Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 28. (Read 10492 times)

jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 13, 2022, 12:42:47 PM
PROVERB: No matter how lion hungry reach e no fit chop grass

MEANING: Always know your worth, don't settle for less.
legendary
Activity: 1106
Merit: 1113
March 12, 2022, 07:03:25 AM
Proverb:  If you pursue dog from shit, na who go eat the shit?
Meaning: Everyone have their own choice, so mind you business.

Proverb: Na person wey no hold money for bar dey say beer bitter
Meaning: Our excuses sometimes is because we don't have the means.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
March 12, 2022, 03:32:23 AM
The proverb is saying that he who does evil thinks that everyone else around him is evil.
You be odogwu! Na so e bi. Chai, I for baff you now but fridge just dey dry. No shaking. I go do am everly.
hero member
Activity: 1078
Merit: 640
Watch&Pray.
March 11, 2022, 06:58:11 PM
Proverb:pikin wey say em mama no go sleep him too no go sleep
Meaning: when you are stopping people's progress, you are not going to progress.
hero member
Activity: 1176
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
March 11, 2022, 09:33:15 AM
Proverb: Person wey dey carry knife kill person, no dey allow person carry knife pass him back.
Meaning:Even the killers are scared of death, protect yourself, don't allow anyone kill you.
I'm sorry to say, the meaning you gave does not represent the proverb you dropped.
The proverb is saying that he who does evil thinks that everyone else around him is evil. For instance, a scammer will hardly trust anyone, even his closest friend with his money, because he will reason that he would be scammed because it's what he does.
jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 10, 2022, 08:57:04 PM
Proverb: Person wey dey carry knife kill person, no dey allow person carry knife pass him back.
Meaning:Even the killers are scared of death, protect yourself, don't allow anyone kill you.
sr. member
Activity: 1036
Merit: 311
March 10, 2022, 02:29:52 PM
I hope you sabi sey dis ones wey you drop here na more or less word play or puzzle, nor be proverbs.
I know na why I no call am proverb I call am beta yarn. But na still African word play how u no follow see am so we for merge the two together
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
March 10, 2022, 02:10:12 PM
~
I hope you sabi sey dis ones wey you drop here na more or less word play or puzzle, nor be proverbs.
sr. member
Activity: 1036
Merit: 311
March 10, 2022, 01:53:49 PM
Beta yarn: Na bird wey miss stone from catapult na him dem dey call bird-flu. Na book wey no gree enter head them dey call book-mark. Na because Choco no like to dey go early na em dem call am choco-late, Na because man no gree leave kpekus na em make them give am break men-o-pause u too do
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
March 10, 2022, 06:51:51 AM
Proverb: Our people talk say na with care nai dem take dey kill fly wey perch for person scrotum sack.
Meaning: You must handle sensitive issues and matters with care.
Na true yarn be dat, and na why almost every persin wey be elder sabi use am. I suppose baff you for dat one but colele wata nor dey my fridge now.


I don see una handwork for here and how una dey throw wisdom enta d mata. My wata dry up na im make I nor fit bless all man. Even those wey I baff small, I supposed review una post history beyond here because e bi like sey I see many merit worthy posts too for different threads. Kudos guys. Una doh.
jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 08, 2022, 12:45:35 AM
Proverb: pikin wey I back Cross River dey complain say e match fish.

Meaning: some people are just ingrates(ungrateful) just help if you want to.
legendary
Activity: 1568
Merit: 1139
Top-tier crypto casino and sportsbook
March 07, 2022, 04:29:44 AM
I dey happy as i dey see say activities for this our corner dey increase day by day, to all our newbies wey dey here, i dey welcome una, make una continue to dey add ginger to our side, we dey do well. I dun come with small wisdom for the house today again, i go like to share am to the benefit of everybody.

Proverb: Our people talk say na with care nai dem take dey kill fly wey perch for person scrotum sack.
Meaning: You must handle sensitive issues and matters with care.
jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 06, 2022, 03:48:41 PM
PROVERB: NO FOOD FOR LAZY MAN NO B FOR PIKIN WEY MAMA DEY SELL FOOD.
MEANING:some people are born with silver-spoon,don't go about competing with them.
legendary
Activity: 1106
Merit: 1113
March 06, 2022, 07:16:32 AM
Proverb: If you pursue mad man wey collect your towel when you dey baff, people go call you mad man too.
Meaning: Two wrongs cannot make a right.

Proverb: Na rat wey dey inside house dey tell rat wey dey outside say fish dey for house
Meaning: Your main enemies are within.

jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 06, 2022, 06:26:22 AM
Proverb:THE SAME WATER WEY BE FISH FRIEND NAI STILL KILL AM.
Meaning:trust nobody, be on your guard.
hero member
Activity: 798
Merit: 1045
Goodnight, ohh Leo!!! 🦅
March 06, 2022, 06:01:26 AM
This is my first trial

Proverb: e no get as rain go fall wey ground no go sabi
Meaning: There's nothing hidden under the sun,it might take people a long time to know but they'll finally get to know everything.
Sandra_ Kiss
jr. member
Activity: 54
Merit: 2
March 03, 2022, 01:00:13 PM
Proverb: NA I GO DO AM LATER NAI MAKE FOWL NO FIT FLY LIKE OTHER BIRDS.
meaning: do what you have to do, there's no right time,everytime is a right time. Don't procrastinate.
hero member
Activity: 1176
Merit: 643
BTC, a coin of today and tomorrow.
March 02, 2022, 01:44:34 PM
Proverb: Animal wey Okpoko kill, the animal deaf.
Meaning: Okpoko na animal wey dey kill other small animals. But this animal dey make loud noise if em dey come. So, any animal wey Okpoko kill na deaf animal.
Dat proverb na basically "Ukpala (grasshopper) wey Okpoko (hornbill bird) kill, na deafness kill am. Nor vex sey I dey make correction here. I believe we dey here to learn. Your analysis na just transliteration too whereas e supposed be metaphorically. D meaning dey hidden inside wen you don advise somebodi on several times but dem nor listen and then something bad come happen to dem as dey nor take your advice.
Oga Mpa, wetin I go vex for na? Anybody wey dey claim know it all na program failure. I like this thread very wey. E dey give wisdom and inspiration. E for good say anybody wey drop proverb, anybody go fit chuck mouth to elaborate am.

Thank you for the reminder say the interpretation suppose dey for English, that means I have been doing it wrongly since. You know say some of us never Tey for here. Keep up the good work.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
March 02, 2022, 01:26:34 PM
Goat wey die inside yam barn, nor be hunger kill am.
Meaning: Anyone who is in the midst of plenty but suffers lack has only themselves to blame.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
February 28, 2022, 08:52:51 AM
PROVERB: Overthinking no dey solve problem.
MEANING: This should be clear for everyone to grab and understand, Take your time with life, overthinking solves nothing as a man/woman rather plan and take actions.

PROVERB:Dem no dey use veks kill fly weh perch for wound.
MEANING: No matter your current state even if hurts badly, you shouldn't take actions with your emotions, showing emotions are true signs of a week man.

PROVERB: Today newspaper go be tomorrow suya wrap.
MEANING: Take life as it goes, Don't be too fast neither too slow, life is gets phase after phase, a poor a wealthy state can turn out to be a poor phase.

Thanks, I'm a newbie here.

Konfam konfam proverbs nai you drop back to back funny proverbs I don laugh my belle scatter but like Mpamaegbu don talk, follow the format we dey use for here. You go highlight the pidgin proverb in bold make eye quick catch am. The meaning of the proverb na for English as you take do your own. Shekena you don finish work
Pages:
Jump to: