fish dey for house
Meaning: Your main enemies are within.

jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 06, 2022, 07:26:22 AM
Proverb:THE SAME WATER WEY BE FISH FRIEND NAI STILL KILL AM.
Meaning:trust nobody, be on your guard.
hero member
Activity: 714
Merit: 1004
Goodnight, ohh Leo!!! 🦅
March 06, 2022, 07:01:26 AM
This is my first trial

Proverb: e no get as rain go fall wey ground no go sabi
Meaning: There's nothing hidden under the sun,it might take people a long time to know but they'll finally get to know everything.
Sandra_ Kiss
jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 03, 2022, 02:00:13 PM
Proverb: NA I GO DO AM LATER NAI MAKE FOWL NO FIT FLY LIKE OTHER BIRDS.
meaning: do what you have to do, there's no right time,everytime is a right time. Don't procrastinate.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
March 02, 2022, 02:44:34 PM
Proverb: Animal wey Okpoko kill, the animal deaf.
Meaning: Okpoko na animal wey dey kill other small animals. But this animal dey make loud noise if em dey come. So, any animal wey Okpoko kill na deaf animal.
Dat proverb na basically "Ukpala (grasshopper) wey Okpoko (hornbill bird) kill, na deafness kill am. Nor vex sey I dey make correction here. I believe we dey here to learn. Your analysis na just transliteration too whereas e supposed be metaphorically. D meaning dey hidden inside wen you don advise somebodi on several times but dem nor listen and then something bad come happen to dem as dey nor take your advice.
Oga Mpa, wetin I go vex for na? Anybody wey dey claim know it all na program failure. I like this thread very wey. E dey give wisdom and inspiration. E for good say anybody wey drop proverb, anybody go fit chuck mouth to elaborate am.

Thank you for the reminder say the interpretation suppose dey for English, that means I have been doing it wrongly since. You know say some of us never Tey for here. Keep up the good work.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
March 02, 2022, 02:26:34 PM
Goat wey die inside yam barn, nor be hunger kill am.
Meaning: Anyone who is in the midst of plenty but suffers lack has only themselves to blame.
hero member
Activity: 966
Merit: 545
February 28, 2022, 09:52:51 AM
PROVERB: Overthinking no dey solve problem.
MEANING: This should be clear for everyone to grab and understand, Take your time with life, overthinking solves nothing as a man/woman rather plan and take actions.

PROVERB:Dem no dey use veks kill fly weh perch for wound.
MEANING: No matter your current state even if hurts badly, you shouldn't take actions with your emotions, showing emotions are true signs of a week man.

PROVERB: Today newspaper go be tomorrow suya wrap.
MEANING: Take life as it goes, Don't be too fast neither too slow, life is gets phase after phase, a poor a wealthy state can turn out to be a poor phase.

Thanks, I'm a newbie here.

Konfam konfam proverbs nai you drop back to back funny proverbs I don laugh my belle scatter but like Mpamaegbu don talk, follow the format we dey use for here. You go highlight the pidgin proverb in bold make eye quick catch am. The meaning of the proverb na for English as you take do your own. Shekena you don finish work
hero member
Activity: 812
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
February 28, 2022, 09:14:12 AM
PROVERB: Overthinking no dey solve problem.
MEANING: This should be clear for everyone to grab and understand, Take your time with life, overthinking solves nothing as a man/woman rather plan and take actions.

PROVERB:Dem no dey use veks kill fly weh perch for wound.
MEANING: No matter your current state even if hurts badly, you shouldn't take actions with your emotions, showing emotions are true signs of a weak man.

PROVERB: Today newspaper go be tomorrow suya wrap.
MEANING: Take life as it goes, Don't be too fast neither too slow, life is gets phase after phase, a poor a wealthy state can turn out to be a poor phase.

Thanks, I'm a newbie here.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
February 28, 2022, 05:20:47 AM
Proverb: Animal wey Okpoko kill, the animal deaf.
Meaning: Okpoko na animal wey dey kill other small animals. But this animal dey make loud noise if em dey come. So, any animal wey Okpoko kill na deaf animal.
Dat proverb na basically "Ukpala (grasshopper) wey Okpoko (hornbill bird) kill, na deafness kill am. Nor vex sey I dey make correction here. I believe we dey here to learn. Your analysis na just transliteration too whereas e supposed be metaphorically. D meaning dey hidden inside wen you don advise somebodi on several times but dem nor listen and then something bad come happen to dem as dey nor take your advice.
You na real Dimkpa for this talk way you reason o, e get any proverb way you no sabi... na you fit to dey moderate this place I swear and you dey do am well.
If person reason that proverb, as you take talk am, na so e be. E dey like that year when I still be mama pikin, when them dey try tell us say make we dey try behave well or listen to warning to avoid gbege. Na so mama go hold and drag your ear con say:

'E go say, person way go hear something, e no dey get big ear'

That na still to tell you say, make you dey try hear word and to avoid palava.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 28, 2022, 04:54:37 AM
I applaud all contributions here but abeg make una dey use the format wey we dey use here wey be sey the interpretation supposed dey for English. Make una see page 1 to see the format in case anybody don forget.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
February 28, 2022, 04:37:20 AM
Dat proverb na basically "Ukpala (grasshopper) wey Okpoko (hornbill bird) kill, na deafness kill am. Nor vex sey I dey make correction here. I believe we dey here to learn.
This our chairman na confam Old man for young man body...i carry palmwine and kola greet you well well. I greet everyone wey dey here, to our newbies wey be real newbies make una take advice from senior men dem, nor dey carry start topic for place wey you just come new.

Proverb: Tenant wey dey owe landlord money, nor dey throw party for compound
Meaning: This proverb na for our newbies, for this forum so, you never pay your dues (no quality contribution from you yet), nor go dey start topics unnecessarily wey go bring your leg out.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
February 25, 2022, 11:33:51 AM
Proverb: Animal wey Okpoko kill, the animal deaf.
Meaning: Okpoko na animal wey dey kill other small animals. But this animal dey make loud noise if em dey come. So, any animal wey Okpoko kill na deaf animal.
Dat proverb na basically "Ukpala (grasshopper) wey Okpoko (hornbill bird) kill, na deafness kill am. Nor vex sey I dey make correction here. I believe we dey here to learn. Your analysis na just transliteration too whereas e supposed be metaphorically. D meaning dey hidden inside wen you don advise somebodi on several times but dem nor listen and then something bad come happen to dem as dey nor take your advice.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
February 24, 2022, 03:41:57 PM
I go contribute to wetin Uchegod don highlight. Igehhh gave a sound warning about plagiarism a day before.
Proverb: our people say when stranger enter new community he nor dey go price chieftancy title
Meaning: when you come to a new place you need to be careful, learn the way of life there before you can blend in
This your proverb just qualify the situation,  no be play. Imagine new person dey go price chieftaincy title, na so strongmen way don dey go just dey look am although for the life na, with money and recruiting the right people, you fit archive anything, even the unthinkable cef. But then, the matter na base on plagiarism and I believe say, she get idea because, she been dey try put links for en post. The legit be say, you no go know when one go escape you if you carry copy and paste for head and people way dey burst matter like this for the forum no dey carry am play. E tire me shah!
hero member
Activity: 966
Merit: 701
February 24, 2022, 10:25:46 AM
I greet una my poeple. As I enter our local board I discover something. Many new accounts just dey pop up they create plenty topics and dem go ban dem because of plagiarism.

Igehh don already advice them not to dey open plenty and careless topics wey dem never get better experience use tall for here.

Me I go drop proverb for our newcomers here and I go try explain the proverb join.

Proverb: Animal wey Okpoko kill, the animal deaf.
Meaning: Okpoko na animal wey dey kill other small animals. But this animal dey make loud noise if em dey come. So, any animal wey Okpoko kill na deaf animal.

I go contribute to wetin Uchegod don highlight. Igehhh gave a sound warning about plagiarism a day before.
Proverb: our people say when stranger enter new community he nor dey go price chieftancy title
Meaning: when you come to a new place you need to be careful, learn the way of life there before you can blend in
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
February 24, 2022, 09:53:14 AM
I greet una my poeple. As I enter our local board I discover something. Many new accounts just dey pop up they create plenty topics and dem go ban dem because of plagiarism.

Igehh don already advice them not to dey open plenty and careless topics wey dem never get better experience use tall for here.

Me I go drop proverb for our newcomers here and I go try explain the proverb join.

Proverb: Animal wey Okpoko kill, the animal deaf.
Meaning: Okpoko na animal wey dey kill other small animals. But this animal dey make loud noise if em dey come. So, any animal wey Okpoko kill na deaf animal.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
February 24, 2022, 06:46:03 AM
Proverb: you nor go fit run leave your yanch for back  
In English: Because you want to run it doesn’t mean you should leave your buttocks behind Lips sealed
Meaning: You should not  kill yourself because you want to gain something
Disclaimer: this proverb get many meaning una fit talk Wetin una know am to mean
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
February 21, 2022, 06:48:26 PM
O Bobbb, e be like say the tung dey everybody body this evening o. All una yarn just dey enter brain finish.
Na that small snake turn python own dey enter my head pass becuase if you look am, na so e be. Watin you dey underrate say na small matter way no touch anywhere, na that same matter people fit rise way be say eh, e go choke you. You no go know how to go round am again than to beg. So for the life, no underrate something or even person because, e fit turn python if you give am the chance way e need. This life now, e be as e get and na head we dey carry follow things, no be power again. Una too much.
Pages:
Jump to: