Pages:
Author

Topic: African Proverbs in Pidgin - page 34. (Read 9479 times)

member
Activity: 67
Merit: 10
October 13, 2021, 03:00:20 PM
My people psquare song just dey play for my head this evening
"E get as e dey do me
Do me
you go wound o
 you go wound o oooh"
Proverb:Them nor dey shook mouth for husband and wife matter if not na you them go take settle their quarrel
Meaning: Choose your battles wisely

Proverb: Student way get F9 for course nor dey go follow crowd to check result
Meaning: No one show cases their failure
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 11, 2021, 12:34:37 PM
Una too much here. Even when I nor dey house, una still dey find time to keep here warm. Kudos! Na some offline stuff wey dey keep try bend my eyes small, nor be sey I abandon here. We dey dis jungle together.
member
Activity: 672
Merit: 19
October 11, 2021, 12:11:18 PM
Na mi first time for here ohhh,no be chise wisdom ornah dey pour for here ohh.
Ornah too much beast all of ornah, infact ornah bam.
PROVERB: person weh snake done bite before, if him see earthworm him go think say nah 🐍 snake.
MEANING: Someone that has been robbed previously of his wealth,when he See's similar stuff's trying to happen he'll be Scared and want to avoid further scenario from happening.
member
Activity: 67
Merit: 10
October 11, 2021, 09:56:05 AM
This na my first time here. I be like pikin way e eye just open na today I dey see Nigeria topics dem. I salute everybody wey tanda for here
Make I follow una catch the tradition cruise
Proverb: Pastor wey no dey receive tithe nor go like church
Meaning: Everybody love appreciation
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
October 11, 2021, 08:39:23 AM
E be like the place cold small o. How una dey na, i say make i pip weather i go see small something for the naija wise quote but, e be like something hold us for leg small. Anyhow na, make i throway something make carry commot cold.

Proverb:
As e be for the Pighin; my people say, "e don tai i see you or you come, better pass you too dey come".
Meaning: Don't make yourself so readily avialable all the time, it devalues you. Be scares and missed at certain times, it adds to the way you carry yourself and the way your viewed/valued by people around you.

Omo brother the place cold nor be small, as i even enter here today, cobweb dun enter my eye sake of say activity nor too dey dey the room again like before. Wetin dey sup really?

@smartvirus, your proverb na ogbonge wisdom for the street. E nor too dey good to dey always dey available sometimes, e dey bring over familiarity and see finish.
 
For my side dem dey talk say na because say "Garri too dey dey house, nai make dem dey call am poor man food." Na the same English meaning e get with your proverb, make person try dey dey scare, so see finish nor go dey, very importantly.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
October 10, 2021, 05:06:29 PM
E be like the place cold small o. How una dey na, i say make i pip weather i go see small something for the naija wise quote but, e be like something hold us for leg small. Anyhow na, make i throway something make carry commot cold.

Proverb:
As e be for the Pighin; my people say, "e don tai i see you or you come, better pass you too dey come".
Meaning: Don't make yourself so readily avialable all the time, it devalues you. Be scares and missed at certain times, it adds to the way you carry yourself and the way your viewed/valued by people around you.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
October 06, 2021, 02:03:21 PM
I dey sight una my guys. Make una nor dey too tey for outside. Here na country home, d wan wey dat man dey run for Aso na cowtry. If you know, you know.
Chaiii, this guy, you dey talk talk o. Omo, our people dey say;

Proverb:
In Pighin: Them no dey tell person say, shit dey smell
I for like write am for Oyibo man tongue but, the way them been dey abi them still cef dey use tackle us this time eh, e no go sure say them understand watin I dey talk.

Though, for Mpamaegbu capping way make me bring that Proverb eh, that na to say, we be Nigerains way dey face the same palaba so, we dey with you for the level. That na to say, we know, we understand.
E just dey pain me sey colele wata nor dey my fridge to dey take sama ogbenge yarns wey una dey drop both here and other places.
You na that kind man normally, you pull weight reach and na so we carry believe you. Over sure dey worry you cef.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
October 06, 2021, 02:03:29 AM
I dey sight una my guys. Make una nor dey too tey for outside. Here na country home, d wan wey dat man dey run for Aso na cowtry. If you know, you know. E just dey pain me sey colele wata nor dey my fridge to dey take sama ogbenge yarns wey una dey drop both here and other places.
hero member
Activity: 1288
Merit: 504
October 03, 2021, 06:25:20 AM
Omo, e don tay small way me touch leg for here o. I dey see am say, una dey do am and no dey dull the place. Na that one show say, all of una na real omo naija way get plans to make we for dey jakpa front. Una dey try. Me don come make I dey follow body dey japka our thing dey go, una know this matter na.

Proverb:
Our people dey say; na person way no sabi leave dey carry leave way th dey use as medicine, put for pot carry cook soup o.

Meaning: You know nothing else, you won't waste opportunities and the resources around you. Always seek to know, knowledge could save your life.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
September 26, 2021, 02:33:45 AM
Persin wey dey sell fowl dey hold am for legs while persin wey wan buy dey like hold am for wings.
Meaning: Everyone likes to amplify what they have to their own advantage.

Na so na, na so e suppose be, nor be say na pride ooo, but na normal ginger and packaging make everywhere for stew. Las las if you nor hype your thing, i wonder who go helep you hype am.

My own proverb, na for small story i go take drop am.


Akpos nor too dey happy, all e friends and guys dey do well, e come dey be like say na Akpos own bad pass. The thing wan really choke Akpos.

Akpos guy, Fejiro carry Akpos go drink small beer for corner one sunday, after akpos dun down like two "HERO" nai e body free small to talk, e carry the matter 2 secs dey clear Fejiro say "joy nor too dey e body" say things and things, say e suppose dey do well pass the way e dey do.

Fejiro look Akpos nai e laugh tell am say - Try dey happy for life first Akpos, "Red oil nor dey stain one finger, e must to touch the other one, Na who God bless last, na e own be Latest".

Meaning/moral: Cheer up and be happy for your brothers success knowing that your own is coming, and when it comes, it becomes the latest as they will celebrate with you too.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 21, 2021, 11:15:09 PM
Persin wey dey sell fowl dey hold am for legs while persin wey wan buy dey like hold am for wings.
Meaning: Everyone likes to amplify what they have to their own advantage.
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 17, 2021, 06:32:57 PM
~snipped~

Ewoo eh  Shocked, I no sabi say e don dey here. No Vex. Make I replace am with this one 👇

PIDGIN: Person wey want something na him hand dey long pass

ENGLISH: What you are looking for is not in your comfort zone. You have to move out to get it.
No wahala bro. Just feel free to drop anyone wey you get. We nor dey make scripts like JAMB for here oh 😆. Nor be WAEC too. But dis wan wey you drop here again sef make sense die too.
hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
September 17, 2021, 06:02:40 PM
Davidvictorson, I welcome you with two hands as you enta dis corner. Na correct thing wey you do as we go dey rub minds dey go. Your proverb make sense but e don already tanda here before 👇

Pikin wey wan chop party rice, e nor dey fear dance.
Meaning: To succeed in life you really don't have to care about negative comments from people.

@XCANA, I salute you too bro. Una welcome. I suppose give una colele wata drink but e neva dey my fridge now.


Ewoo eh  Shocked, I no sabi say e don dey here. No Vex. Make I replace am with this one 👇

PIDGIN: Person wey want something na him hand dey long pass

ENGLISH: What you are looking for is not in your comfort zone. You have to move out to get it.
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
September 14, 2021, 06:20:47 PM
Igbo Proverb: E were otu okuko chuoru arusi abua aja, ha egbuo mmadu mezuo ya.

 " When a single fowl is sacrificed to two deities, they'll kill two humans to complete the offer".

Meaning: Do not apply shortcut to the things of  great importance; the repercussion maybe deadly!
Guyyyyyyyyy, guy you good. Chow, this one hit me for somewhere,  real matter o. The proverb too go and e ethical die. Omo, I go like dey see more and more from you @XCANA, you good. Oya na, make I drop one.

Proverb
In pighin: them say, rain maker way go wait for rain to drop before e go spit for outside, no sabi the work.
In English: A rain maker that waits on the rain to drizzle before spitting out, isn't good at the job

Meaning: prevention is better than cure. You don't wait until it becomes serious before taking the first step.

Una way new for here, we welcome una, make una flex, na we get am!
legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 11, 2021, 01:38:10 AM
Davidvictorson, I welcome you with two hands as you enta dis corner. Na correct thing wey you do as we go dey rub minds dey go. Your proverb make sense but e don already tanda here before 👇

Pikin wey wan chop party rice, e nor dey fear dance.
Meaning: To succeed in life you really don't have to care about negative comments from people.

@XCANA, I salute you too bro. Una welcome. I suppose give una colele wata drink but e neva dey my fridge now.
full member
Activity: 1456
Merit: 148
September 10, 2021, 05:00:03 PM
Igbo Proverb: E were otu okuko chuoru arusi abua aja, ha egbuo mmadu mezuo ya.

 " When a single fowl is sacrificed to two deities, they'll kill two humans to complete the offer".

Meaning: Do not apply shortcut to the things of  great importance; the repercussion maybe deadly!

hero member
Activity: 952
Merit: 824
Livecasino.io
September 10, 2021, 10:12:49 AM
Proverb: Pikin when Dey find party rice, nor suppose to fear dance
Meaning: One must not be afraid to make the necessary sacrifice to be successful.

Proverb: Fight wey you no fit fight for night no start am for day time.
Meaning: Don’t go about looking for trouble is you can’t sustain it.

Proverb: Our beans go don
Meaning: Everyone will be successful it’s only a matter of time.

legendary
Activity: 2674
Merit: 1208
Once a man, twice a child!
September 09, 2021, 06:27:05 PM
Omo this proverb dey to tori my brain, make me self drop my own for una
Proverb
If wall no open, wizard no go enter.
I nor know whether you don see dis thread wey dem post about you for plagiarism here https://bitcointalksearch.org/topic/m.57886867

Smartvirus and Rruchi my brodas, nor be small thing oh. But we thank Baba God sey everi everi don calm down now.
legendary
Activity: 1246
Merit: 1071
September 09, 2021, 02:21:10 AM
Omo @Mpamaegbu, na so I for carry miss you for this we corner o but, God dey shah and this one show say, you na real man of the people with the way people come out con voltage for you. I just get joy say, you d0n show back to join body with me make we dey carry this our corner dey go, na you be the ginger for here and me no for fit do am alone. Oya o, one proverb turn up for we matter...


E sweet me o brother, say them dun pour cold water on top the matter ooo...i dun dey reason say how this place wan take dey without our correct Mpamaegbu, e for quick tire country man. Welcome back.
As God take sharp sharp tidy your case, na so e go run poka own too, IJN.



If wall no open, wizard no go enter.

Welcome oooo brother, as you carry leg waka reach this our corner, na so good thing go dey waka come your side, wetin you go take, we get Kola, we get garden egg & Osoji(groundnut paste), we even have freshly tapped palm wine, just make your choice o, person go bring am come now now.

I been wan ask one question for your proverb - Na wizard you been wan type, abi na lizard? Which one?
legendary
Activity: 1400
Merit: 1108
September 08, 2021, 03:24:39 PM
Omo this proverb dey to tori my brain, make me self drop my own for una
Proverb
If wall no open, wizard no go enter.
Omo, this your proverb make sense o, I don dey reason am since but, the thing no wan gree enter, as in the literal meaning for the life. E go still sure wella if you help me throw small meaning make my head no for burst. Where you dey since cef, you be like correct guy o and you do well say, you don come locate this our small corner. Na so we dey do am for hear o, make we for dey try preserve our heritage. Very soon cef eh, we go store am for blockchain, lol... Anyhow shah, you dey very welcomed for this our corner, try join body with us make we for know you wella, una weldon.
Pages:
Jump to: